Bitcoin Forum

Local => Nigeria (Naija) => Topic started by: CryptopreneurBrainboss on December 21, 2022, 04:39:49 PM

Title: Should Sub-Threads be created or we should freestyle the whole thing?
Post by: CryptopreneurBrainboss on December 21, 2022, 04:39:49 PM
Based on popular demand which I find meaningful, the previous hangout thread has been closed and after we get this board active maybe I go reason open am for other discussion (fit no be this year again maybe 2nd quarter next year) as by then many people go dun sabi say we get Local board and not local thread again or I lock am forever.

We still dey on the celebration and I go like encourage the creating of threads by everyone, the faster we get everything running the sooner we get other wish granted like subboard and merit source for the board etc. Wetin i wan make we discussed for here na only the Sub-Threads mata other mata should lead to their own thread creation.

I no dey discouraged thread creation but we suppose get some sub threads wey go help moderate the spams for the boards. The Sub-Threads supposed be like Introduction threads) to avoid that madness wey dey beginners and help, as new users they introduced themselves with deadliike threads regularly).

I think this Sub-Threads dey important but no be for discussion like politics, Bitcoin or altcoins discussion. Those na popular discussion wey for help the thread creation process on the board dey active, but e get other discussion wey fit dey annoying but if we put them for a Sub-Threads that wey, we go help minimize spam, wetin others think and then u fit give examples of this Sub-Threads wey go make sense. My own na; Introduction & Orientation Camp (here newbies for introduced themselves and ask questions wey others go help them navigate the forum if e dey hard them). Wetin una think

Title: Re: Should Sub-Threads be created or we should freestyle the whole thing?
Post by: Mr.suevie on December 21, 2022, 05:07:34 PM
Well from all watin you don talk,  e deh correct wella because if this sub thread no deh e go deh hard for us wey be newbie sef to relate wella for the board and yes i support you on the idea of newbie introduction to be done on the sub thread wey you deh talk about and again make i just say as newbie wey i be for the forum its not going to be easy to contribute well like that for the main naija thread board as the board is restricted mainly on crypto related discussion. Because most newbie still never understand much about crypto like dat and we go need this sub thread so we too fit contribute small as i suppose say no be all talk go be about crypto for the sub thread  if not most newbie go just deh spam anyhow for the board and not only restricted to newbies alone on the spamming issue.

Title: Re: Should Sub-Threads be created or we should freestyle the whole thing?
Post by: uchegod-21 on December 21, 2022, 05:14:52 PM
NEW TOPIC: Congratulations everyone, we made it, welcome to the Nigerian (Naija) Local baord.
Congratulobia to us. I have been away for 3 days now because of engagement. I be prophet o. My vision was that theymos go give us board on 25th or 1st January. Though I no get time make the post.

... or each person can start a discussion he wants the community to engage in anytime he feel like with a new topic. This also relate to other discussion as well like Music, Football discussion etc. Abeg make everyone contribute so we fit move forward.

Make each person dey start post as e dey be for normal board. So that post wey person no like or no fit contribute, the person go pass. There is no implications just that the local board go dey get pages dey go which is not a problem.

Once again congratulobia to us, we don win.

Title: Re: Should Sub-Threads be created or we should freestyle the whole thing?
Post by: Lorokan on December 21, 2022, 05:40:14 PM
Based on popular demand which I find meaningful, the previous hangout thread has been closed and after we get this board active maybe I go reason open am for other discussion (fit no be this year again maybe 2nd quarter next year) as by then many people go dun sabi say we get Local board and not local thread again or I lock am forever.

We still dey on the celebration and I go like encourage the creating of threads by everyone, the faster we get everything running the sooner we get other wish granted like subboard and merit source for the board etc. Wetin i wan make we discussed for here na only the Sub-Threads mata other mata should lead to their own thread creation.

I no dey discouraged thread creation but we suppose get some sub threads wey go help moderate the spams for the boards. The Sub-Threads supposed be like Introduction threads) to avoid that madness wey dey beginners and help, as new users they introduced themselves with deadliike threads regularly).

I think this Sub-Threads dey important but no be for discussion like politics, Bitcoin or altcoins discussion. Those na popular discussion wey for help the thread creation process on the board dey active, but e get other discussion wey fit dey annoying but if we put them for a Sub-Threads that wey, we go help minimize spam, wetin others think and then u fit give examples of this Sub-Threads wey go make sense. My own na; Introduction & Orientation Camp (here newbies for introduced themselves and ask questions wey others go help them navigate the forum if e dey hard them). Wetin una think

I like as the forma group de locked out, but e remain one thing boss. E take me small time to locate the local board for 9ja.
E go sweet if you put the link to the local board here as the last message for that side. so peeps weh de resume after the holidays go see am straight and ape in to existing discussion.

Also, e go sweet if we open a permanent topic make politics discussion de sup there eg (nigeria politics)
abi wetin my ogas reason

Title: Re: Should Sub-Threads be created or we should freestyle the whole thing?
Post by: Agbe on December 21, 2022, 05:41:57 PM
Based on popular demand which I find meaningful, the previous hangout thread has been closed and after we get this board active maybe I go reason open am for other discussion (fit no be this year again maybe 2nd quarter next year) as by then many people go dun sabi say we get Local board and not local thread again or I lock am forever.
No close am forever but u fit close am till de second quarter of 2023 and that is March 2023. By then many user don dey understand di new board to tok fluently.

We still dey on the celebration and I go like encourage the creating of threads by everyone, the faster we get everything running the sooner we get other wish granted like subboard and merit source for the board etc. Wetin i wan make we discussed for here na only the Sub-Threads mata other mata should lead to their own thread creation.

I no dey discouraged thread creation but we suppose get some sub threads wey go help moderate the spams for the boards. The Sub-Threads supposed be like Introduction threads) to avoid that madness wey dey beginners and help, as new users they introduced themselves with deadliike threads regularly).
Creating of sub-boards na di most important thing 2 do now, bcoz if sub-boards no dey, my brother dis board go pity u. There will bi no arrangement of threads and post. Everything will be haphazard.

I think this Sub-Threads dey important but no be for discussion like politics, Bitcoin or altcoins discussion. Those na popular discussion wey for help the thread creation process on the board dey active, but e get other discussion wey fit dey annoying but if we put them for a Sub-Threads that wey, we go help minimize spam, wetin others think and then u fit give examples of this Sub-Threads wey go make sense. My own na; Introduction & Orientation Camp (here newbies for introduced themselves and ask questions wey others go help them navigate the forum if e dey hard them). Wetin una think
There should be no introduction sub-board, use the naija hangout thread that is locked for that purpose so that the thread will be active. But don't open it for now till March 2023. Newbies that are coming to the forum should discuss straight to the thread created or they can create thread.

Congratulations... Thanks

Title: Re: Should Sub-Threads be created or we should freestyle the whole thing?
Post by: Mr.right85 on December 21, 2022, 06:17:43 PM
Wahoo! E don burst o. So Baba don do 4 us last last. Omo, no be small somtin nd I tank evrybodi  wella. Hw una reali shw say, una want dis tin by hw activ way all of una dey 4 dis our hangout. Una try wella nd I dey very happy 4 dis development.

My hope be say, mak dis development bring us closer nd hopefully, e go help mor of our omo naija way dey d forum to fine hear easily nd evn boost our activity d mor becus like dis nw, dem dey look up to us as d newest local board 4 d forum. E mean a lot to get foothold 4 dis great platform nd dat na sometin way we no gats cast.

Una too much. I salute una.

Meanwhile, the idea of sub board na d best. Forum get pattern, orda local boards kwa still get pattern. Mak our own no dey any difrent. 4 d previous hangout, I go lik say, mak we no lock the hangout shah, mak we rename am. Maybe call am somtin way dey generalising nd accommodating.

Title: Re: Should Sub-Threads be created or we should freestyle the whole thing?
Post by: Hyphen(-) on December 21, 2022, 06:51:23 PM

I think this Sub-Threads dey important but no be for discussion like politics, Bitcoin or altcoins discussion. Those na popular discussion wey for help the thread creation process on the board dey active, but e get other discussion wey fit dey annoying but if we put them for a Sub-Threads that wey, we go help minimize spam, wetin others think and then u fit give examples of this Sub-Threads wey go make sense. My own na; Introduction & Orientation Camp (here newbies for introduced themselves and ask questions wey others go help them navigate the forum if e dey hard them). Wetin una think
There should be no introduction sub-board, use the naija hangout thread that is locked for that purpose so that the thread will be active. But don't open it for now till March 2023. Newbies that are coming to the forum should discuss straight to the thread created or they can create thread.

Congratulations... Thanks
I think the sub-thread for introduction and orientation for Newbies they very necessary because if we talk say make we use the before hangout thread, no be all Newbies fit just scroll to d last page and e fit de discouraging, but as we don get our own local board now make all Newbies just get specific thread for Orientation and proper introduction.
N a for there all proper advises go they and in case them need to know the in and out of the forum the senior colleagues fit go help out for that thread.

Title: Re: Should Sub-Threads be created or we should freestyle the whole thing?
Post by: sokani on December 21, 2022, 07:36:53 PM
Based on popular demand which I find meaningful, the previous hangout thread has been closed and after we get this board active maybe I go reason open am for other discussion (fit no be this year again maybe 2nd quarter next year) as by then many people go dun sabi say we get Local board and not local thread again or I lock am forever.

We still dey on the celebration and I go like encourage the creating of threads by everyone, the faster we get everything running the sooner we get other wish granted like subboard and merit source for the board etc. Wetin i wan make we discussed for here na only the Sub-Threads mata other mata should lead to their own thread creation.

I no dey discouraged thread creation but we suppose get some sub threads wey go help moderate the spams for the boards. The Sub-Threads supposed be like Introduction threads) to avoid that madness wey dey beginners and help, as new users they introduced themselves with deadliike threads regularly).

I think this Sub-Threads dey important but no be for discussion like politics, Bitcoin or altcoins discussion. Those na popular discussion wey for help the thread creation process on the board dey active, but e get other discussion wey fit dey annoying but if we put them for a Sub-Threads that wey, we go help minimize spam, wetin others think and then u fit give examples of this Sub-Threads wey go make sense. My own na; Introduction & Orientation Camp (here newbies for introduced themselves and ask questions wey others go help them navigate the forum if e dey hard them). Wetin una think

Many thanks to you sir Theymos, you gave us the best Christmas present we could ever wish for, and special thanks to CryptopreneurBrainboss, Igehh, Charles-Tim, Mpamaegbu, Agbe and everyone here who made this possible. Congratulations to us all...
This new year go sweet die :)

I think the sub-thread for introduction and orientation for Newbies they very necessary because if we talk say make we use the before hangout thread, no be all Newbies fit just scroll to d last page and e fit de discouraging, but as we don get our own local board now make all Newbies just get specific thread for Orientation and proper introduction.
Nice suggestion, e go help newcomers to easily familiarize themselves with the rules of the local thread.

Title: Re: Should Sub-Threads be created or we should freestyle the whole thing?
Post by: Smartvirus on December 21, 2022, 09:33:50 PM
I think the sub-thread for introduction and orientation for Newbies they very necessary because if we talk say make we use the before hangout thread, no be all Newbies fit just scroll to d last page and e fit de discouraging, but as we don get our own local board now make all Newbies just get specific thread for Orientation and proper introduction.
Sub-thread keh, that na pinned post shah and Igehhh don already prepare watin be like that though, e still dey under scrutiny. As you see, e dom make small poll for votes on on goes and what doesn't go and still, e go abi we go like make every person bring suggestions.

On top of that, e dey very necessary say, the local board get structure. This na to narrow down discussions as well make person no dey put eye for everywhere before e go see watin e dey fine. That structure go even help wella as threads created fort increase and no go dey washed up anyhow like when we go just leave the board like that.

Title: Re: Should Sub-Threads be created or we should freestyle the whole thing?
Post by: Sandra_hakeem on December 21, 2022, 10:58:21 PM
No.  It doesn't make any Sense if we're having a special introduction thread instead of having 'em rookies look at a pinned Post at the top,.. that'll solve alot of their problems and guide 'em on FAQs yunno..
I'm happy to have Theymos grant our request now. It's beens years and counting.. I came in -- just when alot was needed to be done to make him decide whether or not we'll be given a board, and here is it --  a dream come true.
Special thanks to every Nigerian that kept the task on their minds -- to probe the big T, to make lively the little space we were given, to make him/her/them realize that we really meant to explore and to have a place that we could relate together, as brothers, sisters and friends from the same peripherals. I'll urge that whatsoever be done to enhance the sanity of this new granted wish.... Thanks once again

Sandra 🧑‍🦰

Title: Re: Should Sub-Threads be created or we should freestyle the whole thing?
Post by: Mpamaegbu on December 22, 2022, 07:15:56 AM
or I lock am forever.
Abeg oh, nor lock am throwey key like late Nnamdi Azikiwe did wit River Niger. Chai! Owa parents dem tell us fables (fabu) tire dat year sha 🤪

Quote
My own na; Introduction & Orientation Camp (here newbies for introduced themselves and ask questions wey others go help them navigate the forum if e dey hard them). Wetin una think
Sub-board dey very necessary as na im go make discussions tap very well as we go fit easily place topics for boards wey dem belong. The board wey you suggest make sense. I go like make we add, "Off-Topic" too. Na dat place every other issues wey go torchlight matters around religion, family life, scam warnings as e dey be for area, shows, artists, and songs (in fact, entertainment) wey dey jam for naija etc go dey. Make I just hang boots here for now.

Title: Re: Should Sub-Threads be created or we should freestyle the whole thing?
Post by: Hyphen(-) on December 22, 2022, 08:32:24 AM

How una want make these sub-threads look like self? I just they think since yesterday on the nature of discussion wey person go start, but the matter still de under discussion, make we finalize first so dat we go know the kind of sub-threads wey we go bring on board.

As African proverb thread don they added, hope say room go letter day for different Ethnicity ( languages) as we know say we from come from a different location for this Nija, I no mean to make us de divided because I understand why English/pidgin was used as our own official language, I just think say e go they fun if we get such sections. Just a suggestion sha 8)

Title: Re: Should Sub-Threads be created or we should freestyle the whole thing?
Post by: CryptopreneurBrainboss on December 22, 2022, 11:48:10 AM
How una want make these sub-threads look like self? I just they think since yesterday on the nature of discussion wey person go start, but the matter still de under discussion, make we finalize first so dat we go know the kind of sub-threads wey we go bring on board.

As African proverb thread don they added, hope say room go letter day for different Ethnicity ( languages) as we know say we from come from a different location for this Nija, I no mean to make us de divided because I understand why English/pidgin was used as our own official language, I just think say e go they fun if we get such sections. Just a suggestion sha 8)

That African proverb Thread na a perfect example of what a Sub-Threads is, that's instead of everybody coming to create their own topic on African proverb them go fit just hangout there dey discuss wetin dem wan discuss. And as for the ethnicity threads they're also example of Sub thread but make dat one wait first. We never get enough active members from the same geographically location for the country wey go make us begin divide, make we dey concentrate on the genera language for now (pidgin and English).

No need for we to dey stressed about am now sha as I believe, as we dey active and increase, more topics they come up, we go see need for active sub threads to filter discussion and we fit demand for subboard and our matter go dey heard faster. This na just discussed I throw to keep here active for the time being Sha no stress.

Title: Re: Should Sub-Threads be created or we should freestyle the whole thing?
Post by: sokani on December 22, 2022, 12:36:05 PM

Boss as u bring the African proverb thread come here e make sense. But e get wetin I want yan. The way we dey post if we continue like this we go just spam our local board. I go suggest we create a thread call am off-topic where we go fit post  Nigerian government related stuffs or current development in the country as long as e make sense such as fake naira notes and it's security features (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5430981.0) and  Amendment of CBN cash withdrawal policy (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5430955.0), all this posts go come under the off-topic, we discuss and share ideas and opinions. No be say we go dey post any how on the local board. Then we get another thread(s) for altcoin/Bitcoin discussion or we combine both of them, so that our board go dey organize. This na my suggestion.

Title: Re: Should Sub-Threads be created or we should freestyle the whole thing?
Post by: Hyphen(-) on December 22, 2022, 01:39:11 PM
That African proverb Thread na a perfect example of what a Sub-Threads is, that's instead of everybody coming to create their own topic on African proverb them go fit just hangout there dey discuss wetin dem wan discuss. And as for the ethnicity threads they're also example of Sub thread but make dat one wait first. We never get enough active members from the same geographically location for the country wey go make us begin divide, make we dey concentrate on the genera language for now (pidgin and English).
That one de perfect and I understand, I just hope say our people go keep coming here to make our board they active, and I don they see sign say very soon here go they very busy because our brothers/sisters have started creating sub-threads already.

Title: Re: Should Sub-Threads be created or we should freestyle the whole thing?
Post by: Cyber_Alien on December 22, 2022, 04:55:46 PM
Sub-Threads wey go make sense. My own na; Introduction & Orientation Camp (here newbies for introduced themselves and ask questions wey others go help them navigate the forum if e dey hard them). Wetin una think
Basically me I like the idea of this introduction & orientation camp. I think this one go bring more popularity to the group. if una look at most of the guy from other country, na there relationship with one another make there thread dey active. Most of the newbie here in this forum nah our people this go attract them more to come follow yanh for this thread.

Title: Re: Should Sub-Threads be created or we should freestyle the whole thing?
Post by: Maestro75 on December 22, 2022, 05:06:19 PM

Make I thank Theymos or whoever weh make this our local board they possible from the admins. Them try well. Make I also thank all our bosses for Naija weh make this thing also possible. Una too try. My belle deh sweet me for this thing weh happen to us.

I go suggest we create a thread call am off-topic where we go fit post  Nigerian government related stuffs or current development in the country as long as e make sense such as fake naira notes and it's security features (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5430981.0) and  Amendment of CBN cash withdrawal policy (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5430955.0), all this posts go come under the off-topic, we discuss and share ideas and opinions.

If at all we get subboard, that kind matter we you talk na Economy them supposed enter. Them make serious sense. Na matter weh no too make sense, as per deh serious to affect public them deh put for off topic.

Title: Re: Should Sub-Threads be created or we should freestyle the whole thing?
Post by: Issa56 on December 22, 2022, 06:07:02 PM
We never get enough active members from the same geographically location for the country wey go make us begin divide, make we dey concentrate on the genera language for now (pidgin and English).
Since na 3 major languages dey Nigeria, I dey reason make we divide am, na you dey reason am say we people never plenty for each geo political zone, maybe you fit just create poll so that people will vote. If am not wrong, I think the main reason why we didn't get our local board early is because they believe English is our official language and that's the language they are using on forum here. I think e go make sense make we divide so that we go fit get 3 languages and everyone go fit speak their local language there and e no go stop everyone from speaking English Also.

Title: Re: Should Sub-Threads be created or we should freestyle the whole thing?
Post by: CryptSafe on December 22, 2022, 08:48:18 PM

This thread idea make sense o. Sr. Comr. Brainboss your shoe shine wella. This issue of creating sub thread go well o but make we pray say members no abuse am. E go make sense say the sub thread wey you go create go carry better heading wey go go well so that any body wey want Yan go Yan Belle full him mata as e be am wey go make sense no be to come dey Yan careless here.

As I been dey read through I see one of our very own padi dey Yan say make we create board for local language as e be say we naija get three speaking language oga brainboss I no buy that idea o. Unless una want to begin create division here because that's one go make every o man go dey chat for him own language wey no go make sense at all. We say Naija na one indivisible nation make we show de example even here too no b to dey divide the platform. Make we use Pidgin here make no body create any other dialect speaking board for here. Make we leave am for the Pidgin wey we dey speak here.

I no mean to dispute any body o. Na just my own opinion as e be. Make una reason with me.

Title: Re: Should Sub-Threads be created or we should freestyle the whole thing?
Post by: Issa56 on December 22, 2022, 09:15:23 PM

My own na just suggestion and is not mandatory to implement it... Make I use the forum as example for you, why be say as the forum dey we get local board for different languages? Why they no talk say since na bitcoin and cryptocurrency all of us they talk about, e no need to get local board, and as people they post for local board, they no dey post for other sections wey they speak English? If we have sub thread for each language, e no mean say people no go still dey post with English or pigin for normal thread wey people create. As we don get board e no go too make sense say na only English and pigin we go still dey speak alone, pigin no be our official language and no be our local language.

Title: Re: Should Sub-Threads be created or we should freestyle the whole thing?
Post by: knowngunman on December 22, 2022, 09:26:52 PM
First of all I go like congratulate ourselves for getting our board. I see say the local thread dey locked already na why I do my congratulations carry over here. Lol
on to that sub thread Mata, e dey very necessary bosses. If we check mate am we go see say na political issues dey always top discussion for Nigeria on a daily basis. So for sure political sub thread no be bad idea to create. That orientation for newbies also na better idea before dem go loose guard for general forum and chop negative trust or Pam ban. Naija no dey carry last when e reach entertainment. Kiss Daniel and Davido perform for WC22 e no go bad if we get sub thread for jokes and entertainment related discussions. I for like say make we get sub thread for gambling too but we sef no too dey interested in local leagues. Na my little opinion I drop so.

Title: Re: Should Sub-Threads be created or we should freestyle the whole thing?
Post by: Frankolala on December 24, 2022, 02:04:13 PM
I thank appreciate everybody for here and outside this board wey help and support for the creation of this our board,I  support the creation of the sub thread base on the way our Boss CBB don explain am using the ethnic and Africa  proverb thread site as example. This na e go be fun pass becos u fit just tanda for the place just dey catch your trips forgetting say u even dey inside btt forum.

I for suggest say why we no just dey on pidgin only instead of both,English na our borrowed language and if you no hear English,you no go fit express yourself for this forum. I bin mistakenly go miss road enter one foreign board omo I confuse becos I no understand wetin dey there. The idea of division of the language into three for board make sense anyone among the three wey you hear,you can also contribute. Na we board so make we start to enjoy everything naija for here.

Title: Re: Should Sub-Threads be created or we should freestyle the whole thing?
Post by: Lida93 on December 25, 2022, 06:24:27 AM
Based on popular demand which I find meaningful, the previous hangout thread has been closed and after we get this board active maybe I go reason open am for other discussion (fit no be this year again maybe 2nd quarter next year) as by then many people go dun sabi say we get Local board and not local thread again or I lock am forever.

We still dey on the celebration and I go like encourage the creating of threads by everyone, the faster we get everything running the sooner we get other wish granted like subboard and merit source for the board etc. Wetin i wan make we discussed for here na only the Sub-Threads mata other mata should lead to their own thread creation.

I no dey discouraged thread creation but we suppose get some sub threads wey go help moderate the spams for the boards. The Sub-Threads supposed be like Introduction threads) to avoid that madness wey dey beginners and help, as new users they introduced themselves with deadliike threads regularly).

I think this Sub-Threads dey important but no be for discussion like politics, Bitcoin or altcoins discussion. Those na popular discussion wey for help the thread creation process on the board dey active, but e get other discussion wey fit dey annoying but if we put them for a Sub-Threads that wey, we go help minimize spam, wetin others think and then u fit give examples of this Sub-Threads wey go make sense. My own na; Introduction & Orientation Camp (here newbies for introduced themselves and ask questions wey others go help them navigate the forum if e dey hard them). Wetin una think

Also, e go sweet if we open a permanent topic make politics discussion de sup there eg (nigeria politics)
abi wetin my ogas reason
I no sure say it go make beta sense to to com d create permanent topic for politics discussion , it for beta say  we hold on and with time push for subboard specifically for tins like d politics nd domestic Mata, economic  Mata, and any other mata's wey supposed dey too. Make we leave politics issues to still dry run inside the main board itself.

As for wetin cryptoprenuerbrainboss talk about sub_thread ,it no bad as long as na to control spamming and monotonous threads Dem especially from dis our prospective newbie dem wey go always like to dey introduce themselves, mk we no cum dey get plenty different threads talking d same tin all in the name of introduction mk outsiders no com d see our board like child's play.

Title: Re: Should Sub-Threads be created or we should freestyle the whole thing?
Post by: CryptopreneurBrainboss on December 25, 2022, 06:48:11 AM
Also, e go sweet if we open a permanent topic make politics discussion de sup there eg (nigeria politics)
abi wetin my ogas reason
I no sure say it go make beta sense to to com d create permanent topic for politics discussion , it for beta say  we hold on and with time push for subboard specifically for tins like d politics nd domestic Mata, economic  Mata, and any other mata's wey supposed dey too. Make we leave politics issues to still dry run inside the main board itself.

If you see my OP you go see say I no put topics like Bitcoin discussion, politics etc for this sub threads mata because e no make sense to tie those topics that one thread when we supposed use am create more thread and keep the board active. If we put this two discussion including economy discussion for one thread then mata dun finish be dat as here no go dey get active thread.

As for people wey dey suggest say make we get other language thread, I no support that one especially now. Make we try dey avoid creating inactive thread as e go spoil here. Make we create wetin go interest people to talk inside as na that kind threads them we need here. This threads no go just dey  active oh as e gas dey add small small knowledge to people or contribute for the growth of the board.

If we grant Igbo, Hausa and Yoruba threads others go want their own and we no wan carry ethnicity come here. Make we all just dey discuss for pidgin (very important) and English in future when here over serious, we go implement other things like that.

Title: Re: Should Sub-Threads be created or we should freestyle the whole thing?
Post by: BIT-BENDER on December 25, 2022, 08:52:40 PM
I no know for others but I thinks say that’s Hangout board doesn’t need to be closed, Abeg make we check am properly that hangout sub board get really contribution to us getting our own board.

The traffic on that hangout sub board choke. I was really surprised when it was closed  that place na better place where we can gather and still discuss topics in it.

Title: Re: Should Sub-Threads be created or we should freestyle the whole thing?
Post by: Cryptomultiplier on December 25, 2022, 10:52:31 PM
If we grant Igbo, Hausa and Yoruba threads others go want their own and we no wan carry ethnicity come here. Make we all just dey discuss for pidgin (very important) and English in future when here over serious, we go implement other things like that.

This one na fact wey dey. If language threads begin dey, the division go start and many threads go dey irrelevant and just occupy space. Pidgin English wey we dey use na general language for we Nigerians, and we go make this place dey more valued and lively, if we discuss more of the themes and essence of why this forum, this board, and great threads and posts  for this place dey necessary.
We go dey smarter and more ahead with legit information if our post and threads make sense and provide good insight. I no need to stress on how our contribution here go somehow influence the acceptance of crypto currency adoption for we country. E fit happen in the nearest future o.

Title: Re: Should Sub-Threads be created or we should freestyle the whole thing?
Post by: Issa56 on December 26, 2022, 08:20:25 AM
As for wetin cryptoprenuerbrainboss talk about sub_thread ,it no bad as long as na to control spamming and monotonous threads Dem especially from dis our prospective newbie dem wey go always like to dey introduce themselves, mk we no cum dey get plenty different threads talking d same tin all in the name of introduction mk outsiders no com d see our board like child's play.
I think @Lida93 dey correct, we suppose get thread wey newbies wey just dey join the forum go dey introduce themselves so that e no go be like say every newbie go come they create introduction thread. As we never get plenty thread for the board, if we allow newbies they create thread just to introduce themselves na just newbies introduction go just full everywhere wey e no go too make sense. We suppose get place where any newbie wey just join the forum go dey introduce themselves and make we try dey give merit for their so that e go encourage them.

Title: Re: Should Sub-Threads be created or we should freestyle the whole thing?
Post by: Adbitco on December 26, 2022, 09:56:51 AM
Una wedon oo las las we don get our local board, omo apines wan finish me like this.
I don read many tins here nd notin to dey kill ourselves like this, e don set be dat so wetin we go do na to just take our time arrange our board how we want to be just like de wey oda pipo own be so dat e go dey very clear for pipo eyes. So i go suggest say make all everi pend till next year we settle down arrange how tins go be.

Merry xmas to una oo nd appi new year ahead.

Title: Re: Should Sub-Threads be created or we should freestyle the whole thing?
Post by: CryptocurencyKing on December 26, 2022, 05:58:02 PM
I no know for others but I thinks say that’s Hangout board doesn’t need to be closed, Abeg make we check am properly that hangout sub board get really contribution to us getting our own board.

The traffic on that hangout sub board choke. I was really surprised when it was closed  that place na better place where we can gather and still discuss topics in it.
No b lie u talk my broda. As e b now cef, I nevr reali understand d creation of thread 4 dis we new corner. As oppose to tryin 2 dey arrang tins, I 4 say, mak we leave dat place open first. Mak we dey manage am dey go until, we decide if we go lik get sub boards or not and wch particular boards we 4 lik get.
E go gud cef say, pple go dey drop dere suggestion as we dey talk so, later, dem go gather d suggestions, tak am form poll for voting on how many sub board we go lik get nd wch particular boards we need. Dat go help mak we get sense of direction wen we enta here.

Title: Re: Should Sub-Threads be created or we should freestyle the whole thing?
Post by: CryptopreneurBrainboss on December 26, 2022, 08:28:06 PM
I no know for others but I thinks say that’s Hangout board doesn’t need to be closed, Abeg make we check am properly that hangout sub board get really contribution to us getting our own board.

The traffic on that hangout sub board choke. I was really surprised when it was closed  that place na better place where we can gather and still discuss topics in it.

If na Peter obi him go say, I got the advise from a mad man but me I no get am from a mad man instead i get am from our Snr bros Igehhh and e make sense. Make I explain, if we leave that thread open only that thread go dey active for this local board and e go make the place scanty. We want all those topics wey we been dey get on that thread to become their own thread. I no mind if we repeat this topic here as thread but e go make sense since e go bring out a broader discussion on those topics.

You notice people dun reduced engagement here, that's because interesting topic no dey available and we want to address that by encouraging the creation of topics by members. No vex say e dey locked at the moment but immediately we get better traffic here I go reopen am. I dey encourage you and other make una carry those topics una been create for that hangout thread come this board as topic so we fit discuss am well.

Title: Re: Should Sub-Threads be created or we should freestyle the whole thing?
Post by: martyns on December 26, 2022, 10:38:25 PM
Una wedon oo las las we don get our local board, omo apines wan finish me like this.
I don read many tins here nd notin to dey kill ourselves like this, e don set be dat so wetin we go do na to just take our time arrange our board how we want to be just like de wey oda pipo own be so dat e go dey very clear for pipo eyes. So i go suggest say make all everi pend till next year we settle down arrange how tins go be.

Merry xmas to una oo nd appi new year ahead.

I swear,I dey with you senior man for this matta wey you just talk so,say we go calm down arrange our board Wella.The board wey our senior men dem for the forum don create dey burst my brain like this,,,e just dey sweet me.The year don dey end,and we thank God for the protection from when the year start to now wey the year don almost end like this.
The level wey some people been dey when the year been start dey different from the level wey dem dey now.dat is to say this forum don upgrade so many people,we thank God for that,and we also pray say baba God wey don protect us reach now,go protect us reach next year too.

Title: Re: Should Sub-Threads be created or we should freestyle the whole thing?
Post by: Obari on December 27, 2022, 03:30:34 PM

I think this Sub-Threads dey important but no be for discussion like politics, Bitcoin or altcoins discussion. Those na popular discussion wey for help the thread creation process on the board dey active, but e get other discussion wey fit dey annoying but if we put them for a Sub-Threads that wey, we go help minimize spam, wetin others think and then u fit give examples of this Sub-Threads wey go make sense. My own na; Introduction & Orientation Camp (here newbies for introduced themselves and ask questions wey others go help them navigate the forum if e dey hard them). Wetin una think

I agree with you for the last suggestion boss about creating a sub thread for just the beginners over here and possibly pin am as well but I think make we get only that sub thread for now and make we try to dey stick with creations of more threads and topics over here.
And since we never get any moderator for the board I go advice make we no dey spam the board but rather try to dey communicate and pass more information as well as bringing up Nigeria related issues only on the board at least for now.

Title: Re: Should Sub-Threads be created or we should freestyle the whole thing?
Post by: Agbe on December 27, 2022, 05:10:29 PM
You notice people dun reduced engagement here, that's because interesting topic no dey available and we want to address that by encouraging the creation of topics by members. No vex say e dey locked at the moment but immediately we get better traffic here I go reopen am. I dey encourage you and other make una carry those topics una been create for that hangout thread come this board as topic so we fit discuss am well.
Na so bcos we need quality topics 2 cause traffic. To discuss no bi di problem, dis won wey u dey creation of topics, creating topics no bi di problem oh, but quality topics, in di process of creating topics one thing we have to avoid is to avoid spamming, and dat my no 1 campaign slogan in this board. Please I dey beg una when u dey create topics avoid spamming. I don tok am r plenty times when di tin go casaplaka for we unit make nobody no tok say I no tok am. And also avoid account farming. Go nd check Meta to see account farming issues... I no dey tok sae make una no create threads here but please take time 2 reason am.

Please again and again make una avoid Spamming di board. Caution! Caution!! caution!!! Quality threads go promote the board rapidly

Title: Re: Should Sub-Threads be created or we should freestyle the whole thing?
Post by: examplens on December 27, 2022, 05:47:39 PM
Hey, just noticed you got your local Nigeria, dedicated board, I'm so glad all of you managed to fight it. congratulations to the Nigerian bitcoin community.
I remember when you started with the demands, I even partially participated in the discussion. I would say that not much time has passed since that request. looking at your activity, you certainly deserve this.
congratulations once again.  ;)

Title: Re: Should Sub-Threads be created or we should freestyle the whole thing?
Post by: Agbe on December 27, 2022, 06:09:16 PM
Hey, just noticed you got your local Nigeria, dedicated board, I'm so glad all of you managed to fight it. congratulations to the Nigerian bitcoin community.
I remember when you started with the demands, I even partially participated in the discussion. I would say that not much time has passed since that request. looking at your activity, you certainly deserve this.
congratulations once again.  ;)
Sir you are welcome to our local board. In Africa when someone visit a friend, it is cola that is used to entertain the visitor but we don't have cola so I welcome you with a merit. Please accept my offer that represent cola here in the local board. And also thank you for
supporting and locating us to our corner. You are really a friend indeed.

Title: Re: Should Sub-Threads be created or we should freestyle the whole thing?
Post by: Asiska02 on December 28, 2022, 08:10:36 PM
The sub-thread wey you talk say make we create dey very important for dis our naija local as you don talk am say e go reduce spamming and na so e suppose be sef. As I don talk am before, make we create little but not much sub-threads wey we sabi say people dey mostly dey interested in discussions wey comot for there. Na we place and we know how d matters dey be for we country and how we dey take handle am. If we look into am well, we no go lack ideas of d relevant sub-threads wey we suppose create come bring traffic here to our local board.

Title: Re: Should Sub-Threads be created or we should freestyle the whole thing?
Post by: Dzwaafu11 on December 30, 2022, 04:29:41 PM
We go appreciate if you that one for us weh still be newbie if you say make we use the old one e go hard for us to go the last page and some of us fit be discouraged