Bitcoin Forum

Local => Off-topic (Naija) => Topic started by: Timmzzy on August 07, 2023, 05:50:52 AM



Title: Things Dey happen oh
Post by: Timmzzy on August 07, 2023, 05:50:52 AM
I greet una oh, abeg i wan share this headline wey i see from PUNCH NEWSPAPER, saying OGBANJE CHURCH OPENS IN ANAMBRA, like eh weytin be all this things, the matter tire me well well, because like this when i been dey small na NATIVE DOCTORS or native treatments them been dey give this kind of people back in those days...

https://i.ibb.co/g7tHTkw/Whats-App-Image-2023-08-07-at-06-45-54.jpg (https://ibb.co/pP4GzYZ)

I go like follow hear una own opinions inside this matter..

SEE NEWS LINK HERE: https://punchng.com/ogbanje-church-opens-in-anambra/


Title: Re: Things Dey happen oh
Post by: gotzekrul on August 07, 2023, 07:47:46 AM
Omooh i don laugh tire die for here, notin weh we no go see for this country ooo, and funny enough, you go see ppl de troop in de enter..

Ahswear person weh do us this kind tin no good at all, if at all the person don die, make we gather go beg am ooo


Title: Re: Things Dey happen oh
Post by: Kodec5 on August 07, 2023, 06:13:39 PM
We no supposed dey in shock... Any Christian go understand say all the things wey God say go happened during the end time don dey happen already. We jst get to shine our eyes and know where we dey put head.
All those people wey dey find miracle and some called pastors who go professy say in three months time dey go build house, buy car... etc 😂. Make dey better dey careful this world don finish as e stands now make we better hold God.


Title: Re: Things Dey happen oh
Post by: gotzekrul on September 20, 2023, 10:51:28 PM
Hwfa my guys, anybody don go the church, cos e be like say me i go reason to go there make i see how dem de take run their service


Title: Re: Things Dey happen oh
Post by: EluguHcman on September 20, 2023, 11:15:08 PM
If no be one tin self govt suppose dey approve churches for this side of the world we dey.
The mockery and and source of incomes churches is has become too much to bear.

No fear for God again. Na so so dem dey bring fake fake prophecies.
I don talk am to people say... Mind the kind church una dey to, especially the prophetic churches cuz I find out say most prophecies dem dey give there some na lies and most of the deliverances dem dey do na Nollywood (scripted).
And again, most of the problems the church members dey get dey com as programs by their prophets and prophetesses.

So who no get ogbanje no go come this 1? Abi if u want get ogbanje make u com?

I for say God self too dey merciful on some people but I just think of my own shits. 😏
We leave all to God to decide shaa.


Title: Re: Things Dey happen oh
Post by: Smartgoat on September 21, 2023, 06:37:07 AM
I'm not surprised at all, because bible have already told us that many will come in my name to discieve many . which is what's is happening now. and kingdom will rise again kingdom, we are also seeing it. so let's us get prepared because the end time is near.


Title: Re: Things Dey happen oh
Post by: Ever-young on April 18, 2024, 10:18:47 PM
Many things dey really happen well well, wey go give they put fear for person body, because of things wey dey happen, trust no dey again, even to dey help strangers no dey again because of the way things be and people now dey pay back good with evil, because them dey use the good wey people dey do for people against dem, now na good wey person dey do for people na e dey kill most of the people wey dey die o, this world don really spoil, surprise things just dey happen everyday, some na village people while some na we dey do with out hands but in all things mk we dey prayerful o because we no know tomorrow o. Mk problem wey don big pass us no reach us o.


Title: Re: Things Dey happen oh
Post by: DaNNy001 on April 18, 2024, 10:40:53 PM
Sometimes with the things wey person dey hear e dey be like say the whole world sef wan end and na why sometimes I just dey confuse how the whole matter dey go. When we talk about strange things happening my broda person no fit even count them and not to talk of strange deaths wey dey occur for the society is just so alarming. 

No be only ogbanje church dem for call am Mami water church sef 😒 🙄  people go just wake up decide to actually practice rubbish and still showcase for the world.


Title: Re: Things Dey happen oh
Post by: Belarge on April 18, 2024, 11:30:55 PM
Omooh i don laugh tire die for here, notin weh we no go see for this country ooo, and funny enough, you go see ppl de troop in de enter..

Ahswear person weh do us this kind tin no good at all, if at all the person don die, make we gather go beg am ooo
We go de alright, make we just know weytin to use money do when e come and e go de come in block. No b small tori, e sweet me for body well well and I just hope say things go de well for their side. This our country, Nigeria na cruise and we go de continue to de laugh because everybody don tire for the country. e don dey reach time when traditions go dey come out to find clients by themselves, this time na them dey advertise their handwork and they need people to come too.


Title: Re: Things Dey happen oh
Post by: odunybiz on April 19, 2024, 11:13:03 PM
Omooh i don laugh tire die for here, notin weh we no go see for this country ooo, and funny enough, you go see ppl de troop in de enter..

Ahswear person weh do us this kind tin no good at all, if at all the person don die, make we gather go beg am ooo

Nigeria will always be Nigeria. I'm not surprised with this at all. I could remember a church in my area then doing a program called Asale Yahoo(vigil for Yahoo). At this virgil, the pastor will order them to come with their laptops for prayers. Can we call this a real church. These are reason why many churches in Nigeria never changes Nigerians from their bad doings.


Title: Re: Things Dey happen oh
Post by: Bryan jessy on May 15, 2024, 07:09:53 AM
Well, anything is possible in this country so I wouldn't be too shocked hearing this. You know lots of people loves such gathering where miracles are happening according to them, some people believes in miracle centers instead of going on their kneels praying to God and rely on him and waiting patiently for he's time, rather they prefer quick miracles and healing disregarding the sources and the prices to pay later on.


Title: Re: Things Dey happen oh
Post by: Cityhunter34 on June 03, 2024, 08:41:13 PM
We no supposed dey in shock... Any Christian go understand say all the things wey God say go happened during the end time don dey happen already. We jst get to shine our eyes and know where we dey put head.
All those people wey dey find miracle and some called pastors who go professy say in three months time dey go build house, buy car... etc 😂. Make dey better dey careful this world don finish as e stands now make we better hold God.

My brother know be lie you dey talk o make them really dey careful because things dey happen now our days, although this people wey dey call there self man of God Dem dey distroy some many people home with there yeye prophecy sometimes Dem go tell you say your husband dey date another woman just to decieve the person, and the worst part be say na only women wey dey fall victims for this pastors why because Dem too dey like church wey Dem dey do prophecy, however na him make e no dey good make person dey allow in wife to dey go those church wey Dem dey see eye.


Title: Re: Things Dey happen oh
Post by: sotelorene on June 04, 2024, 05:58:22 PM
Just like Kodec5 talk, this one na one of the end time sign though most people no go believe am and some no go understand, them go just see am as ordinary something but e no dey ordinary. Waiting they cause all these things
na because of belief and too much knowledge, e get how pesin go Sabi something reach en go come dey question almost everything wey him en self been believe before but Thank God say them write am bold say na ogbamje church so that any pesin wey you see they go there, know say na ogbamje unlike those ones wey they no go write am but if you check  the church well, you go see fetish things wey dey happen inside there. Choosing what to worship is not illegal, everybody has the right to choose what to belief what not to belief however we should be careful with the people that is/are going to this church.

And as cityhunter34 take talk am too, na so e be. E get people wey go hear say that Ogbamje church dey make people get money and them dey see vision, say if person go the church them go tell you everything concerning waiting make soso pesin no dey do well and most of all these are fake and they are strategy to lure people in and take advantage of them because of their ignorant. Money na waiting dey kill most people this days when dey don hear say if you go this church money go flow, you go see how desperate people go dey rush regardless.