Bitcoin Forum

Local => Nigeria (Naija) => Topic started by: Black susano on July 03, 2023, 11:07:02 PM

Title: Come wetin we see about some Nigerian youths wey use smoking do work of they lif
Post by: Black susano on July 03, 2023, 11:07:02 PM
https://i.ibb.co/84kzRHK/IMG-2109.jpg (https://ibb.co/84kzRHK)

Every day by day this hard drugs called weed, loud, and lce
dey drag our youth closer to their grave this same hard drug matter don mak many of our youths go incensed and mad for the street in fact I been watched a shot video clip on how one guy kiss tranforman just because him go dey on cruise mode, I fit boost tell una say most boys no fit dey without moding two or more raps of loud or weed only say because e dey mak them fresh and eat well, But why most boys dey say smoking no dey kill???

Quote
This poses a question. Why does a country that currently ranks as the country with the most people living in extreme poverty (according to the  End poverty organization), turn out to be so dependent on drugs? According to a UNODC report, Nigeria ranks as the top user of opioids in Africa and the third-highest user of opioids in the world. See world rankings here.

Another report by the UNODC shows that over 14 million Nigerians use one form of opioid or another, and have the most level of prevalence in the world as of November 2020. This number is projected to increase rapidly if the situation of drug abuse in Nigeria persists.

https://radrafrica.com/radrwrites/high-times-nigerians-on-using-drugs-and-surviving-nigeria,/
Quote
[quote/]
I been see this post about how Nigerians are one of the most poorest country but them still dey smoke the painful part be said poverty no wan gree go self people dey suffer 
And all the time na poor Nigerian youth dey tak all this hard drugs pass u no go too see this rich men children dey too smoke am like the poor once. my advice to us be say make we tak am easy e go better one day one love .

Title: Re: Come wetin we see about some Nigerian youths wey use smoking do work of they lif
Post by: Forever101 on October 22, 2023, 10:12:08 AM
This matter wey you talk so, na serious matter ooo, only God know wetin go happen before 2040 if nothing is done. The number of mad people for street don dey increase on daily basis, some people wey of reasoning don even get k-leg.
The so called internet fraud don even worsen the issue, Dem dey smoke suckaway , solution wey vulcanizer dey use and many more things like that.
Some they take different thing just to keep awake through the night.
No sleep in the day, no sleep in the night, Dem don dry finish like dried fish and Dem don dey look like roasted yam.

 Even all this herds men dey high theslmeelves, me I sure say na why them con even dey more dangerous and dey threaten lives for any area wey Dem dey.

This thing naw no be only guys both girls don dey high, for all this girl's wey dey join men high, who go gree marry them. Wahala b like motor with 3 leg

Title: Re: Come wetin we see about some Nigerian youths wey use smoking do work of they lif
Post by: iBaba on October 23, 2023, 06:46:55 AM
There are quite a number of things wey we young people need know about life. Smoking of all those things will only destroy your life. E dey scatter your liver small, small. But e dey surprise person how person go take know say something go kill them, but them go still go on to go smoke. Smokers are liable to die young for people wey dey smoke na wetin dem write on top cigarettes but dem go still go dey smoke am.

Now make we try imagine how much of damage those weeds and Marijuana go dey cost person health, because dem dey more dangerous. But e no concern them as person go still go ahead dey go smoke.

This world is just made of fantasy. We know something will kill us as human beings but we still went ahead to go and kill ourselves by using those things. People go still go run something even on how dem know say the thing go kill them but na so Satan dey corrupt this world. I think that's the difference between this world and the hereafter.

Title: Re: Come wetin we see about some Nigerian youths wey use smoking do work of they lif
Post by: rachael9385 on October 23, 2023, 12:38:21 PM
Although, I don't support the habit of regular smoking or addicted to smoking, but I do believe that everyone have their own reasons of smoking because, some people smoke because of it helps them to think straight, calm their minds or even hype them and so on, if any of these guys happens to smoke for no reason because they just like to be part of what others are doing then the person is not making any sense, like in most countries, people smoke because of the way their weather is, some of these countries are too cold to the extent that most of us in Nigeria even say we won Japa from Nigeria, we no go fit go stay there comfortable, so if the citizens of those countries are smoking then, I will say that it is because of the way their weather is.

But come to think about it, I don't see in any way that Nigeria is one of the countries that consumes more cigarettes or any of them, like if you make a good research (https://www.statista.com/statistics/279872/global-cigarette-production-by-region/) you will see that Nigeria is not leading in terms of cigarettes consuming.

Title: Re: Come wetin we see about some Nigerian youths wey use smoking do work of they lif
Post by: Promocodeudo on October 30, 2023, 04:59:15 PM
This is a serious issue, something has to be done urgently if not this will get out of hand soon, madness will be more in the street and localities soon, the youths now see smoke as nothing, they smoke whatever thing they want without considering the danger of of this drugs to their health and I keep asking where are this things smuggled from, will out government deny being aware of this, I will always Government, if you know that you can't govern well or even keep your campaign promises why will you go for leadership position, it is just a shame that we are helpless to this extent, the leaders of tomorrow are been kept in the dark for them not to remember their target in life, I weep for my country.

Title: Re: Come wetin we see about some Nigerian youths wey use smoking do work of they lif
Post by: Obari on October 30, 2023, 06:18:31 PM
There are several reasons why people smoke and the reason is best known to them and I no wan condemn anyone as I already know say reasons differ but still smoking for the sake of wiping away poverty or brokenness isn't a tangible excuse for smoking especially  cigarettes but I think I've read about some health benefits of Marijuana which is mostly consumed by the youths a d I learnt it also helps to reduce depression and I think you can research more about some health benefits of Marijuana and cannabis and I believe  say we no go really condemn this weed we dey condemn like this.

Title: Re: Come wetin we see about some Nigerian youths wey use smoking do work of they lif
Post by: Gozie51 on October 31, 2023, 08:42:11 AM

To add to wetin you yawn, people wey dey smoke don talk say weed dey make Dem reason well. I remember when dem interview mountain black and mad melon, nothing wey you no go hear about how weed take good and dey help give dem inspiration. Some weeders don also talk say e dey help dem sleep without hangover the next day and say e dey make Dem eat wella. Them say wetin make people dey misbehave and cause trouble when dem take am be say dem no dey eat and if you no eat, the thing dey worry the brain well well and if care is not taken the person go enter kolo levels.

However, that of ciga, me I never hear of any health benefit for that one if no be say your lips go dey black and your lungs too go dey affected according to wetin we don read about the effect of cigarettes smoking.

Title: Re: Come wetin we see about some Nigerian youths wey use smoking do work of they lif
Post by: Obari on October 31, 2023, 09:28:52 AM

But frankly I never really know wetin people Dey smoke comot for ciga especially for this our environment wey hot like this and at some point, I later understand say this cigar of a thing na mostly for people wey Dey cold region say e Dey help heat up their body and if most times smoking na to get high, then why people Dey even smoke ciga wey no Dey even high ? I know of a person wey no Dey smoke anything except oris ciga and I also know of people wey Dey smoke both ciga and every other smoke accessories but the truth be say, na only marijuana so far then don talk better thing about and for those wey no wan answer the name smoker, fit still catch this vibes via monkey tail.
I think I go do some interview with smokers make I know the reasons them Dey smoke

Title: Re: Come wetin we see about some Nigerian youths wey use smoking do work of they lif
Post by: Youngkhngdiddy on October 31, 2023, 10:50:48 AM
To add to wetin you yawn, people wey dey smoke don talk say weed dey make Dem reason well. I remember when dem interview mountain black and mad melon, nothing wey you no go hear about how weed take good and dey help give dem inspiration. Some weeders don also talk say e dey help dem sleep without hangover the next day and say e dey make Dem eat wella. Them say wetin make people dey misbehave and cause trouble when dem take am be say dem no dey eat and if you no eat, the thing dey worry the brain well well and if care is not taken the person go enter kolo levels.

However, that of ciga, me I never hear of any health benefit for that one if no be say your lips go dey black and your lungs too go dey affected according to wetin we don read about the effect of cigarettes smoking.
  People just get the wrong impression about this marijuana, some go even condemn you once day found out say you day smoke Igbo. But we don forget the health benefits way he day also bring, for yankee they don even legalize am because he good for people way get Parkinson. If health benefits no day am I no think a whole country like the united state for agree to legalize am. Doctors sef day prescribe am as drugs to some patients way get anxiety problem make them use calm their nerves. No quote me wrong smoking is actually bad for the health no doubt but it mostly depends what strain you’re on.
  We Nigerian we sabi over do our own thing, all these colos way boyz day do now no follow all this on don day tempered with na why ee day be like say he wan wound person, anything way day add chemical to enhance the reaction is not advisable for you cause even the chemical fit no day good for your body. If you wan know the benefits of smoking Marijuana enter google do research your self . Na why practitioners go advise smokers to de-toxify, as a smoker you suppose day take good care of your health and eat well so that you no be like person way suffer pass.

Title: Re: Come wetin we see about some Nigerian youths wey use smoking do work of they lif
Post by: Hewlet on November 03, 2023, 05:25:03 AM
Na truth you just yarn like this OP! The way our bross them de take follow up this Highness matter no good at all. The majority of our nigas for the street no fit do without being high.
E get one time I been de learn welding for one area like that and that one come make me relate welll with street boys, we go reach around 70 for the street when de do both welding and car maintenance but e shoke me to discover say na just two of us no de de take highness drugs.

When I make my observation na him I find out say na environment cause most of them to de use the drug. Some of them grow up for place where de no de see taking of drugs as bad thing and so de just flow along with the happening in their society.. For person like me when if my people ever hear say I done take one rap eh, dem fit just disown me. That mentality say I de accountable to someone de prevent me from doing some immoral things and I feel say na good thing for me.

Mad people truly full street and most of them enter that madness levels based on the the drugs them take when pass the one there head fit carry. If only our youth go know say na themselves them de harm and if the effect of their action no come today, later in life e go still worry them then, de go stop or at least reduce how much drugs them de consume

Title: Re: Come wetin we see about some Nigerian youths wey use smoking do work of they lif
Post by: Justbillywitt on November 04, 2023, 11:52:16 AM
Everything in life can be abused without proper knowledge. When there high illiteracy level in a society people begin to abuse things. Normally there are people who smoke weed, loud and take consume other drugs in the right proportion and they don't misbehaves neither will you see them in the street corner displaying some worrisome behaviors. Most of the celebrities do take these things and they are productive and are making waves in their respective crafts. There are big men and top politicians who takes drugs in their closet without you and I noticing, yet they will perform their duties and command great followership. Most of our youths lacks knowledge and this is what is causing them to abuse the use of drugs.

Title: Re: Come wetin we see about some Nigerian youths wey use smoking do work of they lif
Post by: Jamestown70 on November 05, 2023, 09:13:06 AM
Omo no be lie this smoking of a thing just dey bother me also the worst part be say girls including married women also indulge in this act, for my area you go see women way dey with pregnancy dey go getto to go smoke waiting one become of the unborn child now that na one question wey I dey ask always wether this women no dey pity their children at all.

Another thing again you see this so called fraudsters (yahoo) boys na Dem make smoking rampant for this country you go see small boy of sixteen, seventeen dey smoke anyhow reasons because one e don get money and smoking to them na part of enjoyment, u no go fit Sidon near Dem way no be smoking Dem dey do always on smoking, naija celebs too no dey try smoking now don turn good living, we no fit count 10  musicians  way no dey smoke so the youth see all this things and begin normalize am.

Title: Re: Come wetin we see about some Nigerian youths wey use smoking do work of they lif
Post by: Dripplurd on November 12, 2023, 09:37:03 AM
There are quite a number of things wey we young people need know about life. Smoking of all those things will only destroy your life. E dey scatter your liver small, small. But e dey surprise person how person go take know say something go kill them, but them go still go on to go smoke. Smokers are liable to die young for people wey dey smoke na wetin dem write on top cigarettes but dem go still go dey smoke am.

Now make we try imagine how much of damage those weeds and Marijuana go dey cost person health, because dem dey more dangerous. But e no concern them as person go still go ahead dey go smoke.

This world is just made of fantasy. We know something will kill us as human beings but we still went ahead to go and kill ourselves by using those things. People go still go run something even on how dem know say the thing go kill them but na so Satan dey corrupt this world. I think that's the difference between this world and the hereafter.

Many of our youth are now involve in that kind of a bad act nowadays,some are smoking cigarette some is ice,or marjuana or even loud and some is even involve in all this things, i can't even imagine how this thing will be destroying there liver gradually and the thing wey dey suprise me for there matter na him be say they use to write that, all the smokers are liable to die young at back of the cigarette carton and still yet you smoke it for godness sake something that i know it will going to destroy my life i am going to move far away from that thing.

Title: Re: Come wetin we see about some Nigerian youths wey use smoking do work of they lif
Post by: Samlucky O on November 12, 2023, 10:12:03 AM
Omo that one no be today news again na. The youth don take highness to another level expecialy this AZAMAN. The one wey funny me be say na small small boys dey run this matter oo and I see say this highness come upgrade as Yahoo boys come plenty. Because when Yahoo boys never too dey, na just weed and AZ them dey take but this ice of a thing no be small thing o. Nowadays increment of mad youths don dey everywhere. Ice and codin na 2 drug wey fit make person get mental issues at early age. Because e dey chop brain or I gonsay e dey gradually damage the brain cells. And when the brain cells don damage wetting go happen no kolo. So make we dey use our head make we dey useful to our parents or siblings and wife/children because dem dey look up to us.

Title: Re: Come wetin we see about some Nigerian youths wey use smoking do work of they lif
Post by: DEAstriker on November 12, 2023, 11:31:07 AM
Omor no be small mater you bring so oo boys and girls just take smoking as there day to day achievement and the thing way dey pain me pass na say some no fit eat without smoking or even do their day-to-day works, waiting you go dey hear na oboy if I no smoke ice I no fit work e dey activate me work harder.. Nonsense thoughts and good thing about this smoking na you go dey hear. But them no no say e dey kill them before there time expecially that one them dey call colos them no finish say e dey make them mad.. but them no fit leave am because of highness. So na beg I dey beg them to leave those hard drugs so them fit dey useful for life.

Title: Re: Come wetin we see about some Nigerian youths wey use smoking do work of they lif
Post by: Dripplurd on November 19, 2023, 08:56:41 PM
There are several reasons why people smoke and the reason is best known to them and I no wan condemn anyone as I already know say reasons differ but still smoking for the sake of wiping away poverty or brokenness isn't a tangible excuse for smoking especially  cigarettes but I think I've read about some health benefits of Marijuana which is mostly consumed by the youths a d I learnt it also helps to reduce depression and I think you can research more about some health benefits of Marijuana and cannabis and I believe  say we no go really condemn this weed we dey condemn like this.

To add to wetin you yawn, people wey dey smoke don talk say weed dey make Dem reason well. I remember when dem interview mountain black and mad melon, nothing wey you no go hear about how weed take good and dey help give dem inspiration. Some weeders don also talk say e dey help dem sleep without hangover the next day and say e dey make Dem eat wella. Them say wetin make people dey misbehave and cause trouble when dem take am be say dem no dey eat and if you no eat, the thing dey worry the brain well well and if care is not taken the person go enter kolo levels.

However, that of ciga, me I never hear of any health benefit for that one if no be say your lips go dey black and your lungs too go dey affected according to wetin we don read about the effect of cigarettes smoking.

Make i add the small that i have to your own brother,  Many Nigerian youths have ruined their lives by engaging in drug abuses,excessive partying ,armed robbery,sexual immortality,and participating in secrete cults and other social vibes inimical to the well being of the society. and for the ciga the more they keep smoking it that how it will keep affecting their lips and their lungs,come to think of it ,if you take a look at the cigarette carton there's use to be a message they pass through to them that is, all the smokers are liable to die young but i think maybe they don't look at the carton if they want to smoke it.

Title: Re: Come wetin we see about some Nigerian youths wey use smoking do work of they lif
Post by: Agbamoni on November 19, 2023, 10:25:31 PM
There are several reasons why people smoke and the reason is best known to them and I no wan condemn anyone as I already know say reasons differ but still smoking for the sake of wiping away poverty or brokenness isn't a tangible excuse for smoking especially  cigarettes but I think I've read about some health benefits of Marijuana which is mostly consumed by the youths a d I learnt it also helps to reduce depression and I think you can research more about some health benefits of Marijuana and cannabis and I believe  say we no go really condemn this weed we dey condemn like this.
There is no genuine reason for a chain smoker to smoke. They love smoking and smoking is very addictive. One thing you should understand about smokers is that they really love the feeling that comes after smoking, it makes them feel like they are out of the world and that feeling is called euphoria which is very addictive. I don't see smoking as something that is bad but the too much intake of it is what feel is not worth it.

There are quite a number of things wey we young people need know about life. Smoking of all those things will only destroy your life. E dey scatter your liver small, small. But e dey surprise person how person go take know say something go kill them, but them go still go on to go smoke. Smokers are liable to die young for people wey dey smoke na wetin dem write on top cigarettes but dem go still go dey smoke am.

Now make we try imagine how much of damage those weeds and Marijuana go dey cost person health, because dem dey more dangerous. But e no concern them as person go still go ahead dey go smoke.

This world is just made of fantasy. We know something will kill us as human beings but we still went ahead to go and kill ourselves by using those things. People go still go run something even on how dem know say the thing go kill them but na so Satan dey corrupt this world. I think that's the difference between this world and the hereafter.

My broda you know say car wey u they enter fit get accident but you still they enter am. You know say plane fit crash why people still they fly for air and you people still know say boat they sink for water they dey travel thorugh sea. Wetin go kill person, person no go know. Just as the bible done talk, unless God watch a city the watchmen watchet in vain. I dont see people wey they smoke till old age nothing do them. Weting they do our contri people espeially those smoking affect nah say them no they treat their health regualry or wash their body system and slo they no they take good vitamins wey they naturally good for the body system. As person they smoke him suppose they clease in body organ, if e they check him body regularly nothing go do am.

Title: Re: Come wetin we see about some Nigerian youths wey use smoking do work of they lif
Post by: Kensure on November 19, 2023, 11:23:23 PM
Omo this matter tire me oh.normally youths don normalize intake of hard drugs,everybody now sees it as a normal thing.the society has become a total mess.the one way they pain me be say some people feel say taking this hard drugs don qualify them to be big boys ,and is becoming alarming.how somebody go hustle finish use the money buy smoke ,no food ,some self they look like mad people just because of hard drugs  .some persons goes to an extend of selling their property or there father’s property just to get high .most person self life don scatter because of this hard drugs.is high time we stop justifying our actions,we have to tell our self the truth that hard drugs is bad .some person say if them no take smoke they no go fit work or chop ,nothing like that .Na some of us don condition our self like that e come be like say na so  e be true true .what happen to blood medicine if you can’t eat ,and what happen to sleeping pills if you can’t sleep.even people that produce it wrote “smokes a liable to die young “ so the earlier people start to they get sense the better.
 
Title: Re: Come wetin we see about some Nigerian youths wey use smoking do work of they lif
Post by: SmartCharpa on November 20, 2023, 10:29:57 AM
https://i.ibb.co/84kzRHK/IMG-2109.jpg (https://ibb.co/84kzRHK)

Every day by day this hard drugs called weed, loud, and lce
dey drag our youth closer to their grave this same hard drug matter don mak many of our youths go incensed and mad for the street in fact I been watched a shot video clip on how one guy kiss tranforman just because him go dey on cruise mode, I fit boost tell una say most boys no fit dey without moding two or more raps of loud or weed only say because e dey mak them fresh and eat well, But why most boys dey say smoking no dey kill???

Quote
This poses a question. Why does a country that currently ranks as the country with the most people living in extreme poverty (according to the  End poverty organization), turn out to be so dependent on drugs? According to a UNODC report, Nigeria ranks as the top user of opioids in Africa and the third-highest user of opioids in the world. See world rankings here.

Another report by the UNODC shows that over 14 million Nigerians use one form of opioid or another, and have the most level of prevalence in the world as of November 2020. This number is projected to increase rapidly if the situation of drug abuse in Nigeria persists.

https://radrafrica.com/radrwrites/high-times-nigerians-on-using-drugs-and-surviving-nigeria,/

I been see this post about how Nigerians are one of the most poorest country but them still dey smoke the painful part be said poverty no wan gree go self people dey suffer  
And all the time na poor Nigerian youth dey tak all this hard drugs pass u no go too see this rich men children dey too smoke am like the poor once. my advice to us be say make we tak am easy e go better one day one love .

All these people that always say that smoking no dey kill, they are illiterate and they don't know anything, weed it self is not mean for everybody, if you dey smoke try and make sure that you still dey chop better thing for body, but some people will not have money, still be smoking that is suffering and killing of body, that's what our young youths are doing this days, you see small small bois wey be under age go dey carry smoking like a joke, i don't even know where we are heading to in this country, because some of the youths are turning to something else with smoking, the funniest part be say no be all of them they smoke better weed sef, some know even get money to get better weed, you know say some weed dey wey be say e dey make person dey dry,  na waiting majority of them they smoke.

I ever saw one guy dey smoke Oris, the guy sef never reach 18 at all, then he read what they wrote on it that smokers are liable to die young leave it now, base on say he dey on a high mode, he said he will leave it tomorrow,  make them no worry, seriously this youths wey dey smoking are just killing themselves, because that thing sef dey make person run mad, they will see say na waiting cause this person problem be that, but if they chose that path, it's hard to do without it even a single day.

Title: Re: Come wetin we see about some Nigerian youths wey use smoking do work of they lif
Post by: Youngkhngdiddy on November 20, 2023, 07:31:09 PM
Omo this matter tire me oh.normally youths don normalize intake of hard drugs,everybody now sees it as a normal thing.the society has become a total mess.the one way they pain me be say some people feel say taking this hard drugs don qualify them to be big boys ,and is becoming alarming.how somebody go hustle finish use the money buy smoke ,no food ,some self they look like mad people just because of hard drugs  .some persons goes to an extend of selling their property or there father’s property just to get high .most person self life don scatter because of this hard drugs.is high time we stop justifying our actions,we have to tell our self the truth that hard drugs is bad .some person say if them no take smoke they no go fit work or chop ,nothing like that .Na some of us don condition our self like that e come be like say na so  e be true true .what happen to blood medicine if you can’t eat ,and what happen to sleeping pills if you can’t sleep.even people that produce it wrote “smokes a liable to die young “ so the earlier people start to they get sense the better.
   Naija be say justification dey for every action. Smoking na norms as it stands because from the general notion, e dey help Dem in its own special way. Some will say it keeps them warm, some will say it relieved them from depression, some will say it contains some kinda herbs or afterwards they'd detoxify. They know the truth but they just gats find way to cover am up. Well you won't blame them. Normally we dey like go extra mile with our own thing.
   The people wey even start the smoking and even need am more cos of their weather no dey even consume am near half of the way we dey consume our own. It's their own decision to change. No matter the level of conviction, if them never decide to change, Dem just no fit change. But nonetheless, let's do our best to stay away from it, no be now wey we go see the effect, the effects na always a long run something, the proper thing to do is abstain or quit if started already.

Title: Re: Come wetin we see about some Nigerian youths wey use smoking do work of they lif
Post by: Philpsticks on November 21, 2023, 09:59:54 PM
The issue is that ...some people might be broke...but you see that money for drugs, they will do anything to get it...
Some people are so addicted to it that they can't go a day without it..I once knew someone back then in school that will even cry ..if he does not get to smoke weed in a day ..and it's really sad..there is no way you will save money through it or even make plans ..its like how we cant do without the Internet ..that how some people can't do without drugs...some poor drug addicts really spend alot money on drugs  ..and that's why they are still poor ..cause any money they have ..its for buying drugs

Title: Re: Come wetin we see about some Nigerian youths wey use smoking do work of they lif
Post by: Philpsticks on November 21, 2023, 10:03:16 PM
This matter wey you talk so, na serious matter ooo, only God know wetin go happen before 2040 if nothing is done. The number of mad people for street don dey increase on daily basis, some people wey of reasoning don even get k-leg.
The so called internet fraud don even worsen the issue, Dem dey smoke suckaway , solution wey vulcanizer dey use and many more things like that.
Some they take different thing just to keep awake through the night.
No sleep in the day, no sleep in the night, Dem don dry finish like dried fish and Dem don dey look like roasted yam.

 Even all this herds men dey high theslmeelves, me I sure say na why them con even dey more dangerous and dey threaten lives for any area wey Dem dey.

This thing naw no be only guys both girls don dey high, for all this girl's wey dey join men high, who go gree marry them. Wahala b like motor with 3 leg
Smoking dey really drain person...especially if you no get money you come dey smoke...e go drain you...
 The fact say people sef no fit do without am..na serious issue...because you won't even be able to make plans for yourself...any small money na smoke ..and na so so kill dem go  dey kill their self  small small....if smoke dey make person activate..just still sha dey prepare for liver failure..cause one day the liver go dey inactive...

Title: Re: Come wetin we see about some Nigerian youths wey use smoking do work of they lif
Post by: Onyeeze on November 21, 2023, 10:26:01 PM
Despite that we dey local board I go talk sey we no need to talk things wey dey like this, e get some people wey be say na weed they make them to dey think well, so e get something wey we  no suppose to dey talk for mouth, don't condemn a food you don't eat because in some countries we I know igbo na one kind thing we they dey take serious pass anything and na wetin they help them to stimulate their body system, so make we no dey bring this kind of discussion here so that we no go dey condemn am

Title: Re: Come wetin we see about some Nigerian youths wey use smoking do work of they lif
Post by: HajiBagi on November 22, 2023, 01:35:32 PM
Make I ask you, anything wey you dey enjoy and you don't want to leave it any time soon will you see it as something that will kill you? The reason why our Young boys no dey see all this thing's as something bad be say they have master with it, he don dey their blood and if some of them no see am smoke in a day they will not enjoy  their self, this smoking have turn some our the young guy's to criminals because if they smoke it they don't care about anything again, it make their brain high to the level that they won't have respect for anybody, and they can do anything like stealing and even cause a fight any where.

But me I still dey wonder, why our government no take any action about it, I have seen a army man smoking igbo before, I was now thinking that when a army is smoking igbo then how can them also stop the young boys for smoking it, our government no dey care about people life again if not they for arrest many people deal with them for smoking all those things and even stop the ways those hard drugs came into the country, I see many countries wey dey arrest people wey dey smoke those things but our Niger own dey different.

Title: Re: Come wetin we see about some Nigerian youths wey use smoking do work of they lif
Post by: Obim34 on November 22, 2023, 10:42:44 PM

I go believe say smoking no dey enjoyable as most people dey speculate am to be na just the sensation and mood e dey put the person on wey dey make many people continue to smoke.

Smoking no bad at a point, cos even the sales of cigarettes dey legal just say they only give warning. Just say the way our youths dey addicted and there reaction after smoking e dey always be on the negative and aggressive, sometimes dey go act up finish con later regret am cos of the effect

Smoking has affected the youths, made some jobless, some ran mad and some reacts aggressively to things which has landed them in jail.

The Government no get enough power to stop the youths from smoking, even our military men dey engage in such act even at this point e don turn normal something for the streets even small children don get addicted to am

Title: Re: Come wetin we see about some Nigerian youths wey use smoking do work of they lif
Post by: Makus on November 23, 2023, 05:07:07 AM
Wattin I get to talk na be say smoke no be wattin our young boys suppose carry for head like the way them dey do now, one song writer say if Igbo no good for your health, quit. But our young boys of nowadays nor dey hear this one again, provided say their friend s they smoke dem sef wan smoke to just feel among and that na very stupid reason for smoking, I don see plenty things wey smoking of this hard drugs dey cause human life. E get one of my padi wey em go smoke wattin no good for em health and now em dey street dey man dey waka, no be everybody wey go smoke, just leave am for who get em strength. Beside even for small cigarette packet dem write smoker are liable to die young, dem how much more wey hard smoke like weed,ice, etc if cause human being. Truth be told, the fact say all this smoke dey give you highness, that alone na evidence say e get high potential to mess with our Brian the wey e want, so for those wey dey smoke, still try make you for reduce am, no go smoke to complete highness.

Title: Re: Come wetin we see about some Nigerian youths wey use smoking do work of they lif
Post by: Prosofina_G on November 23, 2023, 03:26:53 PM
Talking about smoking, this is a very nice topic, but am just seeing it at the surface because tobacco Marejuana and other related drugs  I think it dose not originated in Africa not to talk of Nigeria been the highest rank in smoking.

Many countries has been on the lead when we talk about intakes of drugs since the history of it,  and the abnormalities of this countries is on a very high side because both old and young are on it.

And it has cause so much damage and brought about illnesses and abnormal behaviour most of this countries which are on the leads are
1. Lebanon
2. Greece
3. Nauru
4. Serbia and
5. Tuvalu
This all I can remember hence is far more than this countries mentioned above.

Talking about intake of drugs in Nigeria

We are know that in this country called NIGERIA we are really really not serious about some certain things like intake of had drugs majority of us NIGERIANS see it as cruise while others see it as let me feel among because my friends are doing it.

That's why am totally agreeing to what @rachael9385
like in most countries, people smoke because of the way their weather is, some of these countries are too cold to the extent that most of us in Nigeria even say we won Japa from Nigeria, we no go fit go stay there comfortable, so if the citizens of those countries are smoking then, I will say that it is because of the way their weather is.
Now in Nigeria We want to copy almost everything in other countries, in Nigeria We smoke when the temperature is too high,  in Nigeria We wear big jackets when the temperature is so high, in Nigeria we take so much alcohol because we want to calm down when we have little miss understanding with our wife's, relatives, friends, and families who told us that intake of alcohol calms the Brin.

All this copying can make a man go mad can equally make a man go through mental disorder.
There for we should stop behaving like others or copying them.

Title: Re: Come wetin we see about some Nigerian youths wey use smoking do work of they lif
Post by: Hewlet on November 24, 2023, 11:40:26 AM
Make I ask you, anything wey you dey enjoy and you don't want to leave it any time soon will you see it as something that will kill you? The reason why our Young boys no dey see all this thing's as something bad be say they have master with it, he don dey their blood and if some of them no see am smoke in a day they will not enjoy  their self.
make I make you understand say most of the guys when we smoke already know the health implication of what they are doing but the issue is that because they've become addicted to it, it becomes very difficult for them to do away with it. Normally, that momentary joy when the highness De give them de sweet them for body no be lie but after that most of them no de enjoy there lives again. Some of them no like the fact say there continuous smoking about done de make them slime wetin no good but the matter be say them don already de addicted to the stuff and to break out of addiction no be beans on a normal.