Bitcoin Forum

Local => Nigeria (Naija) => Topic started by: Hewlet on September 25, 2023, 12:54:12 PM

Title: Nija sun fit knack sense comot for your brain
Post by: Hewlet on September 25, 2023, 12:54:12 PM
My country  people, I trowe salute give una o!

You know, one bad thing I know too like about us as Nigerians na say we too de adapt to things too easily. Like, the intensity of sun for the country don really de worry like this on a serious note and we seem not to be bothered about it.

Even though now na raining season, any day when sun wan burst out like this, e no de easy at all.

The worst part is that our government and private sectors are doing absolutely nothing feasible to reduce the rate at which the activities of companies flaring gases and the cars putting out poisonous smoke in the surroundings can be curbed.

People are not even being sensitized that much in society regarding the importance of planting trees in our surroundings and even d trees that are already planted have started  being cut down lately.

I fear for the future of our country because the whole issue about climate change is being taken for granted and it appears as though we are just concerned about the presence at the detriment of the disaster that awaits us in the future.

Title: Re: Nija sun fit knack sense comot for your brain
Post by: Makus on September 25, 2023, 01:21:05 PM
My brother, I think say na only me dey experience this same thing oo, including today the kind of sun wey burst out nearly dry my skull ( joking). But on a serious note for this part of the Niger Delta I go say the measure cause of this high sun radiation na because of bunkry (aka kpo fire, local refinery) but if federal government stop am absolutely naim be say e go red for some people be that, because na their source of income for survival be that. Though NNPC dey destroy the refineries (https://twitter.com/nnpclimited/status/1704205670373904684?t=drg7mHA1UcPVLwvMcSgXOg&s=19) back to back but dem nor dey finish

Title: Re: Nija sun fit knack sense comot for your brain
Post by: Bitco55 on September 25, 2023, 01:46:46 PM
Op,
 E for beta if you been research this topic very well before you con write on am.
First of all, isn't the ability of fast adaption a very good thing? If that's how we are, shouldn't we be thankful for our strong resilience and strength?

 Secondly, concerning climate, haven't you heard of the different kinds of climate around the world?
The reason ours is too hot isn't cause of government or private sector activities. Although that has a role to play, the reason is that we're located very close to the equator where the sun hits more than other regions and therefore we feel the heat from the sun more.
    Think about it, our industrialization isn't even up to half of what you'd find in some other countries, but there are still seasons where snow falls regularly. So, the depletion of the ozone layer is worldwide, not just in our country.

And again, don't blame the government, we even need more industries and privately owned production enterprises in this country.

Title: Re: Nija sun fit knack sense comot for your brain
Post by: Sim_card on September 25, 2023, 02:48:54 PM
Like, the intensity of sun for the country don really de worry like this on a serious note and we seem not to be bothered about it.

Even though now na raining season, any day when sun wan burst out like this, e no de easy at all.
Bros, I no understand you. Abi you be foreigner for our country. No be like this be the nature of our climate, ever since history. So you want us not to dey use to wetin we don dey experience since them born us. Nothing anybody fit do about climate, because na nature. Abi you be Albino.

People are not even being sensitized that much in society regarding the importance of planting trees in our surroundings and even d trees that are already planted have started  being cut down lately.
Planting trees should be based on individuals interest and not a most. If government still dey shout for radio everyday make we dey plant trees, Bros no lie, you go gree plant trees when you never chop. Rich men and some VIP areas plant trees and that is it. Let the government take care of the country problem poverty and unemployment and not trees, because I see planting trees irrelevant on helping our broken economy.

I fear for the future of our country because the whole issue about climate change is being taken for granted and it appears as though we are just concerned about the presence at the detriment of the disaster that awaits us in the future.
Climate change is taken for granted in the whole world, and not in Nigeria alone. How many production industries do we have compared to the second world countries. So this is not about Nigeria alone, but we should focus more on production.

Title: Re: Nija sun fit knack sense comot for your brain
Post by: Forever101 on September 27, 2023, 03:15:03 AM
I laugh in Spanish, e be like say , you no know wetinn to post again. Wetin con concern us with sun matter, abi na we cause am. Make we clear table,  talk better story ooo. Non of us dey stay outside naija , even if we dey stay outside naija, we fit run leave our country for any reason?. If you observe very well, na we still dey enjoy pass in terms of climate condition.

Title: Re: Nija sun fit knack sense comot for your brain
Post by: rachael9385 on September 27, 2023, 03:56:24 AM
Omor you done see am so, e just be like say as the country dey hard nah so even the climate self dey change lolz, like watin our parents been talk say before before this sun no hot like this but now you fit take the hotness of this sun take boil eggs and e go durn Wella.
Anyway when I see the title of this your thread laugh just burst from my mouth and even till naw I they laugh but joke apart, nah so our own country dey even other African countries too hot like that and some sun hot pass 9ja sun, but nah so @baba God way dey for heaven take create the country bro.
Like as you dey so you no supposed to complain because those set of people way they treck from one place to another because them no get money to take pay for transaction, na them suppose to complain, abi you self treck life comot for your legs today?

Title: Re: Nija sun fit knack sense comot for your brain
Post by: iBaba on September 27, 2023, 09:29:53 PM
My country  people, I trowe salute give una o!

You know, one bad thing I know too like about us as Nigerians na say we too de adapt to things too easily. Like, the intensity of sun for the country don really de worry like this on a serious note and we seem not to be bothered about it.

Even though now na raining season, any day when sun wan burst out like this, e no de easy at all.

The worst part is that our government and private sectors are doing absolutely nothing feasible to reduce the rate at which the activities of companies flaring gases and the cars putting out poisonous smoke in the surroundings can be curbed.
My mate, I like the part wey u mention the effect of over industrialization in the country that is caused by rhe government and private sectors in the country and the negligence from the Government and the people at large. How for God sake Sun no go flog us. How many people dey even advocate for the reduction of these fossil fuels and climate change, talk more of how government go take put eye into these things. Our government wey we know, no really care much since dem go fit put food for them tables. But the importance of these advocacies cannot be overstated.
Quote
People are not even being sensitized that much in society regarding the importance of planting trees in our surroundings and even d trees that are already planted have started  being cut down lately.

I fear for the future of our country because the whole issue about climate change is being taken for granted and it appears as though we are just concerned about the presence at the detriment of the disaster that awaits us in the future.

Now to comment on the issue of tree planting na to also talk about the massive deforestation wey dey go on for the country across it's length and breathe. Make we dey ask ourselves this question, how many times we dey use charcoal for Abacha stove and we no bother ask about how that charcoal take come. Before you fit use charcoal, person gaz to cut down a timber/tree and burn am. Another heat go comot there as dem dey remove natural resources wey dey country get to protect us against this ozone layer depletion. Why rain no go dey fall anyhow?

Title: Re: Nija sun fit knack sense comot for your brain
Post by: Obari on September 27, 2023, 11:18:42 PM
This Nigeria dey really tire me as na we dey make things hard when like normally no suppose hard and I no know which side of the country you dey but bro make we rest abeg because the same us na e still complain about the rain and I been don talk am earlier when this rain dey do do, I been just know say na so sun go also shine too because meh, the rain been fall badly this period and I also know say the sun go also shine badly so make we no dey in a haste to dey complain.

I go advice you make you try buy face cap or even umbrella and get ready for the sun mate 😂😂😂

Title: Re: Nija sun fit knack sense comot for your brain
Post by: CryptopreneurBrainboss on September 29, 2023, 04:15:57 AM
The worst part is that our government and private sectors are doing absolutely nothing feasible to reduce the rate at which the activities of companies flaring gases and the cars putting out poisonous smoke in the surroundings can be curbed.

The whole thing is as a result of climate change but we dey country wey nobody gives a fuck about the environment. If we dey care the government for dun find way make light dey regular as e go reduce the rate at which we dey use fuel for the country but na there wey some people for government dey chop from so dem no go bring that suggestions instead dem go wan dey sell their generators to us to buy and fuel for we to use operate am. If to say we no get light problem other solution would had been introduce like the use of electric cars but this one wey be say light no dey, the roads no good, if you go buy electric car na yourself wey you dey do. Nigeria is heavily polluted no be here because everything for the country dey polluted from the air, land to water.

Quote
People are not even being sensitized that much in society regarding the importance of planting trees in our surroundings and even d trees that are already planted have started  being cut down lately.

You wan tell poor man to care about environment when him never chop? Every body dey para for the country so this climate change discussion no be wetin dem wan hear now. Everybody is caring for demselfs so you no get right to tell them how to use their appliances. If he government was responsible like other foreign countries den dem for get mouth in how not to use your cars or generators but this one na all man for himself country  The planting of tree awareness need to get more voice as dis one dey very important because trees contribute alot to the environment so we no need wait for the government to dey do this one but we as NGO's fit dey create the awareness in our neighborhoods.

Title: Re: Nija sun fit knack sense comot for your brain
Post by: Majestic-milf on September 29, 2023, 08:53:48 AM
 The truth be say too much sun dey cause a lot of health issues like sunburn, heat stroke, dehydration, hyponatremia, heat exhaustion amongst many and apart from climate changes wey fit play a role in this mata, I also feel say we no dey protected from this punishment unto say most of our trees don dey cut down to build industries wey release harmful substances into the atmosphere and further adding more fuel to the fire. E no gud but if you ask me, e beta pass wen nah too much rain we dey experience as that go cause erosion and this go pose wahala to our crops which go in turn cause food to dey costly.
 Too much rain go cause flood and that no be something umbrella or cap fit solve. Op dey complain say we too adapt and I come dey wonder if nah bad tin be dat because those people for northern part of Nigeria dey experience more sun pass us and dey don learn to adapt so why the fuss?

Title: Re: Nija sun fit knack sense comot for your brain
Post by: Richbased on October 03, 2023, 08:57:13 AM
My country  people, I trowe salute give una o!

You know, one bad thing I know too like about us as Nigerians na say we too de adapt to things too easily. Like, the intensity of sun for the country don really de worry like this on a serious note and we seem not to be bothered about it.

Even though now na raining season, any day when sun wan burst out like this, e no de easy at all.

The worst part is that our government and private sectors are doing absolutely nothing feasible to reduce the rate at which the activities of companies flaring gases and the cars putting out poisonous smoke in the surroundings can be curbed.

People are not even being sensitized that much in society regarding the importance of planting trees in our surroundings and even d trees that are already planted have started  being cut down lately.

I fear for the future of our country because the whole issue about climate change is being taken for granted and it appears as though we are just concerned about the presence at the detriment of the disaster that awaits us in the future.

Despite the fact that Nigeria is close to the equator thereby making it possible for the sun to fall directly on us I still see that the incessant industrial activities in the country like the gas flaring industry have really dissolve the Ozone layers thereby making the sun to still heat directly on us and the worst part of it is that this flaring industries normally give allocation for individuals to be treated but a set of top leaders succumb this funds to their personal pockets rather than making it available to the public.

The sun have really affected us so much over the years by causing eye problems and even making the roof of our houses to rust earlier than it would have ought to be.

Since there is no way these industrial activities can be stopped considering the fact that gas flaring has aided us so much in boosting the economy of the country and even if it is being stopped the deed has already been done so I suggest that the allocation that is being given to the various communities should be checked by the various industries to know if they're being shared equally to the individuals. And I also suggest that the industries should also make provision for an eye check to check the visibility of the individuals and possible treatment if there is an eye defect.

Title: Re: Nija sun fit knack sense comot for your brain
Post by: Y3shot on October 03, 2023, 10:13:01 AM
Naija people are blessed because we sabi adapt to any conditions and we will still be alright. For naija their is no job from the government and private sector but still the youths are still trying their best to do without the government by creating different ideas of generating income. Because of the strength naija people have to adopt things that's why whenever they go anywhere in the world they do well no matter how what the condition of the place may be . Naija man fit go anywhere whether in a cold weather or hot weather still they will still survive the conditions.

Title: Re: Nija sun fit knack sense comot for your brain
Post by: Miles2006 on October 03, 2023, 11:12:49 AM
I  support wetin you dey talk, but my concern no be the sun sef because for me I believe say na nature. The major problem for this Naija Delta na the bunkry, all this bunkry boys no dey hear word despite say them dey find money but the thing dey affect our health. This bunkry of a thing na very dangerous thing oh because anytime them dey cook that kerosine or what ever, salt go definitely dey for the atmosphere and anytime rain fall the salt go con turn to acid rain and na why most people dey suffer from different sickness like cancer. Na why I no go advice anybody to drink rain water. And even if the rain no fall sef the atmosphere no just dey fine for humans to live

Title: Re: Nija sun fit knack sense comot for your brain
Post by: shepherd_gee on October 03, 2023, 12:05:06 PM
Naija na country wey God bless with rich mineral and natural resources, the sun follow for the natural resources we dey flex. Some countries of the world no dey see sun, talk more of hot weather. If sun no shine for one week na you go still complain why sun never shine.

This is my twenty eight years of experience in Nigeria and I can categorically say that every thing is taken for granted. Nigeria na country wey you fit do anything and go scot free surfer you get person for government wey fit back you up. Na why most of the 1st and 2nd world country dey over look us alot cos dey wonder how we survive with the toxic attitude of leadership and administration.

I have lost hope in Nigeria, they promise us change be it climate change, industrial change or cost of petroleum change; we dey see change.

Title: Re: Nija sun fit knack sense comot for your brain
Post by: Baki202 on October 03, 2023, 08:40:29 PM
My country  people, I trowe salute give una o!

You know, one bad thing I know too like about us as Nigerians na say we too de adapt to things too easily. Like, the intensity of sun for the country don really de worry like this on a serious note and we seem not to be bothered about it.

Even though now na raining season, any day when sun wan burst out like this, e no de easy at all.

The worst part is that our government and private sectors are doing absolutely nothing feasible to reduce the rate at which the activities of companies flaring gases and the cars putting out poisonous smoke in the surroundings can be curbed.

People are not even being sensitized that much in society regarding the importance of planting trees in our surroundings and even d trees that are already planted have started  being cut down lately.

I fear for the future of our country because the whole issue about climate change is being taken for granted and it appears as though we are just concerned about the presence at the detriment of the disaster that awaits us in the future.

Nigerians na survival we be and I like the kind of nature we get but if you look am the nature no too make sense because them get some things we suppose clear out instead of adopting, and this issue of weather they seriously affect us like you no fit comot because of the sun and heat we just have to look for things because sun get the way he they affect person.  like
-like wearing proper cloth
-aviod going  out frequently
-for heat, you fit get AC or a reachable fan.
-Drink enough water
they suppose do sensitization about this weather because of this weather of a thing no funny at all, climate change is not only our country problem but na global problem, and we need to start planting trees because our people don cut our trees finish.

Title: Re: Nija sun fit knack sense comot for your brain
Post by: EluguHcman on October 03, 2023, 10:00:52 PM
Country way never fit build dam to take prevent flood way dey terrorised the country na to go against the will of the sun them fit stand?
This sun own na til they kingdom come oh bit come talk of the causes of the hot temperature, na also something we for fit minimize but due to the country bcoming survival of the fittest e con be like e no fit dey avoidable.
And like this even beautifying flowers are being taken down for cooking and others for furniture work and for constructions.

I fit tell u say hardship 4 the country dey contribute almost 30% of the hotness reason why be say
*Agriculture: U know say agric na farm & during farming we cut down trees for bushes and putting them on fire & the hotness dey to heat the ozone layer sure face of the sun like say e dey melt am.
Like this much number of people now dey go into agriculture to see food chop and to trade to make incomes as investments so as the number such people dey increase so, na so the effects to the sun dey expand.

Also, people running from the rural areas to the Urban areas to come look for survival dey also over populate the Cities with more houses needed for settlement. This as a case maybe dey cus people dey chase water out of him ways way be say the water supposed absolve some of the descendent hotness 4rm above the sun and also to bring calmness bt not anymore due to overpopulation and residential demands.

Others na the flares of oil and gas during explorations & the mechanical consumptions way dey ascend the  radius in a close area of time then causes a thermal evaporation increase to the nature.

Title: Re: Nija sun fit knack sense comot for your brain
Post by: Dripplurd on November 13, 2023, 04:07:39 PM
This Nigeria dey really tire me as na we dey make things hard when like normally no suppose hard and I no know which side of the country you dey but bro make we rest abeg because the same us na e still complain about the rain and I been don talk am earlier when this rain dey do do, I been just know say na so sun go also shine too because meh, the rain been fall badly this period and I also know say the sun go also shine badly so make we no dey in a haste to dey complain.

I go advice you make you try buy face cap or even umbrella and get ready for the sun mate 😂😂😂

My brother i think say na only me dey experience that thing  for were i dey ooo, nija sun no be for here ooo especially this sokoto were i dey wey be desert area the sun wey we dey experience for here fit fry yam i dey tell you but me that i have face cap i don use to complain the wey the remaining people do, and in time of rainy season we don use to have excess of rain here.

So if i am you i will just go for face cap, but i don't no your power but for me that can not afford umbrella i only go for face cap.

Title: Re: Nija sun fit knack sense comot for your brain
Post by: Makus on November 13, 2023, 04:31:31 PM

For this part of the south side of naija wey I dey I go say, the sun don dey reduce unlike rainy season period wey everybody dey expect rain but las las na better heavy sun naim come be dey shine, I no go lie the kind of sun wey dey naija fit boil water wey person fit use make EBA  and the major cause na all this buncry aka illegal refinery wey men dey do for this side naim make the sun dey affect us like this for this side wey be rain forest. I remember that year for biology class wey my teacher tell me say the aggressiveness of African animal na due to the high radiation from the sun wey dey touch their skull, naim make African animal are the most aggressive worldwide.

Title: Re: Nija sun fit knack sense comot for your brain
Post by: Mr.right85 on November 13, 2023, 07:46:59 PM
Omo, I really feel say this our local board for Dey segmented into sub boards so that, we for feet dey fit certain things into places way be say, e no go tire person to discern why the post or why them post am for where them post am.

Climate change na very sensitive discussion but, e go hard for you to tell person way no believe in science say, na this thing dey worry am or na even issue at all.
Something way I no understands with OP be say, you really expect people lot to adapt to changes in there environment?
No forget say the laws of adoption is either you adapt or die out o.
While the preaching remains that mitigations and abstaining from fossil fuel should be practiced, we still be a raw material country, our consciousness Dey very low.

Title: Re: Nija sun fit knack sense comot for your brain
Post by: Youngkhngdiddy on November 15, 2023, 06:55:19 PM

  The steady sun wey we dey face for the country na as a result of some factors wey generally fall under the climate change action and reactions. For the country now, we dey celebrate cool weather because we sabi wetin we dey face when sun come out. It is the extra stress it adds to the day plus the tiredness it gives afterwards, the drained ness, the dehydrated level it places us. At that point we don't know the solution to give, all we'd ever need will be a cool soothing weather or water so our temperature at that time would be balanced.
   Excess heat on a norms isn't good for the body but here in Nigeria we take it in on a daily basis, from excess fossil fuels burning and combustion, it accumulates in the environment and joins with the already heated temperature and then still hits back at us. There just should be proper means created for burning this fuel as it'll help regulate the temperature to some extent. We're suffering enough, we really do not need any extra suffering added.

Title: Re: Nija sun fit knack sense comot for your brain
Post by: Jegileman on November 15, 2023, 07:27:41 PM
The worst part is that our government and private sectors are doing absolutely nothing feasible to reduce the rate at which the activities of companies flaring gases and the cars putting out poisonous smoke in the surroundings can be curbed.

People are not even being sensitized that much in society regarding the importance of planting trees in our surroundings and even d trees that are already planted have started  being cut down lately.

I fear for the future of our country because the whole issue about climate change is being taken for granted and it appears as though we are just concerned about the presence at the detriment of the disaster that awaits us in the future.

I miss out on dis topic, I see say e don tey wey you post about am. Naija na place where d government no reallly dey look into d future before dem take some kind decision for d country. About dis tree planting wey dem no dey carry serious ba, I don see one example for place wey I dey. The former Governor wey rule from 2007-2015 been like dat idea and him initiate well, everywhere for town get trees, even sideways for road, tree dey everywhere, even as you dey cross double lane, d middle na still tree divide am. Den come 2015-2023 wen new government show, since no be d same party dem no continue d good legacy wey him start, na so dos trees take die.

The worst of it all, d Governor come go buy interlogs take put for where d trees dey wey dey demarcate double lane say na beautification. E fine but d town come dey hotter dan before, because even dat tin dey emit hin own heat of sun beat am. Ahbeg dis one na advancement ahbi wickedness to the health of people living there. Here na place wey sun no get joy oo and dem still do something like dis. Dis interlog come dey serve as place for people to dey break rule while driving, if dem see say u-turn too far, dem go just climb there come switch to d other lane. If dem offend or break traffic, na still there dem dey use dodge officials wey dey catch dem. Some initiatives need to be think about very well by our government before dey implement dem.

Title: Re: Nija sun fit knack sense comot for your brain
Post by: RockBell on November 15, 2023, 09:34:24 PM
My country  people, I trowe salute give una o!

You know, one bad thing I know too like about us as Nigerians na say we too de adapt to things too easily. Like, the intensity of sun for the country don really de worry like this on a serious note and we seem not to be bothered about it.

Even though now na raining season, any day when sun wan burst out like this, e no de easy at all.

The worst part is that our government and private sectors are doing absolutely nothing feasible to reduce the rate at which the activities of companies flaring gases and the cars putting out poisonous smoke in the surroundings can be curbed.

People are not even being sensitized that much in society regarding the importance of planting trees in our surroundings and even d trees that are already planted have started  being cut down lately.

I fear for the future of our country because the whole issue about climate change is being taken for granted and it appears as though we are just concerned about the presence at the detriment of the disaster that awaits us in the future.

Adapting to this weather we no get choice, yesterday I went to town and the way the sun was shining and hitting me on my head I drank to sachet of water and I was still tasty and when I got home I was feeling headache because of that exposure to that amount of sun. And the problem is we have cutting down trees that are suppose to be helping us and now we are already facing the consequences of our actions, the best we can do now is to plant more trees. Because it won't get better the greenery are the solution I know of. And most of the companies are suppose to support a EIA report to know the effect of does companies in our environment but know the government is not bothered. So many things are contributing to this whole situation and people need to be aware of so many things about the environment. In the future their is going to be a lot of environmental challenges if we don't start taking actions now.

I laugh in Spanish, e be like say , you no know wetinn to post again. Wetin con concern us with sun matter, abi na we cause am. Make we clear table,  talk better story ooo. Non of us dey stay outside naija , even if we dey stay outside naija, we fit run leave our country for any reason?. If you observe very well, na we still dey enjoy pass in terms of climate condition.

I think he just trying to tell us about the environment that we live in and nothing bad in doing that. Is a thing of concern that anything that affects the environment affects us too. Bros enjoy in time of climate condition have you been to Sokoto or kebbi state before and the whole thing is getting worst every blessed day. And people leaving the country is not because of weather is because they want to make more money.

Title: Re: Nija sun fit knack sense comot for your brain
Post by: Lambaz on November 16, 2023, 04:54:59 AM
Lol. Our problem In Nigeria is too enormous for the government to give full attention to climate control, I wish all aspects of the country is good and we only have climate issues. We will live happily in the country

Title: Re: Nija sun fit knack sense comot for your brain
Post by: Promocodeudo on November 17, 2023, 12:04:36 PM
My brother sunshine nature is something else is only God that will help us, talking about our government doing something to remedy this situation, I think such mindset and hope should be given a little concern if you are conversant with the happenings in Nigeria, the government of Nigeria to be precise from time immemorial don't pay attention to this kind of stuff, as long as it doesen't affect them individually even though it does, the will look for a way to make it suitable for only them alone, I can forget the generation work that we heard that has kick off in a local government in rivers state flagged of by the federal government, if you go to that place and ask the people, there response to you, will be sound strange, we only have media completion of projects here, no environmental impact assessment (EIA) everything is done without direction, we hope and pray that things improve soon.

Title: Re: Nija sun fit knack sense comot for your brain
Post by: Stepstowealth on November 17, 2023, 08:47:20 PM
I fear for the future of our country because the whole issue about climate change is being taken for granted and it appears as though we are just concerned about the presence at the detriment of the disaster that awaits us in the future.
There are many issues and dangers that need to be addressed concerning the society, and how our environment is being endangered. Talking about the dangers of exposure to the sun, many people nor really know and na the people wey dey use bleaching products in the name of organic products i dey pity pass because dem dey really expose themselves to cancer of the skin wey the sun fit cause.

For the other of us wey nor dey bleach, we suppose dey steady dey dey on our better sunscreen to protect our skin, sun shades to protect eyes and caps to protect head when we dey place wey we go dey exposed to sun.