Bitcoin Forum

Local => Nigeria (Naija) => Topic started by: uchegod-21 on December 08, 2023, 09:32:06 PM

Title: Altcointalk forum go be our second online home?
Post by: uchegod-21 on December 08, 2023, 09:32:06 PM
My people!
I carry greetings show face for here and I want make we for discuss one important thing, I no know weda the discussion don dey on ground already, if e dey I go lock this thread.

The mata na Altcointalk forum  (https://www.altcoinstalks.com/index.php). I don see some of our people for this place and I never see some too. With the development sey theymos go ban mixer in this forum from next year, Altcointalk go be second forum for us?

How we see the matter?
People wey never register there, this one na update.
Boss CryptopreneurBrainboss, how about you go open service thread there, I don see other managers they open service thread for there.
We never know how next year go be shaa, but no effort wey waste.

Title: Re: Altcointalk forum go be our second online home?
Post by: Orpichukwu on December 08, 2023, 10:11:13 PM
No place really they like this btt forum, I don scan through that place yesterday I no just too understand how the place be although eh better pass most other crypto forum way I don come across way them just build like news site, as I also notice the forum don they exist for long time now and eh just be like say nah now way dem wan ban mixer for this place now people remember to go their go set their pass, nd nah the campaign way Royse777 wan relaunch their come Kuku trigger men dem to enter their if not most of us been really no no say place like that exist.

To ask if there go be our second home, nah where you understand or u feel comfortable you fit stay call home nah for now way I never understand how the place they work I no fit consider am home and beside here go still they active unless say nah anything way concern altcoin Nia go carry person enter their.

The day way I visit their I see our snr men them for here as part of the active 400 members for their, so I believe the local board also they active their.

Title: Re: Altcointalk forum go be our second online home?
Post by: Dailyscript on December 08, 2023, 10:28:18 PM
E con be like as i join bitcointalk na him i con they hear bout altcointalk. Ah never too familarise myself with this forum how e go con be for me for the other side. But since wey i join this forum ah done really enjoy the discussion and things wey they go on for here. And small small ah don dey familiarise my self for the forum. My question na how i wan use follow up the altcointalk and if they compare bitcointalk and altcointalk which one go be the choice of the masses? As for me nah bitcointalk i wan dey

Title: Re: Altcointalk forum go be our second online home?
Post by: Agbe on December 08, 2023, 10:36:28 PM
E dey good as you bring am come here. But that place e get as e be oh. Everything just dey jagaja although I never registered for there but planning to do that and I was also thinking of Brainboss Managerial Services over there also Igebotz this the best time to showcase your Services over there for now that many managers have not gone there to do or announce their services. You have to do it now. But the arrangements of boards in that forum is not really good compare to Bitcointalk. Everything just in one line and awkward. And according to people the admin is very fast to respond to people there. Bitcointalk will still be the best option for all of us. And the only thing that will make that place boom is the present of mixers. And for now na only one campaign I dey see and di campaign sef na 31 st of dis month nai him go start though by then many others go show face.

Title: Re: Altcointalk forum go be our second online home?
Post by: Obim34 on December 08, 2023, 10:52:13 PM
I don already sign up for there, dat place get better problem, Luke wetin senior man @Agbe talk that forum too dey scattered, starting from their web arrangements, the stress involved there is much and not easy to use for those who are new to this kind of forum stuffs but e dey me easy to navigate cos I don dey use
Bitcointalk forum.

Another problem be say there too dey inactive as people no too dey use am everywhere dey very dry for there. I enter our local board for there omor... Laugh no gree me cos person get post for there wey don stay years for there and na only three replies e get. I for like make Nigerians dominate there kwa. Make dey feel our pressure and we go also get upper hand for there.
All this our big oga dem fit teleport their rank go there so they no go build from the scratch and e go give them enough confidence to dominate.

Title: Re: Altcointalk forum go be our second online home?
Post by: uchegod-21 on December 08, 2023, 11:26:34 PM
E con be like as i join bitcointalk na him i con they hear bout altcointalk. Ah never too familarise myself with this forum how e go con be for me for the other side. But since wey i join this forum ah done really enjoy the discussion and things wey they go on for here. And small small ah don dey familiarise my self for the forum. My question na how i wan use follow up the altcointalk and if they compare bitcointalk and altcointalk which one go be the choice of the masses? As for me nah bitcointalk i wan dey
My brother, make I give you better advice. I go happy say you go read am. If you be genuine newbie, like this na your first account, no near Altcointalk. You no get anything to learn there, unless you wan confuse yourself. No compare the twp forums, at all. Here wey you dey na the Koko. No worry, grow here first, you go easily teleport your account when you don grow .

But the arrangements of boards in that forum is not really good compare to Bitcointalk.
Boards too plenty there. Them create boards for unnecessary things wey for dey off topic. All the altcoins get their own board sef.

Title: Re: Altcointalk forum go be our second online home?
Post by: Samlucky O on December 08, 2023, 11:32:18 PM
I no go lie you that altcointalk dey somehow to me. I mo even know where to start, but naso e dey always be for any new project wey come out. But with time many people go like that place pass here because the interface dey very fine and lovely just that say people never too understand am.

Abeg anybody wey don register for there, make him give us guidelines on how to involve for that side. our elders say "anywhere Banga fruit ripe, na dere you go see birds dey cluster"

Title: Re: Altcointalk forum go be our second online home?
Post by: Makus on December 08, 2023, 11:35:10 PM
Omor, op thank you for bringing this kind of update come this board today oo, when I click the link, the interface of the forum wan be like Bitcointalk own, so I believe say if person wan really use that forum e nor go too hard before we go understand everything wey concern am. And I thing wey still sweet my belle na when I scrol go down come still go find the Nigerian local board, and I still see some of this forum members wey dey there, and some of them don turn boss. But when I observe closely I come see say dem write teleport for some people account, abeg e get anybody wey know the work of that teleport or how Dem take dey run am? Abeg if you get the update make you no forget to share, e go really dey very helpful for the boys.

Title: Re: Altcointalk forum go be our second online home?
Post by: Richbased on December 09, 2023, 07:38:58 AM
E con be like as i join bitcointalk na him i con they hear bout altcointalk. Ah never too familarise myself with this forum how e go con be for me for the other side. But since wey i join this forum ah done really enjoy the discussion and things wey they go on for here. And small small ah don dey familiarise my self for the forum. My question na how i wan use follow up the altcointalk and if they compare bitcointalk and altcointalk which one go be the choice of the masses? As for me nah bitcointalk i wan dey

It sounds really funny in the area you said you've not yet gotten accustomed to Bitcointalk forum now another forum altcointalk has appeared, well it's same with me but however you need to understand that things of this nature are meant to happen in the future in other for there to be competition among the cryptocurrencies but do not be deceived as there is a saying that ''a bird at hand is worth more than millions in the Bush'' so in a nutshell what it means is that whatever you find yourself doing be contented with it rather than looking forward to things that you may never be able to achieve so I prefer staying in Bitcointalk forum and getting used to everything here.

Title: Re: Altcointalk forum go be our second online home?
Post by: Charles-Tim on December 09, 2023, 09:00:13 AM
How we see the matter?
People wey never register there, this one na update.
Boss CryptopreneurBrainboss, how about you go open service thread there, I don see other managers they open service thread for there.
We never know how next year go be shaa, but no effort wey waste.
Let us see the traffic in both sites.

For Bitcointalk:
https://app.neilpatel.com/en/seo_analyzer/backlinks?domain=Bitcointalk.org&mode=domain&locId=2566&lang=en

For Altcoinstalks:
https://app.neilpatel.com/en/seo_analyzer/backlinks?domain=Altcoinstalks.com&mode=domain&locId=2566&lang=en

Mixero campaign has been launches on the altcoins forum, but can you compare the pay with bitcoin forum one:

Bitcointalk:
[CFNP] Mixero ADVANCED MODE Bitcoin Mixer Signature Campaign | Sr+ up-to $250/w (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5423833.0)

Altcoinstalks:
[CFNP]Mixero ADVANCED MODE Bitcoin Mixer Signature Campaign | Ver: Altcoinstalks (https://www.altcoinstalks.com/index.php?topic=312833.msg1452650#msg1452650)

For signature campaign, I see people active on Altcoinstalks as people that do not know how to rank up on Bitcointalk. Altcoinstalks daily, weekly, monthly and yearly traffic are significantly low if comparing it with Bitcointalk. It is a place of less opportunity.

Title: Re: Altcointalk forum go be our second online home?
Post by: Igebotz on December 09, 2023, 09:42:07 AM
For signature campaign, I see people active on Altcoinstalks as people that do not know how to rank up on Bitcointalk. Altcoinstalks daily, weekly, monthly and yearly traffic are significantly low if comparing it with Bitcointalk. It is a place of less opportunity.

Your point is misleading! 80% of active accounts on altcointalk are teleported high ranking accounts from Bitcointalk.

This is not a comparison post because Altcointalk has always been in the shadow of Bitcointalk for a long time, but things are changing due to the forthcoming censorship on Bitcointalk. People value free speech, and removing it would leave this place as desolate as the desert.

Take bounties away from Bitcointalk and the traffic will fall drastically.

We already have the Nigeria Local board With child boards and that's something we have not been able to achieve here.

Title: Re: Altcointalk forum go be our second online home?
Post by: Fivestar4everMVP on December 09, 2023, 09:46:09 AM
How we see the matter?
People wey never register there, this one na update.
Boss CryptopreneurBrainboss, how about you go open service thread there, I don see other managers they open service thread for there.
We never know how next year go be shaa, but no effort wey waste.

For signature campaign, I see people active on Altcoinstalks as people that do not know how to rank up on Bitcointalk. Altcoinstalks daily, weekly, monthly and yearly traffic are significantly low if comparing it with Bitcointalk. It is a place of less opportunity.
You are right, if we begin compare the two in terms of traffic and all that, the plain truth be say, altcoinstalk no near bitcointalk for rank, even for activities.
I personally don dey altcoinstalk since 2020, but na due to lack of activity on that forum make me later become inactive there, there was actually a time when some bounties where held on that forum, I participated in them, but they were all altcoin paying bounties and most of those project never saw the light of the day, so made me to stop being active there and focus more on this forum.

When you say that, those who are active there are people who don't know how to rank up here, that is from the signature ad campaign perspective, you are definitely right to a great extent.

But now that mixers are moving over there, let's see what happens with the traffic on that forum, hopefully, this will be their starting point to achieving the kind of record, or close record of what bitcointalk have already.

Title: Re: Altcointalk forum go be our second online home?
Post by: Hewlet on December 09, 2023, 12:51:48 PM
I been done check am out yesterday but e never really move me to register am like that. Normally for this forum, I never fit de make reasonable contributions for altcoin board and I feel say e go worry me for that side too.

But wetin sweet me for  their be say person fit register new account without using VPN and I feel say that one na plus for that forum but my concern be weda if person join the forum come de do mixer campaign that side, e no go affect the person reputation for bitcointalk? Since bitcointalk done stop mixers for their forun, I de reason weda de go allow make person when de this forum associate with mixers for the altcointalk side.

Title: Re: Altcointalk forum go be our second online home?
Post by: rachael9385 on December 09, 2023, 07:37:20 PM
I done register for the altcoinstalks forum yesterday but the forum no really dey like this Bitcointalk , I no really know wether nah because I no dey use to that forum but the forum no dey clear sha.
As pipo come this forum to learn about Bitcoin and others things way dey related to Bitcoin so e still good make we go that side go learn about altcoins, although I no really give a fuck to some altcoins except ETHEREUM coin but I dey there so that I go also learn about some them.
However, for here we dey always tell our selfs make we go do our own research so that we go understand plenty things way dey inside the crypto space, so watin I dey talk be say that forum nah another alternative place for us to learn about crypto.
As I dey there this little time, I done learn some things and some observe something too. Watin I see there be say each coins get there own board and Bitcoin also dey there and again our own local board self dey there (as we no dey carry last, everywhere we dey).

Title: Re: Altcointalk forum go be our second online home?
Post by: Su-asa on December 09, 2023, 08:17:05 PM
I never hear about that other forum oo, if no be this post I no sure say I done hear that other site before, but I really think I go check am out.
As here not for Bitcoin that other side nah for only altcoins?
E really dey hard when I been won register for here, if no be say my friend tell me about the VPN, I for no even know self. But as I dey see so, e be like say there no need VPN o, if VPN on dey there na be say people go soplos.

Title: Re: Altcointalk forum go be our second online home?
Post by: Stable090 on December 09, 2023, 09:38:39 PM
How we see the matter?
Me I go speak for myself ooo but I reason say na nice thing theymos wan do, because dis one wey any mixer wey dem seize, dem they always link them to forum, make e no come be like say dem go seize forum too, e better make him just put hold to mixer campaigns, make e no come be like say na for forum all those mixers wey dem dey use for illegal activities dey run marketing, because we never know the mixer wey dem go seize again.

For d altcointalk wey u talk about, me self just open am and I never to know d place be self, but like say you no go need merit to rank up for that side, na just to dey post, your activities go dey increase and dem get some specific activities wey u go get to reach particular rank.

But from Wetin I dey see, I no dey sure say traffic go really dey that side, before e just be like say dem abandon that altcointalk, na now wey dem wan carry signature go there e just dey come back to life, but we no fit conclude yet, let’s see Wetin go happen.

Title: Re: Altcointalk forum go be our second online home?
Post by: Gormicsta on December 09, 2023, 09:54:56 PM
My people!
I carry greetings show face for here and I want make we for discuss one important thing, I no know weda the discussion don dey on ground already, if e dey I go lock this thread.

The mata na Altcointalk forum  (https://www.altcoinstalks.com/index.php). I don see some of our people for this place and I never see some too. With the development sey theymos go ban mixer in this forum from next year, Altcointalk go be second forum for us?

How we see the matter?
People wey never register there, this one na update.
Boss CryptopreneurBrainboss, how about you go open service thread there, I don see other managers they open service thread for there.
We never know how next year go be shaa, but no effort wey waste.

The forum go well sha, even though say we no fit compare am to BitcoinTalk, but with time that forum go upgrade pass the way e dey now and better earning opportunities go fit enter am too.

I don go through the forum well well and I see better future there, na just say better traffic no dey there the way e dey here, if not una for dey confirm the pressure.

And again the admin don give opportunities to everybody for this forum make them for for teleport their account go there, that way you fit come retain your present rank for this forum for there, the thing make sense sha oo.

Title: Re: Altcointalk forum go be our second online home?
Post by: Dr.Bitcoin_Strange on December 09, 2023, 11:55:33 PM
I got my Bitcointalk account teleported to ATT the day before yesterday, but the forum looks a bit too quiet compared to BTT. Although I think that's because there isn't much promotion going on in that forum, if most of these mixer campaigns on this forum transfer their promotion there, then ATT might begin to gain more traffic than it already has. It's going to be a gradual process.

Title: Re: Altcointalk forum go be our second online home?
Post by: Cryptomultiplier on December 10, 2023, 04:33:21 AM
No be small changes dey happen at once o. Despite the SEC rulings and fines wey the Binance dey pay, them dey hold all other sectors wey develop mxrs and the likes to ransom.
To those wey don dey earn small small dependent fees from campaigns, this na wake up call to find alternative source of earning, because once the campaign is over, Yoruba people go say, Otilo!
Still na this time those wey love the community and join to gain experience and learn about BTC and its practices go shine and turn up to make the Bitcointalk forum better and lively up to livelihood.

Title: Re: Altcointalk forum go be our second online home?
Post by: Y3shot on December 10, 2023, 09:17:02 AM
I Don see the altcoinstalk forum,  but e get the way the forum be, very different from bitcoin talk forum . I'm so used to bitcointalk forum because it is easy to understand.  The altcointalk forum dey somehow congested in my eyes but I go still go back to see how the forum be , but I so much like Bitcointalk forum I no sure any platform go fit take my attention out from here, Bitcointalk forum is the best among all I have seen maybe because it is the first crypto forum.

Title: Re: Altcointalk forum go be our second online home?
Post by: Jegileman on December 10, 2023, 09:35:25 AM
I dey see say many people dey complain about dat altcointalk forum say dem no too get traffic and d place just dey anyhow. Yes na true, but as a newcomer there definitely e go take time to understand d place and enjoy d use but once person dey familiar with there, e go dey easy to navigate around d place. We know say d place no get traffic, but as people don dey rush go open account for there and d signature wey dem wan carry go there, I know say traffic go begin dey there but e no go come near to dat of bitcointalk for years to come from now.

Title: Re: Altcointalk forum go be our second online home?
Post by: royalfestus on December 10, 2023, 09:52:15 AM
No place really they like this btt forum, I don scan through that place yesterday I no just too understand how the place be although eh better pass most other crypto forum way I don come across way them just build like news site, as I also notice the forum don they exist for long time now and eh just be like say nah now way dem wan ban mixer for this place now people remember to go their go set their pass, nd nah the campaign way Royse777 wan relaunch their come Kuku trigger men dem to enter their if not most of us been really no no say place like that exist.

To ask if there go be our second home, nah where you understand or u feel comfortable you fit stay call home nah for now way I never understand how the place they work I no fit consider am home and beside here go still they active unless say nah anything way concern altcoin Nia go carry person enter their.

The day way I visit their I see our snr men them for here as part of the active 400 members for their, so I believe the local board also they active their.
You dey yan my mind about Altcointalk forum. That forum ehn, e too waka. Dem no dey control users at all to stop spam, but if people wan use am as another forum to talk about topics wey dem don ban for here, make dem build the forum well. I also think say make campaign about mixers dey more for social media instead of signature for the forum.

Title: Re: Altcointalk forum go be our second online home?
Post by: sokani on December 10, 2023, 02:26:19 PM
Let us see the traffic in both sites.

For Bitcointalk:
https://app.neilpatel.com/en/seo_analyzer/backlinks?domain=Bitcointalk.org&mode=domain&locId=2566&lang=en

For Altcoinstalks:
https://app.neilpatel.com/en/seo_analyzer/backlinks?domain=Altcoinstalks.com&mode=domain&locId=2566&lang=en

Bitcointalk pass Altcointalks for everything and no be wetin we suppose debate. Aside the traffic comparison, the UI of Bitcointalk is more appealing than ACT. The place just get plenty boards wey no really make sense to me. But the ban of mixer on BCT and the porting of forum members to Altcointalks could help spice things up.

One thing I observed about the forum is that the admin is very active and he must have seen the ban of mixers as an opportunity to drive traffic to the website. I believe he's open to suggestions and he could maximize this opportunity to breath life into the forum.

Title: Re: Altcointalk forum go be our second online home?
Post by: Charles-Tim on December 10, 2023, 02:49:26 PM
Your point is misleading! 80% of active accounts on altcointalk are teleported high ranking accounts from Bitcointalk.
If you have a statistical information about it, prove your point. I am still not certain that you are correct. If you are good on Bitcointalk, you will be lazy to do anything on Altcoinstalks which I am quit sure about.

I am not on the forum and I am not having any plan yet to register. So I do not have much information about the forum than the absolutely low traffic on Altcoinstalks.

This is not a comparison post because Altcointalk has always been in the shadow of Bitcointalk for a long time, but things are changing due to the forthcoming censorship on Bitcointalk. People value free speech, and removing it would leave this place as desolate as the desert.
Not comparing directly, but the reason I can not join the forum and the reason most likely good forum posters will not join that forum. Get that right. The traffic is 10 times lower or more than Bitcointalk.

Take bounties away from Bitcointalk and the traffic will fall drastically.

We already have the Nigeria Local board With child boards and that's something we have not been able to archive here.
This thread is not about taking bounties away from Bitcointalk. I have not seen anywhere theymos talked about that. Only mixers, and it is because of obvious reason. This is off-topic to bounties.

Also this is off-topic to Nigeria local board discussion.

Title: Re: Altcointalk forum go be our second online home?
Post by: Igebotz on December 11, 2023, 08:23:05 PM
Your point is misleading! 80% of active accounts on altcointalk are teleported high ranking accounts from Bitcointalk.
If you have a statistical information about it, prove your point. I am still not certain that you are correct. If you are good on Bitcointalk, you will be lazy to do anything on Altcoinstalks which I am quit sure about.

I am not on the forum and I am not having any plan yet to register. So I do not have much information about the forum than the absolutely low traffic on Altcoinstalks.

That is your thinking since you believe BTT is the only active forum; you are wrong; most of us belong to three or more forums and are still doing well. Maybe you're missing What's going on there, but nearly half of your present campaign participants and the majority of mixer participants have now transported their accounts to Altcointalk, and some DT1 has already applied for the position of moderator.

Altcointalk does not have much traffic, but as more signature campaigns and bounty campaigns are launched, traffic will increase.

Quote
Not comparing directly, but the reason I can not join the forum and the reason most likely good forum posters will not join that forum. Get that right. The traffic is 10 times lower or more than Bitcointalk.

Traffic is bad but if discussion are organic with less spam then I don't see reasons why good posters won't sign up. The forum is more than 7 years behind BTT so I believe there is much time for improvement.

Quote
This thread is not about taking bounties away from Bitcointalk. I have not seen anywhere theymos talked about that. Only mixers, and it is because of obvious reason. This is off-topic to bounties.

Also this is off-topic to Nigeria local board discussion.

I just told you that the only reason why BTT is having this much DA and DR is because of bounties and signature campaigns. Take it away and the place will become Altcointalk. What's the off topic?

Title: Re: Altcointalk forum go be our second online home?
Post by: Charles-Tim on December 11, 2023, 08:49:57 PM
That is your thinking since you believe BTT is the only active forum; you are wrong; most of us belong to three or more forums and are still doing well.
This is wrong, no one talks about forum generally.

You are misinterpreting me. Who says Bitcointalk is the only active forum? There are difference between active forum and active crypto forum. Yet, I did not mention anything anywhere that Bitcointalk is the only active bitcoin or crypto forum.

To some extent, Twitter and Reddit can be called a forum because they are much more related to a forum. Discord is also related to forum or something.

To be crypto specific, I know of Bitcointalk, Altcoinstalks and Cryptotalk and I have been checking there traffic since 2020. They are all active crypto forums, although Cryptotalk is now mostly about Russians. Altcoinstalks and Cryptotalk are significantly of low traffic when I was comparing them. 10 times lesser traffic or more. But not that they are inactive and of which I did not mention anything like that.

My comparison is correct that those other two forums are not comparable with Bitcointalk. I have account on all the three forums but I chose Bitcointalk for a reason which seem the best for me and I gained more from this forum.

Title: Re: Altcointalk forum go be our second online home?
Post by: Igebotz on December 11, 2023, 09:02:36 PM
You keep changing goal post Charles. You're contradicting yourself and I'm very sure I will see you on altcointalk next year.  ;)

I'm building a community where free speech is allowed and where we don't need to write application for 1 -2 years to get zero response.

My comparison is correct that those other two forums are not comparable with Bitcointalk. I have account on all the three forums but I chose Bitcointalk for a reason which seem the best for me and I gained more from this forum.

Not comparing directly, but the reason I can not join the forum and the reason most likely good forum posters will not join that forum. Get that right. The traffic is 10 times lower or more than Bitcointalk.

Title: Re: Altcointalk forum go be our second online home?
Post by: Charles-Tim on December 11, 2023, 09:22:13 PM
You keep changing goal post Charles. You're contradicting yourself and I'm very sure I will see you on altcointalk next year.  ;)
You can quote the contractions. I will be happy to give you one merit for it. For us to make it fun. I am specific about what I am discussing.

Very likely that I might later teleport Charles-Tim to Altcoinstalks if alts are allowed. I do not even remember the name of my account there, not to talk of email and password. 2020 has been long.

building a community where free speech is allowed and where we don't need to write application for 1 -2 years to get zero response.
You are right about this.

Quote
My comparison is correct that those other two forums are not comparable with Bitcointalk. I have account on all the three forums but I chose Bitcointalk for a reason which seem the best for me and I gained more from this forum.

Not comparing directly, but the reason I can not join the forum and the reason most likely good forum posters will not join that forum. Get that right. The traffic is 10 times lower or more than Bitcointalk.
I did not remember my username, email and password. I have to join now or later if I want to be on that forum. I meant I can not teleport Charles-Tim account. If this is the contradiction. It is not.

Also because I said now that I can not join, I may later be convinced to join. That is human being. Something becoming more positive can change people's intention. Positive feedback mechanism.

Title: Re: Altcointalk forum go be our second online home?
Post by: Igebotz on December 11, 2023, 09:36:11 PM
You keep changing goal post Charles. You're contradicting yourself and I'm very sure I will see you on altcointalk next year.  ;)
You can quote the contractions. I will be happy to give you one merit for it. For us to make it fun. I am specific about what I am discussing.

Very likely that I might later teleport Charles-Tim to Altcoinstalks if alts are allowed. I do not even remember the name of my account there, not to talk of email and password. 2020 has been long.

You were still a newbie on BTT in 2020 so I guess that's why you didn't bother to teleport your account instead you created a new one.   ;D . Well I teleported my account in 2021 while I was already a Sr. Member. Still have posts from 2021 on my profile.

Quote
Also because I said now that I can not join, I may later be convinced to join. That is human being. Something becoming more positive can change people's intention. Positive feedback mechanism.

Signature campaign mechanisms. Fixed for you. Lol Charles  ;D

Title: Re: Altcointalk forum go be our second online home?
Post by: SmartGold01 on December 11, 2023, 10:03:09 PM
That will be the next alternatives to us that like promoting mixers even though say our oga kpatakpata don carry chair seat down ontop this matta wey dey ground like this e no mean say we no get access to browse anoda forum onto say here na him forum or anytin e be. Seriously me don see some people dia and i don also tanana some of our people make dem peep inside there see wetin dey happen weda dem fit like there, odoh some people tell me say there no pure like here and e dey dem left left for eyes, and if you look into de mata if you be pesin wey like to post here you go see say dat place no too pure but how country pipo go do na base on money palaba we go try to get used to that place so that we fit carry am sustain. Me don already show face there at least i dey get familiarized with dey whole every environment before we go finally tuama go there.

Title: Re: Altcointalk forum go be our second online home?
Post by: Davidvictorson on December 13, 2023, 05:49:38 AM
But now that mixers are moving over there, let's see what happens with the traffic on that forum, hopefully, this will be their starting point to achieving the kind of record, or close record of what bitcointalk have already.
I like your balanced perspective on the matter. It is good that it is coming from someone who has been there and kinda know the ropes. Personally, since I teleported my account, I haven't logged in there. But things are going to change not radically or drastically but slow and steadily. It will take a long time for traffic to pick up on that site. If the incentive is high it would be half the time.  Well, I'll say we are in for a long one.

Title: Re: Altcointalk forum go be our second online home?
Post by: odunybiz on December 13, 2023, 11:38:42 PM
I Don see the altcoinstalk forum,  but e get the way the forum be, very different from bitcoin talk forum . I'm so used to bitcointalk forum because it is easy to understand.  The altcointalk forum dey somehow congested in my eyes but I go still go back to see how the forum be , but I so much like Bitcointalk forum I no sure any platform go fit take my attention out from here, Bitcointalk forum is the best among all I have seen maybe because it is the first crypto forum.

Altcoinstalk forum will definitely look somehow to most people since they are not familiar with it. Although I'm not use to it as well but will get familiarize with it if the needs rises.

Title: Re: Altcointalk forum go be our second online home?
Post by: Judith87403 on December 13, 2023, 11:41:53 PM
I no really sabi much about this altcoin forum and how e they work, but although my friend been they tell me about the platform say very soon na were most people go they, so I say make I go clans through about the place, so actually they just they like say na duplicate of bitcointalk forum because everything way they here also they for that side but no matter anything we no go fit compare Bitcointalk forum to that forum because in every way we take evaluate am Bitcointalk forum remains the best.

Title: Re: Altcointalk forum go be our second online home?
Post by: Majestic-milf on December 14, 2023, 08:26:28 AM
 I no really need too much browsing for that place to make my judgement and that nah be say, the altcointalk site look like say e borrow some leaf from BitcoinTalk only say e come forget to arrange am. For me e come be like say the site just gain credence after this mixer issues and e go bad say we carry am dey compare with BitcoinTalk wey don dey do things. I go check the setup and e just be like children playground compared to BitcoinTalk, no detailed arrangement and if you wan find something, I sure say you go loss.
 For the record, the altcointalk site just be alternative just as e name imply, for those wey fit no dey campaign for BitcoinTalk and go like wan try their hand there.

Title: Re: Altcointalk forum go be our second online home?
Post by: Sexylizzy2813 on December 15, 2023, 06:54:21 AM
This Altcointalk Forum self no too make sense for eye, abeg make una no get me wrong oh but wetin I dey try talk be say the way d platform be and this our Bitcointalk e no too look tight or smart.
If not for this issue wey all these Mixers them get i believe say nobody for dy talk about Altcointalk Forum or this thread for no even come out, I just wish say things go come back to normal becos I no see any way wey this Altcointalk fit beat Bitcointalk.

Title: Re: Altcointalk forum go be our second online home?
Post by: CryptSafe on December 15, 2023, 12:36:36 PM
The altcoinstalks platform pattern dey quite different from bitcointalk platform so make we no expect say e go get the same features. I believe say why e dey like that Na sake of say people no too dey parol there wey come make the platform no too dey active as e suppose be. But as it stands now, development dey go on for the platform. Why I talk so be say I notice something one day like that for the platform and Na early this week wey  I check the platform but as I check again I noticed say some features don change and dem don do some touching immediately for the platform wey make am come dey as e dey now.

Senior men dem don teleport go there including some heavy weight managers too wey don set up their campaign announcement thread there. As it stands now, na our very own paddi men dem wey mount there dey  shayo the the place very well.

I believe say as time goes on, that platform go dey in a strong competition and very much active with huge traffic and gradually the developers go begin dey do work on am to give am more touch to perfect am like Bitcointalk.

Title: Re: Altcointalk forum go be our second online home?
Post by: Doan9269 on December 15, 2023, 02:16:32 PM
This is another opportunity i see to all members in taking the promotions of what we do best to the next level in working this out together with the campaign managers we are under, this will also serve as an advantage on the altcoin forum as well to receive the massive influx of the btt members to ressurect back it's traffic it has always been praying for, life is always full of opportunities, may be it's now time for altcoins forum to also receive a change and move forward henceforth.

Title: Re: Altcointalk forum go be our second online home?
Post by: Franctoshi on December 15, 2023, 02:23:02 PM
Bitcointalk will still remain the best to me going on,Though this is my first time of hearing about this Altcointalk forum, but I think with the recent development which bans mixers from running their ads on BTT, and as more mixers will likely start moving into Altcointalk platform to run their ads, this may trigger an increased number of interest or traffic on the platform, and as such members may begin to suggest ways things could get improved with the site, so it can become more user friendly and that way things could get better with time, let's just see how things is going to work out come next year because no one can really predict the future situation of things.

Title: Re: Altcointalk forum go be our second online home?
Post by: electronicash on December 15, 2023, 03:42:36 PM

traffic is important in every platform but if that altcoinstalks will gradually have a lot of information on it and content improves and traffic increases, it will rival bitcointalk. however, bitcointalk will still be the most relevant Bitcoin forum full of information and this is a very historical forum, especially Satoshi's posts.

the people in that forum will always recognize BTT and will probably use the links in bitcointalk as reference.

Title: Re: Altcointalk forum go be our second online home?
Post by: knowngunman on December 21, 2023, 06:31:26 AM
E con be like as i join bitcointalk na him i con they hear bout altcointalk. Ah never too familarise myself with this forum how e go con be for me for the other side. But since wey i join this forum ah done really enjoy the discussion and things wey they go on for here. And small small ah don dey familiarise my self for the forum. My question na how i wan use follow up the altcointalk and if they compare bitcointalk and altcointalk which one go be the choice of the masses? As for me nah bitcointalk i wan dey

E be like say you dey misunderstand something here bro. Both Bitcointalk and altcointalk na cryptocurrency discussion forum for crypto lovers. Nobody dey compare the two here because Bitcointalk na for mainly bitcoin discussion and altcointalk na for other cryptocurrencies other than Bitcoin. Although both of them dey multi task because Bitcointalk get altcoin board for altcoin discussion and altcointalk too get bitcoin discussion section. The choice of which one you go dey depends on wetin you dey interested in, if na bitcoin you wan specialize on, make you dey here jeje and if na altcoin discussion dey sweet you pass, you fit move there but I go like advice you to dey move and freestyle for both forums. As you dey gradually understand this forum, na so you go understand that one too with time if you can remain focused.

I no go lie you that altcointalk dey somehow to me. I mo even know where to start, but naso e dey always be for any new project wey come out. But with time many people go like that place pass here because the interface dey very fine and lovely just that say people never too understand am.

Abeg anybody wey don register for there, make him give us guidelines on how to involve for that side. our elders say "anywhere Banga fruit ripe, na dere you go see birds dey cluster"

Altcointalk no be new project ooo, e don tey wey e dey exist but people no too put body there. I don register for there and e no too dey as people dey talk about it say e dey somehow. Wetin I understand be say anywhere wey person go newly, e go first dey look am somehow but once you understand it Omo you go enjoy am.

To create account sef no hard. Na just normal procedure wey use create account here you go use too for there but if you get plan to teleport your account from this forum to that forum, you go need to use the same username wey you dey use here so everything go align and go easily start your journey there. I dey tell you bro because even people wey dey talk say dem no dey after money don rush go there as some mixer dey plan to launch campaign there.

Title: Re: Altcointalk forum go be our second online home?
Post by: Cryptomultiplier on December 21, 2023, 05:17:12 PM
In all sincerity, I been just they very discouraged since all this banning of mixers start because the development affect me Wella and now na Christmas period wey person suppose go home tell people say BTC they pay, btt forum dey pay, consistent effort dey pay.
I don try port my account sha, but watin dey burst my head now be say person go need to dey update that Altcoin talk side and this Bitcoin talk forum too. E never too clear how person suppose take manage both, but with new challenges comes new responsibilities and new focus and determination.

Title: Re: Altcointalk forum go be our second online home?
Post by: Doan9269 on December 21, 2023, 05:28:09 PM

Maybe we should always remind ourselves of this that nothing is permanent in life, you can check out back in some ago, we have some set of campaign managers and now today, we have almost different set of people, who knows maybe the following could be something else different from what we expect, ban on mixers from bitcointalk should also be considered as another means of maintaining it's reputation and trust, this is not a home that accommodate any kind of shade for doing attrocities, am not saying mixers are, but what will people say about them here on bitcointalk, we may be the next target on attack if we continue to allow them, my opinion anyways.

Title: Re: Altcointalk forum go be our second online home?
Post by: letteredhub on December 21, 2023, 09:35:29 PM
E con be like as i join bitcointalk na him i con they hear bout altcointalk. Ah never too familarise myself with this forum how e go con be for me for the other side. But since wey i join this forum ah done really enjoy the discussion and things wey they go on for here. And small small ah don dey familiarise my self for the forum. My question na how i wan use follow up the altcointalk and if they compare bitcointalk and altcointalk which one go be the choice of the masses? As for me nah bitcointalk i wan dey
person wey know better thing no go think am sed to carry bitcointalk forum and compare with altcointalk forum, the outlook of the interface and traffic for here sef nah standard level , and for me oh BTT dey easily to navigate through and understand sharp sharp for a newbie than that altcointalk, cos even experience members for here the still face small small challenge in understanding how things the operate there sef. But as it don be, nah still opport to use the collect for both sides only say it don increase men them their work load.

Title: Re: Altcointalk forum go be our second online home?
Post by: Marykeller on January 02, 2024, 07:17:49 PM
It is gradually becoming our second crypto online home cos I don the see well known Nigerians as they teleport their account over there. Some don even join mixer campaigns and them don the promote am over there.

This ban of mixer signature campaigns, na em bring peoples mind come for ATT forum via teleporting their account come there. If not of this mixer ban, majority of us for stay put for this forum and we for no know sae em get anything like another crypto forum like ATT.

Since most of us from this forum don teleport themselves come there. Let's see how the traffic go be for there in years to come when the present launch mixer campaigns ends their promotion for there cos as it seems na only the launch mixer campaigns na em bring majority of us come there.

Title: Re: Altcointalk forum go be our second online home?
Post by: sokani on January 03, 2024, 02:10:07 PM
It is gradually becoming our second crypto online home cos I don the see well known Nigerians as they teleport their account over there. Some don even join mixer campaigns and them don the promote am over there.

This ban of mixer signature campaigns, na em bring peoples mind come for ATT forum via teleporting their account come there. If not of this mixer ban, majority of us for stay put for this forum and we for no know sae em get anything like another crypto forum like ATT.

Since most of us from this forum don teleport themselves come there. Let's see how the traffic go be for there in years to come when the present launch mixer campaigns ends their promotion for there cos as it seems na only the launch mixer campaigns na em bring majority of us come there.

I believe no be today some people know ATT but na because nothing dey really happen there na im make people just position here. But the ban don make many people teleport their accounts go there and few years from now de forum fit come close to Bitcointalk. From wetin I dey see, e come be like say the numbers of teleported users plenty pass the numbers of people wey signed up directly on the forum. The launch of mixer there go help the forum and if government ban any of them, another go show up.