Bitcoin Forum

Local => Nigeria (Naija) => Topic started by: Odohu on July 02, 2023, 07:03:16 AM

Title: Bicycle fit be the game changer
Post by: Odohu on July 02, 2023, 07:03:16 AM
Hello my fellow country people. As e be like this for Naija, people don dey think go the direction of bicycle o. If you reason am well, bicycle make sense wella. Na better excise and untop of that, e no dey use fuel and na small money you go use dey maintain am. Those of us wey grow up for village where bicycle dey like benz go fit relate.

Just as motor get types and class, bicycle too get levels. But the good thing be say you you go fit buy bicycle as your pocket reach. With as little as 30k you go fit buy bicycle even though fairly used one and this will save you plenty transport.

I know say risk dey for bicycle too especially for busy cities but because of the small speed of bicycle, accidents no dey kill like motor and okada accidents.

My people how una see am?

Title: Re: Bicycle fit be the game changer
Post by: Frankolala on July 02, 2023, 02:29:21 PM
This is very funny, but na true talk you yarn o. The way things done high due to subsidy matter,transport na another one and man must make movement. Some people for my area don pack their cars and dey enter public transport because if you buy fuel for 530 na air filling station go pump for you. If na waka within your area,you go for use bicycle but if na far place bros you no go for use bicycle if not muscle pull go catch you and you go reach very late. Now wey we dey raining season I no think say bicycle na good alternative because if you starch your shirt come dey ontop bicycle rain come meet you for road na e be say yawah don gas.

Title: Re: Bicycle fit be the game changer
Post by: CryptoHeadlineNews on July 02, 2023, 03:21:09 PM
Bicycle riding is aerobic exercise good for the body to stay fit and in shape, and also good for short distance journeys below the range of 0-1km due to the increase in fuel price, because this is not the first time the price of fuel is climbing up to #600 to #1k per litre and yet we still survived and we will keep on surviving despite anything that happens, as we Nigerians are good at adapting and we have already adapted to this removal of fuel subsidy long long time ago. Because there is already an update now about how to connect cooking gas to generator to power electricity, and people have started using it, and what remains now go be who go discover how to use that same cooking gas to power car, and I bet you, we go all just leave fuel for them to increase am anyhow they like now.

Title: Re: Bicycle fit be the game changer
Post by: Gozie51 on July 02, 2023, 04:38:00 PM

With as little as 30k you go fit buy bicycle even though fairly used one and this will save you plenty transport.

You don call am as little as 30k but remember say na our minimum wage for this country be this oo wey be say some states never still dey pay am.

Anyway, wetin I see for this bicycle matter be say na those wey dey village and rural areas this go fit make sense to. Me I no no whether Tinubu want begin pursue people go village like this oo ;D

And again for those wey dey for town, urban locations wey be express, hmmmm me no go advise this bicycle transport thing oo because our road no even good like those wey dey use bicycle for abroad. See you see orthopaedic hospitals because casualties from accident go plenty oo. Make we just dey careful, make God dey bless him people make we still dey follow dey survive inside this unfortunate harsh economy.

Title: Re: Bicycle fit be the game changer
Post by: RockBell on July 02, 2023, 04:47:46 PM
Hello my fellow country people. As e be like this for Naija, people don dey think go the direction of bicycle o. If you reason am well, bicycle make sense wella. Na better excise and untop of that, e no dey use fuel and na small money you go use dey maintain am. Those of us wey grow up for village where bicycle dey like benz go fit relate.

Just as motor get types and class, bicycle too get levels. But the good thing be say you you go fit buy bicycle as your pocket reach. With as little as 30k you go fit buy bicycle even though fairly used one and this will save you plenty transport.

I know say risk dey for bicycle too especially for busy cities but because of the small speed of bicycle, accidents no dey kill like motor and okada accidents.

My people how una see am?

That's the problem I have with Nigerians our dependency on one thing is too much, and that is why we are always affected seriously every time the government implements any policy, if we had other means of public transportation the subsidy would not have bothered anybody, However, it appears that 80% of transportation is now done by road, which is not what should be the case. Building rails would make interstate travel much easier. If you look at developed nations, you'll see that they hardly ever use their cars. Instead, they take the train or bus. Bro cycling is also a good idea. If you have enough money, you could just buy an electric bike, which eliminates the need to worry about purchasing fuel. All you have to do is charge it.

Title: Re: Bicycle fit be the game changer
Post by: Framelover on July 02, 2023, 07:05:29 PM
Hello my fellow country people. As e be like this for Naija, people don dey think go the direction of bicycle o. If you reason am well, bicycle make sense wella. Na better excise and untop of that, e no dey use fuel and na small money you go use dey maintain am. Those of us wey grow up for village where bicycle dey like benz go fit relate.

Just as motor get types and class, bicycle too get levels. But the good thing be say you you go fit buy bicycle as your pocket reach. With as little as 30k you go fit buy bicycle even though fairly used one and this will save you plenty transport.

I know say risk dey for bicycle too especially for busy cities but because of the small speed of bicycle, accidents no dey kill like motor and okada accidents.

My people how una see am?

Haha!! Very hilarious but e sha dey pipu mind..
E be true say with d way tins de go for we kontry transportation cost don bcum a very big issue… but even as e don turn issue, e get tinz wey we no fit go back to cuz dem go de weird nd example na d use of bicycle as primary mode of transportation (na 2023 we de so). Even though e de pipu mind, shame no go gree dem settle for bicycle as means of transportation. Imagine u de work for bank and u  knack ur shirt and tie, climb bicycle de go work🤣
Aside dat sef, d stress wey de involved.. bicycle dese days now de considered as equipment for exercise.. imagine u de carry bicycle go work and u de climb hilly roads, u go sweat finish for body before u reach work especially if d distance from ur house to work far. 
Above all make we just de pray mek tins better for us as individuals, families, communities and d kontry at large.

Title: Re: Bicycle fit be the game changer
Post by: Davidvictorson on July 02, 2023, 07:17:54 PM
My people how una see am?
Chale this your idea nor bad if to say we dey for country wey be say :
- bicycle get him own lane
- proper security dey to ensure say e go hard before person fit thief your bicycle
- distance between your office and your house nor far

*the risk wey dey for bicycle na raised to power 1000.

One of the ways wey bosses for offices fit help people durin this hard times na to reduce the working days and institute hybrid work. So unless say you dey work for factory and for some other places wey be say e dey very essential say you come work everyday, I nor see the reason why we go dey go work every day of the week during this time for work wey we fit still dey house dey do. This one na another solution for office people. Factory workers them fit try to dey join staff bus or encourage their oga dem make dem buy staff bus if dem nor get. I drop my own suggestion.

Title: Re: Bicycle fit be the game changer
Post by: SmartGold01 on July 02, 2023, 07:49:56 PM
Hello my fellow country people. As e be like this for Naija, people don dey think go the direction of bicycle o. If you reason am well, bicycle make sense wella. Na better excise and untop of that, e no dey use fuel and na small money you go use dey maintain am. Those of us wey grow up for village where bicycle dey like benz go fit relate.

Just as motor get types and class, bicycle too get levels. But the good thing be say you you go fit buy bicycle as your pocket reach. With as little as 30k you go fit buy bicycle even though fairly used one and this will save you plenty transport.

I know say risk dey for bicycle too especially for busy cities but because of the small speed of bicycle, accidents no dey kill like motor and okada accidents.

My people how una see am?

Omo me self been dey reason am but as woman how we go do am na, e no good make we wey be woman start to dey ride bicycle although na good exercise be that o but people go start to dey reason you like say na your own bad pass say you no fit afford to enter motor wey be just common 2#50 to #300 only.
We country don spoil like this o and we pray make things better again.

Title: Re: Bicycle fit be the game changer
Post by: Mate2237 on July 02, 2023, 08:47:12 PM
Oboy dis your yarn na only village di thing go work and cities oo. And one thing be say, there is time for everything on di world wey we dey. Bicycle time e done pass. We no fit go back to bicycle time again, how we won comparate with it sef. Di fuel car def go pass, di next vehicle wey scientist go produce na fuelless cars dem. But di car go cost well well. How I won drive from BY to PH? Omo na die. Dat kind thing w no go work out in this generation.

Title: Re: Bicycle fit be the game changer
Post by: Wiwo on July 02, 2023, 10:01:48 PM

I know say risk dey for bicycle too especially for busy cities but because of the small speed of bicycle, accidents no dey kill like motor and okada accidents.

My people how una see am?

No reason mmmm oooooh,  because there is nothing like a small risk because every accident fir take person's life,  so you no fit say because of the low speed of a bicycle, it accident won't kill somebody because what if in a situation where the bicycle rider is run over by a car on a busy road,  take it as if someone results into the use of a bicycle to go to work instead of a car due to high fuel price?

So we have to put a lot of things in check when making some decisions or assumptions about the advantages of a particular thing.

Title: Re: Bicycle fit be the game changer
Post by: Good_Doctor on July 02, 2023, 10:07:28 PM
Hello my fellow country people. As e be like this for Naija, people don dey think go the direction of bicycle o. If you reason am well, bicycle make sense wella. Na better excise and untop of that, e no dey use fuel and na small money you go use dey maintain am. Those of us wey grow up for village where bicycle dey like benz go fit relate.

Just as motor get types and class, bicycle too get levels. But the good thing be say you you go fit buy bicycle as your pocket reach. With as little as 30k you go fit buy bicycle even though fairly used one and this will save you plenty transport.

I know say risk dey for bicycle too especially for busy cities but because of the small speed of bicycle, accidents no dey kill like motor and okada accidents.

My people how una see am?

Omo I nor lie you personally once in a while e good make person still do exercise with bigmanity and na bicycle fit in apart from say fuel price don high now ... bicycle don dey on the high side because many people wan come dey buy this period so if you first get sharp bicycle before Omo ride am like say you come change game ohh ...me I get my own and I do use am steady

But deep down omo bicycle nor be game changer shaa ... Na second option...hahaha

Title: Re: Bicycle fit be the game changer
Post by: Adbitco on July 03, 2023, 10:24:04 AM
My people how una see am?

Hehe the way the country be self now na something wey go make us reduce expenses we dey find now self at least e go help us wella onto say the fuel price now na casala for we country. If na to move within only the city e better pass to dey enter bolts but come to think of this what if rain fall wetin you go do to fast track your movements, knowing say with moto you go dey fast than using bicycle.

Well, make i just say anything wey get advantage also get disadvantages because you can't compare both since we are in the wet season and rain dey fall unannounced and anytime wey im like in dey fall. The only way i think say entering moto go even better pass na to dey go another state or another LGA wey far from your city e go worry pass.
Anyway, na good suggestion be that but e go only affects those wey no sabi ride bicycle. 

Title: Re: Bicycle fit be the game changer
Post by: CryptocurencyKing on July 03, 2023, 11:38:24 AM
Hello my fellow country people. As e be like this for Naija, people don dey think go the direction of bicycle o. If you reason am well, bicycle make sense wella. Na better excise and untop of that, e no dey use fuel and na small money you go use dey maintain am. Those of us wey grow up for village where bicycle dey like benz go fit relate.
If u sabi watin b comfort, u no go evn think bicycle as e dey sweet u 4 mouth like dis.
Yes country don jaguda, e don turn watin pple no understnd or xpect bt, 2 fall bck 2 bicycle 4 dis our time way we dey try meet up western world, way pple dey reason buy Tesla nd machines way dey use renewable energy sources, bicycle no go come in.

D least we fit do na true unionism ask govmnt 2 luk into d mata well. As e b now way petrol price b #511, mak dem try leave am lik dat. Mak dem generate watin dem fit generate nd fix our refineries.
I no dey see myself risk riding bike way go shine u 4 road if u fall nd d kind sweat u go sweat evn 4 short distance. Na bicycle u wan run go work. Dat na 2 baff wen u reach work o.

Title: Re: Bicycle fit be the game changer
Post by: Odohu on July 03, 2023, 08:14:47 PM

My brother no look am only in the angle of poverty. Make you consider the health benefit too. Even for Oyibo country like Netherlands, Bicycle plenty wella and even people wey chop belle full dey use am with pride. E go even shock you  to know say every person inside the Netherlands get at least two bicycle according to this article: https://www.hollandcyclingroutes.com/

Title: Re: Bicycle fit be the game changer
Post by: Gozie51 on July 03, 2023, 10:37:08 PM

My brother no look am only in the angle of poverty. Make you consider the health benefit too. Even for Oyibo country like Netherlands, Bicycle plenty wella and even people wey chop belle full dey use am with pride. E go even shock you  to know say every person inside the Netherlands get at least two bicycle according to this article: https://www.hollandcyclingroutes.com/

We no doubt say oyibo dey use bicycle take do their kind of shuttle movement but those places their government do road well wey dey give everyone ease of movement. If you want use bicycle there you dey sure say no tricycle or motor go hit you on to say every one get their lane but for naija e no be the same thing.. The challenge for this country full truck remain. Even some west African countries self organise pass naija, I no even talk of South and East Africa.

Title: Re: Bicycle fit be the game changer
Post by: Black susano on July 03, 2023, 11:30:57 PM
Hello my fellow country people. As e be like this for Naija, people don dey think go the direction of bicycle o. If you reason am well, bicycle make sense wella. Na better excise and untop of that, e no dey use fuel and na small money you go use dey maintain am. Those of us wey grow up for village where bicycle dey like benz go fit relate.

Just as motor get types and class, bicycle too get levels. But the good thing be say you you go fit buy bicycle as your pocket reach. With as little as 30k you go fit buy bicycle even though fairly used one and this will save you plenty transport.

I know say risk dey for bicycle too especially for busy cities but because of the small speed of bicycle, accidents no dey kill like motor and okada accidents.

My people how una see am?

(OP) this post really get much sense but no still get sence,
Imagine place like ABJ all most all the areas fall for which other so you mean say! person go clamp bicycle like small pinkin come dey ride on top mak I tell u something u dey only talk about this because of poverty wen hold us ohhh
If not were person one go with bicycle. See look am form my own point of view how many speed I wan use speed before I go work and also with this type of bad roads e be like say body ever pain u before, I bet u if u com back form work you most take drugs first before you get ur self back for that day

Title: Re: Bicycle fit be the game changer
Post by: SOKO-DEKE on July 04, 2023, 08:04:22 AM
Op your suggestion no bad ooo, seriously bicycle can really be game charger on this Mata of fuel cost wen we dey so.this cost of fuel really affected  many people because the cost of transportation is now high and the worker payment rate for this our country is very low, image person they collect fifty thousand naira as salary every month and e kon dey use 500 naira per day for transport  before, now when transport done do 2x e will kon they use 1000 naira,how much d person go get remain.now if this person can get a bicycle the expensive go reduce but the main problem be say riding bicycle to work no be easy thing despite say na part of exercise, person go weak when it get to place work,the clothes go also wet because e go sweat.

Title: Re: Bicycle fit be the game changer
Post by: sokani on July 04, 2023, 01:49:33 PM
Op, this one na very funny one. The suggestion no bad at all especially dis kind time wey we find ourselves for we country. But bicycle get im own pros and cons, and de cons outweighs de pros especially wen u dey for big city. You no go fit dress well con use bicycle go work because de distance to your work place fit dey very far and e go take you longer time to reach, also sweat go mess your clothes. Most people wey dey ride bicycles dey expose, no helmet, no elbow and knee guards and if accident happen, de person fit loss him life or sustain serious injuries. Dis suggestions come handy for people wey dey villages and less busy cities.

Title: Re: Bicycle fit be the game changer
Post by: Odohu on July 04, 2023, 02:41:03 PM

My brother no look am only in the angle of poverty. Make you consider the health benefit too. Even for Oyibo country like Netherlands, Bicycle plenty wella and even people wey chop belle full dey use am with pride. E go even shock you  to know say every person inside the Netherlands get at least two bicycle according to this article: https://www.hollandcyclingroutes.com/

We no doubt say oyibo dey use bicycle take do their kind of shuttle movement but those places their government do road well wey dey give everyone ease of movement. If you want use bicycle there you dey sure say no tricycle or motor go hit you on to say every one get their lane but for naija e no be the same thing.. The challenge for this country full truck remain. Even some west African countries self organise pass naija, I no even talk of South and East Africa.

You just dey talk like my elder brother wey be your namesake... him sabi book like winch. Wetin sweet me for this your comment be say you agree say bicycle get good side and oyibo dey use am too. One thing I wan put inside this talk be say, if plenty people don dey use bicycle for naija you go see say awareness go start and na so e go take catch government attention to put am for consideration when constructing roads and other infrastructures.  Naija strong sha but wey go dey ok one day.

Title: Re: Bicycle fit be the game changer
Post by: EluguHcman on July 04, 2023, 04:35:39 PM
Abeg which kind God u dey serve way u dey use a whole 30k buy just fairly used bicycle? How much be new 1?Na still this era? Bcos even back in the days 30k no b small money.  Where me dey direct to na how u dey belittle 30k cuz na most people salary's 😆. Abeg make we no go dey linger talking of economy and government system cuz of this 30k oh.

As for bicycle to dey economical and less risk of accident, na true talk but if u still want dey among the bigger boys/girls bicycle owners for cities e gets to be auto-bicycle way no get Pedal if not dem go dey look u outdated or say  u like suffer and this kind mentality na 9ja e dey cuz I dey aware of where Israel classifies bicycle where e be say even the riches dey cruise with am.

Truly bicycle na better mobility cuz e dey cheaper, less accident occurrence.

Who else ever think of bicycle being the fastest  mobility bcos the speed dey unlimited so the faster you spin and paddle na the more speed e moves no be like Okada's, Motor's, Aeroplane's and others way get limited speed 🤗

Title: Re: Bicycle fit be the game changer
Post by: ololajulo on July 04, 2023, 05:25:37 PM
If you check Jiji now, the average price of new bicycle don pass 200k, so e no be as cheap as people dey think. Secondly, if you consider the type of road wey dey my house, plenty plenty bumps wey dey make am hard to ride bicycle on the same road with motor, I no go advise anybody wey care about im life to try am.

Title: Re: Bicycle fit be the game changer
Post by: CryptopreneurBrainboss on July 04, 2023, 08:08:53 PM
Hello my fellow country people. As e be like this for Naija, people don dey think go the direction of bicycle o. If you reason am well, bicycle make sense wella. Na better excise and untop of that, e no dey use fuel and na small money you go use dey maintain am. Those of us wey grow up for village where bicycle dey like benz go fit relate.

Belike you no know the country wey you dey if bicycle begin dey get demand just watch as price go boost like fuel price. No be dis country wey person before fit dey buy corrola car for like 800k  or 1 million but as boarder close and bot and Uber begin popular na so corrola jump to lik 3.5 million before you fit get direct Belgium wey go dey alright for you to use without any complain dem. If bicycle become they way forward, the average Nigeria still no go fit afford am as people no go wan buy the old version na the latest ones people go wan dey buy and na so dem go use price wan kill us. This country na from pot to fire, e go hard before something good go happen for the economy of this country.

And this one no be we getting the right president solution because e come dey belike those guys no get say self because of the way the country dey. If tinubu know say him no go fit use our subsidy money do better things wey go better this country make him bring back the subsidy oh before people go die finish because e no easy again. I dey hear self say dey wan increase the fuel again go like 700naira per liter. If dat one happen e mean say 1k no far again and e no go easy for everyone because no matter your means of transportation, e go still reach you either when you wan buy fuel for your car or pay transport go work.

Title: Re: Bicycle fit be the game changer
Post by: Marykeller on July 07, 2023, 02:12:04 PM
I don for ones reason how to get bicycle for myself some time ago but each time I remember the kind bad road wey we get and the way drivers d take drive their motor d make me slack back not to buy bicycle for myself. If not that, I for buy bicycle long ago because peso don tire to the spend up to 1k for small movement wey em d take to d go work tro and from each passing day. How much wey dem the pay peso set? To spend wetin no good for transport

Even though e de pipu mind, shame no go gree dem settle for bicycle as means of transportation. Imagine u de work for bank and u  knack ur shirt and tie, climb bicycle de go work🤣.
I don't think that's the case. People are not shame of getting bicycles for themselves. What they are only afraid of is bad road, accident, the distance they will cover to get to their destinations. If no be that you for see people getting beautiful bicycles for themselves due to the high rise in transportation wey dem d spend for transport.

Title: Re: Bicycle fit be the game changer
Post by: blackened515 on July 12, 2023, 08:04:02 PM
If you check Jiji now, the average price of new bicycle don pass 200k, so e no be as cheap as people dey think. Secondly, if you consider the type of road wey dey my house, plenty plenty bumps wey dey make am hard to ride bicycle on the same road with motor, I no go advise anybody wey care about im life to try am.
The use of Bicycle go reduce the rate we de spend on fuel but if you check am well, we need our cars, them fast pass Bicycle, oyan make we use this illustration, what if rain de fall and we get somewhere wey sharp, weytin we go do? Shey na Bicycle we go use or car, ofcourse na car. Make we just pray make the country better. Bicycles goes well for big cities or better flourished estates for the country, like Lekki Estate or Banana Island, these two place too go well for Bicycle movement. Bicycle still sharp for the movement, because fuel de cost wella for the country. We need to provide solutions to our problems ASAP.

Title: Re: Bicycle fit be the game changer
Post by: Asiska02 on July 12, 2023, 09:26:53 PM

Just as motor get types and class, bicycle too get levels. But the good thing be say you you go fit buy bicycle as your pocket reach. With as little as 30k you go fit buy bicycle even though fairly used one and this will save you plenty transport.

Wetin you mean by bicycle get levels? Make wuna no carry competition come everything o, bicycle na bicycle and make wuna regard am as one. Na as dem dey differentiate am, na him the prices go come dey hike dey go.
And no be everybody fit still afford bicycle as their pocket reach o. That amount you put for bicycle ba, person fit dey use am for Transport or fuel and dem no go still feel anything about am. Everything na choice sha.

Quote
I know say risk dey for bicycle too especially for busy cities but because of the small speed of bicycle, accidents no dey kill like motor and okada accidents.

My people how una see am?

Dis na very good advantage of using bicycle amidst dis fuel price hike wey we dey face currently for the country. But to get a more sustainable and risk free road while using bicycle, the government needs to make provision for alternate route for bicycles to only ply on. They can’t be allowed here because of the express roads which pose a lot of danger to them.

Title: Re: Bicycle fit be the game changer
Post by: Belarge on July 15, 2023, 04:40:32 PM
Op no be lie you talk, as e be na people wey keep bicycle inside house now don bring their bicycle outside come polish am dey use because the cost of fuel don become something else.

For my area now bicycle full street like this, atleast the bicycle go help else movements and save costs till when the fuel price go come down. Even me wey dey here sef if I get small money, I dey think of to buy one small bicycle too wey I go dey use till when the fuel price go come down, I can't come and kill myself....

Title: Re: Bicycle fit be the game changer
Post by: omgitsmehehe on July 16, 2023, 02:43:26 AM
Op no be lie you talk, as e be na people wey keep bicycle inside house now don bring their bicycle outside come polish am dey use because the cost of fuel don become something else.

For my area now bicycle full street like this, atleast the bicycle go help else movements and save costs till when the fuel price go come down. Even me wey dey here sef if I get small money, I dey think of to buy one small bicycle too wey I go dey use till when the fuel price go come down, I can't come and kill myself....
Money wey I get na to take care of my family, and pay for expenses, no b for fuel wey de cost anyhow, we gats see food chop before we buy fuel ooh. The price of fuel no gree come down, na so so hardship we de face daily. No b lie OP talk, Bicycle go be the next concentration for Nigeria, because no b everything person go use bike or car, fuel de cost and the best way to saved ourselves na to do weytin go benefits presently. The worst thing be say, bicycles de even cost now, I no just know where this country de go ooh.

Title: Re: Bicycle fit be the game changer
Post by: libert19 on July 16, 2023, 02:59:45 AM
Just as motor get types and class, bicycle too get levels. But the good thing be say you you go fit buy bicycle as your pocket reach. With as little as 30k you go fit buy bicycle even though fairly used one and this will save you plenty transport.

What currency is that? 30k for bicycle? That's plenty. I bought mine for about $80 4 years ago and use it for 8-10 KM commutes. It's a basic single speed cycle — I heard geared bicycles require regular maintenance, and I hate maintaining things so settled with single speed.

Now, electric bicycles are trending, can purchase here for about $700, if one is satisfied with speed which tends to be 25-30 KM/hr, you get comfort of motorcycle (less or no peddling) with advantages of bicycle, i.e, saving environment, fuel costs, less maintenance.

Using bicycle to reach public transport and from there to your destination, saves huge.

Title: Re: Bicycle fit be the game changer
Post by: Gozie51 on July 16, 2023, 05:47:51 PM

For my area now bicycle full street like this, atleast the bicycle go help else movements and save costs till when the fuel price go come down. Even me wey dey here sef if I get small money, I dey think of to buy one small bicycle too wey I go dey use till when the fuel price go come down, I can't come and kill myself....

Who dey talk of say when fuel price go drop abi come down. This one no possible again because I remember even from president Goodluck Jonathan time when him first say him remove fuel subsidy and price rich 145 naira and him readjust back to 96 naira or so and from then Buhari enter carry price go 150 naira and since then, we know how the price don fly reach. My broda no think am oo, I never hear say fuel price go come down. Abi you dey talk of deregulation? Hmmm, deregulation dey only bring price down when things dey in place like refinery etc but government refinery is not working so make you zero your mind out of that .

Title: Re: Bicycle fit be the game changer
Post by: Smartvirus on July 16, 2023, 08:07:35 PM

Na in times like this way we go remember say, we been dey enjoy ior see better few years back. Na the things fall apart that the center can no longer hold way Chinua Achebe talk about we dey see like this. Anyway, the center still dey hold shah but, fuel go drop shah, e don be rumor way dey go round and no be say rumors Dey always come through but, the pump in price was rumored as well and e happen.

As we no get subsidy again and with every Nigerian living based on watin them fit afford or according to there standards, we go try dey understand the need to use watin we fit generate and regulate our things wella.

Bicycle no go change nothing. Most of us dey reason this thing with the idea of man for head. You don try picture watin woman wan look like on top bicycle through the streets dey go do office work? Abeg, make we leave this bicycle thing.

Title: Re: Bicycle fit be the game changer
Post by: Odohu on July 18, 2023, 08:32:40 AM
Abeg which kind God u dey serve way u dey use a whole 30k buy just fairly used bicycle? How much be new 1?Na still this era? Bcos even back in the days 30k no b small money.  Where me dey direct to na how u dey belittle 30k cuz na most people salary's 😆. Abeg make we no go dey linger talking of economy and government system cuz of this 30k oh.

My brother, I been dey think say bicycle no cost until one dey I carry myself by myself waka enter where them dey repair bicycle go price one. E shock me when they tell me say na 15k for the one wey one of the leg no to go  well and untop of that, I go use like 5k take service am. So base on that,I feel say new one fit be 30k. No forget say ajebo bicycle wey cost 500k dey o. My brother levels dey for every every for 9ja joor.

Title: Re: Bicycle fit be the game changer
Post by: letteredhub on July 18, 2023, 10:28:45 PM
Normally for Europe and the Western world na bicycle many people dey use go work and certain movement them. You can hardly differentiate the poor from the rich for that side and Dem no dey even use am as criteria to use judge who get money or who no get, unlike as the thing be for country side way be say if them see you own just bicycle Dem go say you na poor man.

At least make this fuel price and transport hikes try make us to live certain simple lifestyle wey we dey see for other continents Dem. And with bicycle na indirect daily exercise we all go dey do wen we dey paddle the bike as we dey go out with am. Smiles!

Title: Re: Bicycle fit be the game changer
Post by: Youngkhngdiddy on July 19, 2023, 07:24:10 AM
Hello my fellow country people. As e be like this for Naija, people don dey think go the direction of bicycle o. If you reason am well, bicycle make sense wella. Na better excise and untop of that, e no dey use fuel and na small money you go use dey maintain am. Those of us wey grow up for village where bicycle dey like benz go fit relate.

Just as motor get types and class, bicycle too get levels. But the good thing be say you you go fit buy bicycle as your pocket reach. With as little as 30k you go fit buy bicycle even though fairly used one and this will save you plenty transport.

I know say risk dey for bicycle too especially for busy cities but because of the small speed of bicycle, accidents no dey kill like motor and okada accidents.

My people how una see am?

Hahaha, this your idea na partially better one sha, because many people fit use I'm as form of exercise to maintain fitness while eh dey also serve as transportation, but I believe say this idea go favour only those wey no go fit afford cost of transportation, because you no go expect say a business man wey leave for lagos go use bicycle reach Abuja when eh get urgent meeting there, how about those wey dey travel Inter state na bicycle dem go use they run im?
 The thing we fail to understand na be say when the demand for something dey very high the price go increase and If every body comes decide to buy bicycle the price fit increase from that 30k to 200k or more than, but one thing I like citizens of this our country na be say we dey quick adapt in times of hardship and that na why we dey always survive, if you notice some people done dey convert there generators from using fuel to gas wey dey cheaper and  from my research i hear say eh dey last longer, that one go tell you say for this our country people must always look for other alternatives to survive, maybe time done reach wey dem go start to build power stations for electric cars, and begin to consider am as another alternative since fuel no fit sustain us again due to the hike of em price.