Bitcoin Forum

Local => Nigeria (Naija) => Topic started by: Chilwell on March 07, 2023, 05:44:05 PM



Title: AMONG THE PRESIDENTIAL CANDIDATES WHO DO YOU THINK LOVE NIGERIA?
Post by: Chilwell on March 07, 2023, 05:44:05 PM
To answer this question dey hard becus it depends on the way anyone fit put am.

Now wen dey don finish the election and dey don talk the results den we go know who among dem love 9ja.
On the way I dey think my own no be person wen win fit talk say na him love 9ja past, he fit be said him wen win no even love 9ja, him just get lucky to win. On my on side the person wea love 9ja past na the person wea no win and accept defeat and no cause any problems and dey redy to work together with the win for the peace and progress of our country na the person ba dat.

Watin be ona opinion regarding this questions please.


Title: Re: AMONG THE PRESIDENTIAL CANDIDATES WHO DO YOU THINK LOVE NIGERIA?
Post by: Silver005 on March 09, 2023, 07:47:58 PM
For my own understanding be say na the person wey mases vote and whether he wins or he no win na him love Nigeria because the mases come out in full and vote him because they know wetin e go fit do for our country Nigeria,
No be the one who hijacked the wining of the other person and everybody no say no him win, that one no like Nigeria oooh because e don thief the election results and na so e go thief everything wey Nigeria get ooh fear him ooh 😲😮😲😮😲.


Title: Re: AMONG THE PRESIDENTIAL CANDIDATES WHO DO YOU THINK LOVE NIGERIA?
Post by: Odohu on March 13, 2023, 02:24:49 AM
One way to measure love is showing empathy to the people of Nigeria. You cannot claim to love a people yet you are divisive and insensitive to our unity in diversity.  So far we have listened to the candidates and have seen their actions and inactions. Therefore, I believe we all know who love the country and the citizens more and genuinely want to help salvage the deplorable situation of the country.