Bitcoin Forum

Local => Nigeria (Naija) => Topic started by: Agbamoni on November 16, 2023, 05:18:20 PM

Title: The journey wey you plan the least nah him fit give you the most
Post by: Agbamoni on November 16, 2023, 05:18:20 PM
Sometimes when I de reflect on how far I done come for the tech and cryptocurrency space, and all the things and experiences I don gathered so far, e de amaze me seriously. Growing up, I been de seriously into playing of keyboards and instruments in church and I been seriously think say na from there I go take make a living, later as I begin grow come enter street, the vibes to de follow up church matter come drop and I no come de take the instrument stuff very seriously. I come later enter into phone repairs come de enjoy the work wetin no nice and come even de make small savings say I go use start up my own phone repairs shop. As I get admission into school na there the whole phone repairs matter come die like that and I come say make I try focus on school small but e no take time when the interest begin die down. We just de get small conversation and my friend just bring up the matter weda I de interested to go into tech, I been no take am seriously but with time as I come de visit my guy come de see how him de work, I come say make I follow try see how e de be and with time I come de enjoy the stuff small small.

E done de reach almost 3 years when I don de do this work with my guy and I don get serious sense of fulfilment as I de do the job so! Nah so ah con still join the forum as they come give me update about bitcoin and so far the journey has been filled with fulfillment and happiness.

Wetin I de try talk be say make we no de write anything off like that on  the first appearance, make we continue to de learn anything when de reasonable and useful to learn. you never can tell which one will end up paying you very well in this life.

Title: Re: The journey wey you plan the least nah him fit give you the most
Post by: Churchillvv on November 16, 2023, 06:45:04 PM
Na true talk be this, I like weytin you talk for here say you never can tell weytin go pay at the end. Me self I dey do graphics design and photography but I just no write them off the goal na to make money then push my dream for photography and Cinematography high. E never tail wey I join this forum oo tho I been don create account since last year but na just bounty matter i know but as i come dey de see my guy wey show me the stuff dey always talk about BTC and me I like BTC so I just develop interest come dey flow well with am.
The thing be say nothing wey no dey pay oo but na the one way your head carry or your spirit match with go work for you.
Now self I dey see things here in a different way where I fit show case my talent like for services board etc. So those work wey you learn now you fit channel am put for here in a different style you understand me? You go see say your portfolio dey different from others own na weytin me I just discover. 

Title: Re: The journey wey you plan the least nah him fit give you the most
Post by: Amphenomenon on November 16, 2023, 06:55:29 PM
Wetin I de try talk be say make we no de write anything off like that on  the first appearance, make we continue to de learn anything when de reasonable and useful to learn. you never can tell which one will end up paying you very well in this life.
It's true, I will always say this in anything we want to learn we must learn also to persevere, diligent and consistent in anything we are learning and also have a good reason for doing something so that we won't be moved by people discouragement and negative comments, because if we don't give up they will later come to congratulate us and we might even become a source of inspiration and motivation to them.

Title: Re: The journey wey you plan the least nah him fit give you the most
Post by: Spaceman1000$ on November 16, 2023, 09:12:26 PM
Sometimes when I de reflect on how far I done come for the tech and cryptocurrency space, and all the things and experiences I don gathered so far, e de amaze me seriously. Growing up, I been de seriously into playing of keyboards and instruments in church and I been seriously think say na from there I go take make a living, later as I begin grow come enter street, the vibes to de follow up church matter come drop and I no come de take the instrument stuff very seriously. I come later enter into phone repairs come de enjoy the work wetin no nice and come even de make small savings say I go use start up my own phone repairs shop. As I get admission into school na there the whole phone repairs matter come die like that and I come say make I y focus on school small but e no take time when the interest begin die down. We just de get small conversation and my friend just bring up the matter weda I de interested to go into tech, I been no take am seriously but with time as I come de visit my guy come de see how him de work, I come say make I follow try see how e de be and with time I come de enjoy the stuff small small.

E done de reach almost 3 years when I don de do this work with my guy and I don get serious sense of fulfilment as I de do the job so! Nah so ah con still join the forum as they come give me update about bitcoin and so far the journey has been filled with fulfillment and happiness.

Wetin I de try talk be say make we no de write anything off like that on  the first appearance, make we continue to de learn anything when de reasonable and useful to learn. you never can tell which one will end up paying you very well in this life.
Normally na so life dey, the things way u no expect na go turn out to be the thing way go give you headway in life. The tech and cryptocurrency industry has been explored by good number of Nigerians youths, and they are really doing a good job in making a good living out of it.
I can actually relate to your story, though some of us have a different story to tell.

Title: Re: The journey wey you plan the least nah him fit give you the most
Post by: Cryptomultiplier on November 16, 2023, 10:34:11 PM
Wetin I de try talk be say make we no de write anything off like that on  the first appearance, make we continue to de learn anything when de reasonable and useful to learn. you never can tell which one will end up paying you very well in this life.
It's true, I will always say this in anything we want to learn we must learn also to persevere, diligent and consistent in anything we are learning and also have a good reason for doing something so that we won't be moved by people discouragement and negative comments, because if we don't give up they will later come to congratulate us and we might even become a source of inspiration and motivation to them.
This is true in everyway and it would require one to stand firm on this earth in any profession of this life.
Successfully is done so when through thick and thin one doesn't give up, the celebration would be massive.
. The key note is to plan ahead and achieve the little factors in the grand plan.

Title: Re: The journey wey you plan the least nah him fit give you the most
Post by: Peter Faith on November 16, 2023, 11:13:31 PM
Sometimes when I de reflect on how far I done come for the tech and cryptocurrency space, and all the things and experiences I don gathered so far, e de amaze me seriously. Growing up, I been de seriously into playing of keyboards and instruments in church and I been seriously think say na from there I go take make a living, later as I begin grow come enter street, the vibes to de follow up church matter come drop and I no come de take the instrument stuff very seriously. I come later enter into phone repairs come de enjoy the work wetin no nice and come even de make small savings say I go use start up my own phone repairs shop. As I get admission into school na there the whole phone repairs matter come die like that and I come say make I try focus on school small but e no take time when the interest begin die down. We just de get small conversation and my friend just bring up the matter weda I de interested to go into tech, I been no take am seriously but with time as I come de visit my guy come de see how him de work, I come say make I follow try see how e de be and with time I come de enjoy the stuff small small.

E done de reach almost 3 years when I don de do this work with my guy and I don get serious sense of fulfilment as I de do the job so! Nah so ah con still join the forum as they come give me update about bitcoin and so far the journey has been filled with fulfillment and happiness.

Wetin I de try talk be say make we no de write anything off like that on  the first appearance, make we continue to de learn anything when de reasonable and useful to learn. you never can tell which one will end up paying you very well in this life.
no be lie thank you for your words of encouragement,, normally when you dey start something wey you non know anything about e dey hard well well but when you hear from people wey don get experience and how Dem take start e go help beginners not to give up. Besides we all know say nothing good comes easy ,,so na to stay focused because na who give up nai loose guide . Na to tell yourself say as long as mister A fit do am ...me too can do it

Title: Re: The journey wey you plan the least nah him fit give you the most
Post by: CryptoHeadlineNews on November 16, 2023, 11:57:29 PM
Wetin I de try talk be say make we no de write anything off like that on  the first appearance, make we continue to de learn anything when de reasonable and useful to learn. you never can tell which one will end up paying you very well in this life.
Omo.. You really don talk am finish, and I really dey very happy say at least you are not a lazy person, but a person with a consistent hustling spirit, which is what made you test most of these skills, and today you are already into tech and Bitcoin-related. Because most times one of the big mistake post of our students make is relying  only on school alone,  forgetting the fact that in this present era, your ability to earn higher is a factor dependent on how many skills wey you get. Hence, while starting life, eh dey very good to learn one or two skills

Title: Re: The journey wey you plan the least nah him fit give you the most
Post by: Samlucky O on November 17, 2023, 02:54:49 AM
This matter you bring for here na true Matter. For person to succeed for 9ja you must dey Versatile. You go must they sharp to adapt to any new latest update. But no be the wrong one o. But you know what? the thing wey go make you rich they always dey common for person eye. If them tell me say something wey dey like this forum dey I no go gree. Because people mindset don curupt say anything wey dey bring steady money online na Yahoo. The person wey introduce me to this place because of his achievements sofa people don concluded say na Yahoo him dey do. At a point I nearly believe until him come initiate me for this him Yahoo wey be this forum. Before my doubt come clear about that.

That's why we dey always pray say make oluwa help us locate our destiny helper. Because no matter how hard working you dey or how many handwork you get if your destiny helper never locate you, all those things wey person learn fit no put beter food for person mouth, or probably no ft give you as much as expected.

Title: Re: The journey wey you plan the least nah him fit give you the most
Post by: EluguHcman on November 17, 2023, 11:15:02 AM
Just as says... A plan is always of plan A's while better plans mostly comes from plan B's.
Who no understand this lyrics well, make em pick potential points on the necessities of diversifying of investments way be points say if this on never ripe, the other go ripe to fit provide you with the needs to solve your matters.
So as acquiring knowledges in diversifications is profitable because no one knows the available opportunity way go be your open doors in the future.
Sometimes eeehh.... We just force in to where we no fit-in but when where we are fit-in showcases, we no even need muscles to get on na why we need to keep grinding, striving and hunting til we get to a contented ring and make we no underrate any opportunities at all because deep in, no be every one way where rags be mad person after engineers way dey field of work no get time to romance with swagging while at work.

Make we learn to take chances and also give chances benefit of trials.

Title: Re: The journey wey you plan the least nah him fit give you the most
Post by: Hewlet on November 17, 2023, 05:09:15 PM
Sometimes when I de reflect on how far I done come for the tech and cryptocurrency space, and all the things and experiences I don gathered so far, e de amaze me seriously. Growing up, I been de seriously into playing of keyboards and instruments in church and I been seriously think say na from there I go take make a living, later as I begin grow come enter street, the vibes to de follow up church matter come drop and I no come de take the instrument stuff very seriously. I come later enter into phone repairs come de enjoy the work wetin no nice and come even de make small savings say I go use start up my own phone repairs shop. As I get admission into school na there the whole phone repairs matter come die like that and I come say make I try focus on school small but e no take time when the interest begin die down. We just de get small conversation and my friend just bring up the matter weda I de interested to go into tech, I been no take am seriously but with time as I come de visit my guy come de see how him de work, I come say make I follow try see how e de be and with time I come de enjoy the stuff small small.

E done de reach almost 3 years when I don de do this work with my guy and I don get serious sense of fulfilment as I de do the job so! Nah so ah con still join the forum as they come give me update about bitcoin and so far the journey has been filled with fulfillment and happiness.

Wetin I de try talk be say make we no de write anything off like that on  the first appearance, make we continue to de learn anything when de reasonable and useful to learn. you never can tell which one will end up paying you very well in this life.
This is very inspiring. As you journey through life, keep learning whatever skill you are privileged to learn because they will save you from some messy situation you might find yourself in. Also know that no knowledge is a waste, keep learning and accumulating them, this way, you will always be relevant wherever you find yourself.

Title: Re: The journey wey you plan the least nah him fit give you the most
Post by: Roseline492 on November 17, 2023, 05:57:45 PM
Nice one OP, the truth of the matter be say life is full of dynamics, because sometimes when we are still teenagers there are things we wish to become when we grow up but when the time comes what you will find yourself  doing may not be what you were thinking to become, and sometimes for you to reach out to the goal you had envisioned for, that's when life will move you ups and down by doing so many things you never imagine to do but at last you will see yourself arriving to your goal that's why I said life is full of dynamics.

Title: Re: The journey wey you plan the least nah him fit give you the most
Post by: Obim34 on November 18, 2023, 12:36:09 AM
OP some rounds of applaud for this thread, in as much life remains unpredictable one can never tell what the future holds or what will become of the person in time to come. All plans we build, skills learnt and to be learned are just base on  a blind state cos we never can tell where our success can come from.
Like you said make we no dey take chances anything wey we come across make we learn am wella. Like this everybody get him own process wey him don pass and no be wetin we even plan from time, most of us even get handwork but you see this life carry belle, we no know when and wetin him go born na gradual process we get to take things serious, time don come we get to rely on our smartness and not hard work alone
I believe doing tech as a youth is much satisfying and enjoyable with less stress involved

Title: Re: The journey wey you plan the least nah him fit give you the most
Post by: Jamestown70 on November 18, 2023, 12:50:21 AM
Nice one u never can tell how love go play at the end somebody just need to encourage and continue with him hustle, I just happy for you sha I pray this btc so I go understand am then chop from am🙏

Title: Re: The journey wey you plan the least nah him fit give you the most
Post by: Promocodeudo on November 18, 2023, 08:54:30 AM
The future is unpredictable, that is why anything you are doing, do it well because you can never tell which of them will be the major source of your income later, or your the one that will change your your story, in anything one is doing, we should make sure that we give it our conversation and learn it very well, for me, I never thought that I will be here today, when I first heard about this forum I immediately pick interest because I wanted to know more about Bitcoin, and I know that with the knowledge I will get here through the various threads that will be discussed, I will be able to grab one or two things, as it stands now, what we need to succeed in this country as youths is thinking outside the box and making use of our initiatives, making sure at all time that we mingle with right minds.

Title: Re: The journey wey you plan the least nah him fit give you the most
Post by: Justbillywitt on November 18, 2023, 10:13:42 AM
Op na true you talk like this. Me I be person wey like to dey dey independent since I was small. Initially I na drum me I been dey play for my local church. I once had a dream of playing drum for one of these big churches. But as come dey grow up I come dey see say life for dream and reality no be the same thing. Me I be person wey no even get hope say I go ever go university for this life. So after my secondary school I go learn pillar work. I come good for the work and I was making money from it. One day somebody come tell me say e get one work wey them get for me, I went for the work my brother na big work oo for one estate wey them been dey build for my side. Na so I collect the job and the money really big, so I come calculate watin go be my profit at the end of the job  because I go call other work men to help me. So I come say omo this money go fit carry me go far for university if I gain admission and that period jamb form still dey on sale. Na so I go pick jamb form oo. E no too long I deliver the job and my profit was about 500k that time country never bad reach like this and the school wey I been wan enter school fee was about 22k as an indigene. I write the jamb come gain admission and na so I train myself for school. Na hand work wey I learn come give me the opportunity to be a graduate. Imagine say I no learn the work how my life for be today. I for no fit go university my brother. So I will encourage everybody to learn handwork even as a graduate, for those wey no get opportunity to learn it before now.

Title: Re: The journey wey you plan the least nah him fit give you the most
Post by: Miles2006 on November 18, 2023, 12:24:04 PM
Op your speech is a word of encouragement, some go say na motivational speaker or na quote. Just the way you encounter challenges na so everybody dey face challenges, all this ones na part of hustle for life but no one knows what life has to offer so e good make everybody work hard for a better life. Everyone will always say be patient with whatever you're doing but I don't understand this kind of patient cause person suppose get two plans for life, plan A and plan B, for me patient get limit and most people will stick to one plan forever but life no dey like that I no  know if na ignorance.

Title: Re: The journey wey you plan the least nah him fit give you the most
Post by: Mayor of ogba on November 18, 2023, 04:46:03 PM
Op, na better talk you talk like this o. This story makes me remember one online hustle I be dey hustle, the hustle be they pay my guy better money when I never start, but when I come join the hustle the thing come stop to dey pay as e dey pay before, and that one no make me stop to they push the hustle to see my payment from the online hustle. What motivated me not to give up was because I done see my guy wey teach me the work dey pull out 100k Naira every month for the hustle. For my year 4, person wey be dey train me for school come loss in work e no come dey train me again, and thing come hard for me to even sub dey follow up the work come become a problem. Before I knew the hustle Start to dey pay me and come dey enjoy my life dey solve my problems by myself and I come dey even send money to my parents self when I dey school. Wey thing I dey try talk be say anything wey your friends introduced you to wey no bad and money dey comot from the thing, if you join am no give up say you no see money early for the thing, just keep on pushing as far as say you done see say money dey comot from the thing, one day you go start to see money from that thing too.

Title: Re: The journey wey you plan the least nah him fit give you the most
Post by: Kelward on November 18, 2023, 05:33:03 PM
Na true OP talk, because most of us wey de for dis forum fit no get am for dem agenda say na crypto matters na im dem go later settle for. Some na situation of di country fit make dem profession not to de marketable again, whereby dem go de look for wetin to do come land dem for dem present job, some fit be say na greener pasture dem de find wey come land dem for where dem de now, while odas na by chance dem take enter di kind business or work wey dem no plan before.

My own story be say wen I de grow up, na music be my talent, who tell me say I no go become a professional musician, dat person no like me be dat. Long story short, I de do small business now, join with the knowledge of bitcoin, wey I learn for dis forum take de invest small small.

Title: Re: The journey wey you plan the least nah him fit give you the most
Post by: iBaba on November 18, 2023, 05:43:49 PM
My person, you see that statement wey dem dey talk say, patience is a virtue or the patient dog eats the fattest bone are both great adages wey carry strong, strong meanings. I don come of age now wey I realize say nothing for this earth dey ever come easy not to now talk of good things with laudable milestones, you no go wan imagine how tasking and competing e go be to record success. Until you become very patient with all the hurdles of life, you can hardly live a good and healthy life.

Constituency is key to success was another popular proverb that was shared amongst us when we were young people while growing up and after some years down the lane, I now understand what this means in a clearer picture because consistency is specially rewarding to an individual as well as an entrepreneur.

I remember the days when I used to play around Canva for the sake of fun. It got to a level I gradually started getting little jobs for basic designs. Today I get more advanced and professional jobs such as Billboard and Digital Signage designs, Inforgraphics, Basic Ux/Ui amongst other specific and good paying jobs. With Canva pro, I have the ability of making mockups, removing of background from images as smoothly as possible.

Therefore, I believe in the statement wey you talk say na journey wey u plan least sometimes na hin dey give you the most.

Title: Re: The journey wey you plan the least nah him fit give you the most
Post by: Agbamoni on November 20, 2023, 07:55:08 AM
Op, na better talk you talk like this o. This story makes me remember one online hustle I be dey hustle, the hustle be they pay my guy better money when I never start, but when I come join the hustle the thing come stop to dey pay as e dey pay before, and that one no make me stop to they push the hustle to see my payment from the online hustle. What motivated me not to give up was because I done see my guy wey teach me the work dey pull out 100k Naira every month for the hustle. For my year 4, person wey be dey train me for school come loss in work e no come dey train me again, and thing come hard for me to even sub dey follow up the work come become a problem. Before I knew the hustle Start to dey pay me and come dey enjoy my life dey solve my problems by myself and I come dey even send money to my parents self when I dey school. Wey thing I dey try talk be say anything wey your friends introduced you to wey no bad and money dey comot from the thing, if you join am no give up say you no see money early for the thing, just keep on pushing as far as say you done see say money dey comot from the thing, one day you go start to see money from that thing too.
Make money no be the only thing wey go push to join something. If check weting I been talk, u go see almost everything wey I do nah because of say I like and the passion con they to do am. You know say competition they everywhere and people only wants the best or at least one of these best to work for them. So as day they goes by need they wey he say you suppose upskill or increase your value by learning more things wey go make your services more important so that they go choose you. And this can only be done when you have the zeal and passion. If this things no they, any day the money stop to they pay you go stop for there too, con go they find another way.

Title: Re: The journey wey you plan the least nah him fit give you the most
Post by: Asiska02 on November 20, 2023, 08:33:33 AM
E done de reach almost 3 years when I don de do this work with my guy and I don get serious sense of fulfilment as I de do the job so! Nah so ah con still join the forum as they come give me update about bitcoin and so far the journey has been filled with fulfillment and happiness.

Wetin I de try talk be say make we no de write anything off like that on  the first appearance, make we continue to de learn anything when de reasonable and useful to learn. you never can tell which one will end up paying you very well in this life.

All dis tin wey you pass through na part of struggle wey everybody dey pass through first before making it in life. The process just different, but everybody get him story to tell on how dem take make am reach d stage where dem dey so. Your person wey show you way really like you and you suppose show big appreciation to am for dat because no be everybody dey help others dis days. As you don find dis forum you come dey benefit from am, no relent to go find oda means of making money too. Your knowledge for here no fit go but d oda benefits wet you dey get for here fit stop, end or pause at anytime. So try look for anoda means outside d forum to compensate yourself with. One way no be way now for naija.

That's why we dey always pray say make oluwa help us locate our destiny helper. Because no matter how hard working you dey or how many handwork you get if your destiny helper never locate you, all those things wey person learn fit no put beter food for person mouth, or probably no ft give you as much as expected.

That is why e no good make you get negative impressions or vibes of person if you no really know the truth of the matter. Dis tin don take many people down than bringing dem up. When you see someone making achievements on something, make we no just look am like say him don dey into illegal activity online just like dat, e fit be your destiny helper wey go lead you to your own success too. If you get privilege to near dos kind people, ask dem politely to show you d way and if dem no gree no force dem and no go cast their matter outside. Just humbly leave and look for anoda means to try oda legit means of fending for yourself. Because him no help you no mean say anoda person no go dey to help you.

Title: Re: The journey wey you plan the least nah him fit give you the most
Post by: Agbamoni on November 21, 2023, 08:19:44 PM

Weting you talk they true cos e make sense say person no put all in eggs for one basket. This life eh, especially for naija e make sense make you diversify your source of income. Person no fit they financial stable if him they get only one source of income. Because you fit they feel say you they okay but once family con enter, your wife and your children, nah their person go no say e no easy.

If you they look how things they, plenty opportunities still they the country but the hard part nah to find am or find person wey go fit link you up. Normally ah no go blame person wey they lock up to show people in way of success cos ah done see where person help person nah the person wey he help nah him wan con spoil in business for ma. Nah why people no they people be tha. The heart of man at times e they desperately wicked and deceitful.