Bitcoin Forum

Local => Nigeria (Naija) => Topic started by: JamesBorn on April 14, 2023, 03:36:10 AM



Title: How market today o?
Post by: JamesBorn on April 14, 2023, 03:36:10 AM
How e dey be my people, I know say things never too balance since all this catacata and wahala of wi government. Nah me warri pikin I no send the government self. Government weh no fit arrange better life for his person, na so so beg everybody dey style dey beg in the street of naija, market no sell, food self no come gallant make man pikin no fall for road, they think say nah epilepsy dey hold am, na hunger, oreh.

How things be for your side nah, wetin you don kpaff this year? Wetin you achieved since weh our yeye goment take destroyed people plans since this year start. Area? I wan hear your yan


Title: Re: How market today o?
Post by: Charles-Tim on April 14, 2023, 07:02:08 AM
Nigeria has poor economy, even Africa a whole continent. There are still rich man in Nigeria. Although, unemployment is increasing, but if you see opportunity, try your best to grab it than blaming the government.


Title: Re: How market today o?
Post by: Marykeller on April 14, 2023, 05:03:01 PM
I no go talk sae this year d good nor bad, but despite everything wey  peso the see and experience for this our country, peso need to thank God sae em d alive to see another beautiful day. As things never bam yet for our side, no mean sae em no go bam tomorrow. Na why peso d pray everyday make Oluwa run things for am than hoping on our government.

Hope still d sha, our dreams and aspiration for life wey go still get am as long as sae you believe in yourself and you are not ready to give up on life because you think sae the system bad and no need for you to give life a big shot


Title: Re: How market today o?
Post by: Merit.s on April 14, 2023, 06:23:15 PM
I just want make we no put hope on Nigeria government,since na disappointment na e dem carry baf themselves. E better say we rely and depend in God to see us through this country plenty problems,so that we go fit achieve our destiny. This country na place wey fit crush your destiny to pieces with their bad government. Just dey do anything wey you know say you fit do to survive and use style dey find a better way to upgrade to the next level,if you see the opportunity. Put your trust not on man but on baba God,since na only him sure pass. Our government na one chance bus na e them be.


Title: Re: How market today o?
Post by: Gozie51 on April 16, 2023, 04:30:00 PM
No be today wey Nigerian government don fail her citizens. I believe say since wey all of us see ourselves for naija say dem born us, na so we don see say the government no send so we no go dey still put our hope on dem. The past presidential election confirm everything say the people wey be say na dem dey control dis county dey use dem hand put someone there to continue impoverishing masses. Which way we dey go like this? I no want talk too much.


Title: Re: How market today o?
Post by: Belarge on April 17, 2023, 10:59:23 PM
Government no dey offer us anything, we just dey dey live like people wey Dem adopt, we dey suffer for this country, nothing dey work this time, but na only God we dey hope for shall, because if na government eh, nothing go ever come out, this government just Care about themselves and them family, dem no care about us at all, na only when e reach election Dem dey need us,
E really hard for us wey be Nigerians this time oo, market really dry like stock fish, but anyhow e be shall we go survive, na God be our only hope now...