Bitcoin Forum

Local => Nigeria (Naija) => Topic started by: sokani on January 02, 2023, 04:59:15 PM

Title: INEC: Underage voters will be arrested
Post by: sokani on January 02, 2023, 04:59:15 PM

Quote
The Independent National Electoral Commission (INEC) says visibly underage persons who attempt to vote during the 2023 elections will be arrested. Festus Okoye, INEC national commissioner for information and voter education, said this on Monday during an interview on ‘The Morning Show’, a programme by Arise Television. Okoye said in an effort to address issues around underage registration, INEC has summoned all its officers in areas where underage registrations were recorded.
As we dey gear up for the 2023 elections wey go kickstart with the presidential election on 25th february 2023, na him INEC national chairman for information and voter education Fetus Okoye, don come out come talk say any underage person wey come out come vote, dem go arrest such persons. Well...  I like as dem they loud as to our hearing and I know say na naija we dey and there's still going to be defaulters and we know say na for northern part of naija na im this underage voters registration dey common, but INEC go fit really persecute this persons? Also, INEC say dem get 93.5 registered voters and dem go publish the list on 16 January before the election go start... Wetin una think concerning making the registered voters list public?

Quote
The parents will also be arrested for aiding and abetting such a venture.
This one go dey hard to carry out ooo...  As most of the underage voters wey be Almajiri with no parent, wey dey street dey beg with plates... how dem want take arrest the parent? Abi dem just dey talk am so that parents and guardians go advise their wards?

Source: https://www.thecable.ng/visibly-underage-persons-who-attempt-to-vote-will-be-arrested-says-inec/amp

Title: Re: INEC: Underage voters will be arrested
Post by: Dzwaafu11 on January 02, 2023, 06:59:53 PM
To me how deh go talk say any underage voter they go arrest am how they go take arrest like some villages.
These wey election don deh come na him INEC deh come with new New rules and regulations some people wey no get parent nko or some people wey no dey vote for there area make they just forget about that underage of something make they allowed everybody to vote for there choice..
If they want to do for some places na war go start because no parent go allowed police or any other uniform person con carry him pikin for him presence definitely people go fight be that na

Title: Re: INEC: Underage voters will be arrested
Post by: Frankolala on January 02, 2023, 08:10:05 PM
Senior man all these mata na super story,how INEC won take arrest these under age them,it's impossible. INEC just dey talk make e be say them do their work and sanitize people but all nowhere e go reach bcos INEC self dey collect bribe.

Who won arrest them,shey na the P.O for polling unit,wey be corper na e won tell police or the security officer wet dey attached to him unit to arrest under age wet their Godfather dey there ?

Abi na S.P.O wey dey in charge of the ward,wey be say politicians son already give am block to lock up on anything wey dey happen for there so that make things go as planned. Na collation officer won also arrest,wey dey busy dey think how e go do e work well with mago,mago make e be say all the result rhyme after e don collect mega. All these na the problem for Naija,e easy to talk but had to do.

Title: Re: INEC: Underage voters will be arrested
Post by: Davidvictorson on January 03, 2023, 07:15:56 AM
~snip~
My broda this INEC sef and their leadership they carry talk well well. Even the olopa wey dem dey post to all those polling units nor get power to do anything. Rigging go dey go on for their front dem nor fit get power to talk because dem sabi say them go collect wotowoto. Abi na soldiers dem wan use take arrest underage voters? Anyways, me I believe say dem talk this thing so that the international community and external observers go feel say these people get small sense but dem nor fit fool us.

Title: Re: INEC: Underage voters will be arrested
Post by: CryptopreneurBrainboss on January 03, 2023, 07:51:26 AM
The Independent National Electoral Commission (INEC) says visibly underage persons who attempt to vote during the 2023 elections will be arrested. Festus Okoye, INEC national commissioner for information and voter education, said this on Monday during an interview on ‘The Morning Show’, a programme by Arise Television. Okoye said in an effort to address issues around underage registration, INEC has summoned all its officers in areas where underage registrations were recorded.

Dem wan tell us another story again like no be wetin dem dey talk right from day one, still you dun here say dem do any mass arrests even as we dey get update say underage voting dey ongoing in specific location nothing dey still happen. All this one na political talk so dem fit use hold any of their opponent wey no correspond to their desires. Underage voting na very serious issue for Nigeria election and no be wetin we go fit combat by putting out useless threat like arrest wey we Nigerians no dey fear again. We need to put better process for ground wey go help address the issue.

Firstly the body wey dey handle election gas no dey corrupt as if they're corrupt then we can't achieved anything. Then better electronical steps need dey in place to make sure those registering aren't underage. We get banks maybe we using banks to issue this forms to their customers could help since you must be up to 18years before you're allowed to own a bank account or better biometric procedure gas dey deployed. you dey see all this manual registration wey we dey do na him dey cause must of the problem like underage voting etc.

Title: Re: INEC: Underage voters will be arrested
Post by: sokani on January 03, 2023, 08:39:01 AM
some people wey no dey vote for there area make they just forget about that underage of something make they allowed everybody to vote for there choice..
Bro... I no really understand your statement here. You dey talk say make dem allow underage voters to vote? INEC no go allow underage voters to vote because these set persons no really know what it means to vote, even in civilized nations you must be 18 and above to vote.

Dem wan tell us another story again like no be wetin dem dey talk right from day one, still you dun here say dem do any mass arrests even as we dey get update say underage voting dey ongoing in specific location nothing dey still happen. All this one na political talk so dem fit use hold any of their opponent wey no correspond to their desires. Underage voting na very serious issue for Nigeria election and no be wetin we go fit combat by putting out useless threat like arrest wey we Nigerians no dey fear again. We need to put better process for ground wey go help address the issue.

Firstly the body wey dey handle election gas no dey corrupt as if they're corrupt then we can't achieved anything. Then better electronical steps need dey in place to make sure those registering aren't underage. We get banks maybe we using banks to issue this forms to their customers could help since you must be up to 18years before you're allowed to own a bank account or better biometric procedure gas dey deployed. you dey see all this manual registration wey we dey do na him dey cause must of the problem like underage voting etc.
Oga Brainboss you don raise valid suggestions wey really make sense. The idea make voters get some kind of forms from banks or BVN print out to be eligible to register for the INEC election, in my own opinion e good but e go reduce the numbers of voters because no be everybody wey get bank accounts for this country. Some of our mama, papa, grand mama and grand papa wey dey villages no get bank accounts, so e go be a problem.

Abi na S.P.O wey dey in charge of the ward,wey be say politicians son already give am block to lock up on anything wey dey happen for there so that make things go as planned. Na collation officer won also arrest,wey dey busy dey think how e go do e work well with mago,mago make e be say all the result rhyme after e don collect mega. All these na the problem for Naija,e easy to talk but had to do.
My broda this INEC sef and their leadership they carry talk well well. Even the olopa wey dem dey post to all those polling units nor get power to do anything. Rigging go dey go on for their front dem nor fit get power to talk because dem sabi say them go collect wotowoto. Abi na soldiers dem wan use take arrest underage voters? Anyways, me I believe say dem talk this thing so that the international community and external observers go feel say these people get small sense but dem nor fit fool us.
Corruption na one serious issue for we country, everybody wan collect him own share of the national cake.

Title: Re: INEC: Underage voters will be arrested
Post by: Agbe on January 03, 2023, 03:47:14 PM

Di picture u si na which region children e dey there? no bi di northern region? Under age voting go still happen r di north whether we like it or not, in 2015, a Commissioner of police was burnt to dead with his family bcuz im bin again di under age voting in di north. So dis law wey dem dey tok, na onli 4 di West, East and di South. Dis tok na just to make pple believe sae dem dey do work. INEC at di north has been instructed to do everything 4 Atikowa 2 win. Bt di tin go shock dem dis time. We go run am as tilapia way, everyone go hear di scores. Obi go carry am

Title: Re: INEC: Underage voters will be arrested
Post by: Marykeller on January 03, 2023, 06:35:17 PM
Underage voting don d happen all this years, I no know why INEC come d sound like sae this year election go be different from other election periods. Anyway all eyes are them this time around. Make we see how em go be at the end.

We Nigerians we already know region wey d practice underage voting. When I first hear the news, I begin d laugh cos I know how em d be for North when it comes to elections. Underage voting no go d easy this time cos the major top political aspirants of the North d involved  and you go find them for all the political parties(PDP, APC, and LP) and you know what? em no go d easy cos none of them go accept am for the favor of the other.

Title: Re: INEC: Underage voters will be arrested
Post by: uchegod-21 on January 03, 2023, 07:04:40 PM
E go hard to fit implement wetin you yarn for op. You know why?
Na because plenty people wey dey do the underage voting na from the Northern ruling class. If you arrest them, just one call dem don release them.

Apart from this one I yarn for up. If you check Naija law sef, e be like under age no dey appear for court apart from the case of murder.
So, how dem go use prosecute the underage voters?

Title: Re: INEC: Underage voters will be arrested
Post by: sokani on January 04, 2023, 12:42:42 PM
Dis tok na just to make pple believe sae dem dey do work. INEC at di north has been instructed to do everything 4 Atikowa 2 win. Bt di tin go shock dem dis time. We go run am as tilapia way, everyone go hear di scores. Obi go carry am
Na our prayers be that ooo, make the best candidate win. We never recover from Buhari led administration, we no want suffer for another 8years.

Underage voting don d happen all this years, I no know why INEC come d sound like sae this year election go be different from other election periods. Anyway all eyes are them this time around. Make we see how em go be at the end.

We Nigerians we already know region wey d practice underage voting. When I first hear the news, I begin d laugh cos I know how em d be for North when it comes to elections. Underage voting no go d easy this time cos the major top political aspirants of the North d involved  and you go find them for all the political parties(PDP, APC, and LP) and you know what? em no go d easy cos none of them go accept am for the favor of the other.

Many eyes dey and e get some elder statesmen wey don secretly endorse some candidates wey no be from north and them too go do all it takes to make sure say their candidate win. I just hope say we go get a free and fair election, las las make the people's choice win.

E go hard to fit implement wetin you yarn for op. You know why?
Na because plenty people wey dey do the underage voting na from the Northern ruling class. If you arrest them, just one call dem don release them.
Apart from this one I yarn for up. If you check Naija law sef, e be like under age no dey appear for court apart from the case of murder.
So, how dem go use prosecute the underage voters?

I no really no if juvenile no dey appear for court for naija, I think it's something I need to find out. But we get juvenile prison and persons wey dey less than 18 wey default the law dey still face the law. But na naija we dey and na the north dey run de show for this country. Just as you yarn one phone call dem go release them.

Title: Re: INEC: Underage voters will be arrested
Post by: Sexylizzy2813 on January 04, 2023, 03:09:01 PM
This matter wey dy like this no be today e start nah, my question nah, why e be say nah only the northern side this thing dy common? E be like say na circle we just dy run round becos another election we go still hear the same thing but no action. Some times I dy ask myself if this election nah real something or them dy carry am joke with us.
If we decide not to come out for this election with our PVC wetin go happen? How them wan take play with the counting of voters if nobody com vote? Well nah God go help us.

Title: Re: INEC: Underage voters will be arrested
Post by: Coyster on January 04, 2023, 04:44:47 PM
The wahala of underage voting starts from the registration of underage voters, na from there INEC suppose begin tackle the matter, no be only on election day them suppose they find underage voters to arrest, them suppose don issue this warning to both 'prospective' underage voters and to their officials even before registration of PVC's start.

E go they difficult to completely eradicate underage voting for Naija, but we suppose fight am, come reduce am to the minimum; and INEC suppose start with their officials wey they register underage voters/allow underage people to vote; everything still boils down to corruption, that is the where most of our problems stem from, me i believe say if corruption fit reduce for every sector in Nigeria, the country to better. Make we see how things go pan out after they make the voters list public and on the election day proper, if them go fit quell underage matter, then the higher the chance of the best candidate winning.

Title: Re: INEC: Underage voters will be arrested
Post by: Lida93 on January 04, 2023, 06:57:08 PM
Why the INEC officials go allow com dey do the underage registration at di first place sef, if I wan tlk my mind then I go say na to first arrest the INEC officials wey work for those places dem wey dis underage registration happened, so dem go serv as scape goat (deterrent) to other in the future. Na the only strong decision wey INEC need start wit to show say dem really stand against all this underage registration and other corrupt matas wey go wan cause katakata for we electoral process dem. Or abi di INEC officials wan say dem no see say d children never reach 18+ bfor dem still register dem? Arresting the children and their parents alone dey show INEC dey exempt their officials wey also act unprofessional in their duty by registering underage children Dem.

For this country we don tire for audio talk talk make dem every institutions dem take beta actions wer necessari na di only wey tins go go well for we country.

Title: Re: INEC: Underage voters will be arrested
Post by: sokani on January 04, 2023, 08:26:42 PM
my question nah, why e be say nah only the northern side this thing dy common?
If we decide not to come out for this election with our PVC wetin go happen?
I think the major cause of the large number of street kids for this part of we country na because of illiteracy. Abeg ooo... Come out come exercise your civic duty as a citizen, that your vote go fit make a difference and remember to vote wisely.

E go they difficult to completely eradicate underage voting for Naija, but we suppose fight am, come reduce am to the minimum; and INEC suppose start with their officials wey they register underage voters/allow underage people to vote; everything still boils down to corruption.
Why the INEC officials go allow com dey do the underage registration at di first place sef, if I wan tlk my mind then I go say na to first arrest the INEC officials wey work for those places dem wey dis underage registration happened, so dem go serv as scape goat (deterrent) to other in the future.
Thank you guys for your suggestions. Just as una talk it begins with the INEC officials wey register them at the first place. If them really wan fight underage voting and corruption na to get hold of the INEC ID cards. With the numbers on the card dem go get information about the polling units and from their dem go get and arrest the officials wey register the underage voters.

Title: Re: INEC: Underage voters will be arrested
Post by: KupaCrypto on January 05, 2023, 11:03:30 PM
The possibility of arresting this underaged voters nai I still they reason, abi dem wan go there house go catch dem or them go wait for them for election day for polling unit, well if dem be catch them e make the voter process a little bit transparent and the rest of us wey dey see the other elections as rigged them go really happy for this development, this underaged voters I know say them go dey mostly the northern states so government gates put eye on them oooo.. make this election try they free and fair.

Title: Re: INEC: Underage voters will be arrested
Post by: Rruchi man on January 06, 2023, 06:31:42 AM
INEC just talk this one make all the people wey dun dey complain about the news and videos in circulation about underage voting use am take hold their body small. Nor be today for this our country nai we dey hear many audio doings wey nor dey ever happen. How you wan take arrest underage children? abi dem feel say this children go stand for line?? I don't believe them one bit! If they intend to want to stop this underaged voters before the election comes, make dem review their voters registry, then invalidate all the underaged voters wey dem find for their system. E nor go too dey hard, make dem just start with Northern states cos na there this people plenty pass.

When dem dun run that one first, na that time we go know say dem dun serious.

Title: Re: INEC: Underage voters will be arrested
Post by: Issa56 on January 06, 2023, 07:19:36 AM
We all know say that one no go easy, na for North na him underage voters common, no be say e no dey other regions but north own plenty pass. If you wan see underage voter's na inside villages you go visit, na places wey dem dey rig election anyhow be that, but I no dey sure say police or INEC officials go see underage voters for village and they go arrest them. You no fit misbehave for village wey you never go before, forget say police dey, one or two police no fit fight entire village, you know say those villagers no go allow police carry the person wey dem arrest commot, some villages dey wey even network no dey wey police go call for backup.

The only places wey I know say dem fit arrest people na for inside city and dey no too dey rig election for city, na for villages dem they rig election.

We also need to blame the INEC officials, no be them register all those underage voters or they get how they take dey run am wey INEC officials no go know say na underage those people wey register be?

Title: Re: INEC: Underage voters will be arrested
Post by: Cantsay on January 08, 2023, 09:14:00 AM
[...]
Quote
The parents will also be arrested for aiding and abetting such a venture.
This one go dey hard to carry out ooo...  As most of the underage voters wey be Almajiri with no parent, wey dey street dey beg with plates... how dem want take arrest the parent? Abi dem just dey talk am so that parents and guardians go advise their wards?

The way when I reason am be say if those underaged voters get parents them go arrest them but if them nor Kon get parents them go arrest only them. Because in the case of those Almajiri since nobody (parents) dey for dem nah only dem dey go carry comot go police station.

This matter wey dy like this no be today e start nah, my question nah, why e be say nah only the northern side this thing dy common? E be like say na circle we just dy run round becos another election we go still hear the same thing but no action.

The thing be say those when dey contest they try to use the condition of the citizens to take do mago-mago for elections since dem know say most northeners dey suffer from poverty dem go Kon dey use money take dey make dem do wetin dem know say nor good. For example this issue of underaged voters; as little as 20k fit make those Almajiri when never reach the age to vote go register for voters card. Them fit just reach INEC office lie say dem don pass 18 years all because of money.

Quote
If we decide not to come out for this election with our PVC wetin go happen? How them wan take play with the counting of voters if nobody com vote? Well nah God go help us.

I nor go lie during the time when I go collect my card for INEC office I almost give up on the card collection. Imagine person go commot for house by 6 am return 3 pm without he card and the INEC official go come dey tell us say our card never come say make we come back again meanwhile nah them tell us for news say make we go collect our card. All these things join wetin make people dey participate for political apathy. My only prayer now nah make those when still dey struggle with their card collection nor give up because if them do nah all of us go gather suffer am if the wrong person enter office.

Title: Re: INEC: Underage voters will be arrested
Post by: sokani on January 08, 2023, 03:38:44 PM
The way when I reason am be say if those underaged voters get parents them go arrest them but if them nor Kon get parents them go arrest only them. Because in the case of those Almajiri since nobody (parents) dey for dem nah only dem dey go carry comot go police station.
E get news wey make headline for United States about 2-3 days ago, wey a 6 years old shoot him teacher for school and she dey face life-threatening injuries. Dem come dey talk say this kind of thing never happen before, dem talk say dem go find out how the child get hold of gun carry come school... Say the matter no even reach juvenile, that dem dey reason how dem want take judge the matter, say dem fit put the child for foster care service.

America na place wey dey respect the rule of law. I stand to be corrected. But I no think say there's any place for the law wey talk say dem go arrest kid parent wey go partake in electoral fraud. Where dem fit arrest a parent na when dem try to protect their kids after dem don commit this crime. I see this statement by INEC as warning to parents and guardians to advise their wards and nothing more.

Title: Re: INEC: Underage voters will be arrested
Post by: Sexylizzy2813 on January 09, 2023, 10:06:52 AM
my question nah, why e be say nah only the northern side this thing dy common?
If we decide not to come out for this election with our PVC wetin go happen?
I think the major cause of the large number of street kids for this part of we country na because of illiteracy. Abeg ooo... Come out come exercise your civic duty as a citizen, that your vote go fit make a difference and remember to vote wisely.

My brother sometimes we need to dy ask if our vote really count because some of us dy reason, like me dy ask that same question self. How I go come out to vote con still dy run at the same time? Nah wah oh... Na masquerade play or nah election for this contri? I no wan play with my life oh.

Title: Re: INEC: Underage voters will be arrested
Post by: Itzjimmyvic01 on January 09, 2023, 03:22:35 PM
Almajiri go full cell if say Naija na sane country wey dey uphold the law but las las, they go still park these kids, give them card wey they don register on that day and they go vote

Title: Re: INEC: Underage voters will be arrested
Post by: Hyphen(-) on January 09, 2023, 08:39:37 PM
Underage voting don d happen all this years, I no know why INEC come d sound like sae this year election go be different from other election periods. Anyway all eyes are them this time around. Make we see how em go be at the end.
E sure say dis year election go de extremely different because say youths don show dem say dem de concern and dem wan make dem monitor d election back to back. Na why INEC wan try make dem run d election free and fair.

Quote
We Nigerians we already know region wey d practice underage voting. When I first hear the news, I begin d laugh cos I know how em d be for North when it comes to elections. Underage voting no go d easy this time cos the major top political aspirants of the North d involved  and you go find them for all the political parties(PDP, APC, and LP) and you know what? em no go d easy cos none of them go accept am for the favor of the other.
No cap, na for North dis under Age voting de happen wella, but e no mean say e no de happen for oda side of d country, because all dis politicians fit do anything just to win election; but dis time, e go hard dem to rig dis election as we don de their head trying to expose dem if dem f up.

Title: Re: INEC: Underage voters will be arrested
Post by: Cryptomultiplier on January 09, 2023, 09:33:38 PM
I just dey remember how the last presidential election be. Na so news dey everywhere of how underage voters for North participate, but nothing dem fit do finally.
My question firstly na, who registered this underage voters? No be still INEC officials do the registration?
Secondly, I think before persons cast their vote the voting officers should impartially compare the card information with the person in possession of it to first confirm the age before allowing such a person or persons cast their vote. Unless the place where such election is meant to hold don't mind the turnout or voters profile, then useful pre-voting screening like this should be ignored.

Title: Re: INEC: Underage voters will be arrested
Post by: KupaCrypto on January 10, 2023, 01:48:15 PM
Arresting underaged voters won't really stop irregularities in the fourth coming election but it will arrest the situation to an extent, there are other set of individuals who specialises in electoral irregularities, such as Thugs, our politicians, some Inec staffs too, and so on, all this people should be fished out together with the underaged voters and be rested so elections will be free and fair .
Even the government in some states still participate in electoral irregularities and as such the government should first make themselves an example for the rest of us to follow as no one is above the love.
Most times security personnels are also use to carry out this electoral irregularities which is not a good reputation ok their side.

Title: Re: INEC: Underage voters will be arrested
Post by: Coyster on January 10, 2023, 02:54:57 PM
Most times security personnels are also use to carry out this electoral irregularities which is not a good reputation ok their side.
You no lie at all, electoral malpractice they happen in so many ways than one, underage voting na one of them, but there are others too and i hope say INEC and the security agencies they look into the matter. As things be so, the only thing wey i fit request from Naija government be say make they do their best to ensure say election they free and fair, them no give us jobs, electricity, good roads, security, etc, no wahala, but make them try for this election, so that the people's candidate can be elected, so we go see if things go change for this country. Security of lives and properties is also very important in polling units, all this things suppose they in place so that the process go they smooth, free and fair.

Title: Re: INEC: Underage voters will be arrested
Post by: Mr.right85 on January 10, 2023, 06:38:19 PM
U knw where dis mata cast frm, na frm d registration process itself.
Jst carri eye see d image way dey 4 dat OP. U no nid persn 2 tell u say, dis pple na children dem be. Say na children way neva age betta 10yrs finish cef. Stil, u see dem 4 registration ground nd officials stil key dem in 4 dere system. In fact, na dere d arrest 4 start if dem reali wan tak dis mata serious.
I show say, evry system get code way fit link am to persn way dey run d registration. If dem start wth arresting pple way register under age voters first, ordas 4 tak note not to dey try register dem, let alone, 4 dis kids to dey com do registration or evn get liver com election ground.

I knw say, to luk system age no fit b red flag 4 underage bt, d passport way follow na d first red flag nd if such pikin ahq 4 election ground,na full verification. As e b  lik dat, mak dem no end am 4 jst arresting d pikin dem bt, mak dem extend am to d official way get mind key dem in.

Title: Re: INEC: Underage voters will be arrested
Post by: Dr.Bitcoin_Strange on January 10, 2023, 08:34:21 PM
It's just all palter palter for the INEC commissioner to have made those threats that have been neglected for so long, a rule that is even a Nome to the northernants. There are villages where this rule cannot be taken seriously, except in some cities. Mahmood Yakubu, being the INEC chairman, should take that law more seriously in his place because "charity begins at home." 😂😂 A Bauchi man like him should start that law at his place first.

Normally, underage 🔞 voting is a tabu according to the constitution, but the House has taken it as a norm in its place and this are still same people trying to introduce underage voting.

Quote
Controversy over the planned introduction of underage voting, widely alleged to be disguised in a cloak of child-wives’ rights by the National Assembly Joint Committee on the Independent National Electoral Commission (INEC), has escalated, with INEC insisting on the sacrosanctity of the constitutionally recognised voting age of 18 years. INEC said no matter the amendments to the Electoral Act, it will remain inferior to the 1999 Constitution.
Source  (http://www.thisdaylive.com/index.php/2021/01/03/national-assembly-inec-clash-over-proposed-voting-rights-for-child-wives/amp/)

lso, INEC say dem get 93.5 registered voters and dem go publish the list on 16 January before the election go start... Wetin una think concerning making the registered voters list public?

@OP, It's 93.5 million, not just 93.5.
Toward making the registered voters public, I don't think is going to cause any harm, so let's see if they keep to their words in 6 days time from today (16/01/2023).

Title: Re: INEC: Underage voters will be arrested
Post by: SOKO-DEKE on January 10, 2023, 10:46:23 PM
Underage voting don d happen all this years, I no know why INEC come d sound like sae this year election go be different from other election periods. Anyway all eyes are them this time around. Make we see how em go be at the end.
Seriously, e dey hard to see underage on polling unit try vote in my place ooo, because I dey will not even allow them,infact why did INEC registered at first time. But from what I dey see INEC no wan make them blame them at the end.
quote author=Hyphen(-) link=topic=5432751.msg61569594#msg61569594 date=1673296777]
E sure say dis year election go de extremely different because say youths don show dem say dem de concern and dem wan make dem monitor d election back to back. Na why INEC wan try make dem run d election free and fair.
Waiting to make this year election differ from other ones at pass na advancement of technology from waiting I dey hear. Wen dey use advanced machine for election it go dey easy to monitor and hard to ring.
We Nigerians we already know region wey d practice underage voting. When I first hear the news, I begin d laugh cos I know how em d be for North when it comes to elections. Underage voting no go d easy this time cos the major top political aspirants of the North d involved  and you go find them for all the political parties(PDP, APC, and LP) and you know what? em no go d easy cos none of them go accept am for the favor of the other.
I agree with you it go dey hard to practice underage voting this term around. As for me ooo all dis underage voting no be issue becus I know sai na small tin wen everyone fit disallowed in him/her polling unit sofar it above d law. But the may tin make INEC no try ring the election becus anytin is possible in naija.

Title: Re: INEC: Underage voters will be arrested
Post by: Mate2237 on January 10, 2023, 11:09:57 PM
I com dey hear sae, bayelsa State command of police Patrol team arrested won Cotonou minor of 12 years nd di boy dey speak only Cotonou , so dem come carry di boy go to do Cotonou community in di state and when dem translate di boy language, he said it was on Fulani man that brought down there to vote for the forthcoming election in Nigeria. So dat meaning, underage voting can not be automatically remove I. Nigeria.

Title: Re: INEC: Underage voters will be arrested
Post by: DaNNy001 on January 10, 2023, 11:30:26 PM
Senior man all these mata na super story,how INEC won take arrest these under age them,it's impossible. INEC just dey talk make e be say them do their work and sanitize people but all nowhere e go reach bcos INEC self dey collect bribe.
I no know oo but this years elections just dey do me like say e go dey somehow special but all the whole wuruwuru wey dey happen before for Nigeria elections no go fit Just stop like that  finish so the change na small small, maybe inec fit srart by denying all this underage voters a chance for this time around general elections first , but that one sef go hard oo because Nigerians things once money don dey involved the whole mata don change.
  All this talk fit be story sha boss,  but eventually one-day the storyline go end for them to tell. But one thing wey we should do as Nigerians is to have a positive mindset towards our betterment one-day.

Title: Re: INEC: Underage voters will be arrested
Post by: Majestic-milf on January 11, 2023, 04:19:54 AM
I com dey hear sae, bayelsa State command of police Patrol team arrested won Cotonou minor of 12 years nd di boy dey speak only Cotonou , so dem come carry di boy go to do Cotonou community in di state and when dem translate di boy language, he said it was on Fulani man that brought down there to vote for the forthcoming election in Nigeria. So dat meaning, underage voting can not be automatically remove I. Nigeria.

 That Pikin no fit travel on em own com Bayelsa say him wan com vote na, dem don dy find way to take spoil oda state names make e no be say nah onli Fulani dem dy do dat underage voting.
 And again bruv, dem fit stop underage voting automatically oh, onli if dem no go allow dem cast there vote and gather dem on dat election day put dem for prison by doing dis one oda underage voters go fear to com out. Dis style suppose happen wen dem dy follow go for voters card enrollment self, stop dem early and you stop underage voting oh, na so I think say to use stop dis underage voting go dy possible.

Title: Re: INEC: Underage voters will be arrested
Post by: sokani on January 11, 2023, 11:30:00 AM
I no know oo but this years elections just dey do me like say e go dey somehow special but all the whole wuruwuru wey dey happen before for Nigeria elections no go fit Just stop like that  finish so the change na small small, maybe inec fit srart by denying all this underage voters a chance for this time around general elections first , but that one sef go hard oo because Nigerians things once money don dey involved the whole mata don change.
  All this talk fit be story sha boss,  but eventually one-day the storyline go end for them to tell. But one thing wey we should do as Nigerians is to have a positive mindset towards our betterment one-day.

I just get the feeling say this time election go dey different. The young nigerians don tire for everything as it can be seen in the ENDSARS protest. For the first time we saw Nigerians irrespective of our ethnic and religious divide came together and brought down the country to a standstill. I don't know how many of you watched the ENDSARS video at Lekki tow gate but I saw young Nigerians like myself telling the security operatives to shoot that they are not moving an inch when they are being shot at, and one of them even in his dying breath was singing the national anthem. Omo... this gave me goosebumps. I know some bullion van politicians will try to hijack the election but I just have this feeling that we are going to get it right this time.

Title: Re: INEC: Underage voters will be arrested
Post by: martyns on January 14, 2023, 10:46:08 PM

You dey correct my mate,but I still dey fear say the election go dey bloody.If the normal thing wey we dey see for other elections nai we still see for this one,my mind dey tell me say some group of people go still come highjack the whole thing and make the election not to be free and fair.
If the election is done in a way that they allow people vote their choices,it would have been better,but they won't let that happen,they will always find a way to make the election full of corruption.We will only try our best, to make sure say we vote in our person wey we feel say e go help us.

Title: Re: INEC: Underage voters will be arrested
Post by: Majestic-milf on January 15, 2023, 07:58:37 AM

 I no fit understand why we no fit do this our election free and fair for this contri, e fit happene say nah free and fair election but before you go cast your vote reach house you go hear say them don hikack the ballot box carry am run. Now you go dy ask if your vote go count becos if them cancel that center them fit no let una re-vote again. So we go just pray and hope for the best when we do our part.

Title: Re: INEC: Underage voters will be arrested
Post by: uchegod-21 on January 15, 2023, 08:23:07 PM
I com dey hear sae, bayelsa State command of police Patrol team arrested won Cotonou minor of 12 years nd di boy dey speak only Cotonou , so dem come carry di boy go to do Cotonou community in di state and when dem translate di boy language, he said it was on Fulani man that brought down there to vote for the forthcoming election in Nigeria. So dat meaning, underage voting can not be automatically remove I. Nigeria.

Cotonou to share boundary with Bayelsa, how come e be say na Bayelsa dem catch the under age voter. Them try check the details wey dey the PVC and see where em register. E fit be camouflage to diversify attention to the south and people wey get the deal go dey run am.

Title: Re: INEC: Underage voters will be arrested
Post by: CryptSafe on January 16, 2023, 08:48:32 PM

Quote
The Independent National Electoral Commission (INEC) says visibly underage persons who attempt to vote during the 2023 elections will be arrested. Festus Okoye, INEC national commissioner for information and voter education, said this on Monday during an interview on ‘The Morning Show’, a programme by Arise Television. Okoye said in an effort to address issues around underage registration, INEC has summoned all its officers in areas where underage registrations were recorded.
As we dey gear up for the 2023 elections wey go kickstart with the presidential election on 25th february 2023, na him INEC national chairman for information and voter education Fetus Okoye, don come out come talk say any underage person wey come out come vote, dem go arrest such persons. Well...  I like as dem they loud as to our hearing and I know say na naija we dey and there's still going to be defaulters and we know say na for northern part of naija na im this underage voters registration dey common, but INEC go fit really persecute this persons? Also, INEC say dem get 93.5 registered voters and dem go publish the list on 16 January before the election go start... Wetin una think concerning making the registered voters list public?

Quote
The parents will also be arrested for aiding and abetting such a venture.
This one go dey hard to carry out ooo...  As most of the underage voters wey be Almajiri with no parent, wey dey street dey beg with plates... how dem want take arrest the parent? Abi dem just dey talk am so that parents and guardians go advise their wards?

Source: https://www.thecable.ng/visibly-underage-persons-who-attempt-to-vote-will-be-arrested-says-inec/amp

This is very laughable. Is it now that they realized or know about the underage voting. They  denied the complaint on the underage voting of 2015 https://www.google.com/url?sa=t&source=web&rct=j&url=https://www.ndr.org.ng/underage-voting-inec-denies-culpability/&ved=2ahUKEwif6vjs9sz8AhVCsKQKHdBcAMU4ChAWegQIBBAB&usg=AOvVaw2UweTU90WCKYDOYEgqgMa4. and now they are quick to make noise to justify their shortcomings. They already have their plots in mind so no need for these threats.
These underage voting mostly happens in the North which I will suggest to them to focus there this coming election because they are the soul initiators of this underage voters registration. The state government can not tell us that they are not aware of such because they are also beneficiaries of that act.
Who do they want to arrest? Is it the almajiri that walks about with plate on their hands begging for food or the  the imported fulanis from niger republic that have already been out in place for the act. They are even talking of arresting their parents too. I luagh I Swahili. They should continue.

Title: Re: INEC: Underage voters will be arrested
Post by: RockBell on January 16, 2023, 10:08:11 PM
This thing they pain me and this matter na always from the north look does children face wey they the postal, I love the fact say inec chairman don make the matter clear they see you they catch you, I  go even raise the matter for our radio station make they hear for there ear, I they wonder who they register those boys self but I love the update wey chairman drop.

Title: Re: INEC: Underage voters will be arrested
Post by: NdaMk on January 17, 2023, 12:52:18 PM
Almajiri go full cell if say Naija na sane country wey dey uphold the law but las las, they go still park these kids, give them card wey they don register on that day and they go vote

Dis no make sense and we hope everything go change this time around. I know say e dey very hard to implement rule in Nigeria and still abide by it. I hope say dis one dem go follow am and do the needful for d country. Because all dis underage no know anything about voting and dem go direct dem to vote for a particular party wey dem want neh.

Title: Re: INEC: Underage voters will be arrested
Post by: Belarge on February 05, 2023, 05:50:41 PM
If Dem for fit arrest underage voters e for really make sense oo, but we know say na lie Dem dey lie, Dem no go do anything,
I can even say as INEC chairman(Mahmood Yakubu) dey there, en fit get en own pay master wey go tell am wetin en go dey do for that office, he might also have his own preferred candidates, so en go do everything possible to make sure say en own candidate win,

So all those things wey INEC dey talk to arrest underage voters na lie e no go fit work, make Dem no just announce am, make Dem start the arrest and show us proves so that we go believe Dem if not we no go gree abeg, Dem to dey lie...

Title: Re: INEC: Underage voters will be arrested
Post by: Silver005 on February 06, 2023, 01:28:49 PM
It is a welcome development,if really the officers are going to act on the directive that are been given to them and not to be compromized by the political, because bribe and corruption have become the order of the day,it is against the law in Nigeria for underage to vote in an election,so I support the INEC official to stand on their grand against the underage voting and persecute whom ever that was cought in such act without no mercy,so as to give us free,fair and credible election come 2023,so I urge The INEC chairman and all the working committee to come together to prove to the world that Nigeria can be better again..

Title: Re: INEC: Underage voters will be arrested
Post by: azuaza on February 08, 2023, 07:42:30 PM
That would have been better. But, how would they be punished? I think parents too should be held responsible for their children doings. Parents are supposed to watch over their children not to engage in underage voting.

Title: Re: INEC: Underage voters will be arrested
Post by: Sharonchy on February 09, 2023, 07:10:02 AM
That law is not realistic because you have already called them underage which simply means the law cannot really hold them, inec should flush such underage registered voters out of there database not by issuing a may threat they cannot implement.