|
Title: Silk Road Case: De Real, Untold Story. Na Karpelès be Satoshi or DPR? Post by: sokani on September 07, 2023, 12:41:02 PM Translated Topic in Pidgin Language: Silk Road Case: De Real, Untold Story. Na Karpelès be Satoshi or DPR?
Original Topic: Silk Road Case: The Real, Untold Story. Is Karpelès Satoshi or DPR? (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5211862.msg53418864#msg53418864) Author: GazetaBitcoin (https://bitcointalk.org/index.php?action=profile;u=1285797) E get any person wey don watch de latest documentary about Ross Ulbricht? You fit find am here Youtube (https://www.youtube.com/watch?v=EvN32yFSeks) (or for dis second link (https://odysee.com/@MadMaxMedia:1/Silk-Road:0)) and na Free Ross organization na im create am. I dey ask because I notice some interesting allegations, besides all de wuru-wuru wey dem do during de trial. De wuru-wuru wey dem do against Ross Ulbricht (I think) many people sabi well well de details about de case, many of dem xtraelv bin also torchlight am for im very interesting topic (https://bitcointalk.org/index.php?topic=4437773.0). However, some of de details (atleast I no no) wey de documentary expose. Some dey very unrealistic (like de suspicion say Mark Karpelès be Satoshi, which I no say actually na fake, but no bodi no de truth), but some raise questions though... Besides, de film give de idea say Karpelès fit be DPR, and not just Satoshi.
Examples of de similarities in UI between de sites: https://i.ibb.co/tCT5jqQ/DreIDOD.png
However, wetin de documentary yan, Karpelès (de alleged owner of BitcoinTalk) fit don plant this information or by another user wey get high level of access. Besides, de way Alford find de respective email, dem fit compare am wit " finding a needle from a pile wey fit dey like de size of de internet" (which I totally agree). In other words, for all de people wey dey try to find information about de SR owner, Alford only manage to find dis email address. From there de idea con come up say dem fit don plant de information. Because someone wey get high access fit don make de respective post in de name of Ross and hand over de information to Alford, make everything look real. De entire documentary dey very interesting, but na de first 35 minutes na im dey raise de questions wey dis current topic talk about. Karpelès fit be Satoshi and also DPR? Another aspect wey de documentary no mention but de forum know about am na say Karpelès bin also perform audit for BitcoinTalk, maybe dis aspect for raise more suspicion for de documentary. I believe say na how de attacker carry out de attack: after de 2011 hack of de forum de attacker bin come put some backdoors. Mark Karpelès bin come remove dem wen him run post-hack code audit, after small time, de attacker come use password hashes wey him obtain from de database in other to take control of an admin account and put back de backdoors. In de end, I wan mention say I find de entire film very interesting, wey bring new details about Ross case, about de unbelievable way de judge treat am and de sabotages some secret agencies/agents perform towards other agencies/agents. I recommend everybody to watch am, na a must watch documentary! Title: Re: Silk Road Case: De Real, Untold Story. Na Karpelès be Satoshi or DPR? Post by: GazetaBitcoin on September 07, 2023, 04:28:21 PM Thanks again Sokani as you take translate another of my topic! I appreciate all your efforts!
Dis na very special topic wey mainly dey dedicated to raising awareness about Ross Ulbricht unfair trial. Many people bin accuse am without proper knowledge of de case. E dey easy to talk many things, but as you watch dis amazing documentary, you go understand say things bin no dey dat simple with am. Agencies bin dey fight each other to take over de case, corrupt DEA agent dey steal BTC from Silk Road: Dem no gree make Ross authorized witnesses appear for court, de persecution bring unauthorized evidences to de court and de judge accept am just to make an example of Ross - all dis and many mata you go understand from de topic and from de documentary. Finally, one man dey serve 2 life sentences for prison + 40 years bonus(how any person fit take fulfill this kind sentence?!?) without parole, because him dey run a website (!!!) and for him first offense, while de administrators of SR 2.0, 3.0 or other dark markets dem bin don caught dem, imprison dem, and already release dem. Fair justice? Yes, sure!!! |