Bitcoin Forum

Local => Nigeria (Naija) => Topic started by: Hatchy on October 29, 2023, 09:51:20 AM



Title: Free money wahala!!
Post by: Hatchy on October 29, 2023, 09:51:20 AM
my country people, greetings. so recently a friend of mine who still dey into cryptocurrency but not Bitcoin con dey gist me about all these online miners and airdrop matter, and how so many of them don actually pay am. he still tell me say some two still don turn out to be waste of him time and till date, all the coin wey e dey mine for there just dey useless for wallet. As we dey talk, na e con show me  one miner like dat wey e dey mine for over 7 months now. d miner dey mine eth and talk say until e don mine reach 0.005 eth before e go fit withdraw d coins go wallet. e show me say miner don finally reach d specific amount but when e con dey try withdraw, Dem con dey tell am to deposit 0.005 eth first before e go fit withdraw any money from d Website. as I see dis wan, I just smile because even him self know say na scam.

dis one con make me remember say back in days, there were many off these free miners wey still dey pay person. but now na scammers na come dey run all off them. how you go pay 0.005eth take withdrawal 0.005 eth. it's obviously a scam attempt any one wey mumu try pay money give such website, e money don go. I just say make I bring d matter con our local board as I see say e go dey help full to many of our members here wey still dey new. as I don first write before for one of my thread. Things wey people dey do wey fit put their funds for wahala (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5469277.msg62948572#msg62948572)
you go see say all these free thing fit put your funds for wahala. no matter d price wey dem dey talk tay wine you no fall for any shit. many guys wey I know don loss Dem money and e no get how u wan take get am back.

I con as my guy where e for dey see all these kind links to such rubbish sites, na e tell me say Dem full YouTube. you see the social medias today don turn something else. some time when even me dey scroll through you tube. I dey see many of such videos wey go write 10-20 website that can give you free money. all these sites are nothing but scams or fake website wey just dey there to catch people wey no smart. if Dem don do one or two thing finish you go dey see d money for there Dem go con tell you say make u deposit so so and so amount of money before you go withdraw. d worst part be say Dem fit use these links take hack your wallet. we should all be smart and vigilant. there's nothing like free money on the internet.


Title: Re: Free money wahala!!
Post by: Odohu on October 29, 2023, 10:15:39 AM
Me I know plenty people wey dey mine all these free token them but the thing no move me for body at all at all. Not only say majority of them na scam, they are pure waste of time. The people wey manage collect small money na like once in five years, the money self no reach anything.

If you consider the time you dey spend, the data you use, the memory space of your phone or laptop and the risk you dey exposure yourself to connecting your system to those networks or downloading and installing some of those softwares, it will become clear say na direct waste of time.

As me I no dey do am, I no fit advice anybody to put body for that thing.... e no worth am walahi talahi


Title: Re: Free money wahala!!
Post by: Humblevirus on October 29, 2023, 11:06:43 AM

To get that free money na big wahala for internet ooo, unless someone is just lucky, especially in the cryptocurrency section, because it is the cryptocurrency industry, a lot of scammers are facing this day's to scam people. Make person just imagine what happened to your friend for mining coins for a long period of time after all the stress it discovered say na scam things.what a pity life. I never mined coins before, but there are some people that mined some years ago who say it pays them, but nowadays scams target the portion that is an easy way to attract a lot of people who are looking for free money. The funniest part that will pain person pass is the time wasted on it. Nowadays, if someone wants to involve itself in any airdrop or mining stuff, they need to be very careful; if not, they will scam them. So with this kind of stuff playing around in the cryptocurrency industry, we newbies have to be very careful not to involve ourselves in finding easy money.


Title: Re: Free money wahala!!
Post by: rachael9385 on October 29, 2023, 11:24:28 AM
E really dey very hard to get free money, more especially from online, I done see some of those free token stuffs but I no dey talk am serious because those things me I just dey take them like waste of time and more over, some of this things nah just another way to take scam pipo way put interest for ram, like way the op talk day the guy done reach to withdraw but them say make em still deposit before em go fit withdraw lol chai (see scam), that nah big scam, just imagine say now the guy foolishly deposit the money ::) e go just be like film for em eyes the way the money for take enter voice mail, even the won way e been deposit self e no go see con talkless of the won way em won withdraw.
Those tokens them I believe say now e no dey pay again, nah before before way BTC never even com on board nai those kind the pay.


Title: Re: Free money wahala!!
Post by: Fivestar4everMVP on October 29, 2023, 11:50:07 AM
Na true say no free money for internet, but on some how, some lucky people still dey see free money collect from time to time.

But anyway, no be that one make us dey discuss this Sha, so make I bone that side.

Let me say that 99.99 percent of all this mining stuff are nothing but either a scam waiting to happen, or a ponzi scheme that will eventually crash when new people stop joining and new fresh money stops entering their system so they can use and pay the old members. We must always be vigilant and try as much as possible to avoid such platform because the chances of getting money out of such a platform is always slim, most especially for those joining late if the site is a ponzi scheme, like the one reigning in my area now, they call it Argo, I just dey pity people wey dey put money for this supposedly mining company - as they call themselves.


Title: Re: Free money wahala!!
Post by: Agbamoni on October 30, 2023, 10:34:55 AM
Normally free things they purge. Ah no no why since the origin of this mining something my interest no even they am. The only one ah fit remember say ah do na one music app like that wey ah they do some task like watching of videos and playing of music then if i get like 100 points ah fit withdraw am. E dey take me up to 1 week to get those point and after that 1 week the money they only b 2$. All those things nah waste of time cos if you calculate the money you go carry buy data and the time wey u go spend to con they play those music and watch video with other small small task person done use that time do better things. Na so ah use stop, but ah never try do anything wey be say nah mining cos e no they pay even the pi network sef wey them carry preach everywhere ah no do am for one day. My beleif nah say nothing good comes easily and nobody go one give you money wey u no get better thing to offer to am.


Title: Re: Free money wahala!!
Post by: Doan9269 on October 30, 2023, 12:17:21 PM
I can't remember if I've participated in any thing of such again called cloud mining ever since i discover that everything was just nothing than a waste of time, why will you be too eager of making money without coming across things like this, they will use your time, energy, data and at the end of it all, there will be no reward awarded because they will subject you to an unfinished task that you cannot cope or manage to finish, this is more often a scam and people are getting to realized that, after alot of others have been a victim of many related offers.