Bitcoin Forum

Local => Nigeria (Naija) => Topic started by: Obari on February 26, 2023, 04:45:55 PM

Title: Abeg all this political Mata for different threads don do.
Post by: Obari on February 26, 2023, 04:45:55 PM
I just dey check local board since morning and I no go lie say I never tire because me I don tire for how everybody really just one just this election matter scatter the board with political Mata and rather than doing this spamming why we no just create on thread for political matter for presidency and when the time for state elections reach, we also create thread for each state, by so doing, the spam rate go reduce badly.

Na just my opinion, wetin una think.

Title: Re: Abeg all this political Mata for different threads don do.
Post by: Charles-Tim on February 26, 2023, 05:15:38 PM
The threads should be considered as spam in my opinion, election discussions should have been on a single thread. Even bringing new topic should have been on a thread.

Example is this long discussion:
El Salvador has become the first country to make #Bitcoin legal tender!  (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5342087.0)

That single thread is full of many topics and replies to each topic which is about El Salvador making bitcoin a legal tender and not going beyond it than necessary.

Title: Re: Abeg all this political Mata for different threads don do.
Post by: Nwada001 on February 26, 2023, 05:51:47 PM
Have also taught about this. Since we don't have a moderator yet here we should help the board by keeping it clean our self..
Sometimes I find it difficult to drop a post/comment because I don't really know where to add it and where not to.

Title: Re: Abeg all this political Mata for different threads don do.
Post by: Cantsay on February 26, 2023, 08:14:03 PM
Just see clear example of wetin we dey talk about.

https://i.ibb.co/nznyDyq/Screenshot-20230226-211102.jpg (https://imgbb.com/)

Tell me now wetin be the difference between both threads? Sometimes I dey wonder if dem nah by force to create new thread. If you nor get any new good thread idea why nor join the existing ones?

Title: Re: Abeg all this political Mata for different threads don do.
Post by: BIT-BENDER on February 26, 2023, 09:01:55 PM
It’s a pity that after we struggled so hard to get our own board we would threat it this way by spamming all around the place. I still no understand why everyone think it’s necessary to start post about the election.

I just they go through the board now and I Dey see high numbers of post relating to the Nigerian general election, it’s best that we limit it to one or two and any thing way you one contribute you fit contribute am for there.

Title: Re: Abeg all this political Mata for different threads don do.
Post by: Coyster on February 26, 2023, 09:49:14 PM
My brother i tire pass you, i don't just understand how everybody wan post new thread about the election, if you wan discuss election matter, just do so in the original thread wey another person don create for that purpose, no need to start your own thread na. Wetin e mean be say many people no they read, them go just come start new topic, comot, come again start new topic, comot again; abeg e no make sense, the spam wey they this board don they too much.

Having said that, make una remember say admin been give us this local board after a very long time of asking, and if you check well the baba no they too approve local board requests, so we suppose set good example na. Activities no be by too much threads wey plenty of them na spam, wetin we they find na quality and constructive activities. E come be like say we just they scramble to fill up the board with posts, abeg make una stop.

Title: Re: Abeg all this political Mata for different threads don do.
Post by: sokani on February 27, 2023, 11:59:49 AM
E just dey too much and na duplicate of wetin another person don post before and we too we no dey try because we dey comment on this these threads because we want make our post count for the monthly highest post for we local board. If we dey report this posts or call the attention of the posters to it, e go help to reduce spam and bring sanity for our local board.

Title: Re: Abeg all this political Mata for different threads don do.
Post by: Davidvictorson on February 27, 2023, 12:01:10 PM
On the one hand, I understand wella why this talk plenty, first be say na the most important election wey Naija go don hold and secondly, the youths don wake up politically now and dem put body for the matter. So e make sense say every Tom, Dick, and Harry go get their own opinion.

On the other hand, I agree very much with Obari. Me sef don tire wella. All these threads and topics na something wey person fit still read for Twitter, Instagram, Facebook, LinkedIn, TikTok and the rest of them. I wish say we get our own local moderator wey go fit dey delete, lock some duplicate or irrelevant posts. Anyways like my grandma go always talk, dem nor dey use rush dey lick soup wey hot. We go get am right soon enough. 

Title: Re: Abeg all this political Mata for different threads don do.
Post by: Obari on February 27, 2023, 01:48:31 PM

Aswear boss them no dey use rush lock soup wey hot na why we just gats take things easy and also call on everyone to not spam the board as this very one fit make @theymos change mind come dey vex for us.
The forum no give any fuck about our election and no be forum we go dey do voting so I no really see any need for the unnecessary threads.

E just dey too much and na duplicate of wetin another person don post before and we too we no dey try because we dey comment on this these threads because we want make our post count for the monthly highest post for we local board. If we dey report this posts or call the attention of the posters to it, e go help to reduce spam and bring sanity for our local board.

Na the duplicate topics own dey pain me pass
Like dem no dey read to check for topics before posting ?
That's not right and make we no rush dey report as we all dey here dey hustle and make we no call attention come our board abeg.

wetin we they find na quality and constructive activities. E come be like say we just they scramble to fill up the board with posts, abeg make una stop.

Na always quality over quantity and na one value we suppose to dey instill In the minds of people and newbies and we all suppose to dey preach the gospel of quality.

I just they go through the board now and I Dey see high numbers of post relating to the Nigerian general election, it’s best that we limit it to one or two and any thing way you one contribute you fit contribute am for there.

Legit as you talk am boss and just as one person don first talk say dem no dey use rush lock soup wey hot, so I Believe say gradually we go build the board rightly.
And most of this threads and from newbies and I hope them dey see all this cautions.

Have also taught about this. Since we don't have a moderator yet here we should help the board by keeping it clean our self..
Sometimes I find it difficult to drop a post/comment because I don't really know where to add it and where not to.
Always feel free to do your things in the forum.
The only major rule the forum frowns so much at is plagiarism and we dey try build local board no mean say we all must create thread na, me personally barely dey create threads here but I know say I suppose dey very active for the local board.

The threads should be considered as spam in my opinion, election discussions should have been on a single thread. Even bringing new topic should have been on a thread.

Example is this long discussion:
El Salvador has become the first country to make #Bitcoin legal tender!  (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5342087.0)

That single thread is full of many topics and replies to each topic which is about El Salvador making bitcoin a legal tender and not going beyond it than necessary.
You said it all sir and I'm sure we'll get to that very level with time.

Title: Re: Abeg all this political Mata for different threads don do.
Post by: Marykeller on February 27, 2023, 04:35:57 PM
If to sae creating different topic of Nigeria election go count I for like am but as em d like this nothing the count for Naija. Even if you like scream from now till tomorrow, this our bad politicians and corrupt INEC no send.

Seriously, we suppose to the give orientation to d people wey we d introduce for this forum. The way wey Nigeria mata d take the spread for this forum d tire me. You go see how peso go carry existing discussion or mata wey the happen for our country d post am anyhow for the forum like sae our mata plenty pass others. I know sae wetin we d pass as Nigeria citizen plenty but at least make we minimize our grievances for the forum. We get social media platforms to do that.

In all of this wey d happen for this country we pray for a better Nigerian at the end of the presidential election. Na wetin I look up to

Title: Re: Abeg all this political Mata for different threads don do.
Post by: Frankolala on February 28, 2023, 07:03:54 PM
Anyway sha make we just tolerant the election thread dem because na very critical condition Nigeria dey now and so many people won talk about the election. But the area of spamming na e no come make sense because na same old talk we go dey repeat.

After we hear the final result, I believe say all those election threads to stop or e go reduce so that make we see front to discuss other matters. Nigeria self to like to dey copy,copy as e dey our blood. After now,e for make sense make everything politics dey under one thread and everything economy also dey one thread to make am look legit. If you won come up with new topic wey dey similar to the one wey already dey for board, abeg just comment under.

Title: Re: Abeg all this political Mata for different threads don do.
Post by: CryptSafe on February 28, 2023, 07:35:27 PM
Comrade you this thing you talk like this don dey me to talk since. As you see this our kocak board, them don spam the board too much with election and naira swap matter too much so tey me myself I don tire.  How person go see topic wey dey closely related to wetin him want to post instead of commenting on the thread the person go open or create another thread for topic wey din already dey in discussion. The mata sef don tire person. If e go dey possible wey Dem go assign moderator to our local board immediately so that our board go dey well coordinated this spamming don too much. Make we to dey coordinate ourselves for here to dey atleast look into topics to know say this topic match with wetin we want to post then make our post for that thread instead of to dey open another thread for similar topics.

Title: Re: Abeg all this political Mata for different threads don do.
Post by: Rruchi man on March 01, 2023, 06:57:21 AM
Apart from all the yeye topics wey concern elections wey some kind people dey start, e still get some other kind discussions wey some newbies dey start wey nor just go well kpatakpata, and e dey baffle me. All the yeye topics cun dey cover topics wey dey engaging wey person suppose dey shook mouth. All the senior men for here abeg, for any person wey you dey introduce to forum, try dey make dem know say nor be social media platform wey dem go just taklk anyhow for entertainment, na serious thing we dey do for here, make dem dey try bring up reasonable discussions and topics make e nor be like say na yeye talk we dey always talk for this side, if dem nor get topic, make dem first dey observe, na so fowl dey do when e land for new place, you go first stand with one leg before you go stand with two legs.

Title: Re: Abeg all this political Mata for different threads don do.
Post by: Obari on March 01, 2023, 10:47:12 AM

Chief na true you talk and some of this niggas really need to take some chill pills and know say life for here no be by speed, even me most times my chairman dey vex say I dey  bother am too much, no be say I no fit run am but for the sake say I no wan too make mistakes na why I dey follow who know road strictly.

I no go blame people wey dey create topics randomly especially the election related ones because right now everybody dey para so since them no see who to use the pressure follow, make dem just bring am come forum but I hope say after this elections we go resume clean up.

Title: Re: Abeg all this political Mata for different threads don do.
Post by: CryptSafe on March 01, 2023, 12:48:53 PM

Comrade no be small thing o. Make the election do come and go abeg make we breath fresh air. The mata just tire me sef. Since e be say na here Dem fit dey pour out their mind and anger no wahala we go try help calm Dem down till election finish make we see as things go dey after the election. Another thing now na to see if thymos go assign moderator to our board and make e for be a high rank member from here wey know the in and out of our matter so that no matter go dey ground for our board here. Not only that, e for good make them give or create for us child board so that we go get other sub boards wey go carry other topics like politics wey go carry this election palava wey full for everywhere for our local board. Atleast, our board go dey a bit coordinated if the child board dey for us here e go make sense.

Title: Re: Abeg all this political Mata for different threads don do.
Post by: Coyster on March 01, 2023, 02:12:33 PM
Na always quality over quantity and na one value we suppose to dey instill In the minds of people and newbies and we all suppose to dey preach the gospel of quality..
Na wetin many Nigerian users no know, the main thing no be to fill up the board with new posts or to they start new threads, everything suppose happen in an organic way, no need to rush anything, i go they happy even if we still they for the first page of this board, but with only quality threads and posts, and not all these duplicate posts wey i just they see everywhere for this board.

Having said that, my Nigerian brothers make we calm down, we fit lowkey they chase quality users comot from this board, if you just look at the first page of this board you go see plenty threads wey no suppose they here because they are duplicate threads and spam. We don complain tire, but at this point ehn, e be like say the only solution here na for us to get our own Nigerian moderator wey go be Nigerian user.

Title: Re: Abeg all this political Mata for different threads don do.
Post by: Obari on March 01, 2023, 04:30:04 PM

Nothing go sweet pass us getting our own moderator especially now because if we no get am, plenty things fit go wrong and with the presence of a moderator, I'm sure plenty other things go fall back in place.

Chief no vex oo, I dey see your name once once and I don fear to follow you yarn since I no dey certain but I dey happy as people don come out and I believe say we go make things right again together.

Title: Re: Abeg all this political Mata for different threads don do.
Post by: Dr.Bitcoin_Strange on March 01, 2023, 09:28:08 PM
Members who are starting this thread are junior members, members, or newbies, and they may think that posting rules and guidelines are only followed in other serious boards like Bitcoin discussion, reputation, or meta, but posting in this board should have some rules to be followed by members too.

I don't usually create a thread without searching to confirm if there is already an existing thread like that, and the problem here is that some of these newbies may not really know that creating the same thread is just spamming. I propose that there be a pin thread on this board that states, "Members read before posting here," and in that thread, the rule to refrain from posting on this board should be stated. The rule may not work 100% of the time because some people are constantly breaking rules, but I believe some will try to read before posting, which may help. Just my opinion, though.

Title: Re: Abeg all this political Mata for different threads don do.
Post by: Mate2237 on March 01, 2023, 09:58:16 PM
I created this thread https://bitcointalk.org/index.php?topic=5431489.0 4 us to discuss Nigerian Government and Politics but our Boss said it would not work in that way because the board needs to be expanded to pages.
No be every discussions fit inside one topic even though dem get the same name or similar name. Two topics fit dey related but with different write up from the OP point of view. We are just two page into this board and about one month of board creation. If we no get anything to show of the activeness of the board e go make theymos disregard any requests for a new board for other locality and might even regret granting this one.

I understand say the issue of duplicate topic go become an issue since everybody go wan create threads and things happening over here are the same so they'll be similar but later understand say e go hinder the growth of the board if we put everything into threads and some people no sabi create a reasonable thread self. If you see duplicate topic wey look like 70% alike DM the OP to lock the thread and write in the other topics or report the topics to moderator and when doing so highlight the original topic wey e dey duplicate so that way dem review, them go get better judgement. I dun report like 5 topics and they have been removed from this board, even though they ignore others no mind, still report when you see new defaulter posts.
so na di expansion we dey so, Me I don see di future of di board before I created that thread to cube di scenario. Nd I was ready work fused political  discussions to di thread but since boss has said it, I have to lock di thread for everyone to air their views on different threads. And d result is getting better every day, at least we have entered page 5 now. So OP, what you are saying is Atiku and Obi, Tinubu has already won the election, so follow di Government to develop di board and allow di kwantri (board) to expand. If u can't beat dem u join dem. Igebotz, Charles-Tim and Agbe e don tok tire but no avail so dem don leave. Dis board spamming 4 no dey like dis if caution was given from beginning.

Title: Re: Abeg all this political Mata for different threads don do.
Post by: CryptopreneurBrainboss on March 02, 2023, 04:41:07 AM
I created this thread https://bitcointalk.org/index.php?topic=5431489.0 4 us to discuss Nigerian Government and Politics but our Boss said it would not work in that way because the board needs to be expanded to pages.

If all those low quality posts been started where on that thread, it would had still been a spam thread because they're all spam and if the thread was reported to be locked for spamming, it'll be locked or discourage users from engaging on the thread. The topic causing a nuisance is election matter and not politics entirely because there are so many quality politics related threads that have been started by different high ranked members dat doesn't fit to be in one thread.

Before your thread I raised the attention since with this; Should Sub-Threads be created or we should freestyle the whole thing? (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5430883.msg61477787#msg61477787) Election matters could have been easily handled by putting everything in one thread but not politics entirely. Politics is a broader discussion and that's why it has its own board on the forum. In future we'll get a politic sub board. The issue here is low quality posts and repeated topics which I'm surprised same members complaining are still responding to those topics.

If a repeated topic is created and we join hands to report it, it'll be locked or send the OP DM to locked since they're similar. Putting all election matters into one thread is OK but putting all politic matters into one thread isn't, it'll obstruct the flow of conversation and many of you won't even visit that thread just as we were complaining with the hangout thread..

Title: Re: Abeg all this political Mata for different threads don do.
Post by: Charles-Tim on March 02, 2023, 04:42:23 AM

I can not agree more, you are correct, but just that politics needs its own board. I wanted to start a topic about it before, but I was very busy and also that the main board is just like politics board which may raise the concern that we also still need more main board topics which are not politics before it can be done. But the need of a board for politics is imminent.

Title: Re: Abeg all this political Mata for different threads don do.
Post by: CryptopreneurBrainboss on March 02, 2023, 06:00:53 AM
board. I wanted to start a topic about it before, but I was very busy and also that the main board is just like politics board which may raise the concern that we also still need more main board topics which are not politics before it can be done. But the need of a board for politics is imminent.

We will request for that maybe in the second quarter of the year but my issue with everyone complaining is what are they doing to improve the board, they aren't participating in discussion outside politics and other topics aren't getting enough attention yet they want to put the whole politics discussions in one thread? That's not smart. How many topic has any of them engage in outside politics discussions. Okay if you don't see any topics why don't you create one.

I haven't seen any reasonable topics on Bitcoin or even altcoins coming from this people and when you create one they don't engage but yet they complain. People spam and you can't eliminate that even the general board is having same issue but what are you doing to combat it, have you reported the posts or send them DM? Before we get a permanent solution in future, we should all engage ourselves on the board, report whatever topic or post you feel doesn't deserve to be on the board and create more topics outside politics discussion so we get a politics board with that evidence.
https://i.imgur.com/MkvMIIv.jpg

Title: Re: Abeg all this political Mata for different threads don do.
Post by: CryptSafe on March 02, 2023, 11:44:30 AM
I created this thread https://bitcointalk.org/index.php?topic=5431489.0 4 us to discuss Nigerian Government and Politics but our Boss said it would not work in that way because the board needs to be expanded to pages.

If all those low quality posts been started where on that thread, it would had still been a spam thread because they're all spam and if the thread was reported to be locked for spamming, it'll be locked or discourage users from engaging on the thread. The topic causing a nuisance is election matter and not politics entirely because there are so many quality politics related threads that have been started by different high ranked members dat doesn't fit to be in one thread.
Before your thread I raised the attention since with this; Should Sub-Threads be created or we should freestyle the whole thing? (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5430883.msg61477787#msg61477787) Election matters could have been easily handled by putting everything in one thread but not politics entirely. Politics is a broader discussion and that's why it has its own board on the forum. In future we'll get a politic sub board. The issue here is low quality posts and repeated topics which I'm surprised same members complaining are still responding to those topics.
If a repeated topic is created and we join hands to report it, it'll be locked or send the OP DM to locked since they're similar. Putting all election matters into one thread is OK but putting all politic matters into one thread isn't, it'll obstruct the flow of conversation and many of you won't even visit that thread just as we were complaining with the hangout thread..

I think there is something we are not getting. I have taken my time to read although the topics here and do you know that most of the topics are similar which all of them can be on one thread but I just think that most people here do not want to comment on any other peoples topic rather, they create their thread so that others would comment on theirs there by making room for duplicate topics which is irrelevant at this point and if you notice most posts here on our local board are just scanty with no
or little responses or comments on them.
If we had a pinned and locked thread or topic as the number topic at the first page on our board stating some guidelines and principle governing this board I think most of these things we are discussing over would be minimal and also new bies should be given orientation too because most of them have no clues in how things work here so they operate without being updated

Title: Re: Abeg all this political Mata for different threads don do.
Post by: Mate2237 on March 02, 2023, 02:51:28 PM
Anyway sha make we just tolerant the election thread dem because na very critical condition Nigeria dey now and so many people won talk about the election. But the area of spamming na e no come make sense because na same old talk we go dey repeat.

After we hear the final result, I believe say all those election threads to stop or e go reduce so that make we see front to discuss other matters. Nigeria self to like to dey copy,copy as e dey our blood. After now,e for make sense make everything politics dey under one thread and everything economy also dey one thread to make am look legit. If you won come up with new topic wey dey similar to the one wey already dey for board, abeg just comment under.
You are one of them that encouraging shit post in the board. Even di following users, Merit.s, Obari, there some post you see in board that u just pass by. If no comment on di post di op will not create such threads, but whereby uses make comments on such post it encourages di user (OP) to do am again. Oya look at dis thread,
https://bitcointalk.org/index.php?topic=5440221.0 all those newbies, Jr members, members and full members are cause of all dis nonsense.to clear the board. We have to report some accounts to be ban so others will learn from it.

Title: Re: Abeg all this political Mata for different threads don do.
Post by: Fivestar4everMVP on March 02, 2023, 09:54:31 PM
Na some more sensitization we need for this board, else people go just the create new thread anyhow, but anyways, politics, and most particular, the elections in Nigeria, is the current thing on board, it's what everybody everywhere is discussing, as a patriotic Nigerian, you can not deny or say you are not affected, we all are affected in one way or the other, so this I believe is one of the reasons why alot of persons, instead of commenting on other thread, would rather opt to creating a new thread so that he or she can be heard and maybe receive comments too - do not blame them.

I believe it will all pass as soon as the elections come and go.

Title: Re: Abeg all this political Mata for different threads don do.
Post by: SatoPrincess on March 02, 2023, 10:19:56 PM
I created this thread https://bitcointalk.org/index.php?topic=5431489.0 4 us to discuss Nigerian Government and Politics but our Boss said it would not work in that way because the board needs to be expanded to pages.

If all those low quality posts been started where on that thread, it would had still been a spam thread because they're all spam and if the thread was reported to be locked for spamming, it'll be locked or discourage users from engaging on the thread. The topic causing a nuisance is election matter and not politics entirely because there are so many quality politics related threads that have been started by different high ranked members dat doesn't fit to be in one thread.

Before your thread I raised the attention since with this; Should Sub-Threads be created or we should freestyle the whole thing? (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5430883.msg61477787#msg61477787) Election matters could have been easily handled by putting everything in one thread but not politics entirely. Politics is a broader discussion and that's why it has its own board on the forum. In future we'll get a politic sub board. The issue here is low quality posts and repeated topics which I'm surprised same members complaining are still responding to those topics.

If a repeated topic is created and we join hands to report it, it'll be locked or send the OP DM to locked since they're similar. Putting all election matters into one thread is OK but putting all politic matters into one thread isn't, it'll obstruct the flow of conversation and many of you won't even visit that thread just as we were complaining with the hangout thread..
+1
Since we don’t have an active moderator, I think the best approach to handling these kind of topics is by not reacting or commenting on these threads. I get discouraged to contribute here because of this problem. It seems any news that is on my browser is a topic on our board. It’s somehow that we complain about the low quality and still comment on the threads to meet up quota. I believe if we ignore the threads the OPs will buckle up and realize they are doing something wrong.

Title: Re: Abeg all this political Mata for different threads don do.
Post by: Agbe on March 03, 2023, 06:22:13 AM

SatoPrincess have you said all. The problem we are having is commenters. Really because of the weekly quota users comments on shit post, even the OP is included. Even yesterday when this thread was created others were creating more and another's were busy commenting on them. I have said this mani times just waiting for Brainboss activation, I will turn 2 lovesmayfamilis here

Title: Re: Abeg all this political Mata for different threads don do.
Post by: CryptopreneurBrainboss on March 03, 2023, 09:19:24 AM
SatoPrincess have you said all. The problem we are having is commenters. Really because of the weekly quota users comments on shit post, even the OP is included. Even yesterday when this thread was created others were creating more and another's were busy commenting on them. I have said this mani times just waiting for Brainboss activation, I will turn 2 lovesmayfamilis here

No be lie, like many posts have reported to be deleted or locked but got a free pass because comments dun much for the topic and when you read the comments dem na rubbish everybody dey talk. Na another stress to come dey report each comment one by one especially as the moderators no dey understand our language. Well if you noticed many of the election posts has been locked and never to be commented on again well that's because they were reported. Make everybody understand say reporting of post is still taken into actions so make we continue dey report the nonsense posts as we dey see them.

As for my activation I no understand wetin you mean, make I dey tagged them? I dey against misuse of the trust system because if you do such then dey wait for ur own karma one day. We can train dis guys to be better as most of them discover here on their own instead been introduced by already existing members, d difference is always clears as dey no get mentors but some wey get mentors dey misbehave shall but nevertheless we go achieve our aim for the board soonest.

Title: Re: Abeg all this political Mata for different threads don do.
Post by: Obari on March 03, 2023, 11:37:36 AM

@brainboss if for nothing I dey like the fact say you dey very understanding and na wetin we actually need now, no be to fight or beat anyone as we all there here to hustle and beside there is no harm in writing a newbie account wey dey too post trash rather than reporting and bringing serious attention to the new board.

@Agbe abeg your last comment on this my thread been dey talk about OP wey be me or maybe I no read and get the right understanding of wetin you dey talk but if na me you dey talk about, then abeg I go plead make you try pint out topics or threads wey I don create wey no sharp make I simply just lock am or move am to off topic because to the best of my knowledge, I dey sure say I dey do my best to the growth of the forum and the board and I always dey open to criticism and correction.

Title: Re: Abeg all this political Mata for different threads don do.
Post by: royalfestus on March 03, 2023, 11:48:08 AM
In my opinion, unnecessarily long threads can be reported to the forum moderators, but I do not think it should get that far. I am not a regular visitor to Nigerian threads on the forum, and posting in a thread on a topic of concern is not limited, but these Nigerians ger the way they flood everything and draw attention to themselves. Could you please tell me why they are like that? no be only naija dey this forum now. There is a way to block new accounts that do not appear relevant in the forum, I also think the forum is still requesting funds to open an account, why so many people who are unsure of what to do.

Title: Re: Abeg all this political Mata for different threads don do.
Post by: Obari on March 03, 2023, 12:00:54 PM

@royalfestus I believe say the forum still dey require payment before opening an account and beside one other reason wey make I personally no dey report this threads be say, I know say writing no easy and the quest to meet up with activities and required merit for a certain rank dey push people into mass creating of irrelevant threads and to me I go say rather than report the to moderator, why not write them a PM and tell them what to do rather than drawing attention to ourselves.

Title: Re: Abeg all this political Mata for different threads don do.
Post by: Agbe on March 03, 2023, 04:48:30 PM
@Agbe abeg your last comment on this my thread been dey talk about OP wey be me or maybe I no read and get the right understanding of wetin you dey talk but if na me you dey talk about, then abeg I go plead make you try pint out topics or threads wey I don create wey no sharp make I simply just lock am or move am to off topic because to the best of my knowledge, I dey sure say I dey do my best to the growth of the forum and the board and I always dey open to criticism and correction.

I said so because you are promoting those spamming poster by commenting on them. I have seen u on those poster. U post gud but at dat aspect is not gud.

In my opinion, unnecessarily long threads can be reported to the forum moderators, but I do not think it should get that far. I am not a regular visitor to Nigerian threads on the forum, and posting in a thread on a topic of concern is not limited, but these Nigerians ger the way they flood everything and draw attention to themselves. Could you please tell me why they are like that? no be only naija dey this forum now. There is a way to block new accounts that do not appear relevant in the forum, I also think the forum is still requesting funds to open an account, why so many people who are unsure of what to do.

@royalfestus I believe say the forum still dey require payment before opening an account and beside one other reason wey make I personally no dey report this threads be say, I know say writing no easy and the quest to meet up with activities and required merit for a certain rank dey push people into mass creating of irrelevant threads and to me I go say rather than report the to moderator, why not write them a PM and tell them what to do rather than drawing attention to ourselves.
Reporting those trash is the best way now because we have been saying time without number. I was a member Igebotz was telling me nd warning and I quickly understand and adopt to di system. Igebotz will tell di worst part of me in the forum bcos he knows me well. And I take am as a correction. Just one example is nice for others. As we dey tok dis one like dis users are busy dropping di nonsense...

Title: Re: Abeg all this political Mata for different threads don do.
Post by: Belarge on March 03, 2023, 05:37:36 PM
Na true you dey talk bro, but on a long run some new members like us no dey notice this spamming based on say so many topics don come up already and no be everybody dey get the patience to dey check topics before Dem post new ones, so my suggestion be say if you see members wey dey spam topics, you just need to hint Dem and let dem know, I sure it will help if you hint Dem...

Na so me I think oo

Title: Re: Abeg all this political Mata for different threads don do.
Post by: Obari on March 03, 2023, 06:49:49 PM
~snip~

My chief you don talk highest and I thank you so much say you pont out this issues give me and sincerely speaking, I personally no been see reasons to report those threads because I no been wan call attention to ourselves as this my local mentality dey make me feel like say if I dey report those threads, thymos fit vex come dey regret giving us a board and e go Mae life hard for other local threads wey go dey seek for board, so forgive me for that ignorance.
I actually been dey bored with all those threads but I been dey feel like say rather than leaving the topics unengaged make I engage am and truly na my bad 😞 abeg forgive me everybody wey dis my act provoke.

We all dey try in our little way but abeg make una try cut hand comot for this spamming matter and only chuke mouth for Mata wey you get talk rather than trying to chuke mouth everything wey person talk.

~Obari~