Bitcoin Forum

Local => Nigeria (Naija) => Topic started by: Forever101 on September 16, 2023, 08:13:58 AM

Title: Why dem dey invest and Dem no dey get money
Post by: Forever101 on September 16, 2023, 08:13:58 AM
My piple, make una shift come make we reason this matter wey dey ground bcos many Nigerian na hustler yet Dem dey suffer. I wan talk about wetin dey cause this kind thing , well, no be all I wan talk, na just the one wey dey very important I wan make we reason am .

Shae una no say almost 80% of our youth na ihn dey gamble their money with one platform or the other with d hope say Dem go make big money one dey, many person don gamble so tey Dem no fit buy food for their own mouth again. This same issue don scatter relationship and marriage, many student too wey dey addicted to gambling don drop out for school, some papa no fit send pikin go school bcos Dem dey find magic wey go happen through gambling.

Pesin wey dey gamble ihn money more ten years with no result, wetin go be in later result, na abject poverty. As we dey talk am so, some people dey wey be Bitcoin investor and na gambler Dem be, na gambling Dem dey waste their profit from bitcoins.

Na why gambler no fit get money be this, when Dem win any money after plenty days, weeks, months or years of trying , Dem go hope say make Dem use the money play bigger one if anything go fit drop. Na so them go play until some go sell their property.

My piple, wetin I wan make e clear to us be say, to dey gamble no be wey to make money wey dey sure bcos if we calculate all the money wey u don use since you start to dey gamble, e reach build house or send pesin go university.

Everybody fit choose wetin Dem go do ooo, no be by force but me just get small advice say either you find better business or you avoid addiction and always check if u no dey loose so dat u go fit take correct measures.

My piple wetin una think for this matter wey I just yan so

Title: Re: Why dem dey invest and Dem no dey get money
Post by: Charles-Tim on September 16, 2023, 08:53:08 AM
My piple wetin una think for this matter wey I just yan so
I can not agree more than this. A good suggestion is to use 1% of monthly income to gamble. If you are earning ₦100000 monthly, use just ₦1000 to gamble. Some people may not agree with me, but if you want to enjoy gambling, us the amount of money that you can afford to lose to gamble.

Title: Re: Why dem dey invest and Dem no dey get money
Post by: Lida93 on September 16, 2023, 11:16:40 AM
My piple wetin una think for this matter wey I just yan so
I can not agree more than this. A good suggestion is to use 1% of monthly income to gamble. If you are earning ₦100000 monthly, use just ₦1000 to gamble. Some people may not agree with me, but if you want to enjoy gambling, us the amount of money that you can afford to lose to gamble.
This one you talk na just the only way to use the enjoy gambling be that. And for people wey see gambling as fun this idea go sink well inside them for them to use am according to how them dey earn as salary.

Nah those wey take gambling as source to use make money go see this idea as something wey hard to do, the excuse go be say 1% too small nah. And that kind talk na dey make dem spend on beyond what they can afford to lose.

Title: Re: Why dem dey invest and Dem no dey get money
Post by: Odohu on September 16, 2023, 11:23:06 AM
Na lack of strategy dey cause the kind failure wey people dey fail for gambling. Make we no forget say plenty successful gamblers dey for Naija, example is Mayor of Ekiti (https://twitter.com/Ekitipikin?t=punX_n2iSc6_nEuGcfalZQ&s=09). He is a successful gambler that have dealt with several bookies on various occasions. I know say grace follow but person gat apply strategy because na lack of strategy go make person take all him money play gamble when you know say na game of probability.

E dey pain me when I see the kind attitude some people dey form untop gambling... your family never chop you carry the small money you get go dey play gamble. Naija no too dey play gamble self... visit US and see how gambling and casino centres plenty and many people dey play am... but e come be say our people no add sense untop am.

For Naija now, if them know say you dey play gamble, the first thing them go say you be useless and irresponsible man. E no suppose be like that. Make people dey add brain sha.

Title: Re: Why dem dey invest and Dem no dey get money
Post by: Majestic-milf on September 16, 2023, 12:46:44 PM
Na why gambler no fit get money be this, when Dem win any money after plenty days, weeks, months or years of trying , Dem go hope say make Dem use the money play bigger one if anything go fit drop. Na so them go play until some go sell their property.

My piple, wetin I wan make e clear to us be say, to dey gamble no be wey to make money wey dey sure bcos if we calculate all the money wey u don use since you start to dey gamble, e reach build house or send pesin go university.

The funny part be say them get the belief say if them put a bigger amount, a bigger win go come their way and this mentality dey blind them from taking their winnings home. Gambling nah something wey if you no get self control, you fit enter sapa mode in a matter of seconds. Just like Bitcoin investment, if you dey gamble understand say nah risk you dey take and nah 50-50 something, e fit enter and e fit cut but some dey believe say if e no enter the first hand, e go possibly enter the second one.
 This kind thing nah sometin wey dey worry for society but how we wan take stop am? I feel that nah individual race.

Title: Re: Why dem dey invest and Dem no dey get money
Post by: Charles-Tim on September 16, 2023, 01:12:18 PM
Make we no forget say plenty successful gamblers dey for Naija, example is Mayor of Ekiti (https://twitter.com/Ekitipikin?t=punX_n2iSc6_nEuGcfalZQ&s=09)
You do not have to refer to successful gamblers, it is just a way to encourage people to gamble more and more people will lose money to gambling. If you are not offering gambling service but depending on playing gambling to earn more, that is a fast way someone is driving himself to a remorseful life of depression.

E dey pain me when I see the kind attitude some people dey form untop gambling... your family never chop you carry the small money you get go dey play gamble. Naija no too dey play gamble self... visit US and see how gambling and casino centres plenty and many people dey play am... but e come be say our people no add sense untop am.
Betting agents are in almost every streets in my town. The Southern part of Nigeria is full of gambling agents. Gambling is allowed in many part of the North and many Nigerians are gambling there. Nigerians also are gambling, we do not have to compare because this thread is not a about comparison.

Many Nigerians view gambling as a harmless leisure activity: a recent study of the Nigerian general population found that 36% of adult respondents had gambled and 53% of these people were daily gamblers.

If most of our women are excluded (because most of them are not gambling), that percentage is huge. Most young guys in my street are gambling.

Title: Re: Why dem dey invest and Dem no dey get money
Post by: Adbitco on September 16, 2023, 01:15:43 PM
Make I also address this issues as little I can because na small small we dey take leave bad attitudes. Somehow gambling na investment but when we noticed say nothing dey come out for months or weekly we supposed paused that investment because no results instead our people go still say hope dey while you and I know say no hope.

The biggest mistake we dey always make be say we dey always think say we get time but deeply bro we no get time again, have you considered your real age and think of how many years you need to hustle more to raise your own personal family? Yes this one go vex some people but I go take am say na unserious element go pick offense say why I dey talk like this.

Everything na planning, if you plan you self and your years you go see say better go come out of your works and things you budget. Most at times we go just feel say if we keep gambling one faithful day we go blow but make I tell you the truth, those people wey get that site no be mumu people them know how hard e dey for people to win any bet because, sometimes me dey reason am too the way you predicts games no go be the out and sometime you go dey surprised how come.

Yes, see wetin dem dey do be say them dey always make things dey real for eyes but within their system them know wetin them dey do. But people wey no dey reason out of the box no go understand the logic behind the thing, although I no go say me na expert for gambling but after I take sit come seat down I come know say this one na destiny waster so e go better you shift my thinking to something much better than putting hope for money I know I can't even see for 10 years to come.

Another again na laziness dey cause am why because you see say you don graduate from school with first class or distinction and you see say you no fit start work with at least 30k to 50k, why can't you manage and at the time while you keep praying for a bigger Job or have you also forgotten that those small works or jobs gives you exposure and connect you with a better people in your field of work?

Yes na true me na living example wey get exposed through smaller works to a much higher works, e for say I talk say for what should I go do work of 30k or 50k I for no get lifting and keep in mind that is only God that blesses man, and he can only blessed with the work of thy hands. So like this if you no get at least small job to do how Him fit carry blessed? No way!

So I go say make we remove pride and greed accept reality and know that you have things on your neck to tackle instead of waiting for an awoof money to just hit your balance for place a simple bet, bro things doesn't work that way and even though you must gamble do not capitalized on it otherwise you can't go further to hustle aside it rather you would always want to wait till your luck counts by then you have wasted 10 years for nothing without skills.

Make I rest my case before some people go pick offense but the truth is always bitter and make we no see every small opportunities as a life changing ones because you should know that good things doesn't comes so easily so do not be attracted to investment platforms as well since most of the scammers are really using that aspect to scam people online and in real worlds.

Title: Re: Why dem dey invest and Dem no dey get money
Post by: promise444c5 on September 16, 2023, 01:41:45 PM

Everything na planning, if you plan you self and your years you go see say better go come out of your works and things you budget. Most at times we go just feel say if we keep gambling one faithful day we go blow but make I tell you the truth, those people wey get that site no be mumu people them know how hard e dey for people to win any bet because, sometimes me dey reason am too the way you predicts games no go be the out and sometime you go dey surprised how come.

Normall those site won't make you win easily but instead,  they make you have hope of winning by choosing randomly to give a massive win. However,  to keep you gambling they will pay you little back out of the money lost to them by you . So this will always raise your hope that you will win one day. However if it come to past and you are part of the random  people then count it a jackpot.

Title: Re: Why dem dey invest and Dem no dey get money
Post by: Adbitco on September 16, 2023, 01:48:40 PM

Na wetin make people no fit leave gambling because when them see say them get little winning their brain go rise and them go think say na better thing be that, make we always remember say this gambling no come today and e go dey here we still go as well if you used brain play you no go become addicted gambler or seeing yourself as someone who often make looses when ever you places bets.

Title: Re: Why dem dey invest and Dem no dey get money
Post by: Odohu on September 16, 2023, 01:56:53 PM
Make we no forget say plenty successful gamblers dey for Naija, example is Mayor of Ekiti (https://twitter.com/Ekitipikin?t=punX_n2iSc6_nEuGcfalZQ&s=09)
You do not have to refer to successful gamblers, it is just a way to encourage people to gamble more and more people will lose money to gambling. If you are not offering gambling service but depending on playing gambling to earn more, that is a fast way someone is driving himself to a remorseful life of depression.
I don't know if you see gambling as entirely bad, if that be the case, I do not share that notion with you because gambling is not an entirely bad business... it is just the approach of some people that make it look as if it is bad. Come to think of it, gambling have been there right from time, from pools to papa Ijebu, and now betting and casinos, it has always been there. People have made successes in it.
I still maintain that if proper strategy is applied, gambling can be a very profitable venture. I just gave one example of successful gambler, the list is long.... I even know those who are not ready to work for anybody because they are making it big from gambling. It is all about strategy. I know it is in human nature to criticise what they don't understand so I will not be surprised if many people condemn gambling.... but for the records, gambling is business that you can win with the right strategy.

One good thing you should know about gambling is that it gives people hope which is very good for our health as depression is sometimes the absence of hope

Title: Re: Why dem dey invest and Dem no dey get money
Post by: Franctoshi on September 16, 2023, 04:26:35 PM
The problem here be say plenty pple no get work for we country, e come be say Gambling na him be the surest way to make a living.
Wetin dey happen here be say, If you come start gambling and you lost the first time wey you play,  you go definitely dey tempted to play again make you recover your first money, and you don enter wahala be that.

 Another thing wey make people dey play gamble and dem no dey win money be say,  Imagine how person go take #100 go stake up to 15 -50  games for one slip dey expect say him go win 1 million and become rich overnight, na him make plenty people dey lose money.

I been fall victim of this before until I come learn my lessons, if you wan profit small without losing all the time, stick to playing one or two-games alone to always avoid cut one and stake with a reasonable amount of money u can afford loose. Make you no fear , if you win you win , if you lose you lose, I assure you will see an improved result if you try this method.

Title: Re: Why dem dey invest and Dem no dey get money
Post by: Forever101 on September 16, 2023, 06:02:07 PM

Normall those site won't make you win easily but instead,  they make you have hope of winning by choosing randomly to give a massive win. However,  to keep you gambling they will pay you little back out of the money lost to them by you . So this will always raise your hope that you will win one day. However if it come to past and you are part of the random  people then count it a jackpot.
That's nothing but the truth, most gamblers always think they are smart. The person that owns the gambling companies established them for their own interests and they have their ways of keeping their users with them

Title: Re: Why dem dey invest and Dem no dey get money
Post by: CryptopreneurBrainboss on September 16, 2023, 11:54:33 PM
My piple, wetin I wan make e clear to us be say, to dey gamble no be wey to make money wey dey sure bcos if we calculate all the money wey u don use since you start to dey gamble, e reach build house or send pesin go university.

Gambling so no be wetin you go call investment, just because people dey use am cashout no mean say na investing. E just belike yahoo, because say people dey use am cashout no make am business. Gambling na wetin we suppose dey use to catch fun and entertainment but as dem talk, dis days na wetin you dey do dey enjoy wey dey give you joy na wetin suppose dey pay you too that's why dey say turn your hobby into your job and dat's why many youth dun dey carry ring light every dey do influencing job because dey spend most of their time on social media and they want to be making money from it. Nobi everybody dey lose for gambling so if e dey favor you no wahala you fit continue to dey do am but just try make e no become an addiction problem because e go run you dry. Addiction no be for only people wey dey lose oh because as you dey win so, you need dey watch ur back too.

As you dey wonder where people dey see money gamble, you dun forget say gambling no need much money so, the least 100 h to 1k you dun knack you better odds wey if e sure for you, you fit carry better money go house. Job no dey my broda and people dey find wetin dem go use hold body abi you want make dem go steal or dey uptain people upandan. Gambling na wetin boys dey carry hold their side and although e no dey always click for dem but dat one time wey e enter they give dem better joy and dem get hope say e go click another day.

Everybody fit choose wetin Dem go do ooo, no be by force but me just get small advice say either you find better business or you avoid addiction and always check if u no dey loose so dat u go fit take correct measures.

My piple wetin una think for this matter wey I just yan so.

So if everybody fit choose wetin dem go do, whey you come dey worry yourself, dem know where there weight reach so allow dem make dem carry their cross because you no go carry am for dem. Gambling no be bad thing, difference dey between bad things and good things and also things wey be say dem just dey their dey but when you no do am well e go bad for you but when you run am well e no go good for you and na so gambling just dey. You suppose know ur limit and arrange yourself well so you no go go do pass yourself come dey blame the innocent gambling people dem wey just dey try make end means too and dey provide the platform for you to take run your matter.

Title: Re: Why dem dey invest and Dem no dey get money
Post by: EluguHcman on September 17, 2023, 12:56:38 AM
The possibilities to ruin a business, lavish money or even living a wasted dey very entertaining by addicted gamblers.

I take this for an experience shared is a teacher so to everyone, no wait to sit before the black or white boards or even sitting before a counselor before u fit learn or pick points way dey necessary to u.

1 of the worse categories of persons to entrust money or property for n hand na addicted gambler (s) them dey lost, consciousness of trustworthy if u entrust any with dem.

I remember 1 of my friend way him sister entrust her #60K with him, just within 5 days him gambled all the money including him phone to stake bets and lost all.
Na then him eyes opened and in few days him sister ask am to send am #10K out of the money and hold the rest but to bo avail. Him come dey run Helter skelter looking for solutions til person borrow am #5K but guess what? Him use the #5K go bet again with the believe say him go realize all that of him sister money wasted in the gambling.
Yet him stil dey tell me say him believe say him to be big man through gambling and him no fo stop gambling til him win bigly. Jesus, who do this one?

My people eehh... See! Spirits of possessions dey on many kind oh and this gambling stuff own dey very high.
Una know say e get how u go loose or dey committed to  gambling e go yield u lot of regrets?

Battles of addicted gambler (s)
*Ruin of resources
*Looses of funds and properties
*Engagement to borrowing
*Attracted to stealing
*Lost of personalities/carelessness
*Untruthful
*Frustrations/mental breakdowns
*Lead to suicidal  etc.

To my best research, addition is something that almost gone to stay in for a life time depending the stage it was before battling to let go otherwise, you can fight an addition for years after years without getting off 📴 it. So  I will bring this strategy up in accordance to your addition but I will be specifying on the gambling.

Characters to be considered to get out of get gambling addictions
*Stay of the environment
*Stay of the people that influences you
*If you must have memories towards the path, let it be the negative side of it so you don't find good reasons to embark.
*Don't engage on a challenge/debate towards the path
*Don't clamour of an ex. expert but a shitty fucked up ass.
*Tend to be a good leader of followers. Possibly an offspring.

Addiction is indeed a battle to swim out of and I hope we have got to learn by what happened to others without expecting them to happen to us before we could say we have got experience?

Title: Re: Why dem dey invest and Dem no dey get money
Post by: Adams0001 on September 17, 2023, 02:37:57 AM
The problem here be say plenty pple no get work for we country, e come be say Gambling na him be the surest way to make a living.
Wetin dey happen here be say, If you come start gambling and you lost the first time wey you play,  you go definitely dey tempted to play again make you recover your first money, and you don enter wahala be that.

 Another thing wey make people dey play gamble and dem no dey win money be say,  Imagine how person go take #100 go stake up to 15 -50  games for one slip dey expect say him go win 1 million and become rich overnight, na him make plenty people dey lose money.

I been fall victim of this before until I come learn my lessons, if you wan profit small without losing all the time, stick to playing one or two-games alone to always avoid cut one and stake with a reasonable amount of money u can afford loose. Make you no fear , if you win you win , if you lose you lose, I assure you will see an improved result if you try this method.

Na the truth be that, people dey play gambling because dey no get work for the country and the country done hard now, but i just dey imagine person dey use 100# play almost 30 game to win big money that one go hard before he happen, if no be say you be lucky person the best thing person fit do be say make him dey stake 2odd and double your money that one dey sure pass then playing 15 to 30odd to start thinking about how can the games enter.

people were dey play gambling na the money dey fit lose dey dey use play bet,  anything for this life na just risk we dey take anytime to get profit, dey get people were sabi play gambling very well and dey use to win anytime dey stake money for bet, because even gambling too you go get knowledge about it very well before you stake money. i just believe say if you no take risk for this live you he go hard for you to be successful person.

Title: Re: Why dem dey invest and Dem no dey get money
Post by: Salahmu on September 17, 2023, 11:28:58 AM
When we talk about gambling we shouldn't channel our view point on one direct but we should also need to evaluate the positive outcome of gambling to others because just as you have a real job were you go every morning other sees gambling as there real time job which is actually paying them irrespective of there losses, there are persons who gamble for a living and may have achieve a great things for himself through gambling so if someone like is advising about gambling he encourage people to join it but shouldn't allow yourself to be addicted to it. While those that doesn't gamble always sees a gambling as a means of losing money, gambling is only good for those that have self discipline were as they cannot exceed there targeted deposit and withdrawal weather losing or winnings, in summary gambling is a vise versa because is neither good nor bad is just based on individual mindset about gambling because in as much as people are losing money others are also making money so what works for others may not work for you.

Title: Re: Why dem dey invest and Dem no dey get money
Post by: Forever101 on September 17, 2023, 02:45:57 PM

If you are seeing it from that point, I will like to ask you, how many successful gamblers do you have in your area in a year. Gamblwrs in my areas have work and they keep wasting their money on gambling every year. For the past 20years, there has not been a record of anyone becoming successful through gambling in my local government.

Title: Re: Why dem dey invest and Dem no dey get money
Post by: Davidvictorson on September 17, 2023, 03:05:35 PM
My piple, wetin I wan make e clear to us be say, to dey gamble no be wey to make money wey dey sure bcos if we calculate all the money wey u don use since you start to dey gamble, e reach build house or send pesin go university.
My broda, I like this your advice o. And I agree with wetin you yarn. But one thing be say, gamblers no go ever hear word...and as our people talk say fly wey nor dey hear word go follow dead bodi enta grave.

E go hard to for gamblers to take another person advice because we don normalize am now. For all over social media people dey drop game and whatever have you. E too plenty.

I follow concur with wetin Charles-Tim talk but 1k per month for 100k salary nor go fit make sense to any gambler. Las las Sha be best advice wey a gambler fit get na the one him give himself.

Title: Re: Why dem dey invest and Dem no dey get money
Post by: Sim_card on September 17, 2023, 06:06:07 PM
My piple wetin una think for this matter wey I just yan so
The truth be say lack of job, don make youths dey look for any means to survive without any qualification. Most gamblers wey think say gambling na investment for them mostly, na the only hope wey them go fit use hamma. Wetin I see be say, everybody won hamma, but them no know how to go about am, especially the ones wey no won involve their hands for bad thing. This na e make you see say many youths dey into gambling, but them forget say you can't win the house hedge and many of them don already become addicts wey make, e hard to counsel them and make them listen. I no see gambling as any investment rather I see am as a means of entertainment and if you know understand this, then gambling go be a means of wasting your funds.

Title: Re: Why dem dey invest and Dem no dey get money
Post by: rachael9385 on September 17, 2023, 08:59:46 PM
Well, any body way say gambling na part of investment, nai be say that person either the gambling they favour am or the gambling they gain from am, e get 2 things way they involved:- 1, lose and 2, win, if you no lose for gambling you go win, but I know come understand why some gamblers no they think am like that.
Another thing be say e no good to they addicted to gambling, for this country now people done put their hands for different things and some they do business, investment and some go into gambling, now if you go imagine well those people way no get business but any little money way enter their hand them go use am go bet game, how those people go take progress if them no win bet? Although say some of them gambling fit done help change their life but the once way gambling done scatter their life plenty pass.

Title: Re: Why dem dey invest and Dem no dey get money
Post by: Dr.Bitcoin_Strange on September 18, 2023, 05:30:02 PM
snip

OP, your points are good, but also, it's not everyone and not also all gamblers that are notorious gamblers. Many people are still using their brains, while others, who have always been carried by gambling, are doing their thing, and there's a saying, "You can never help everyone at once." So, there's no way you can convince all compulsive gamblers at once to stop gambling. Here, now, the advice goes to every gambler: just gamble responsibly, or, like my boss has said below, it's wise to only gamble with the amount that the person can afford to lose without even being affected emotionally.

My piple wetin una think for this matter wey I just yan so
I can not agree more than this. A good suggestion is to use 1% of monthly income to gamble. If you are earning ₦100000 monthly, use just ₦1000 to gamble. Some people may not agree with me, but if you want to enjoy gambling, us the amount of money that you can afford to lose to gamble.
[/quote]

LOL ;D, Charles-Tim, I can bet that this advice is literally coming from a non-gambler; it makes chuckle. Seems you don't gamble at all because #1000 is too small to gamble with, especially for someone earning #100,000. Although, like you said in your last statement, gambling with what one can afford to lose is what gives you the taste of gambling, if the gambler overstakes and loses the bet, they definitely will have some regretful feelings in their head.

Title: Re: Why dem dey invest and Dem no dey get money
Post by: Salahmu on September 18, 2023, 10:03:56 PM
If you are seeing it from that point, I will like to ask you, how many successful gamblers do you have in your area in a year. Gamblwrs in my areas have work and they keep wasting their money on gambling every year. For the past 20years, there has not been a record of anyone becoming successful through gambling in my local government.
I have seen a person doing very well through gambling, don't get me wrong I'm only saying what i saw, if you have not seeing someone who won a bet around your neighborhoods doesn't mean that gamblers from other areas will not win or perhaps maybe you have not work round enough to no if actually people are winning on gambling or not, there are good gamblers who doesn't allow themselves to be overwhelmed in gambling and doesn't bet too high, they get two odds and stake higher which gives them chances of always wining, I no gambling is not good and has caused many alot of damage but there are persons who are surviving through gambling.

Title: Re: Why dem dey invest and Dem no dey get money
Post by: Ikechi on September 19, 2023, 07:33:08 AM
Personally I see gambling as game of luck. 50/50 u ft win, u ft lose. Most people see am as an opportunity to try thier luck to increase Thier earnings. I am never against gambling but I am seriously against gambling addiction. And the truth is that gambling can be very addictive. I have never seen any man that rose to success through gambling and that was why I personally quit gambling.

Title: Re: Why dem dey invest and Dem no dey get money
Post by: Mayor of ogba on September 19, 2023, 09:58:52 AM
Gambling na bad thing if you no dey chop from am because you fit ready to use way thing your family or the money way you go use chop use play gamble with the hope say when the gamble enter your family go chop better thing. You go carry am play 2 odds, 3 odds, 4 odds, and 5 odds, and the gamble go still cut. You fit use this update way I want drop here play your gamble so that e no go enter your blood. We know say if person dy play gamble from Monday to Sunday say na die b that. so, I dy suggest say if you no want make gamble enter your blood just dy play only on weekends (Saturday and Sunday)if you no chop either Saturday or Sunday you need to wait till another Saturday or Sunday to try another luck. If you use this update gambling no go enter your blood and you no still wast much money on gambling o.

Title: Re: Why dem dey invest and Dem no dey get money
Post by: AYOBA on September 19, 2023, 03:14:27 PM
My piple, wetin I wan make e clear to us be say, to dey gamble no be wey to make money wey dey sure bcos if we calculate all the money wey u don use since you start to dey gamble, e reach build house or send pesin go university.
Everything now is all about knowledge and still some pipo no understand, if not how can a person go Carry himself go do wetin e don't have knowledge of it, and even some wey know about gambling not all dey win always. Because wetin dey killed some pipo is that how you go play like 20 game and stake N200 dat means e dey aspect to win big money how is it possible?

Title: Re: Why dem dey invest and Dem no dey get money
Post by: sokani on September 19, 2023, 06:31:49 PM
My piple, wetin I wan make e clear to us be say, to dey gamble no be wey to make money wey dey sure bcos if we calculate all the money wey u don use since you start to dey gamble, e reach build house or send pesin go university.
Lol... Na you wey get sense dey reason like that, most of dem no dey reason that way, because e don turn to addition. Dem believe say one day e go jellof for dem and dat day fit no come. Di one wey dey pain me pass na gamblers wey dey use money wey no be their own to gamble. Maybe dem send di person message or dem give am money make him keep, so him come decide to try him luck with di money and before you know it dem don collect everything. But anyhow we wan look di mata sha, e get some persons wey get star for gambling, no be say dem no dey lose but their wins exceed their loses and dem don use am achieve beta things.

Di summary of di mata be say if gambling no dey work for you, quit no be by force say you go hit your first million for gambling and always play with wetin you no go fit afford to lose.

Title: Re: Why dem dey invest and Dem no dey get money
Post by: Dobabe on September 20, 2023, 05:55:29 PM
Perfectly said, people go just dey spend their hard earn money for gambling and wetin dey pain me pass be say no profit for the gambling even if profit dey sef e no pass 70%. My idea for people wey dey play gamble wey no dey see profit....make them use the money open small business or invest on the money because people dey loss money well well  for this gamble and anybody wey dey loss money for something no dey happy and some of them go dey feel depressed.

Title: Re: Why dem dey invest and Dem no dey get money
Post by: Obari on September 20, 2023, 07:17:07 PM
Well, I wan first correct the impression  say people no dey make money from gambling and that one na very big lie as u dey very sure say alot of people especially the youths don get a very stable life through gambling and I no really sure say person go gamble for over 10 years without any result and go still dey very persistent in it.
I understand  say addiction dey very real but rhe truth be say, nobody go dey very addicted to wetin he no dey see result either once or twice.
This your talk for sweet pass for gambling  board but nevertheless I just no buy your ideas for this  thread and wan let you know say people still dey chop better money from gambling.

Title: Re: Why dem dey invest and Dem no dey get money
Post by: gotzekrul on September 20, 2023, 11:16:41 PM
People de make am for this gambling ooo, but the tin be say e de very addictive, to stop am na wahala, na govt no gree provide jobs na why youth just think say dem go fit make am thru gambling, some will make it, some go go village, na so life take be..

Make we sha gamble responsibly..

We need everything to be green to win why the bookies just need one red to win, na so life be

Title: Re: Why dem dey invest and Dem no dey get money
Post by: Fivestar4everMVP on September 21, 2023, 05:01:24 AM
Na true talk op talk so, most especially, mentioning the area of gambling, several of our youths today are so addicted to gambling, and not just the youths, but our fathers too, it's really unfortunate though.

I personally do gamble, but I am not an addict, and most of the time, my gambling is for a reason which I believe many of us here can relate to, if you don't know, ask me and I will tell you ...

I have always advised youth to either learn a trade and go into business, or learn a skill, thank God today, one does not have to break the bank to learn a skill, there are many great things many of us can learn to do through cheap or free online courses, but unfortunately, they never seem to listen .

Title: Re: Why dem dey invest and Dem no dey get money
Post by: SmartCharpa on September 22, 2023, 08:38:07 AM
Well, any body way say gambling na part of investment, nai be say that person either the gambling they favour am or the gambling they gain from am, e get 2 things way they involved:- 1, lose and 2, win, if you no lose for gambling you go win, but I know come understand why some gamblers no they think am like that.
Another thing be say e no good to they addicted to gambling, for this country now people done put their hands for different things and some they do business, investment and some go into gambling, now if you go imagine well those people way no get business but any little money way enter their hand them go use am go bet game, how those people go take progress if them no win bet? Although say some of them gambling fit done help change their life but the once way gambling done scatter their life plenty pass.

We know say gambling win or loose dey, but e get one thing wey dey gambling you go first waste money to the extent you will feel like giving up in life, if God con help the person life e fit get like one winning after wasting a lot of money, our country now a gamblers are very much than those with job, even person wey get business or an investment if he continues to dey gamble without any winning how him go take do? To dey gamble for this life e no good for some people in fact me i can't advise anybody to dey gambling because I know say it will not going to end well, some youth wey no even get any side job will make gamble to be after their life e dey make some people to dey even thief when they don't have money to play game.

Title: Re: Why dem dey invest and Dem no dey get money
Post by: Majestic-milf on September 22, 2023, 11:39:30 AM
 Gambling get good and bad days and sometimes, on a bad day e dey give sign say that day no be day to win. How? You fit stake several games that day and none go give favorable result but just say them believe say e fit enter for them, you go see them funding their account so them fit recover. Got some people, e no go clear them for eye till them use moni wey dey reserved for something else. In essence, if person no get control over gambling, that nah the surest way to make you broke nai make just like alcohol intake, gambling nah something you sopoz involve in responsibly.

Title: Re: Why dem dey invest and Dem no dey get money
Post by: Victorybit1 on September 22, 2023, 12:58:08 PM
I will always say this, it is greed that will make anyone not gamble responsibly. Some people made it through gambling and used the profit to invest in something else rather than putting it all back again and ending up losing all in the end. Recently I won something hooge, after several years of betting. I used the money to support my side business. Just because I won now, it doesn't mean, I will use money that I'm supposed to use for something else to play bet, when my spare money for bet is finished, I lock up till I have another spare one to play again. This is how I do my own gambling.

Title: Re: Why dem dey invest and Dem no dey get money
Post by: Richbased on October 09, 2023, 11:05:07 AM
My piple, make una shift come make we reason this matter wey dey ground bcos many Nigerian na hustler yet Dem dey suffer. I wan talk about wetin dey cause this kind thing , well, no be all I wan talk, na just the one wey dey very important I wan make we reason am .

Shae una no say almost 80% of our youth na ihn dey gamble their money with one platform or the other with d hope say Dem go make big money one dey, many person don gamble so tey Dem no fit buy food for their own mouth again. This same issue don scatter relationship and marriage, many student too wey dey addicted to gambling don drop out for school, some papa no fit send pikin go school bcos Dem dey find magic wey go happen through gambling.

Pesin wey dey gamble ihn money more ten years with no result, wetin go be in later result, na abject poverty. As we dey talk am so, some people dey wey be Bitcoin investor and na gambler Dem be, na gambling Dem dey waste their profit from bitcoins.

Na why gambler no fit get money be this, when Dem win any money after plenty days, weeks, months or years of trying , Dem go hope say make Dem use the money play bigger one if anything go fit drop. Na so them go play until some go sell their property.

My piple, wetin I wan make e clear to us be say, to dey gamble no be wey to make money wey dey sure bcos if we calculate all the money wey u don use since you start to dey gamble, e reach build house or send pesin go university.

Everybody fit choose wetin Dem go do ooo, no be by force but me just get small advice say either you find better business or you avoid addiction and always check if u no dey loose so dat u go fit take correct measures.

My piple wetin una think for this matter wey I just yan so

Well it's not easy for anyone at all in this country, before our youths are not too involved in gambling like this even some persons used to hide and play gamble because of what people will say when they find out you're a gambler. Alot of people were afraid of getting involved in gambling related activities because of what people will say of you but because of economic hardship, lack of job opportunities for our youths a lot of them have been so devoted to gambling to the extent that any money they make from other source they channel it to gambling with the hope that they will make it big one day but yet this gambling keeps taking them backwards, some persons even spend almost all the whole day in gambling offices instead of looking for Jobs they now see gambling as the easiest way to make money and they even increase their interest whenever they hear that someone won millions of naira you will see people trooping to play gamble with the beliefs that they can also win.

This gambling have really caused lots of harm to our youths as most of them involve themselves in criminal activities just to get money to stake online games. Some people even use various tricks to convince people to get money from them to play gamble. Many of our youths have devoted their life to gambling as they spend most of their time, their money and their energy in gamble but at the end no positive results.

Sometimes I don't blame our youths as our government have really jeopardize the hope of the masses and have made life unbearable for the Nigerian youths more especially the people who suffered aand passed through academic discipline(Graduates).

Well, I thank God for platform like this as this platform have help a meaning number of our youths to disconnect their energy from gambling and focus their energy on hustling online just like other countries does. This platform have really opened the eyes of some youths towards digital ways of making a living.

I want to commend the people behind the brain and successes of this platform in our local board here people like crytopreneur brainboss, huge black and so many other legends that have taken their precious time to support each and everyone of us here to help us grow to a certain height, kudos to all of you that are doing great jobs here to make this platform convenient for all of us.

Title: Re: Why dem dey invest and Dem no dey get money
Post by: Silver005 on October 09, 2023, 01:11:33 PM
My piple, make una shift come make we reason this matter wey dey ground bcos many Nigerian na hustler yet Dem dey suffer. I wan talk about wetin dey cause this kind thing , well, no be all I wan talk, na just the one wey dey very important I wan make we reason am .

Shae una no say almost 80% of our youth na ihn dey gamble their money with one platform or the other with d hope say Dem go make big money one dey, many person don gamble so tey Dem no fit buy food for their own mouth again. This same issue don scatter relationship and marriage, many student too wey dey addicted to gambling don drop out for school, some papa no fit send pikin go school bcos Dem dey find magic wey go happen through gambling.

Pesin wey dey gamble ihn money more ten years with no result, wetin go be in later result, na abject poverty. As we dey talk am so, some people dey wey be Bitcoin investor and na gambler Dem be, na gambling Dem dey waste their profit from bitcoins.

Na why gambler no fit get money be this, when Dem win any money after plenty days, weeks, months or years of trying , Dem go hope say make Dem use the money play bigger one if anything go fit drop. Na so them go play until some go sell their property.

My piple, wetin I wan make e clear to us be say, to dey gamble no be wey to make money wey dey sure bcos if we calculate all the money wey u don use since you start to dey gamble, e reach build house or send pesin go university.

Everybody fit choose wetin Dem go do ooo, no be by force but me just get small advice say either you find better business or you avoid addiction and always check if u no dey loose so dat u go fit take correct measures.

My piple wetin una think for this matter wey I just yan so

Well my dear wetin you talk na true and you no say pesin we don sey addicted to comot na problem, and wet you go understand for life be say everybody no be the same as you reason no be as another person reason am because so no believe say the no go make through gambling because them they see others wey win money for gambling and they think say na there be the easiest way to make money, and wetin dey pain me pass be say this pesin wey the play gambling some time e no dey chop and e go carry the money wey e suppose use take chop go play gambling, make i tell you wetin gambling dey cause:
(1) e dey make pesin dey lack of money,a gamblers no dey get money for hand
(2) fight dey come out of the gamblers area anywhere wey them dey play gambling them dey fight well well for there, especially where them dey play whot
(3) gambling go make you dey get hope say if I play this one I go win na so you go dey play dey go before you no it you don become poor man or woman
(4)gambling dey make pesin dey sell sell property anytime anyymoment because you want to play gambling and you no get money at hand you go carry one of your property begin fine who go buy am.
(5) gamblers dey hold debt well well.
Wetin gambling dey cause e too plenty i no fit mention am finish, so I join to advise everybody wey dey do am to play small wey no go make dey poor or begin sell sell property ok, I greet una well well..