Bitcoin Forum

Local => Nigeria (Naija) => Topic started by: MainIbem on December 13, 2023, 06:06:06 PM



Title: Newly launched token alerts
Post by: MainIbem on December 13, 2023, 06:06:06 PM
Merry Christmas my fellow kontri man I carry small open eyes news come this angle this evening because I believe say like this every body don dey prepare for the bull run. E get some people wey neva touch their holds I means the one for BTC but still anyhow e be make I just try let most of us know say this period na injury point wey be say every body eyes dey shine based on wetin dem go do to carry take better bitcoin wey you hold for yourself for this bull run.

Now get the code say scammers or people wey want collect your hand earned money for free go carry fake project come launched for this forum then dem go enter twitter go make small noise so that people go see dem after which dem go launch and start making sales at this point you dey exchange your hard earned money to fake tokens. Them target na those our brothers wey focused their minds to double dem investment that is, pipo wet dey always expect to receive 10x to 1000x pump so that dem fit make big profits.

Although una fit see am say I just dey cap for nothing but believe me or not, I don get experience here and me self don fall victim for this kind things plenty times during time of ICO, IDO and even in this IEO so I say make enlighten those our brodas wey carry profits put for head, even if you must do anything abeg try hold BTC strong abeg this one no body fit scam you run except say you lose guard go exposed your seed phrase or private keys.


Title: Re: Newly launched token alerts
Post by: Mate2237 on December 13, 2023, 07:39:04 PM
Op this your thread e don full this corner well well so frankly speaking this your own e no come make sense again. We don discuss this matter tire. https://bitcointalk.org/index.php?topic=5476594.0 others are still there if you make the search bar you will see more of them. Please always use the search bar and google search to confirm the topics before starting a new topic and for for me oh this topic is not needed. We all know from the beginning that scammers are moving around whom to be victimized. This topic is a music we are singing in the forum so if any still fall victim then na the person problem.

At first base on the topic I think say you don go see new project at somewhere wey you carry come yan us. And when I read the first paragraph, I think say you go provide some of the scam matter but nothing come out. No be every time we go make thread, sometimes make we use as comment, merit go still come if it solve, answer and contribute to questions.


Title: Re: Newly launched token alerts
Post by: Makus on December 13, 2023, 08:54:17 PM
@mate2237 wattin you talk na true sha, say this kind of thread Dem many for this forum, and the op for fit just comment for other thread than to create em own. But wattin the op do sef no still bad because, this period na injury time and anything fit shele, so the thread dey act like remainder for us, make we for fit refresh our mind and return to the normal practice instead of to allow long throat and big eye, finish our bitcoin investment. Beside Mate2237 the link wey you post na link to entirely different thread wey dey talk about scam links wey dey fly around for social media while the op they talk about, selling your bitcoin to go buy shitcoin or scam project because you dey find huge profit of like 10x increase.

I know say you wan help the local board from spamming, but if na only me, this post dey very important as reminder for this period wey everywhere dey hot for scam matters. And the experience wey the op share na eye opener to many people wey dey think of to divert from bitcoin to altcoin.