Bitcoin Forum

Local => Nigeria (Naija) => Topic started by: Forever101 on November 07, 2023, 03:42:32 AM

Title: With the current hardship??
Post by: Forever101 on November 07, 2023, 03:42:32 AM
For a while I have been away, just taking a break though. So my country people, how una side and how the harmattan of our economy they blow for una side. As the country be na everyday things dey dey hard, money no reach to buy things anymore, how person go come invest for this harsh time.

If e happen say , everywhere red for you, you fit chuck hand for your investment take save your self from the current economy situation even when you know say, Bitcoin halving dey for one corner

Title: Re: With the current hardship??
Post by: Amphenomenon on November 07, 2023, 04:07:24 AM
The economy is bad and will still get worse but the fact is that it doesn't mean you have to be taking your invested bitcoin. To avoid all this set up plan for your bitcoin investment, invest in a amount that you know will not affect your cost of living, you are investing not saving so if you continue to take what will now be left of your investment funds?

Title: Re: With the current hardship??
Post by: Gozie51 on November 07, 2023, 05:45:48 AM
If you know get real need to dip hand inside your bitcoin investment e better make you leave am because this coming halving be like say e go really dey bullish with how things dey go for global economy. The wars wey dey go on don cause inflation to dey increase and that one don dey make more people dey carry fiat take hedge in btc, so e go make more value for btc. But if person get health issues and other serious challenge wey him go carry the money from bitcoin take solve then it should be done afterall na your money and na person wey dey alive dey invest.

Title: Re: With the current hardship??
Post by: Makus on November 07, 2023, 07:53:50 AM
For a while I have been away, just taking a break though. So my country people, how una side and how the harmattan of our economy they blow for una side. As the country be na everyday things dey dey hard, money no reach to buy things anymore, how person go come invest for this harsh time.

If e happen say , everywhere red for you, you fit chuck hand for your investment take save your self from the current economy situation even when you know say, Bitcoin halving dey for one corner

First of all welcome back from your trip outside this forum, normally na everywhere the hardship harmatan dey blow and person wey say e no dey blow for em side, mean say that person dey on better Fundz or e nor dey the country at all. Then when we dey talk about Bitcoin for this kind of economy, our baba dem dey always advise say Bitcoin no be do or die affairs, if you no fit meet up again abeg just try make you take care of yourself because na who dey alive na im dey invest for Bitcoin, you fit just stop for the main time until you balance again. If not na wattin be the profit to dey rush rush when if hunger hook you well na still your coins you go sell with drop by transact fee or withdrawal process. Person wey say e no go chuk hand put for em investment when everywhere red, make you just know say that person get backup wey e go return to.

But before this time e for good make person get small savings for fiat because of all this kind of things, and person wey like to enter bitcoin holding make e make sure e get work wey dey pay, if not na front and back that Lind person go dey go, Bitcoin was created for all but no be everybody go fit put body do am.

Title: Re: With the current hardship??
Post by: rachael9385 on November 07, 2023, 08:05:40 AM
For a while I have been away, just taking a break though. So my country people, how una side and how the harmattan of our economy they blow for una side. As the country be na everyday things dey dey hard, money no reach to buy things anymore, how person go come invest for this harsh time.

If e happen say , everywhere red for you, you fit chuck hand for your investment take save your self from the current economy situation even when you know say, Bitcoin halving dey for one corner
Guy,,, the main coco be say, make person no go invest for Bitcoin if him no get any means of making money, watin I mean be say, if person no get job make em no go invest for Bitcoin because the investment no go get any valuable value.
Many jobless pipo go think am say, Bitcoin nah the easiest way for them to make quick money (while nai lie). For inside Bitcoin investment, if person no get good source of income (steady income) the person no go fit hold em coins for long terms because as SAPA hole am em go press the sell button and if care is not taking, the person go even fit sell all em holdings, so creating a good source of living first before investing in Bitcoin is the major thing some investors should do before investing into Bitcoin.

Title: Re: With the current hardship??
Post by: Samlucky O on November 07, 2023, 09:20:31 AM
If e happen say , everywhere red for you, you fit chuck hand for your investment take save your self from the current economy situation even when you know say, Bitcoin halving dey for one corner

Bitcoin investment no be something person sopos to dey toch anyhow. That's why dem dey always tell us say every money wey we get make we dey always take small small portion dey invest for Bitcoin. Maybe out of %100 make we dey save at least%5 to %10 every week so that in time like this. you no need to reason on how to sell your Bitcoin for Xmas celebration.

Title: Re: With the current hardship??
Post by: Adams0001 on November 07, 2023, 11:05:19 AM
For a while I have been away, just taking a break though. So my country people, how una side and how the harmattan of our economy they blow for una side. As the country be na everyday things dey dey hard, money no reach to buy things anymore, how person go come invest for this harsh time.

If e happen say , everywhere red for you, you fit chuck hand for your investment take save your self from the current economy situation even when you know say, Bitcoin halving dey for one corner

No dey rush life anything where people dey do na gradually the economy no dey stable like before, bitcoin no be thing where you go dey rush since you no get money no think say you go use your savings money invest for bitcoin the money you save you budget am for something else so you see the economy no go straight forward you go use the money make you invest make you get profit, but you know that bitcoin is volatile the price can fluctuate anytime, I see you asking these questions I think you don't have anything doing Just keep saving and have a place where you can generate income so that you can have enough money to invest in bitcoin. No one can predict bitcoin so if you invest now and the price drops dramatically, you won't be able to be patient and leave it for the long term because you don't have enough money.

You see how the economy dey now just go find work do or any business where you fit do and survive because we don't know when this hardships go stop now we just need to work hard and stop complaining because na our leaders dey make things hard for the youth, every 8 years new government comes site something most change buhari turn president things hard foodstuffs just add price nothing come down, He close border say make we dey do things buy our self make we no buy any product from outside, now Tinubu turn president he just remove subsidy for fuel everything just increase price fuel where we dey buy 160 litres done reach 623# each litres now anything you on go buy if the price to high and you complain dey go talk say fuel done cost.

So my bro, how this thing dey happen for naija you think say he go stop now if this our leaders fight for solution but dey don't know go do because na them dey cause am corruption done full everywhere because na every year things dey happen you go just dey see different things just pray and look for something doing that you make you survive and be getting small money because we don't no when this hardships go stop we just dey pray make the thing stop soon and make the country good for us, Just go find anything to do and forget about this issue for naija all these big peoples where you see dey don't no waiting dey sub because dey get money even whatever cost dey go purchase am because money know be their problem so my bro just leave this wahala and hustle that all and you go enjoy.

Title: Re: With the current hardship??
Post by: Youngkhngdiddy on November 07, 2023, 10:04:10 PM

  Omor the hardship dey tire  everybody eye, both old and young, poor and rich, everybody is hit hard. Right now even getting cash gifts from people seems like a huge task cos of the economic situation. The solution is not saving cos a time will come when these savings would be needed. It's not even just mere earning, a random or low earning will still mean struggling through survival, do your best to earn big so the struggle will be less.
 Invest in productive businesses is also a good idea but be cautious of the investment, and do not use all the savings. Everyone is in a haste to make meaning out of life even in this hard situation, so the whole process is getting tough and challenging but one just has to scale through. It's not our fault, it's evident that our corrupt, greedy and self centered leaders are just not ready to help change the system and status of the economy but what can we actually do.

Title: Re: With the current hardship??
Post by: nelson4lov on November 07, 2023, 10:44:46 PM
If e happen say , everywhere red for you, you fit chuck hand for your investment take save your self from the current economy situation even when you know say, Bitcoin halving dey for one corner

The truth is that I would definitely do that if push comes to shove because the truth is this is life and how much one has doesn't really matter much if you're bot alive or well to enjoy it. So yes, I go commot am keep myself up and running because as long as life dey, hope dey and more opportunities to recoup go come.  Although I know say I fit miss out from the potential upside opportunity wey bitcoin hallving go bring but that notwithstanding, more opportunities go come. People wey enter crypto when Bitcoin peaked $20k in 2018 been think say them dey late to the party.

Title: Re: With the current hardship??
Post by: iBaba on November 07, 2023, 11:11:27 PM
For a while I have been away, just taking a break though. So my country people, how una side and how the harmattan of our economy they blow for una side. As the country be na everyday things dey dey hard, money no reach to buy things anymore, how person go come invest for this harsh time.

If e happen say , everywhere red for you, you fit chuck hand for your investment take save your self from the current economy situation even when you know say, Bitcoin halving dey for one corner

My mate, e hard for me so tey I no get any money to save for investment now. Na so so hand to mouth I dey take survive now. It's unfortunate that we have to discuss this more than one times here but it just shows how realistic and truthful the current situation is now. Nigeria is almost bent on its knee as a result of the hardship the citizens are facing.

The fuel pump is getting more expensive by the day which is the reason why commodities in the market is also following the upward trend of becoming more expensive by the day. Surprisingly none of these commodities are scars in the market or at the farm. Not even the petrol in its self that is scares. But our leaders and the bourgeois will always create an avenue to make life uneasy on the young ones . We need to arise o compatriots and come together under a single voice and character of national interest above every other personal interests we have

Title: Re: With the current hardship??
Post by: Jamestown70 on November 08, 2023, 02:52:32 AM
🤧🤧 this our present economic status is so bad imgaine a litre of fuel #700 in my area our viewing centre now they dey very scanty because of the increase in fuel and also the increase in our part, this na just my own experience o what of other person's out there way things dey very bad for them how them dey cope omo everything dey God hand to handle

Shalom

Title: Re: With the current hardship??
Post by: Hewlet on November 08, 2023, 05:12:04 AM
For a while I have been away, just taking a break though. So my country people, how una side and how the harmattan of our economy they blow for una side. As the country be na everyday things dey dey hard, money no reach to buy things anymore, how person go come invest for this harsh time.

If e happen say , everywhere red for you, you fit chuck hand for your investment take save your self from the current economy situation even when you know say, Bitcoin halving dey for one corner
e de very funny how topics relating to the hardship in the country don become the most comfortable topic for people to easily relate with. And some lazy people go even use this whole "the country is hard" stuff to support there laziness and won't go out there and look for something reasonable to start there lives with.

One thing we need understand for the situation of our country be say I no de even see any possibility say things go better like that anytime soon but you self fit make the decision to better your life by being intentional about your financial state and with time, if dollar like make e rise or drop, if fuel like maker e scarce or not or the price of yarn go as high as possible, e no go affect you that much.

And the thing about investing into bitcoin or any other investment you de do be say you no go see say hunger de show you shege and you know say you get wetin you fit sell use sustain yourself den still allow hunger to continue making mess of you. The temptation to use your investment take hold body for the moment go come to your mind and you might not be able to resist it.

What I'm saying in essence is this, regardless of the harmattan when de blow every where, make we still try find something wen we go do when go fetch us some money so our mind fit commot for our bitcoin investment.

Title: Re: With the current hardship??
Post by: Y3shot on November 08, 2023, 09:03:04 AM
Country hard oo, this time wey we find ourselves in is a very difficult time, money no even get value and even if money dey to even business it is so difficult to think of the business to do . But since the country done be like this their is nothing one can do it is just better for one to remain positive that better things will come one day. The price of things in the market is very expensive that 500 naira no come get value again.  I think the hardship is really affecting everyone irrespective of the class you belong to. Government no even dey try to make effort for things to get better.

Title: Re: With the current hardship??
Post by: Zanab247 on November 08, 2023, 10:20:43 AM
Quote from: Forever101
For a while I have been away, just taking a break though. So my country people, how una side and how the harmattan of our economy they blow for una side. As the country be na everyday things dey dey hard, money no reach to buy things anymore, how person go come invest for this harsh time.
If you are ready to invest in BTC in this bear run, I don't think the hardship will stop you not to invest because as some people are complaining about the hardship in the country,there are some people celebrating their different estates and other business they are establishing in the land. Harmattan is my best period but is not strong yet in my area but it look like what will increase heavy before the end of this week.
Quote
If e happen say , everywhere red for you, you fit chuck hand for your investment take save your self from the current economy situation even when you know say, Bitcoin halving dey for one corner
I no fit sell my BTC I struggle to buy for dis bear season because of d economy situation than to bear d hunger and d hardship because I no dat our government go do something soon to remove dis inflation dat is causing many people to do bad things just to sustain for their living. Now dat will begin to dey see some signs in d crypto market that look like say d price want to go up like d way it go up last 3 years for those that invested to earn well.

Title: Re: With the current hardship??
Post by: Lida93 on November 08, 2023, 10:27:59 AM
Country hard oo, this time wey we find ourselves in is a very difficult time, money no even get value and even if money dey to even business it is so difficult to think of the business to do . But since the country done be like this their is nothing one can do it is just better for one to remain positive that better things will come one day. The price of things in the market is very expensive that 500 naira no come get value again.  I think the hardship is really affecting everyone irrespective of the class you belong to. Government no even dey try to make effort for things to get better.
The height of economic hardship in the country is becoming unimaginable that you don't know where to place your hope in for a better tomorrow. Worst of it all is that the prices of goods and services are increasing 3x higher of it's previous price within the spate of every three months and the government with all the economic policies they are making we are not feeling a remedial effect.

The scary gull about this hardship is how it's penetrating into all economic class in the society with scarcely any person not complaining how's things has been tough their their livelihood. The rhetoric is that if the rich and wealthy are complaining about the hardship then how's the poorest of the poor surviving in this hard times. I am trying not to imagine it.

Title: Re: With the current hardship??
Post by: EluguHcman on November 10, 2023, 09:22:11 AM
Of course nobody go get money somewhere and u dey at the point of desperate need of money and u just chill. No way. Even I don hear some of us say... "Nomatter how needy them be say e get some person's them no fit meet as needy".

I think those set of persons never dey handicap situations before.
This na same thing OP dey relate about here.
U no fit dey take because u dey stick to the hodl of your Bitcoin while u roasts. Life before Treasury pleasures oh my people.

Such situation na really why person no need to rely em source of earning on Bitcoin because the frustrations that is accompanied when u want to sell your Bitcoin for just small tin like hungry dey very unbearable when u stays behind in just no time after your selling and see the bull-run in the Bitcoin markets.

Title: Re: With the current hardship??
Post by: Spaceman1000$ on November 10, 2023, 02:11:05 PM
For a while I have been away, just taking a break though. So my country people, how una side and how the harmattan of our economy they blow for una side. As the country be na everyday things dey dey hard, money no reach to buy things anymore, how person go come invest for this harsh time.

If e happen say , everywhere red for you, you fit chuck hand for your investment take save your self from the current economy situation even when you know say, Bitcoin halving dey for one corner

The investment way you make, na to save you from the raining days, so if you're raining days don reach, Omo na to put hand inside that your investment collect small, take survive first.

You no go dey inside water soap  dey enter you eyes na. Except say your investment Never mature, or e dey at a cradle stage, that wan be say, I go say make you look for another hustle take dey hold your side, pending when you go get a return in your investment.

Title: Re: With the current hardship??
Post by: Promocodeudo on November 10, 2023, 02:17:25 PM
OP, welcome back from your time off, we need to understand that as Nigerians, the suffering is everywhere just those in power and the influential people don't feel it much, they only feel it when they buy petroleum products which they use lesser amount of money to purchase before or payment of flight ticket, but as an ordinary citizen, we feel it in all aspect, you talk about one withdrawing investment to help him or herself, op, you have forgotten so quick that, it is not everyone that's here that have an investment in either bitcoin or in other things, some people barely have mobile data to even browse the internet, the case of hardship in Nigeria has taken another shape, if someone has an investment it is good to withdraw a little to solve some issues,thats if there is know alternative, but on general note having an extra hustle aside your investment is good, that's if you can lay hand on one.

Title: Re: With the current hardship??
Post by: Obim34 on November 10, 2023, 02:37:02 PM
The hardship touch every body and e no easy but one thing be say we must surely out grown this level and for here rain still dey fall heavily I no know for you and where u see ur own harmattan 😅

Just as e red so, from my own perspective I no go advise you to chuck hand come remove funds from your investment portfolio, e no go make nah before you bring the money invest shebi u see say na for the long term and you don cross ur mind finish, make u no come go back for wetin u don decide. Try relax options choke and as well if u dey earn monthly try as well to dey secure emergency funds cos the way e be now money no get to finish for person hand

Title: Re: With the current hardship??
Post by: RockBell on November 10, 2023, 05:39:34 PM
Country hard oo, this time wey we find ourselves in is a very difficult time, money no even get value and even if money dey to even business it is so difficult to think of the business to do . But since the country done be like this their is nothing one can do it is just better for one to remain positive that better things will come one day. The price of things in the market is very expensive that 500 naira no come get value again.  I think the hardship is really affecting everyone irrespective of the class you belong to. Government no even dey try to make effort for things to get better.
Things are getting more difficult and when you do your observation well you will know that it is not only in this country, the world is suffering from a global economic downfall just that ours is worst, the majority of people living in this country are just trying to survive and naira as lost its value and the dependence of dollar is serious affecting our own market, in the sense that if the dollar is high so is the price of stuff, our market should depend on our own currency then it will be better. let us just be positive and hope for the best to come. even a thousand naira does not have value anymore and if you notice our politicians they don't steal millions anymore they are still billions because millions can keep them up anymore.

Title: Re: With the current hardship??
Post by: Victorybit1 on November 10, 2023, 06:01:38 PM
If you dey invest in bitcoin, just know say is a long-term investment, remove your mind from it. Only invest what you can afford to let go for a long time.
In this present economy, everyone should have something doing and not rely on an investment.

Title: Re: With the current hardship??
Post by: Marykeller on November 10, 2023, 08:15:41 PM
If e happen say , everywhere red for you, you fit chuck hand for your investment take save your self from the current economy situation even when you know say, Bitcoin halving dey for one corner
That one for d if to sae peso d solely depend on bitcoin for survival. But as the matter be so, peso get other side hustle wey em d into to cope and manage em self for this hardship wey APC led government bring give us so.

Peso investment for bitcoin na for the future, na why em be sae, before peso start em investment journey for bitcoin, you are advice to invest with money you never the use so since the future can't be ascertained to know when bitcoin go do well for price for peso to withdraw em profits for em bitcoin investment.

I no d sure sae whether I go fit d among those wey go chuck their hands for theor bitcoin investment wey dem d make since toward the halving and bull run, just because of the present economic situation of the country.

As I d so, I no think sae I go fit risk my future riches for the present situation of the country. As I come know sae the bitcoin wey I hodl today go do marvelously well for price tomorrow when the bull run start by 2024

Title: Re: With the current hardship??
Post by: Roseline492 on November 10, 2023, 10:51:54 PM
For a while I have been away, just taking a break though. So my country people, how una side and how the harmattan of our economy they blow for una side. As the country be na everyday things dey dey hard, money no reach to buy things anymore, how person go come invest for this harsh time.
My brother e no easy ooh but however we no they reason those matter again because e done become normal thing for we 9ja here, however I don't no how people for take cope like say online self no they, so perhaps online done creat plenty opportunity way be say u no gat depend on the government make them give you work before you go start to they make money.

So plenty courses they online way you go fit learn and apply for work online because if we talk say we go wait for our government before we go start by the time we go realize ourselves old age done come.

Title: Re: With the current hardship??
Post by: Y3shot on November 10, 2023, 11:09:03 PM
For a while I have been away, just taking a break though. So my country people, how una side and how the harmattan of our economy they blow for una side. As the country be na everyday things dey dey hard, money no reach to buy things anymore, how person go come invest for this harsh time.

If e happen say , everywhere red for you, you fit chuck hand for your investment take save your self from the current economy situation even when you know say, Bitcoin halving dey for one corner
No be small thing my brother, economy hard no be lie. Money no even reach anywhere to buy things for market again,  everything fir market they very expensive and the worst thing about this thing is that the price keeps increasing every day. The country dey in a terrible situation wey be say e go hard for things to become normal.  Right now the price of petrol is very high and naira to Dollar is very high too, this is what is really affecting the price of things in the market.  The government no dey even try at all for things to get better in the market , the only thing dem dey fight for is for their own pocket.

Title: Re: With the current hardship??
Post by: gabbie2010 on November 10, 2023, 11:39:10 PM
For a while I have been away, just taking a break though. So my country people, how una side and how the harmattan of our economy they blow for una side. As the country be na everyday things dey dey hard, money no reach to buy things anymore, how person go come invest for this harsh time.

If e happen say , everywhere red for you, you fit chuck hand for your investment take save your self from the current economy situation even when you know say, Bitcoin halving dey for one corner
Man must survive at all cost so even if situation tight the last option na to dip hand into investment to save the situation afterall hunger know no anybody even with Bitcoin halving coming up person must survive first, it's very unfortunate that the country economy is very bad, inflation is too high and cost of goods and services don high such that salary alone is not enough to cater  for all those expenses, infact people wey even get investment are even very lucky some people no get that opportunity they live from hand to mouth, unfortunately our politicians don scatter everything with the removal of fuel subsidy making things to be more difficult, I pray we all survive the current hardship.

Title: Re: With the current hardship??
Post by: Onyeeze on November 11, 2023, 03:30:03 AM
For a while I have been away, just taking a break though. So my country people, how una side and how the harmattan of our economy they blow for una side. As the country be na everyday things dey dey hard, money no reach to buy things anymore, how person go come invest for this harsh time.

If e happen say , everywhere red for you, you fit chuck hand for your investment take save your self from the current economy situation even when you know say, Bitcoin halving dey for one corner
This man wey una dey call una president wey be rich man wey no even win one vote for nigeria make everything to be worst since wey e be una president, I no sey nigeria wey be our country e dey hard before somebody can control nigeria well and remove inflation but president Goodluck Jonathan  did it and everybody for nigeria dey rejoice and dey celebrate but since dey use national independent commission to remove Good luck Jonathan wey be better president for our country naija na e make we dey suffer different things, all una leaders wey dey government house na dem the course our problem for this country, so I dey one place dey do my business and for get government and their leadership wey be yeye leadership

Title: Re: With the current hardship??
Post by: Jegileman on November 11, 2023, 08:12:16 AM
For a while I have been away, just taking a break though. So my country people, how una side and how the harmattan of our economy they blow for una side. As the country be na everyday things dey dey hard, money no reach to buy things anymore, how person go come invest for this harsh time.

If e happen say , everywhere red for you, you fit chuck hand for your investment take save your self from the current economy situation even when you know say, Bitcoin halving dey for one corner

We all understand say d economy for d country bad but make dat one no make us go take decision wey no go make sense later. Money wey don enter bitcoin, make we dey try comot our mind for there and we no dey pray say we go dey situation wey go make us go touch dat money back because say d economy bad and we no get choice dan to go do dat. Any money wey I don put for investment, e don dey there be dat until d time wey bull run come. Anything wey good dey take time to happen and if I say I no wan wait patiently, I go miss out greatly for dis thing wey I don dey anticipate for long. Make we try comot our eye for our bitcoin investment, make we sought for other means to make money so dat we no go touch d investment even as d economy bad reach.

Title: Re: With the current hardship??
Post by: Asiska02 on November 11, 2023, 08:38:33 AM
For a while I have been away, just taking a break though. So my country people, how una side and how the harmattan of our economy they blow for una side. As the country be na everyday things dey dey hard, money no reach to buy things anymore, how person go come invest for this harsh time.

Dis economy breeze dey really blow dey hit everybody o but we still dey gallant and we no he step back or give until we achieve wetin we want. The economy bad well well but dat one no go stop us say we no go do d right tin if e come to investing for bitcoin. We go dey save dey invest for bitcoin no matter how small e be, I just know say one day we go get better profit for dis hard decision wey we take, even as we dey try manage everyday.

Quote
If e happen say , everywhere red for you, you fit chuck hand for your investment take save your self from the current economy situation even when you know say, Bitcoin halving dey for one corner

Make we no touch money wei don entails there, if we touch am so, our 1BTC no go be 1BTC again o. Even as d market don dey green so, make we no dey carried away by d little profit wey don dey on top, make we just hold d ones wei we don put till better time come to cash an out.

Title: Re: With the current hardship??
Post by: Forever101 on November 11, 2023, 08:11:54 PM

Dis economy breeze dey really blow dey hit everybody o but we still dey gallant and we no he step back or give until we achieve wetin we want. The economy bad well well but dat one no go stop us say we no go do d right tin if e come to investing for bitcoin. We go dey save dey invest for bitcoin no matter how small e be, I just know say one day we go get better profit for dis hard decision wey we take, even as we dey try manage everyday.

Make we no touch money wei don entails there, if we touch am so, our 1BTC no go be 1BTC again o. Even as d market don dey green so, make we no dey carried away by d little profit wey don dey on top, make we just hold d ones wei we don put till better time come to cash an out.
my brother ur talk na better one, hmmm the situation wey country dey now and wetin we go aspect in there nearest months no dey friendly oooo. Wetin person go do now, money wey person dey earn no increase and yet cost of living dey increase, how man go cope.make God help us all, amen

Title: Re: With the current hardship??
Post by: Chilwell on November 16, 2023, 01:09:42 PM
The economy is bad and will still get worse but the fact is that it doesn't mean you have to be taking your invested bitcoin. To avoid all this set up plan for your bitcoin investment, invest in a amount that you know will not affect your cost of living, you are investing not saving so if you continue to take what will now be left of your investment funds?
Na the mistake wey some people dey make be that, they no dey plan things well well because people they shout say Bitcoin halving dey near some people go park all their money and even sell some of the few things dey get to come dey part of people wey go benefits from the gain, I dey support wetin dey dey do ooo because the way wey country dey now everybody dey fine way to make money and bitcoin na the way now but the koko be say make we dey reason any matter well well before we go into it.

Now wey everywhere hot now person need to they plan well well because the way wey things dey increase prices day by day if we no plan am e go affect our investment because e go lead us to dey put hand for the investment wey we don't do before and e will come be say we no invest at all. The thing be say make we dey predict the future either positive or negative so things no go hard for us because if e come positive na our gain e be and if na negative we dey save.