Title: [Pigin: Tutorial] PGP Signature - Encrypt/Decrypt message (Linux Only) Post by: Mia Chloe on December 05, 2023, 08:36:26 AM Original Topic: [Eng: Tutorial] PGP Signature - Encrypt/Decrypt message (Linux Only) (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5472957.msg63109905#msg63109905)
Author: Learn Bitcoin I greet oo my people! I don re-post mdayonliner (https://bitcointalk.org/index.php?action=profile;u=1432468) [Eng: Tutorial] PGP Signature - Encrypt/Decrypt message - Fingerprint (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5469280.0) bcos of say d foto of d original post don break( e no de show again b cos of imgur server matter 4 forum) and d pesin way create d post no de cum online again.As Husna QA com Yan me (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5469280.msg62952506#msg62952506), I con decide say make I write tutorial 4 pipo way de use linux. Image source: encriptados.io ➥ Other PGP Teaching way de:
➥ Install Gnupg and gpa: Oya make we start! U go open ur terminal den u go paste dis command way de here so Code: sudo apt-get install gnupg2 gpa If u don First give root privilege, e no go ask for password.but if u neva give root privilege abeg u go need write ur system password,and e suppose install gnupg2 and gpa.see am as e suppose b 4 d picture way de down here; Quote ➥ Generate Key: U go Paste dis command line 4 ur terminal Code: gpg --full-generate-key RSA keys fit b from 1024 bits go reach 4096 bits long. 3072 na d default one, but na 4096 I go create here. So u go rite 4096 com press enter. See d image 4 down here; Now, u fit set date way ur keys go take expire. 0 mean say d key no go expire. I de use zero 4 dis tutorial .u go type 0 com press enter. you go rite Y com press enter again.E suppose ask 4 ur real name (no b must say na ur real name u go put), email, and comment. I go write my own.Then u go write 0 com press enter again.e go ask 4 ur passphrase, rite ur passphrase put , and e suppose generate ur keys. See am 4 d image way de down; Now u go paste dis command line Code: sudo gpa If you get dis error ; Code: failed to load module canberra-gtk-module Code: sudo apt update Code: sudo apt install libcanberra-gtk-module libcanberra-gtk3-module -y Afta dat one, u go sti try Code: sudo gpa Ok. I don already generate my keys , and u fit see am 4 down here ; ➥ Export Public Key: To take export ur public key,u go need to right-click 4 ur key com selet Export keys... Quote Den u go Select where u want make e save com write name join wit .txt extension (file name.txt).4 my own I write publickey.txt To take see ur public key, u go open d file. 4 my own case, dis na my public key Code: -----BEGIN PGP PUBLIC KEY BLOCK----- ➥ Export Secret Key: To take export ur Secret key, u go right-click 4 your key, com select Backup, den u go save d file. E go ask 4 ur passphrase. Quote ➥ Send Message way De Encrypted: Now I go send message way de encrypted give BitcoinGirl.Club and I go use him Public Key: Code: -----BEGIN PGP PUBLIC KEY BLOCK----- I don save him public key block 4 inside .txt file and I don import am. See d image 4 down; Quote Now u go click d Windows tab com click d Clipboard. Quote U go rite ur message,com click d file, den u go choose encrypt (See am 4 d image way de down): Now u go click Bitcoingirl public key den u go click d sign join .E go ask 4 ur passphrase; u go enter ur passphrase and gbosa! ur message way u encrypt go show 4 ur Clipboard. Code: -----BEGIN PGP MESSAGE----- Na so we de run am o. We don finish like dis. O.Abeg sha tell me if I make any mistake 4 here cos na only one month I don use Linux reach o. If u de get any issue, post am here, and I go try help u fix am. Even If say I no fit do am men Dem de 4 dis place way fit sti run am well 4 u. Title: Re: [Pigin: Tutorial] PGP Signature - Encrypt/Decrypt message (Linux Only) Post by: Makus on December 05, 2023, 01:36:53 PM Op thank you very much as you bring this kind of better knowledge come board, this pgp message encryption na the best way wey I don know how to send private message publicly. Person wey wan send massage make na only one person you want make e fit understand wattin you wan pass as message, na this best way wey I know be this. According to wattin I been read dem talk say the idea of this pgp message encryption na from when we been never advance wey military dem dey use codes take dey pass message during war between nations, so that na only their person go fit understand am come reply in same code manner. However today na wattin most people don dey use, even my self been don encrypt one message send give Bitcoingirl and na only am fit read the message and e come reply to prove say e work.
Though, I nor know weda hacker fit penetrate oo, but even if them try I know say e no go easy. This process for Linux look like say e go hard oo, the one wey I been do na for windows I use and na for kleopatra I take encrypt the message. I for like try am but I no get Linux OS and I no dey plan to remove my windows install Linux. Title: Re: [Pigin: Tutorial] PGP Signature - Encrypt/Decrypt message (Linux Only) Post by: Mia Chloe on December 05, 2023, 05:07:19 PM Op thank you very much as you bring this kind of better knowledge come board, this pgp message encryption na the best way wey I don know how to send private message publicly. Person wey wan send massage make na only one person you want make e fit understand wattin you wan pass as message, na this best way wey I know be this. According to wattin I been read dem talk say the idea of this pgp message encryption na from when we been never advance wey military dem dey use codes take dey pass message during war between nations, so that na only their person go fit understand am come reply in same code manner. However today na wattin most people don dey use, even my self been don encrypt one message send give Bitcoingirl and na only am fit read the message and e come reply to prove say e work. Guy Linux sharp oo and na open source sef e no b like windows way get malware sara.i go advice make u change go Linux especially if u get asset 4 dat ur computer.E go only take u small time take adapt but later later u go com like am.Though, I nor know weda hacker fit penetrate oo, but even if them try I know say e no go easy. This process for Linux look like say e go hard oo, the one wey I been do na for windows I use and na for kleopatra I take encrypt the message. I for like try am but I no get Linux OS and I no dey plan to remove my windows install Linux. Title: Re: [Pigin: Tutorial] PGP Signature - Encrypt/Decrypt message (Linux Only) Post by: Learn Bitcoin on December 08, 2023, 06:16:43 AM I tank u well well Mia Chloe 4 d translation way u hep me do.i de hope say 9ja pipo go learn sumtin well well from am. PGP na secure technology way fit help us send message way Dem encrypt give pipo make other pipo no fit read am. E get time b4 wen Dem sti de control internet.and pipo way get d website fit check ur message.
Dose message no de end to end encrypted as Dem de talk am so if u wan share sumtin way de private make sure say u use PGP tay encrypt am instead of normal words. Title: Re: [Pigin: Tutorial] PGP Signature - Encrypt/Decrypt message (Linux Only) Post by: Wiwo on December 08, 2023, 07:15:20 AM Ops you have done really well by putting this up together to help newbies or even old members in guide to safely send an encrypted message I remember some time ago when I was still a newbie, trying to figure out how to send an encrypted message it was hell for me to get it right, but with this tutorial, many of those who may have not done this before will eventually have a guide that will put them through and have it easily understood and apply since you wrote this thread in pigin since that na our own language where we dey understand most for this local board.
So for sure, this thread will help well for our local board and I would like to commend you for coming up with this and I have taken note of your efforts and in due time we will smile. Since you asked if there be any correction or suggestions, I for like to make you put in additional demands for anyone who want to try out in practice how to send an encrypted message you can put up your PGP public key here and let some try it out by encrypting a message using that and you verify such even if it a few of them at least that will give more inside practical experience to them and another reader, hoping to see that development if it appealing to you. Title: Re: [Pigin: Tutorial] PGP Signature - Encrypt/Decrypt message (Linux Only) Post by: promise444c5 on March 29, 2024, 08:40:27 PM Bump
|