Bitcoin Forum

Local => Nigeria (Naija) => Topic started by: Sexylizzy2813 on January 24, 2023, 12:15:11 PM

Title: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: Sexylizzy2813 on January 24, 2023, 12:15:11 PM
My fellow contri piple this NEPA issue nah really wahala we need to look into becos as we dey so we nid light to use do plenty things like to run our business make we no get money wahala. If light dey steady I no see any reason why my neighbor go go buy gen dey use am make noise and fuel prize self no dey help matter. Some of us wey no fit buy gen and fuel join no go fit even enter this forum dey do the normal thing.

Some piple area like my own self, we no trust the way light dey go OFF more than wen e suppose dey ON. The most annoying part nah the bill we dey receive every month, e reach to use pay pikin school fees oh. Make e no make piple reason something bad for NEPA oh, becos how you go use light for 3hrs per day (that's if dem pity us oh) then bring #30,000 plus bill or even more than dat self and expect us to jubilate like Arsenal wey win match, make we go dey pay that kind high bill eh, ha, na wa oh. And if them take the light we fit stay for darkness for like 3-5 days or even more e go give mosquito power to invade us like Russia wey invade Ukraine.
Me I weak abeg... How una see this issue wey strong pass karnel?

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: HajiBagi on January 24, 2023, 06:41:17 PM
My brother nepa issue Don chock me for neck because as he stands now I no fit talk anything about nepa because even if we talk now no matter how na them get their thing no be government property again that is why them too dey do waiting them like and no matter how we take vex about the bill or saying that we go take action we no get power to take any decisions because any how he be we no fit do without light, so na our leaders wey go sell light we go blame if not na waiting we go talk now we go still talk every day about nepa matter.

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: RockBell on January 24, 2023, 09:08:28 PM
My fellow contri piple this NEPA issue nah really wahala we need to look into becos as we dey so we nid light to use do plenty things like to run our business make we no get money wahala. If light dey steady I no see any reason why my neighbor go go buy gen dey use am make noise and fuel prize self no dey help matter. Some of us wey no fit buy gen and fuel join no go fit even enter this forum dey do the normal thing.

Some piple area like my own self, we no trust the way light dey go OFF more than wen e suppose dey ON. The most annoying part nah the bill we dey receive every month, e reach to use pay pikin school fees oh. Make e no make piple reason something bad for NEPA oh, becos how you go use light for 3hrs per day (that's if dem pity us oh) then bring #30,000 plus bill or even more than dat self and expect us to jubilate like Arsenal wey win match, make we go dey pay that kind high bill eh, ha, na wa oh. And if them take the light we fit stay for darkness for like 3-5 days or even more e go give mosquito power to invade us like Russia wey invade Ukraine.
Me I weak abeg... How una see this issue wey strong pass karnel?
The matter done tire me I swear I been think say na only my side but be like say the thing touch everywhere and nepa get mind come my area come they treating people upon say them no give us light and running generator again no be small matter oh the way fuel cost now the thing they fear me I swear if you see 5000  naira fuel you go fear, things just they worst fuel we no see light we no get.

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: SOKO-DEKE on January 24, 2023, 09:53:29 PM

Toh naso NEPA dey misbehave since I Sabi them, I no trust them for that NEPA light Mata again and I no go dey trust them as far I still dey dis contri. Since I was born and mature 4 dis naija I neva witness NEPA light for 24hour in my life, so i Don stop dey vex on top their Mata now becus even I vex I get nothing to do them. But waitin dey weak me pass be sai some people dey still get dis NEPA light wella especially does rich men areas according to people.
The most annoying part nah the bill we dey receive every month, e reach to use pay pikin school fees oh. Make e no make piple reason something bad for NEPA oh, becos how you go use light for 3hrs per day (that's if dem pity us oh) then bring #30,000 plus bill or even more than dat self
Na so NEPA bill dey be, even you not use their light their bill na constant with stable price. So d best way na to get ur prepaid meter to avoid their constant cheat. I remember time wen asuu go for strike for some months wen no student dey lodges could u guys believe sia NEPA still dey bring Bill to my lodge and those money dey accumulate dey time we resume. Seriously dey be werey

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: Majestic-milf on January 24, 2023, 11:23:57 PM
 OMG, this thread enter eyes no be lie because NEPA no care if you use light or not all them know be say make month run make them come share bill and to disconnect your light. Boys don do them something for some part of my area and them don give that part respect, imagine when them bring bill for that part of my side but no light for 3weeksand inside that 3weeks nah like flash them flash am, so when them come to disconnect nah push them push ladder comot from poll, if no be God persin wey dy up for don break leg.
 Ever since that day NEPA dy behave them selves but you suppose know say no matter how you praise them small korma must dy for there body... Make I no reason fuel own matter because to get am e be like say you dy fetch water with jerican wey dy lick, well nah them sabi... Only if steady light dy who go reason to buy gen and buy fuel?

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: martyns on January 25, 2023, 04:27:47 AM
Omoh,some places like portharcourt better small for nepa light oh,wetin we dey see for here,our eyes no fit talkam.Infact some places no dey get nepa light at all.
I dey stay for Bori, where we no dey see light at all,but wetin surprise people pass be say this period wey we don already dey used to darkness,and using generators,light just show from no where.Everybody gat to go find out why them give us the light.Now we don find out say election weh dey by the corner,nai make them give us the light,so that we go fit vote them into sit during election.

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: CryptSafe on January 25, 2023, 08:02:44 AM
This one na serious matter. The NEPA matter tire person wella. The issue of epileptic power supply dey one area and another na over estimated bill and another na say Dem no dey take meter reading month end Dem don bring bill come. Somebody go just dey for office at his or her own convenience write bill for distribution to consumers to pay when dem no come take the meter reading for the month in some cases, no light for some weeks Dem go still give you bill even wen e be say Dem cut your wire my brother Dem no send you o, month end Dem don come give you bill for light wey you no use. NEPA matter don worse pass olopka palava.  Even the prepaid meter na wetin I no understand, that one dey burn light fuel before you go know my brother your recharge don dey exhausted. I tire for them. E for better say man do solar Dan to dey get headache for this NEPA matter.

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: Sexylizzy2813 on January 25, 2023, 01:10:18 PM
This men dem get bad habit full body I no lie, if dem bring bill today na so dem go kip light like say na so dem dy do and if dem cut light dem go kip am make e pain piple wey no pay bill wey dem disconnect... Everything wey dis NEPA dey no joy wey connect to am at all, dem no dey try at all.

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: KupaCrypto on January 25, 2023, 02:29:20 PM
Omo, this NEPA people no dey try oo, we never see light for the past 6 months and them no even send us , them say pole fall some people dey say transformer spoil so we no know the one wey be the issue, and e dey affect our day to day activities especially now wey one litre of fuel na 500naira for my area , how many litres you wan buy to full you tank, so e dey worry our business too, becos for light person no fit on generator for customers to see waiting dem wan buy and NEPA no dey come .

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: sokani on January 25, 2023, 09:11:55 PM
Nepa na serious issue for this country. For my area dem dey try sometimes but for like 2 weeks now I never see light. Transformer spoil so some part of my area dey get light while some part no get light. E dey painful say person go dey pay for service wey im no dey get. End of the month this niggaz go bring bill again and if you no pay dem go cut you off. Prepared meter is still dey best as u go only pay for the light wey u use.

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: Asiska02 on January 25, 2023, 09:31:34 PM
Everybody dey always get their own different story for NEPA matter. E be like the light issue come worst sef after dem finally sell the NEPA itself to private company. Those people dey sell light out neh now to highest bidders. Dem no wan dey give light to places where dem no go get money recover from after supplying dem steady light. To some extent I no blame dem but na the government wey sell the authority of the company give them. Last last I still believe say na dis same government be the private sector wey still buy am come dey milk its people again.

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: KupaCrypto on January 26, 2023, 02:18:53 PM
You have two buildings, one  for residential and the other for renting shops , the residential building has a prepaid meter but the once for renting shop is not connected to NEPA, so you want to use a shop in the other building for a purpose and you decided to connect the light from your residential building to two shops in the other building, remember the residential building has a working prepaid meter which is reading, NEPA comes and cut the wire, the question is
1. My prepaid meter is reading and am recharging it based on the light I use from my residential building to the shop are they right to cut it??
Because like this I dey vex ooo, I dey para
 Make Una advice me abeg.

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: Sexylizzy2813 on January 26, 2023, 08:31:32 PM

Big boss no too vex plenty becos this NEPA piple be like police men dem wey get plenty charges for we the customers and you go reason with dem and also yan dem why you make that move, dem like when you behave as if you no know wetin you dy do but know your right oh...
For the advice I no too know where I wan point hand but all I know be say them fit tell you say na illegal connection and even upon that still rub mind with them before you know them go dance to your turn, but no use vex follow this matter.

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: Davidvictorson on January 26, 2023, 10:24:35 PM
We don dey use to the prolonged power outage so tey even when dem bring light and e stay pass 5 hours, the Nigerian in us go dey beg dem to take the light because dem fit nor bring am again for the next one week. You sef know say na true. Right now sha anybody wey still dey put hope for NEPA  just come. The other day, I dey read for news as how South Africans dey complain about their recent power cut. For my mind, i just say, welcome to  our reality. Unlike our naija we know say their own na temporary our own never get any end in sight yet.

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: Enjoyment on January 26, 2023, 10:25:13 PM
My brother NEPA matter no be small matter, for my area nah heat won kill us oooh

Even water, don still add money before talking of cold water, expect if you fit fight for filling station and buy fuel to on generator.

My people as the country be now hmmm me i don't know what to say.

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: CryptopreneurBrainboss on January 27, 2023, 10:07:24 AM
The most annoying part nah the bill we dey receive every month, e reach to use pay pikin school fees oh. Make e no make piple reason something bad for NEPA oh, becos how you go use light for 3hrs per day (that's if dem pity us oh) then bring #30,000 plus bill or even more than dat self and expect us to jubilate like Arsenal wey win match, make we go dey pay that kind high bill eh, ha, na wa oh.

Na here the stori off me as I just experience my own recently. Me I no dey fit stay without light so steadily my gen dey dey on but which dey I hear knock wey no dey familiar. As I opened na NEPA people oh, if no be say na wan find banny like dat I for dun slap person daughter wetin no good at all. Dem bring bill come say make app the 15 people wey dey yarn make dem pay #13k each like seriously you need dey anger wey we carry chase dem comot our compound.

Like we wey be say for night hours wey dey get light on a constant, na him you dey bring #13k each for 15 people to pay wey be say normal na like #25k wey we dey pay for the whole compound ahhh. The light situation for my side need do better, na only this light wahala dey disturb me but I never too reason am sha as God dey provide fuel money. My side go well like the house and environment dey very comfortable to me. If God fit just touch this people their heart our lights situation improve na to settle down for this side self remain.

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: Sexylizzy2813 on January 27, 2023, 12:43:35 PM
If God fit just touch this people their heart our lights situation improve na to settle down for this side self remain.

My broda if you talk say make God touch them no forget say nah still humans wey them be oh I mean greedy humans for that matter. E dy like the same thing we dy talk say make God touch our government, God don touch them but them go gree change?
Like this now them don take our light and we no dy expect am any time soon if not by 4am or 5am for tomorrow morning oh, so this light issue dy give me heat for brain. If your area good e better make you stay there dy manage the small light you dy see oh.

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: SmartCharpa on January 27, 2023, 10:01:50 PM
My fellow contri piple this NEPA issue nah really wahala we need to look into becos as we dey so we nid light to use do plenty things like to run our business make we no get money wahala. If light dey steady I no see any reason why my neighbor go go buy gen dey use am make noise and fuel prize self no dey help matter. Some of us wey no fit buy gen and fuel join no go fit even enter this forum dey do the normal thing.

Some piple area like my own self, we no trust the way light dey go OFF more than wen e suppose dey ON. The most annoying part nah the bill we dey receive every month, e reach to use pay pikin school fees oh. Make e no make piple reason something bad for NEPA oh, becos how you go use light for 3hrs per day (that's if dem pity us oh) then bring #30,000 plus bill or even more than dat self and expect us to jubilate like Arsenal wey win match, make we go dey pay that kind high bill eh, ha, na wa oh. And if them take the light we fit stay for darkness for like 3-5 days or even more e go give mosquito power to invade us like Russia wey invade Ukraine.
Me I weak abeg... How una see this issue wey strong pass karnel?

My brother this nepa matter tire anybody as i dey lie this na heat i dey so,  for my side sef person go pay for nepa bill at the end of the day light go dey on and off by itself not even 24h ours light and dey will later begin dey tell stories that something hot, this our country nepa and government they are all f9.

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: Marykeller on January 28, 2023, 01:05:16 PM
Each time I remember our Nepa matter, em no d give me joy at all. You go manage get few hours light today, tomorrow you no go see am at all. As big as our country dey, we no fit boost for steady light for a day. Wey be sae our neighboring country like Ghana d see light on a reg.

Wetin the vex me pass be sae this light issue of a thing na wetin our politicials dey take do campaign. They go promise steady light give Nigerians but the moment d enter office, them go find means to catch out big from am.

We thought that handling the NEPA to private sector go better for us, at least we go d see light, we no know sae em go turn out to be the worst. Them no give you light and the expect make you pay for NEPA bill for the month. If light no d for a month, your NEPA bill go d increase the go. Not minding sae u no get light. Is that not wickedness?

Believe me, this our country no bam. Em get so many things wey FG needs to checkmate into, not only light. All this private sectors wey dey for this our country d cheat us and them no d value their customers. More especially DStv, networks(MTN, glo and Airtel), banks etc

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: Fivestar4everMVP on January 28, 2023, 01:43:26 PM
The light mata for my area no be here again, i no even know wetin i go say na im happen, light been dey very stable for my side through out last year, but immediately we enter January, everything just change..
- First, early December last year, dey increase our light bill 25 percent wetin we dey pay before, we self come dey happen say they increase the money with hope say we go enjoy light this year more than we enjoy am last year..
- Secondly, we no come dey see light again, just immediately after we celebrate new year finish on the first of January, dey take light, until fifth of January before dey bring am again, as they bring am so, e no reach one hour, dey take am again, as i dey type like this, we never see light for the past one week.. The mata tire me no be small.

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: Sexylizzy2813 on January 29, 2023, 11:12:39 AM
My fellow contri piple this NEPA issue nah really wahala we need to look into becos as we dey so we nid light to use do plenty things like to run our business make we no get money wahala. If light dey steady I no see any reason why my neighbor go go buy gen dey use am make noise and fuel prize self no dey help matter. Some of us wey no fit buy gen and fuel join no go fit even enter this forum dey do the normal thing.

Some piple area like my own self, we no trust the way light dey go OFF more than wen e suppose dey ON. The most annoying part nah the bill we dey receive every month, e reach to use pay pikin school fees oh. Make e no make piple reason something bad for NEPA oh, becos how you go use light for 3hrs per day (that's if dem pity us oh) then bring #30,000 plus bill or even more than dat self and expect us to jubilate like Arsenal wey win match, make we go dey pay that kind high bill eh, ha, na wa oh. And if them take the light we fit stay for darkness for like 3-5 days or even more e go give mosquito power to invade us like Russia wey invade Ukraine.
Me I weak abeg... How una see this issue wey strong pass karnel?

My brother this nepa matter tire anybody as i dey lie this na heat i dey so,  for my side sef person go pay for nepa bill at the end of the day light go dey on and off by itself not even 24h ours light and dey will later begin dey tell stories that something hot, this our country nepa and government they are all f9.

F9 mean say hope dy for this current government but for now no be when we go dy wait make them use plenty talk talk full our ears, as e be so make we try no listen to them, nah to use our power which is the PVC to change this change them give us for 8yrs. Better person dy wey go help us clear our suffer.

As for that heat wey dy do you comrade, just go pour water for body,better days ahead.

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: Kgdktac on January 31, 2023, 03:49:54 PM
For where I dey currently live, 1year don pass we Neva see light, na wisdom we use come go install solar since six months ago. Now I no dey complain much. I wonder how people dey manage dey buy fuel now. God abeg help us

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: Sexylizzy2813 on January 31, 2023, 04:05:38 PM
For where I dey currently live, 1year don pass we Neva see light, na wisdom we use come go install solar since six months ago. Now I no dey complain much. I wonder how people dey manage dey buy fuel now. God abeg help us

Wait oh... Electric pole no dy una side wey go fit make NEPA piple come una area abi them just abandon una say una no from this contri or wetin?
Make una shake body nah, that's if NEPA piple still dy around una area oh cos I no see why piple dy suffer for wetin we get.

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: Kgdktac on January 31, 2023, 04:11:51 PM
For where I dey currently live, 1year don pass we Neva see light, na wisdom we use come go install solar since six months ago. Now I no dey complain much. I wonder how people dey manage dey buy fuel now. God abeg help us

Wait oh... Electric pole no dy una side wey go fit make NEPA piple come una area abi them just abandon una say una no from this contri or wetin?
Make una shake body nah, that's if NEPA piple still dy around una area oh cos I no see why piple dy suffer for wetin we get.

We do shake body o, maybe somebody around here make somebody vex or something,  otherwise I can't say at all. Wickedness dey for dis world I tell u. People around here don forget say Dem dey bring light

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: Adbitco on January 31, 2023, 04:13:30 PM
Hehe.. This is a serious issues about NEPA in our country most especially my area in ph, I don't even know how they are manipulating the power and expect people to pay bills. We were using direct power, like, use then after month runs out they get us Bill, but it was so outrageous and we were finding it difficult to pay our bills till our landlady decided to change it to PPM (Pre Paid Meter) where we are now economicing the use of our power consumption. So the good thing there is that 'if there's no power our subscription remains intact until there is power before it starts reading or consuming'. But guess the worst part of it is that we can't use Air conditioner or Pressing Iron and even Washing machine, we do avoid anything that will consume the power so quickly.
To crown it all, our country is not really helping out things concerning electricity and in fact, all aspects of life they are backwards.

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: Broadanbig on January 31, 2023, 05:19:45 PM
My brother e get as e be o. NEPA matter no follow at all. Them no dey show us love here. For we country naija, NEPA no get joy for we people them no go give you light but Dem go want to collect bill month end where e be say na Dem go dey for their office write bill give you just a one commenter talk here na so Dem dey do o. Sometimes sef light we no dey see eye but when month end, Dem go bring bill come. Sometimes too when month din dey end, Dem go bring light like two to three days then Dem go bring bill come the bill sef no be say na meter reading o but over estimated bill for that matter.  With all these their behavior, one has no choice than subscribing to NEPA to save you some strength as fuel to Ms another wahala.

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: Agbe on January 31, 2023, 08:57:43 PM
I called dis one as a rhetorical question in Nigeria. I have argued dis issue with colleagues time without number but it is only few understands me. I like ur question but my question is have you slept with nepa 4 just 24/7 hours in your area? Some pple say yes while odas sae no. Well States are different, most people dat sae yes can't distinguish NEPA light with Tobine light. In a community in my state, light does not blink or off for months, and dat is Tobine not NEPA. And most people use day as a NEPA which is not. NEPA Never again and again never gives 24/7 hours light bcoz those who control NEPA di big Oga dem r di managing directors in the Petroleum Marketing system... As it is fuel is at the high peak and there is no NEPA light, so you must buy... Political Economy of African States. I don't want to tok 2 much.

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: Silver005 on February 01, 2023, 03:46:01 PM
No be small thing ooh, this country don tire person ooh which one we go talk, this NEPA of thing be say I no blame them na our leaders na him I go blame wey carry our property sell give one person,wetin we go fit talk now,e dey run e business The way wey he like,so wetin I dey talk be say na our leaders fault,na make we dey pray for baba God to give us better leaders this coming election wey go change everything we the bad leaders don spoiled and buy this our NEPA back na my own talk be that..

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: Belarge on February 05, 2023, 09:36:01 PM
Chai this matter now sef no be small matter oo, NEPA no dey try for my area at all, we dey suffer for light, I wish say this platform get voice note make I use voice note cry and talk how NEPA dey treat us for our area,
Sometimes in a week na just 2 times we dey see light, sometimes we no dey see the light at all, as I dey talk to you now  no light, we Don spend money to use charge phone tire because the Gen wey we dey use for house don kuku spoil,100 naira every day for charging, omoh I just tire,  and wetin dey pain me pass be say when month go
end NEPA go dey share bills for us to pay, I just tire sef...

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: Mr.right85 on February 05, 2023, 09:58:26 PM
I called dis one as a rhetorical question in Nigeria. I have argued dis issue with colleagues time without number but it is only few understands me. I like ur question but my question is have you slept with nepa 4 just 24/7 hours in your area? Some pple say yes while odas sae no. Well States are different, most people dat sae yes can't distinguish NEPA light with Tobine light. In a community in my state, light does not blink or off for months, and dat is Tobine not NEPA. And most people use day as a NEPA which is not. NEPA Never again and again never gives 24/7 hours light bcoz those who control NEPA di big Oga dem r di managing directors in the Petroleum Marketing system... As it is fuel is at the high peak and there is no NEPA light, so you must buy... Political Economy of African States. I don't want to tok 2 much.
No be lie u talk shah. On d matter say, Nepa no fit giv u 24/7 light. I no knw plenty on dis turbine stuff bt, I recall say, my school bin get am once b4 dem sell am. Evn wth dat, d light no bin only dey blink, e bin dey close eye sleep sme kind times.
E really dey possible say light no dey blink? Abi u jst raise d matter up small becus, equipments dey need rest some kind times o, mak dem 4 reduce wear nd tear with issues of over heat nd tins like dat.

Anode point way u bring up na d scarcity 2 ensure say pple buy fuel bt 4 dis one eh, evn d nepa na business. Pple dey pay bill 4 usage. I no go con spoil my own so dat u kwa go chop. Hw u see am?

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: martyns on February 08, 2023, 11:42:15 PM
My own area worst oh,the way them take dey do us ehn,e dey like say the people wey dey live for this side no belong to the country  at all,because dem dey give us the light only when them feel like to give us.Despite all the support wey people of my side dey put during election,dem no dey appreciatam with as commons as light.This side is very bad.
We are used to the darkness now,so we no dey too complian again because even if you shout from now till tomorrow,as e dey there mind nai dem dey do us,so e better make we just remain silent,anytime e hungry dem to give us,dem go give us.

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: Obari on February 10, 2023, 05:30:07 AM
Baba @OP abeg try comot your mind for nepa wahala because me I dey 100 percent certain say e get places wey dey enjoy this light on steady basis with a very minimal bill if I'm not wrong and atleast in a day una dey see light na because for my area, Dem go give us light for one day and take am for three days and e come be like say we are already getting used to it if not even used to it.
To run on generator no even follow for this context as fuel don really turn blood diamond now and the reason to the fuel scarcity I never really hear am or Mae I say understand am.
No be everything be prayers because Nigeria dey pray to God for the basic things government suppose give us 

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: Majestic-milf on February 13, 2023, 12:47:55 AM
 OP when e come to NEPA matter I no sure if I don praise them one day say them try, try for where? NEPA wey get mind make mosquitoes to be my room mates, my body don full mark like say nah tribal mark I get, them even cari me put for darkness wey I no fit help myself out from. See eh, to tell you the truth if NEPA nah person I need to vote for I no sure say I go get PVC. I just need to park comot from this area if e go help.

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: EarnOnVictor on February 13, 2023, 09:26:16 AM
E no new say we no dey beta country, nothing good 4 Naija, mo just dey manage and hustle more to make tins beta 4 us personally if we no won japa. Nepa issue no be today, no solution to am, d only resolution on their part na to suck innocent Nigerian dry of their hard earn money with their huge bills. I swear, if any nepa bring #30,000 come my side, I go tell dem make dem remove their wire say I no dey do again, I go do solar immediately.

That amount too plenty, make nna try get prepaid nau, u no go dey pay much, #2,500 a month go do for everything if u get stuff 4 house. Even d light no dey come regularly, but prepared no go cheat u as wetin u use na in go comot ur pocket.

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: Cryptomultiplier on February 13, 2023, 09:35:52 AM
The NEPA matter tire person. As them hype prepaid meter reach, those wey switch from estimated bill format to prepaid no dey even enjoy any benefit.
I no fit begin air my concerns because the heat go double right now o.
Let's vote wisely o! It really matters.

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: Wiwo on February 13, 2023, 12:09:39 PM
As a professional best practice,  get an alternative power supply,  is either you get Gen set or you get solar energy as an alternative because,  right from inception electricity supply in Nigeria has been epileptic and poor, we're 9ja households can't boost 5 hours of electricity supply.
-So instead of leaving your business at the mercy of Nepa you have to think of alternative ways to generate electricity for your use.
-For my area, Nepa dey try well well, we get steady light for here but at least we still dey spend 2-3  hours a day without light, so if you get alternative you can possibly not go off supply for 24/7.
-But I sure say why we dey see light like this, na because of our location since na capital and na City centre I dey, light no fit dey go off light that.
-I know we have some local governments within Nigeria that have not seen light for up to 4 months and yet their pay bills that is how bad the situation has become

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: Sexylizzy2813 on March 02, 2023, 08:29:07 AM
Let's vote wisely o! It really matters.

Even if we vote wisely e go change the fact say all politicians for this contri get plenty bad side pass the good side?
Make we just pray say person wey enter there go do better pass the old ones, becos this men no reason say we dy for heat and we dy try our best to play our part as citizens of naija, my own be say make them forget there pocket small reason our side small. NEPA self nah humans like us oh, that means nah we dy kill ourselves by our self.

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: King GK on March 02, 2023, 09:21:59 AM
Omo my forum mate! E no easy for my area nepa matter reach our neck o! heat full everywhere no fan to blow persons self to phone charge  na problem fuel don cost to the matter just hard self see nepa bills they want kill person government dey do there own see nepa own see money own wic one we go face my country people God go help us all

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: Nheer on March 02, 2023, 10:11:45 AM
So far so good for my area this days nepa dey try for us for like how many weeks now we de get light back to back, somtimes for like 3days dem no go blink the light and anytime dem carry am dem go bring am back within like 2hours them go com leave am again like another 2-3 days straight. I no know maybe na because of election wey bin de come dem de give us light bit sincerely this February Nepa really try for us gaan. Nepa have been good to us lately and i hope dem go fit just continue like this.

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: Cantsay on March 02, 2023, 09:20:29 PM

I still dey experience the same thing for my area, most especially when they start to they collate result for 24 hours NEPA nor touch the light for my area and if them take the light before you know them don restore power back, everybody Kon even dey fear say once dey take the light nah till next month before we go see am again.

But now dem don return back to their three hours in a day light and the funny part be say nah for night dem dey bring when all store don close, so those people when need the light to do their work nor dey see am use.

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: Cryptomiles1 on March 03, 2023, 01:33:59 PM
My brother this NEPA whahala no be here oo because like this e red for everywhere both my side and like this na PPM we dey use and e finished like mad. Like this the kind bill wey we dey pay everytime dey make me feel like to relocate go my LGA wey be say light dey waste everytime, no body to use am and house rent cheap too. But how we go do since we country insecurity too high every body run go ph city wey no body sabi you.

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: Hope jeffrey on March 04, 2023, 10:53:14 PM
For my area dem dey try sha if dem bring am for night around 9:00pm dem go keep the light till the next morning and me because of my work I dey always come back late so once I reach house e no go too tai light go come so for me na good oh.

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: Majestic-milf on March 08, 2023, 08:48:47 AM
My brother this NEPA whahala no be here oo because like this e red for everywhere both my side and like this na PPM we dey use and e finished like mad. Like this the kind bill wey we dey pay everytime dey make me feel like to relocate go my LGA wey be say light dey waste everytime, no body to use am and house rent cheap too. But how we go do since we country insecurity too high every body run go ph city wey no body sabi you.
I follow join you for this ya pain my brother. My own case be say where I dey, the bill no only plenty, but I no dey see light take use do wetin I sopoz do. Secondly,  the landlord no play me tape say e dey owe outstanding bill and nah so I just dey pay unnecessarily.
 The contri don sour and as e dey, village come dey get better amenities pass city sef.
 
Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: Cryptomiles1 on March 08, 2023, 09:36:52 AM

Omo no be joke like village get more better stands pass city oo because if you enter there hide yourself inside dey run ur matter no body go chuck eyes for ur business, na only ur mama and ur wife fit know wetin you dey sub inside house. Light dey and no competition between u and person, no bills everywhere soft.

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: Lida93 on March 21, 2023, 11:00:18 AM

Some piple area like my own self, we no trust the way light dey go OFF more than wen e suppose dey ON. The most annoying part nah the bill we dey receive every month, e reach to use pay pikin school fees oh. Make e no make piple reason something bad for NEPA oh, becos how you go use light for 3hrs per day (that's if dem pity us oh) then bring #30,000 plus bill or even more than dat self and expect us to jubilate like Arsenal wey win match, make we go dey pay that kind high bill eh, ha, na wa oh. And if them take the light we fit stay for darkness for like 3-5 days or even more e go give mosquito power to invade us like Russia wey invade Ukraine.
Me I weak abeg... How una see this issue wey strong pass karnel?
Make I act like say I no see dat part of ur discussion wey no see other team dan Arsenal cum dey use for this mata cos s mata fit long.... As for NEPA abi na PHED wey Dem call dem here, those pipo na just same character Dem get nationwide, the small hrs in a day we all agree to dey get light we no dey even see am half sef. And na wen few days wey Dem wan cum collect lik bill Dem go cum give us light lik say we na mumu.
The beta tin u fit do for urself as business man wey gett need for light to use dey do ur work na to jxt buy beta gen den dey try fuel am only say na cost of expenses go jxt tie d person for neck cos profit u supos get for business gen servicing and fuel go chop am finished. Naija too hard to run business aswr!

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: Majestic-milf on March 23, 2023, 02:00:53 AM
My brother this NEPA whahala no be here oo because like this e red for everywhere both my side and like this na PPM we dey use and e finished like mad. Like this the kind bill wey we dey pay everytime dey make me feel like to relocate go my LGA wey be say light dey waste everytime, no body to use am and house rent cheap too. But how we go do since we country insecurity too high every body run go ph city wey no body sabi you.
I follow join you for this ya pain my brother. My own case be say where I dey, the bill no only plenty, but I no dey see light take use do wetin I sopoz do. Secondly,  the landlord no play me tape say e dey owe outstanding bill and nah so I just dey pay unnecessarily.
 The contri don sour and as e dey, village come dey get better amenities pass city sef.
 
Omo no be joke like village get more better stands pass city oo because if you enter there hide yourself inside dey run ur matter no body go chuck eyes for ur business, na only ur mama and ur wife fit know wetin you dey sub inside house. Light dey and no competition between u and person, no bills everywhere soft.
The Koko be say the civilization wey pipo dey leave villages come city for don dey get k-leg. Asides from the light system, some roads dey follow suffer dis deficiency wey light dey sufa too. But as you see am light dy really show say some places det develop pass the other and road wey you see so piple no dey reason am like light.

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: Alphakilo on March 23, 2023, 08:35:17 AM
Nepa mata don tire me. E better say make dem cancel nepa for this country make we know say we no kuku get light for our country. We dey pay for nepa bills every month but we dey always dey for darkness. When dey wan come collect light bills dey go bring light that day, after that fiam, dey go off light.
We never ever get light for complete four hours in a day. If them bring the light after 30 munits them go carry am till next day.
I don tire for nepa mata.

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: Majestic-milf on March 24, 2023, 12:59:18 AM
 As I dy like this I just dy vex but I no wan show am at all, I dey find way make I raise fund to take buy generator because this NEPA issue dey make me no dey come do the normal thing for this forum and e dey pepper my inner self, abeg all my senior comrades I no know how una wan do am to help me add make I buy Gen make I know say nah filling station I go channel my complain go drop cos nothing dey happen for NEPA mata.

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: Marykeller on April 04, 2023, 04:20:25 PM
Nepa light for my area now don the vex me badly. Could you believe sae for the past a month or so, peso neva get light up to 5times and them don bring bill of 10k naira give peso sae make em pay for the light wey em no get. Anyway, I no get problem with them until the time for payment and disconnection of light na when people from my side go show them pepper of the stuff wey they are made off. After making people to spend much money for fuel, them the bring bill give peso of the light wey em no see. What an arrant nonsense be that. Making someone go about with charger.

It's hard time for Nigerians to the make Nepa understand sae the light wey dem give us if peso no see light wella them no go pay Nepa bill for the month. It makes no sense for paying Nepa bill of wetin peso no see.

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: martyns on April 07, 2023, 08:40:33 AM
As I dy like this I just dy vex but I no wan show am at all, I dey find way make I raise fund to take buy generator because this NEPA issue dey make me no dey come do the normal thing for this forum and e dey pepper my inner self, abeg all my senior comrades I no know how una wan do am to help me add make I buy Gen make I know say nah filling station I go channel my complain go drop cos nothing dey happen for NEPA mata.
You funny sha,make dem find way raise fund for you make you take buy generator,say the light go reach everybody wey raise the fund for you? You funny.Same thing dey happen for our area oh,we no dey talkam again for here because we don seeam as normal thing,we don dey used to that fact say light no dey reach this part of the country,and government no dey reason the people wey dey here dia Matta.During that period of election,when dem been want make people vote for them,dem been bring light so that e go call the mind of the people to talk say government don dey reason our matter,not knowing it was just a strategy to carry get vote from people.After the election,we never see light again,and we don also dey used to dat fact,we go still survivam,nobody go die.

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: Sexylizzy2813 on April 10, 2023, 10:54:37 AM
I dy complain for the light wey no too dy come for where I dy stay before, now I don see light wey I no go say light no dy come but for this new place I dy na PPM wahala I dy face so, our landlord con dy behave like NEPA man, carry load full him house dy consume the unit we buy still dy expect us to dy pay as if we get plenty load wey dy finish the unit fast fast.
Me I just tire, now I tell am say I no do again make him give us our own PPM before I open eyes close this man don disconnect my line weybwe never get our PPM, this contri self eh.

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: Mr.suevie on April 12, 2023, 07:27:33 PM
The nepa or should I say phcn Mata Don tire everybody for the country but the mata be say no be everywhere nai dey experience this light issues for my place here for Bayelsa state  ogbia local government ORUMA TOWN light no dey go at all na only when I Don leave there Enter yenagoa wey be propose capital of the state nai Nepa come dey deal with me, for yenagoa e hard make dem bring light people dem dey only experienced light once in a blue moon.

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: CryptSafe on April 13, 2023, 10:16:42 AM
As a professional best practice,  get an alternative power supply,  is either you get Gen set or you get solar energy as an alternative because,  right from inception electricity supply in Nigeria has been epileptic and poor, we're 9ja households can't boost 5 hours of electricity supply.
-So instead of leaving your business at the mercy of Nepa you have to think of alternative ways to generate electricity for your use.
-For my area, Nepa dey try well well, we get steady light for here but at least we still dey spend 2-3  hours a day without light, so if you get alternative you can possibly not go off supply for 24/7.
-But I sure say why we dey see light like this, na because of our location since na capital and na City centre I dey, light no fit dey go off light that.
-I know we have some local governments within Nigeria that have not seen light for up to 4 months and yet their pay bills that is how bad the situation has become

As a guy into ITC, you need not to depend on NEPA here in Nigeria otherwise frustration is your next name. In Nigeria, power supply is not taken seriously by the government hence the epileptic power supply across all division. In other to avert business lose and other challenges in the cause of electricity outtage.  One would need to source or make readily available other means of electricity supply such as solar power, generator, inverter etc only with thee alternative options, one would be able to sustain themselves in their various businesses which requires constant electricity.  What baffles me most is that NEPA being fully aware of their lapses in power supply still at month end sends bill to people to pay up for what they did not consume.

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: Philpsticks on April 14, 2023, 03:48:39 PM
Nepa na serious issue for this country. For my area dem dey try sometimes but for like 2 weeks now I never see light. Transformer spoil so some part of my area dey get light while some part no get light. E dey painful say person go dey pay for service wey im no dey get. End of the month this niggaz go bring bill again and if you no pay dem go cut you off. Prepared meter is still dey best as u go only pay for the light wey u use.
No be lie bro I agree with you prepaid is the best but the problem be say even the prepaid self you go still they recharge bro because if light the for a whole week money they count before you know 5,000 don finish

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: Wolfblood200$ on April 19, 2023, 11:56:22 AM
Nepa dey try for my area but prepaid taref don increase

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: Sexylizzy2813 on April 24, 2023, 11:21:05 PM
Nepa dey try for my area but prepaid taref don increase

My broda this prepaid swit oh but I been dy hear say e get as them go set am the unit you buy go dy run fast fast like "need for speed" till e finish.
Me I for like am to dy our house but the fund to get am too much, installation self get em own money, why everything about NEPA] dy too cost money self? I tire oh.

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: Stable090 on April 30, 2023, 08:22:37 PM
The problem  is that since it starts raining  only people  with prepaid are at advantage, since the unit will not burn but if it bill issued then you are at serious  disadvantage since the light consumed is not measured but issued out of guess, i hope hope the light situation  gets completely  better and we currently  hope for a better Nigeria, if not the light situation  as gotten worst  and it keeps getting  worst with large amount  of bills issued  to consumers.

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: Nwada001 on May 01, 2023, 06:52:37 AM
Prepaid something make sense for areas where u no say onah no too they get light and u they leave 4 compound way no too dy corporate, u get ur own huz. If nah for yard like were I they stay, nah we they enjoy the light pass, we they get light just as people way they across they get way dy use prepaid. Almost all of us get fridge, electric stove, iron and other things way they consume power well well. So we we they the close no gree make them put prepaid for our street. Every month end dem go carry bill like 15-20 give each of the compound. We no they reason am becauz we no watin we they consume, if we split our self eh no they cost us pass the least 1k-1.5 4 each head something way I know fully well say 2k self no for serve me for prepaid.

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: Sexylizzy2813 on May 05, 2023, 04:47:23 AM

My broda the prepaid go well sometimes but the main thing be say when to use those big big appliances like iron and fridge them you go start to reason how fast e go consume your unit, and if not that one, where e sweet nah where no NEPA man go carry bill wey them no construct well come give you every month like you talk, 15k and above. E no fit happen with PPM at all.
I bin hate prepaid oh but now, our love don dy strong small small, remain to like NEPA wey I no sure if e fit happen.

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: Sidra101 on May 09, 2023, 02:27:04 PM
Very bad I swear.. they're not doing us good at all, they are the real devil of our time... We really needs to pray very well about them.. Because it seems  they are taking over the country now. #Darkness

Title: Re: How NEPA dey treat you for your area? Good or bad?
Post by: Sexylizzy2813 on May 11, 2023, 11:01:21 PM
I no know about some of una oh but I just wan ask, how una dy manage for this lack of light when it comes to using this forum? Because I see this place as office for many of our oga them, this thing just enter my head. Imagine say you no get Gen how you wan take operate your phone to do your normal post count to dy active for this forum?
As I enter dy wear this logo a.k.a Avatar I just noticed say na now I go see shege if NEPA continue like this oh... Wahala no fit finish but something need to be done I swear.