Bitcoin Forum

Local => Nigeria (Naija) => Topic started by: Kelward on August 23, 2023, 12:11:18 AM

Title: How signature campaigns de take make money for di forum.
Post by: Kelward on August 23, 2023, 12:11:18 AM
I don de reason dis matter for some time now, about how di signature campaigns de take make money for inside bitcointalk forum. Aldo I never reach full member rank for di forum, to understand as dem de take operate, so I reason say as I de privileged to get older members wey de run things with dem, say make I ask una how? Di main reason wey I wan know be say for my small experience about businesses, di main reason wey dem de take advertise na to reach a wider audience wey new people go de see dem products everyday, so dem go de get new customers to de patronize dem. But na only members wey de for di forum alone de see dis adverts or campaigns. So how di campaigns de take increase sales and recover di payments to members, as na only dem and junior members de see di adverts.

I de wonder weda dem de pay members to de advertise  and create awareness for dem products or dem de pay members to de patronize dem products? Lastly weda dem products de promote bitcoin?

Abeg if dis na forbidden question, our ogas dem fit to lock di thread. But if na correct question, make una help me chuk mouth for di matter?

Title: Re: How signature campaigns de take make money for di forum.
Post by: Charles-Tim on August 23, 2023, 12:22:38 AM
But na only members wey de for di forum alone de see dis adverts or campaigns. So how di campaigns de take increase sales and recover di payments to members
People that are not registered on this forum can see the ads.

I de wonder weda dem de pay members to de advertise  and create awareness for dem products or dem de pay members to de patronize dem products?
They are creating awareness for their products and servies. Because of the awareness, more people will use their products and services in a way they will also make profit.

If not profitable, the company will stop the campaign. If the company noticed profit, the campaign will continue.

Lastly weda dem products de promote bitcoin?
What they care more about is how they can benefit their customers and make more money from their customers.

Title: Re: How signature campaigns de take make money for di forum.
Post by: CryptoHeadlineNews on August 23, 2023, 02:52:39 AM
I don de reason dis matter for some time now, about how di signature campaigns de take make money for inside bitcointalk forum.
Okay, how signature campaign dey carry make money be say when they launch campaign here, they create an awareness to a large number of audience wey dey always come visit this site every day, and likewise when a project run a Facebook, Twitter & Instagram bounty campaign, they end up creating awareness across all those social media, whereby for those who love what the casino or project offer, they end up giving it a try, and if they love it, they promote/recommend it to others.

Quote
Lastly weda dem products de promote bitcoin?
Yes, because since the forum itself is all about Bitcoin, whichever project or casino advertised is expected to target the same Bitcoin users.

Quote
Abeg if dis na forbidden question, our ogas dem fit to lock di thread. But if na correct question, make una help me chuk mouth for di matter?
Abeg, there is nothing like forbidden question my friend, because na person wey no know dey ask questions and you just did. So never be scared to ask question my friend.

Title: Re: How signature campaigns de take make money for di forum.
Post by: Nwada001 on August 23, 2023, 02:57:26 AM
di main reason wey dem de take advertise na to reach a wider audience wey new people go de see dem products everyday, so dem go de get new customers to de patronize dem. But na only members wey de for di forum alone de see dis adverts or campaigns. So how di campaigns de take increase sales and recover di payments to members,

Even if nah the forum members alone dem they see the adverts, eh enough members still they way go patronize those companies way they advertise for here as the forum get about  3 million + users  (https://bpip.org/) way dy registered for this forum even as nah just 50k + of them they active, eh still reach enough number to carry create awareness.

Nd as the member way dy above don talk, people way no even they registered for this forum they come here ones, ones to come gather information, which be to read thread to thread, and as them dy read am they see am so, few out of plenty of dem go try click 4 the link way dy the signature which go help the project way dy under that signature get small customers. nah just as google ads them they appear for plenty site nah so this signature just wan dy inform of. people see here as better source for information, nah why dem they come here come research, even if people no register under the link way dy signature, dem they sometimes go outside the forum go make research about the project then them go change carry other link register den add small profit to the company.

Title: Re: How signature campaigns de take make money for di forum.
Post by: Timmzzy on August 23, 2023, 08:56:07 AM
well with the small thing wey dey talk for my head like this as we dey wear the signature so ehh... like this one i dey wear so now the activities wey we dey do for here dey also create awareness outside because ni make spreadsheet dey and the team get the spreadsheet as evidence to show any investor say see their sig, and secondly social media too dey also help them promote. back den around 2018 and 2019 i remember advertising COLD WATER starch for facebook so all this things get ways wey them dey take sale our their products.

Title: Re: How signature campaigns de take make money for di forum.
Post by: Gozie51 on August 23, 2023, 10:51:31 AM
Na simple matter you dey ask. That signature campaign na normal advert wey people dey do for radio, newspaper or television. Some people self dey carry their advert come meet you for house like people wey dey sell things, soap on promo, noodles and many more like that wey dem dey even carry for motor as you know. Some people dey also do T-Shirt and customize their company name their. So signature campaign na same way, if you click those their link it will take you to the adverts of the company running the signature campaign so you go fit choose to do business with them. But one unique thing about this forum be say she represent the biggest bitcoin community and crypto too with highly reputable reviews, so those people wey dey run btc and altcoin related products dey like come here because dem sabi say the forum get global coverage for cryptocurrency.

Title: Re: How signature campaigns de take make money for di forum.
Post by: CryptSafe on August 23, 2023, 11:47:55 AM
You get a point of conversation here. E good say you bring up this topic for dis discussion. The main reason of advertising na to get through to a larger audience for marketing. This audience now would be the market target for the business to strive on for profit making.

Here onboard this platform, one of the major reasons for this campaign is for  reliability in the sense that members would prefer projects running campaign here ie they feel they are safe  doing or dealing with such project as their presence is recognised here and  another thing is that the number of daily engagements here is very much enough to attract traffic to any of the signature campaign. Do not forget that most people here are not just here for fun but for business. Some do  daily routine check for casinos, and other projects to invest in and also some do research for others too.

Lastly, the talk of payment for advertising here, yes they do pay for avatar and signature space to members selected for the campaign purpose. So that is why you see campaign managers put up advert and do take time to select members carefully to do the task and after that, based on the mode of agreement between the both parties, the campaign manager pays accordingly depending on the terms and conditions of engagement.

Title: Re: How signature campaigns de take make money for di forum.
Post by: Mpamaegbu on August 23, 2023, 02:24:49 PM
But one unique thing about this forum be say she represent the biggest bitcoin community and crypto too with highly reputable reviews, so those people wey dey run btc and altcoin related products dey like come here because dem sabi say the forum get global coverage for cryptocurrency.
I nor even sabi sey dis forum na she e bi. I bi dey think sey na hermaphrodite 🤔

Dat thing wey you yarn there na the koko be dat about here bein d biggest (and most active) crypto community. On top of that, projects wey dey come here sabi sey reviews and comments here dey make sense die. Dem dey get value for their businesses and na wetin make dem dey rush come here. Those ones wey d campaigns nor favour dey stop running am once dem assess their balance sheet and take stocks. Shebi we see as many mixers came up immediately wey Chipmixer get dat gbege wey hit dem a few months ago. Those projects dey patrol here before dat incidence and once dem see sey Chipmixer don go down, they immediately floated their campaigns here. Na so e dey be.

Title: Re: How signature campaigns de take make money for di forum.
Post by: Sim_card on August 23, 2023, 08:08:28 PM
OP, you know say this community get population as @Nwada don already give the figures and na e make you see say this people dey come here for advert because only the population for here wey dey active if them patronize you,you go hammer. And no still forget say most money wey these companies dey pay for signature campaign still dey go back to the company. Many people for here,the moment wey them pay them,if na the one wey like to gamble,he don use him own gamble and I don still hear a forum member wey say him signature campaign money na him e dey take gamble weekly. Rich people dey here wey see that pay as less and nothing he fit do for them. Na we Naija due to bad economy dey appreciate the funds die.

Title: Re: How signature campaigns de take make money for di forum.
Post by: SmartGold01 on August 23, 2023, 08:28:20 PM
I don't think this should bother you for now because I know that when time comes you would surely understand how the process works and how things are handled over here, but what I know is that no signature campaign will run over here without them arming at something very helpful to them.

Signature campaign as said has been already answered by users above but if you must know, they are only seeking for them to get a wider exposure and audience and, also keep in mind that those projects never rely on a particular site to run their adverts.

For example, there was a day I was watching football and I noticed stake.com was printed into their clothes they wore.. that's to say that they are not only limited to Bitcointalk but are also running their ads elsewhere but Bitcointalk is a community that focuses on bitcoin related discussion and they want to maintain their stayed over here without just ending in an unwanted way since they knows the importance of here.

But nevertheless, reduce your focus from that aspect and seek on how to increase in level and advance your wisdom bank.

Title: Re: How signature campaigns de take make money for di forum.
Post by: DaNNy001 on August 23, 2023, 08:31:23 PM
I go just emphasise on the part of you saying weda na forbidden question or not. My brother I understand the reason for watin go make you reason like this but it's pretty clear questions nai be the bedrock of so many solutions to the problem and confusion this world had to offer as no ever fear to ask questions my broda, see as you don ask this one nai plenty answer and awareness about how the signature campaign dey work don come so it's also one the main reason sef wey we dey here to seek answers to things we don't know

Title: Re: How signature campaigns de take make money for di forum.
Post by: Mate2237 on August 23, 2023, 08:48:33 PM
Dis your thread e dey make sense wella. Signature Campaign as di name implies it is the link at the bottom of the user nai dem dey advertise and any one wey clink that link go carry u go to di site. And plenty gamblers e dey di forum and dem dey gamble steady. You can read this for more guidelines for Signature Campaigns https://bitcointalk.org/index.php?topic=1684035.0,  forum na very big place to do advertisement and companies go still get enough money. Because people dey use the company service well well.

And apart from that, users wey dey the forum sef dey tell their friends outside to use the company service. And from there too they can get customers and make their money. And not only forum di advertisement dey go on, the company dey place advertisement for plenty places. Dem dey do am in other social media and physical placards so dem dey make money from different advertisement methods.

Title: Re: How signature campaigns de take make money for di forum.
Post by: CryptopreneurBrainboss on August 23, 2023, 10:16:13 PM
I don de reason dis matter for some time now, about how di signature campaigns de take make money for inside bitcointalk forum. Aldo I never reach full member rank for di forum, to understand as dem de take operate, so I reason say as I de privileged to get older members wey de run things with dem, say make I ask una how? Di main reason wey I wan know be say for my small experience about businesses, di main reason wey dem de take advertise na to reach a wider audience wey new people go de see dem products everyday, so dem go de get new customers to de patronize dem. But na only members wey de for di forum alone de see dis adverts or campaigns. So how di campaigns de take increase sales and recover di payments to members, as na only dem and junior members de see di adverts.

Nobi every business wey come the forum dey make money and that's why some campaigns no dey last and dem dey easily close within couple of months wey dem launch their signature campaign. The two companies wey dey make money pass for the forum na casino campaigns and mixers campaign and that one na because they already get their interest ordinance plenty for the forum but for other types of companies dem wey no dey too benefits from their direct advertisment for the forum and na where the second benefits comes in wey be to bring traffic to their sites and increase their ranking for Google search engine with the click wey dem dey get here wey go put their website in better position to be seen by those searching for similar contents on the internet.

I de wonder weda dem de pay members to de advertise  and create awareness for dem products or dem de pay members to de patronize dem products? Lastly weda dem products de promote bitcoin?

Abeg if dis na forbidden question, our ogas dem fit to lock di thread. But if na correct question, make una help me chuk mouth for di matter?

Dem no dey pay to patronized them, dat one no be good business idea na abi you dey do charity for business to dey reason go dat way. Dem dey pay to promote the business and the promotion on Bitcointalk helps the project via webpage visit and as I explain above. Most signature dey indirectly promote bitcoin because anything wey bring about the use of Bitcoin dey promote bitcoin as the more the business dey get profits dey more dem go put money for other advertisement wey no dey related to the forum and dem fit dey get new customers wey go get interest in their service and if dem never hear about Bitcoin before, na new client wey Bitcoin dun get be dat. Some casino dey bring in more Bitcoin users than any of the other means dem wey we dey think say they help the growth of Bitcoin like media coverage etc

Title: Re: How signature campaigns de take make money for di forum.
Post by: Kelward on August 24, 2023, 03:30:56 PM
di main reason wey dem de take advertise na to reach a wider audience wey new people go de see dem products everyday, so dem go de get new customers to de patronize dem. But na only members wey de for di forum alone de see dis adverts or campaigns. So how di campaigns de take increase sales and recover di payments to members,

Even if nah the forum members alone dem they see the adverts, eh enough members still they way go patronize those companies way they advertise for here as the forum get about  3 million + users  (https://bpip.org/) way dy registered for this forum even as nah just 50k + of them they active, eh still reach enough number to carry create awareness.

Nd as the member way dy above don talk, people way no even they registered for this forum they come here ones, ones to come gather information, which be to read thread to thread, and as them dy read am they see am so, few out of plenty of dem go try click 4 the link way dy the signature which go help the project way dy under that signature get small customers. nah just as google ads them they appear for plenty site nah so this signature just wan dy inform of. people see here as better source for information, nah why dem they come here come research, even if people no register under the link way dy signature, dem they sometimes go outside the forum go make research about the project then them go change carry other link register den add small profit to the company.

50 thousand active members wey de discuss bitcoin, crypto matters and oda off topics everyday, dat na one complete community, I bin no know about dis information before now, thanks for di update. So even if na the forum members alone de see di adverts, and up to 50℅ of dem de patronize dem, dat na something. As you and CharlesTim don point out other people wey no be forum members de also visit di forum and dem de see di  adverts, some go also decide to visit some signatures and patronize dem.

E show say di forum na very good place for business advertisements, because of di traffic of activities wey de happen for inside. Both members and none members of di forum wey de visit am everyday de see all of di signature campaigns, and  dat na enof reason for de signatures to de continue to campaign.

Title: Re: How signature campaigns de take make money for di forum.
Post by: Fivestar4everMVP on August 25, 2023, 01:51:21 PM
Visit this website https://www.similarweb.com/website/bitcointalk.org/#overview (https://www.similarweb.com/website/bitcointalk.org/#overview) to read the full information on bitcointalk ranking and other important information, i believe that should clearly answer your question.
According to the information on similarweb, this forum has an average everyday visits of 1.3 million, that means that over 1.3 million people visit the forum, and that i believe include members and non members of the forum, and in that number, an average of 53.65 percent of visitors view one full page before leaving, and every visitor views an average of 4.28 pages before leaving the forum, and the average time each visitor spends on the forum is 3 minutes minimum..

https://talkimg.com/images/2023/08/25/Mr4N5.png

And like i believe you have been told, signature ads on this forum are viewable to both members and non members of this forum, so this simply means that, the signature ads you see are not the companies advertising to just members of this forum alone, but they are also advertising to the visitors of this forum as well, i hope this is clear enough.

Title: 📆 Mark your calendars! The campaign kicks off on August 21st at 6PM UTC and run
Post by: Siam09 on August 25, 2023, 02:20:29 PM
I don de reason dis matter for some time now, about how di signature campaigns de take make money for inside bitcointalk forum. Aldo I never reach full member rank for di forum, to understand as dem de take operate, so I reason say as I de privileged to get older members wey de run things with dem, say make I ask una how? Di main reason wey I wan know be say for my small experience about businesses, di main reason wey dem de take advertise na to reach a wider audience wey new people go de see dem products everyday, so dem go de get new customers to de patronize dem. But na only members wey de for di forum alone de see dis adverts or campaigns. So how di campaigns de take increase sales and recover di payments to members, as na only dem and junior members de see di adverts.

I de wonder weda dem de pay members to de advertise  and create awareness for dem products or dem de pay members to de patronize dem products? Lastly weda dem products de promote bitcoin?

Abeg if dis na forbidden question, our ogas dem fit to lock di thread. But if na correct question, make una help me chuk mouth for di matter?

Title: Re: How signature campaigns de take make money for di forum.
Post by: Kelward on August 26, 2023, 07:13:25 AM
Visit this website https://www.similarweb.com/website/bitcointalk.org/#overview (https://www.similarweb.com/website/bitcointalk.org/#overview) to read the full information on bitcointalk ranking and other important information, i believe that should clearly answer your question.
According to the information on similarweb, this forum has an average everyday visits of 1.3 million, that means that over 1.3 million people visit the forum, and that i believe include members and non members of the forum, and in that number, an average of 53.65 percent of visitors view one full page before leaving, and every visitor views an average of 4.28 pages before leaving the forum, and the average time each visitor spends on the forum is 3 minutes minimum..

https://talkimg.com/images/2023/08/25/Mr4N5.png

And like i believe you have been told, signature ads on this forum are viewable to both members and non members of this forum, so this simply means that, the signature ads you see are not the companies advertising to just members of this forum alone, but they are also advertising to the visitors of this forum as well, i hope this is clear enough.

This your enlightenment over clearly answer my question, because I bin get information from a member for dis thread say about 50 thousand people de visit this bitcointalk forum everyday, and I  reason say dat number fit encourage di signatures to de campaign for di forum. But dis your information wey you back up with fact really overwhelm me, 1.3 million people de visit di forum everyday, dis one na sure banker say di campaigns no fit stop, because na real business place dis forum be for dem.

One of di things wey I like about dis forum be say every information about am de accessible, except say person no know where to go search am.

Title: Re: How signature campaigns de take make money for di forum.
Post by: Juicyhome on July 10, 2024, 05:50:57 AM

Bitcointalk na one forum for cryptocurrency minners and investors,  you no fit read or research about bitcoin and u no visit this forum. So any company wey dey privilege to advertise their product or services here don already reach worldwide. The population on this forum alone is enough to promote any brand. Never underrate this forum for advertisement,  once a company name appear here you go sell and make more profits. The money them they pay for campaign here na change to those company and if the forum no they benefit them, you for no they see company coming for signature advert. As them they benefit well na e make them still dey come this forum. To me  forum  advertisement cheap than TV and radio advert, if you know how much them they pay for 1min advert on TV and radio and yet most of those TVs and radio no get viewer reach bitcointalk, so company they benefit well here.

Title: Re: How signature campaigns de take make money for di forum.
Post by: SmartGold01 on July 12, 2024, 07:34:33 PM
The only thing I see say this company they make from the sig be say if any person search about bitcoin for internet and the thing related to gambling e go carry am come this forum automatically the person go click on the link wey dey for profile from there the person go sign up although some people here too dey register on those betting site to place bet and if them lose the casino wey dey run signature here go benefits am from their ends, remember say na only we people wey dey hard to release money take place bet our money not 1$ to 10$ as higher but oyibo dem fit lose $1m from bet just the famous rapper dey use $300k above imagine say them get luck see this kind people wey dey bet like this how you think say them no fit afford to pay for signature campaign?

Title: Re: How signature campaigns de take make money for di forum.
Post by: Mpamaegbu on July 16, 2024, 04:11:19 AM
The only thing I see say this company they make from the sig be say if any person search about bitcoin for internet and the thing related to gambling e go carry am come this forum automatically the person go click on the link wey dey for profile from there the person go sign up...
Na dat one even be d main reason wey make projects dey rush come here pass any orda forum to advertise. Here dey give dem hyper and super exposure well well, nor be lie. Na only here be d place wey search engine carry give me wen I dey search to know wetin Bitcoin be in 2017 as a greenhorn through CMC of those days. E bi like sey CMC don chill now like over warmed soup sha with Coingecko and Cryptorank and other aggregators taking d shine off it. Those days, CMC be like god. Dat na to show sey nothing lasts foreva. Maybe one day too, anoda strong man go overtake dis forum too. Make we brace up and acquire orda skills outside here.

Title: Re: How signature campaigns de take make money for di forum.
Post by: Juicyhome on July 16, 2024, 10:48:57 AM
The only thing I see say this company they make from the sig be say if any person search about bitcoin for internet and the thing related to gambling e go carry am come this forum automatically the person go click on the link wey dey for profile from there the person go sign up although some people here too dey register on those betting site to place bet and if them lose the casino wey dey run signature here go benefits am from their ends, remember say na only we people wey dey hard to release money take place bet our money not 1$ to 10$ as higher but oyibo dem fit lose $1m from bet just the famous rapper dey use $300k above imagine say them get luck see this kind people wey dey bet like this how you think say them no fit afford to pay for signature campaign?
na true you talk, this forum dey all search engine as source of information concerning cryptocurrency and gambling issues. But aside that one them come for advert make dem dey popular in the world too, this forum dey get millions viewer per day, than some media houses wey de run advert and forum dey cheaper than them. So as business man you go choose forum wey get plenty audience than media houses wey dey very expensive to advertise.

Title: Re: How signature campaigns de take make money for di forum.
Post by: DubemIfedigbo001 on July 16, 2024, 10:38:22 PM
Marketing is an important factor in any company, it helps the company increase the visibility of their product to both prospective clients and helps reassure old clients that they are still in business and waxing strong. The more people see your product advertised, the more they would want to give it a trial.

It also helps for brand building as your marketing style and content defines your brand and helps create a certain image and perception of the product in people's mind, leading to higher patronage.

Marketing creates avenue for proper customer support which we can see here in the forum as almost, if not all campaigns have their representatives to attend to issues with their products. and this reassures clients that they are in safe hands as their concerns are treated as a matter of urgency  and importance. clients are also given proper orientation on the accurate engagement patterns during marketing.

It opens possibilities of partnerships with the big fishes as bigger companies or individuals can pick interest in your company and offer partnership deals that would benefit the company.

I would also mention that effective marketing helps keep your company one step ahead in a competitive environment. On the overall, marketing drags more clients and retains the former ones for companies running signature campaigns in this forum. This forum is very large and effective as even registered and non-registered members can have a peak at the promotional activities going on here, so the visibility is of maximum efficiency and drags traffic(leads) to the companies of concern.

Title: Re: How signature campaigns de take make money for di forum.
Post by: Stable090 on July 17, 2024, 08:35:38 PM
I don de reason dis matter for some time now, about how di signature campaigns de take make money for inside bitcointalk forum. Aldo I never reach full member rank for di forum, to understand as dem de take operate, so I reason say as I de privileged to get older members wey de run things with dem, say make I ask una how?
Signature campaign for forum na advertisement now, signature and avatar wey you Dey wear, people Dey see am, and e Dey create more awareness about the company now, and as your profile Dey, anybody wey click your signature space, e go carry them go the project wey you Dey market there website, and dem go fit make use of am.

di main reason wey dem de take advertise na to reach a wider audience wey new people go de see dem products everyday, so dem go de get new customers to de patronize dem. But na only members wey de for di forum alone de see dis adverts or campaigns.
So you Dey reason say new people no Dey join d forum be that? No reason am ooo plenty people Dey dis forum wey Dey gamble well, and new people still Dey join d forum on a daily basis. If the company no Dey see d impact of the marketing on the forum, Dey go don stop now, some campaigns don spend 3 years and more on the forum, if impact no Dey, then y dem go still Dey spend money.

Title: Re: How signature campaigns de take make money for di forum.
Post by: Barikui1 on July 18, 2024, 07:04:42 AM
I don de reason dis matter for some time now, about how di signature campaigns de take make money for inside bitcointalk forum. Aldo I never reach full member rank for di forum, to understand as dem de take operate, so I reason say as I de privileged to get older members wey de run things with dem, say make I ask una how? Di main reason wey I wan know be say for my small experience about businesses, di main reason wey dem de take advertise na to reach a wider audience wey new people go de see dem products everyday, so dem go de get new customers to de patronize dem. But na only members wey de for di forum alone de see dis adverts or campaigns. So how di campaigns de take increase sales and recover di payments to members, as na only dem and junior members de see di adverts.

I de wonder weda dem de pay members to de advertise  and create awareness for dem products or dem de pay members to de patronize dem products? Lastly weda dem products de promote bitcoin?

Abeg if dis na forbidden question, our ogas dem fit to lock di thread. But if na correct question, make una help me chuk mouth for di matter?
My brother, you don talk well, if I look am from a business angle, e dy very clear say na advert them dy do, Dem dy try create awareness to the general public wey dy use this forum and people wey no be regular member of their goods and services wey Dem get to offer, and to be sincere, na wen people know of ur products Dem fit use your service or goods.

Secondly, if I dy correct here, you ask if their products dy promote Bitcoin, you know say as we dy here so in this forum, na Bitcoin community and cryptocurrency generally, so any business wey dy transact in Bitcoin or other cryptocurrency go normally dy here, no be for mile 1 market Dem go go, na crypto community like this, them go come do their business, so na normal thing.

And lastly,  concerning the question, no reason am, na normal thing, I believe say person wey ask questions no dy miss road, you just dy curious to know how things work here, so you no commit any offense

Title: Re: How signature campaigns de take make money for di forum.
Post by: Kelward on July 18, 2024, 08:57:02 AM
How time flies, dis na question wey I ask for August, last year, wen I still de for member rank. Since den I don increase my knowledge for di forum to understand say Bitcointalk no be ordinary forum, na a place wey de de very active for 24 hours and many people de visit am everyday. Dat na why e be place wey companies de come to take advantage of di traffic to advertise dem products and services. I no think say e get any oda discussion forum wey de active like this forum and di crypto knowledge and information wey we de get for here na second to none.

So as Bitcoin adoption de increase geometrically and dis na di pioneer forum for im discussion, na im make am di best place for companies to de campaign for dem products.