Bitcoin Forum

Local => Nigeria (Naija) => Topic started by: Barikui1 on January 24, 2024, 06:17:01 PM

Title: Why it's very risky to leave your coin in an exchange
Post by: Barikui1 on January 24, 2024, 06:17:01 PM
My country people good evening inside this evening, e get one thing I wan talk about wey I think say na very big mistakes and disaster waiting to happen if we continue that trend, see most of us crypto enthusiastic no know how risky e be to leave our coin in an exchange, if you don here about this phrase, not your key, not your coin, you go understand well wetin I dy try to talk.

Their are some questions we need to ask our self, question like, if this exchange all my coin dy get K leg, na who I wan hold? Make we try use people dy learn, make we no allow am to happen to us first before we learn,  that is why for this forum them dy always dy advice everyone to use self custodian wallet, so that you no go wake up one morning come dy hear stories about your investment.
Make we just look how FTX just run into bankruptcy wey make so many people money plus life savings get K leg till today,  abeg make we thread wisely.

Title: Re: Why it's very risky to leave your coin in an exchange
Post by: Makus on January 24, 2024, 06:45:12 PM
This na matter wey need to dey come up all the time because almost everyday naim newbie dey enter this forum, and no be every body get this update. Of anything happen to any exchange wey your money dey inside, my brother e don go be that oo. The major target of hackers na exchange and if them successfully get one down, the amount of money wey Dem dey commot no be here oo, and you fit be victim. Even if say you use exchange take receive money, make you move the money comot for your safety. Had it been I knew, naim bad pass oo.

Last year the amount of hackers matter wey we hear too many, for person to dey loose guard for that kind matter. E before to make the right changes now, than make life teach lesson before you go know wattin dey for ground.

Title: Re: Why it's very risky to leave your coin in an exchange
Post by: DubemIfedigbo001 on January 24, 2024, 09:31:51 PM
Exchanges are just like market places, you go there to buy and sell, everybody needs to understand this. When you leave your coin there, its just like you're intentionally leaving your money at the marketplace under the custody of people you don't know nor trust and you wouldn't blame anybody if you go back and fail to see your coins.

Leaving your coins in exchanges is the very basic sign of crypto handling carelessness and once a platform is centralized, you're not the one in control, so you can expect anything to happen. Non-custodial wallets are the best. There are likes of Electrum, blue wallet and sparrow wallets. Go for wallets that gives you full authority over your funds.

Title: Re: Why it's very risky to leave your coin in an exchange
Post by: Su-asa on January 24, 2024, 09:47:31 PM
Those way create those exchanges wallets no come the game to joke with anybody, so if anybody like make em wise up,, make bad thing no happen one day when we go hear say the most popular exchange wallet way we dey use fine collapse and people money wey dey inside done go.

I got use my self as a good example, my first Bitcoin was purchased through third party and instantly I transferred it to an electrum Bitcoin wallet because say the first wallet we e dey no dey safe, in everything we do concerning crypto currency, we should always put safety first. Without our safety in crypto currency we can not hold and we can not also gain profit, now if one can not protect his coins how can he get profit? That's is not possible.
However the earliest time we know this things that's the best time we should take it seriously for we not to be a victim of loses. Crypto scam are misleading some investors through social media.

Title: Re: Why it's very risky to leave your coin in an exchange
Post by: DaNNy001 on January 24, 2024, 10:21:39 PM
My country people good evening inside this evening, e get one thing I wan talk about wey I think say na very big mistakes and disaster waiting to happen if we continue that trend, see most of us crypto enthusiastic no know how risky e be to leave our coin in an exchange, if you don here about this phrase, not your key, not your coin, you go understand well wetin I dy try to talk.

Their are some questions we need to ask our self, question like, if this exchange all my coin dy get K leg, na who I wan hold? Make we try use people dy learn, make we no allow am to happen to us first before we learn,  that is why for this forum them dy always dy advice everyone to use self custodian wallet, so that you no go wake up one morning come dy hear stories about your investment.
Make we just look how FTX just run into bankruptcy wey make so many people money plus life savings get K leg till today,  abeg make we thread wisely.
This na normal warning wey dem give us every time even as we dey and I no know if you don actually hear this saying wey talk say so far as no be you get the key no be your coins and this issue with exchange nai go explain this saying properly. If you leave your coins for exchange, na the exchange nai get the  exchange nai get full control because of say e dey centralize and you fit hear story say dem don hack their company and all your coins don go be that so keeping it offline is always better because dat one na you get your keys.

Title: Re: Why it's very risky to leave your coin in an exchange
Post by: I_Anime on January 24, 2024, 10:26:17 PM
Nah true you talk beta learn from others than experience, we normally know say experience is the best teacher but nor still forget say nor be friendly one ohh. E go teach you the hard way. At first make never too understand this crypto space I dey normally dey leave my funds for people hand (centralised exchange) after I duh purchase am.

Why most people dey leave am dey think say e go reduce fees matter. But as time goes on I con know say to leave your asset for vex account dey risky ohh say anything can happen to it any time. Nah I jejely transfer all my asset from cex account to my custodial wallet ohh. So as you purchase the particular coin way you wan buy just transferred am go any Dex wallet of your choice.

Title: Re: Why it's very risky to leave your coin in an exchange
Post by: Mate2237 on January 24, 2024, 10:49:38 PM
Op I fit talk say dis one na spam post because there are many thread wey we don talk dis matter plenty time. At first I think say na question you want ask and I was also preparing to answer the question but when I opened the thread na another thing I come see. Op have you heard, "Not your key not your coins" statement before? And also do you know where di phrase was emanated from? It was from this kind of thread so we are not new to this kind tok.

But Op you still need to know that many people dey keep coins for centralized exchanges because of the high transaction fee charges. Like yesterday I transferred 0.008 to busha and I was charged 7$ for the transaction. So I decided to transfer all my coins to exchange so that I will reduce code when I like to sell bitcoin next time.

Title: Re: Why it's very risky to leave your coin in an exchange
Post by: Dr.Bitcoin_Strange on January 24, 2024, 11:41:26 PM
This information was not taken seriously by some investors until they had a few experiences with some failed exchanges and also those that got hacked.

There was one old exchange named Cryptoopia that got hacked some years ago. I lost about 1k+ doge coins on that exchange, and I only remembered having doge coins on that exchange when the coin began to pump in 2021. Right from then, I just learned a lesson not to keep coins on exchange, although I did not really take it very seriously. But after I learned about the phrase "not your key, not your coin," I became more concerned about my crypto asset.

Title: Re: Why it's very risky to leave your coin in an exchange
Post by: Stable090 on January 24, 2024, 11:43:45 PM
My country people good evening inside this evening, e get one thing I wan talk about wey I think say na very big mistakes and disaster waiting to happen if we continue that trend, see most of us crypto enthusiastic no know how risky e be to leave our coin in an exchange, if you don here about this phrase, not your key, not your coin, you go understand well wetin I dy try to talk.
Na better post u carry come here ooo, I don dey see this kin post for other threads, but e too make sense d way you carry am come dis our board. Some people dey think say if they leave their coin for exchange, it’s easily accessible, and you go fit sell d coin when you like and you go convert money to naira easily. I know say no be lie, e dey easily accessible, but if we reason d risk wey dey involved, then we go know say e no make sense at all. If anything happens to the exchange, then your money to dey follow the exchange to go be that ooo, and no reason say a exchange security dey tight, if dey wan compromise am, dem go run am.

There are some questions we need to ask our self, question like, if this exchange all my coin dy get K leg, na who I wan hold?
U no fit hold anybody now, na urself u go hold, because you sabi d truth about leaving coin on exchange, and you still decided to leave it their, then na u do yourself, because nobody wey u go talk say u wan go meet.

Make we just look how FTX just run into bankruptcy wey make so many people money plus life savings get K leg till today,  abeg make we thread wisely.
Seriously FTX matter alone self suppose don learn lesson, you no see d massive amount wey go for that FTX, I even sabi one exchange wey close down, but like say dem done open na Hotbit dem dey call am, but e take more than a year before dem come back, so e no really make sense to dey leave coin in exchanges.

Title: Re: Why it's very risky to leave your coin in an exchange
Post by: Pi-network314159 on January 25, 2024, 12:30:15 AM
Even as say dem dey talk this matter say not your key not your coin, no mean say person no fit use CEX For other reasonable things. Wetting me I see there be say exchange wallet na just place to receive coin and sell, after which you go fit still transfer am go any DEX wallet. Like me if them dey send me my signature campaign money na binance exchange I go reacieve am sell am and send to my bank account and if I wan save any one for wallet I go just use am but coin for the exchange then send am to Dex wallet because E dey cheaper to receive and buy coin on exchanges than to receive am for DEX because e go delay you in time of transfer and also the transaction fee dey high.

The truth be told, exchange no be place to keep coin. But do to risk now exchange don become a home for many to keep their coin. Because no body wan loss fund to transaction fee.

Title: Re: Why it's very risky to leave your coin in an exchange
Post by: EluguHcman on January 25, 2024, 01:04:10 AM
Obviously what has an advantage is otherwise accompanied with disadvantage. The wallet exchange offers a one way transaction exchange with zero fees since the coins is already stalled in an exchange wallet but reverse be the case that the Coin owner is not 100% custodian in an assurance of a centralized security charges to his coins likely to be that your coins are exposed to the possibilities of losts and the Coin owner is not legally entitled to hold the wallet exchangers responsible for any lost count while trading with them.
On a serious note, I wonders why the Security and Exchange Commission (SEC) can not be held responsible or be questionable on a case like this.

Title: Re: Why it's very risky to leave your coin in an exchange
Post by: Mayor of ogba on January 25, 2024, 02:37:54 AM
Anyone using the centralized exchange to save his bitcoin is just gambling with his bitcoin because the person might wake up one morning to see that he or she can't access his fund because the centralized exchange has been hacked or the centralized exchange is bankrupt. Let's always learn to withdraw our bitcoin to a noncustodial wallet where only we will have access to it. Also, protect your seed phrase or private key so that someone will not get access to it, because if they do, you will lose your bitcoin.

Title: Re: Why it's very risky to leave your coin in an exchange
Post by: Asiska02 on January 25, 2024, 06:56:55 PM
My country people good evening inside this evening, e get one thing I wan talk about wey I think say na very big mistakes and disaster waiting to happen if we continue that trend, see most of us crypto enthusiastic no know how risky e be to leave our coin in an exchange, if you don here about this phrase, not your key, not your coin, you go understand well wetin I dy try to talk.

Not your keys, not your coins na one of the most used word or phrase for dis forum when it comes to security and privacy of your coins. Many people dey neglect dis warning and always dey feel day nothing to happen to their coins become dem trust the exchanges wey dem dey use save their money inside. But dem no know how big the exchanges wey don crash before dey, e dey least of expectations say something like dat fit happen to any exchange like dat. The earlier we pay heed to dis warnings the better for us and our savings in crypto for the future use of them.

Quote
Make we just look how FTX just run into bankruptcy wey make so many people money plus life savings get K leg till today,  abeg make we thread wisely.

Fire no dey burn person two times for d same location unless d person an mumu and him no go ever wise again. People west fall victim of FTX scam go be the least to think of leaving even a penny for any exchange now. E cost more of dem their life savings and had to become poor again. We no which for that kind scenario to happen for cryptocurrency world again but even as we dey pray, we suppose dey careful make we no allow us become scape goat first for this kind situation after the many warnings we don see for the forum.

Title: Re: Why it's very risky to leave your coin in an exchange
Post by: Uhwuchukwu53 on January 28, 2024, 08:25:52 AM
My country people good evening inside this evening, e get one thing I wan talk about wey I think say na very big mistakes and disaster waiting to happen if we continue that trend, see most of us crypto enthusiastic no know how risky e be to leave our coin in an exchange, if you don here about this phrase, not your key, not your coin, you go understand well wetin I dy try to talk.

Their are some questions we need to ask our self, question like, if this exchange all my coin dy get K leg, na who I wan hold? Make we try use people dy learn, make we no allow am to happen to us first before we learn,  that is why for this forum them dy always dy advice everyone to use self custodian wallet, so that you no go wake up one morning come dy hear stories about your investment.
Make we just look how FTX just run into bankruptcy wey make so many people money plus life savings get K leg till today,  abeg make we thread wisely.

Op this your matter is very helpful, this is one mistake many make including me some time ago when join crypto as was trying to mined some coin and kept them in an exchange all of a sudden after a long time awaiting listen the coin disappeared I was imagining the course of it some exchange is not helpful in security your money  gather knowledge and experience from that event. Thanks for this greater exposure if this write up like the scripture he that have ear let him hear as many have emphasize on there experiences concerning keeping of coin in an exchange.

Title: Re: Why it's very risky to leave your coin in an exchange
Post by: Obim34 on January 28, 2024, 09:34:29 AM
Anyone using the centralized exchange to save his bitcoin is just gambling with his bitcoin because the person might wake up one morning to see that he or she can't access his fund because the centralized exchange has been hacked or the centralized exchange is bankrupt. Let's always learn to withdraw our bitcoin to a noncustodial wallet where only we will have access to it. Also, protect your seed phrase or private key so that someone will not get access to it, because if they do, you will lose your bitcoin.
People make same mistakes even when they have full knowledge on how risky it is to hold their Bitcoin in Cex. Cexs are mainly made for trading and not actually holding for a long term due to many factors that may cause losing one's funds. Nevertheless little portion of Bitcoin can be held first during accumulation then later transfered to a non custodial wallet.

Title: Re: Why it's very risky to leave your coin in an exchange
Post by: CryptopreneurBrainboss on January 28, 2024, 09:40:00 AM
Their are some questions we need to ask our self, question like, if this exchange all my coin dy get K leg, na who I wan hold? Make we try use people dy learn, make we no allow am to happen to us first before we learn,  that is why for this forum them dy always dy advice everyone to use self custodian wallet, so that you no go wake up one morning come dy hear stories about your investment.
Make we just look how FTX just run into bankruptcy wey make so many people money plus life savings get K leg till today,  abeg make we thread wisely.

E get one illustration wey I see online one day, when you buy phone wetin be the first thing wey you dey do? Nobi to buy screen guard and phone cover to use secure you phone. If we fit do something like that for phone to protect am then wetin dey stop us from protecting our investment. Ignorance no be excuses oh, scammers and hackers no go use say you no know free you. You need to protect your investments and the best way to run that kind matter na to dey in charge. Nobody go fit guard your investment reach you so why you dey leave am in the hands of the centralized services providers.

Exchange oh whether na centralized ones or those decentralized one, no one safe to use hold your Bitcoin or other altcoins self (if you be person wey dey invest inside altcoins). This advice is always welcomed on the forum to enlighten people because alot of us still dey use exchange and all this centralized services providers without knowing the risk involved. For people wey know the risk and still dey use them that one na their own wahala but for people wey no know, E good to dey remind them always like this.

If you no get money to buy hardware wallets, you fit use electrum in an airgapped devices and you no get wahala provided say you fit secure your investments from hackers well for the electrum wallet. Same for altcoins, search for non custodial wallets them (decentralized wallets) wey you go use store and never use exchange wallets for storing of your cryptocurrency.

Title: Re: Why it's very risky to leave your coin in an exchange
Post by: Benedictare on January 29, 2024, 09:25:18 PM
 Cryptocurrency Exchange  is a market place online which accepts users to buy, sell and trade cryptocurrency ,it is,like online brokerage in functioning as users can put in money like fiat currency and use the money to buy cryptocurency. Since cryptocurency exchange is a market  place ,you can not keep your  money in a market place because alot of things will happen to your money ,the same thing also to your coin.

   It is risky to leave your coin in an exchange because of the market risk like,

▪ You cannot get your money when you need it,no freedom of controlling your money, insecurity.
▪ Exchangers are easily been  attacked and hacked also opened to cyber criminals, counterparts risks e.c.t.
   A lot of people buying and miners lost their investment on exchanges . At times it is good for you to save your money in you personal wallet ,in other for you to have control over it

Title: Re: Why it's very risky to leave your coin in an exchange
Post by: Pokapoka124 on January 29, 2024, 09:59:14 PM
E don tay we don dey yan this matter still on still some people nor won hear word. Them believe say all this exchange nor go fit carry their money run. If you try explain give them make them fit understand, them go clear you say this their exchange na US based and nothing dey hapun. I go just weak when I hear people talk like this, I go come dey wonder how them take get bitcoin.

Title: Re: Why it's very risky to leave your coin in an exchange
Post by: EL MOHA on January 29, 2024, 10:19:45 PM
E don tay we don dey yan this matter still on still some people nor won hear word. Them believe say all this exchange nor go fit carry their money run. If you try explain give them make them fit understand, them go clear you say this their exchange na US based and nothing dey hapun. I go just weak when I hear people talk like this, I go come dey wonder how them take get bitcoin.

Senior man you see this matter ehnn i swear na like all those Ponzi schemes wey we Dey see around, them go scam People today and plenty people go lament and regret am, then tomorrow another of this thing go come and same people go go put money. The other day I hear person Dey talk say binance get SAFU and because of that your money no fit lose, even if you advice this kind people Omo them no  go listen oo sometimes he better make them learn the hard way. Another thing weh I notice with exchange’s now na that separate wallet wey them get and people Dey treat am too as wallet because them provide them seedphrase.

If you no get money to buy hardware wallets, you fit use electrum in an airgapped devices and you no get wahala provided say you fit secure your investments from hackers well for the electrum wallet. Same for altcoins, search for non custodial wallets them (decentralized wallets) wey you go use store and never use exchange wallets for storing of your cryptocurrency.

Na better advice be this boss man but i Dey feel say sometimes this airgap device go hard to set up for some newbies or some of them fit even go make mistake come carry am go online. So better for newbies na to buy hardware wallet because the amount an the same with getting new gadget now.

Title: Re: Why it's very risky to leave your coin in an exchange
Post by: Su-asa on January 30, 2024, 04:07:14 PM
E don tay we don dey yan this matter still on still some people nor won hear word. Them believe say all this exchange nor go fit carry their money run. If you try explain give them make them fit understand, them go clear you say this their exchange na US based and nothing dey hapun. I go just weak when I hear people talk like this, I go come dey wonder how them take get bitcoin.
Exchange wallets no be where investor go hold e money, that exchange wallet na place of selling, na make them call am exchange wallet, the buyers go credit you to your bank account, you go also fit swap your coins, you go still fit buy Bitcoin and other things but no be place to hold, Bitcoin, person fit try am with shitcoins or altcoins but make person no eventually use exchange wallet take hold em coins because one day be one day when the exchange go close down and em coins go lose finish, e just also dey like when people dey use microfinance bank dey save money until one day the microfinance banks them short down, were the person won go find them?
So, na very simple thing to do, when we just use safer wallets go hold our coins instead of to go dey use exchanges way one day then fit run away and our coins we no go see.
The more we dey they aware of all this things the more we dey know them all,  but some people go still prove stubborn even when na the truth you dey tell them but one day them go use one person as a very big example to all of them, but we do not pray for that.

Title: Re: Why it's very risky to leave your coin in an exchange
Post by: Mate2237 on January 30, 2024, 04:35:03 PM
E don tay we don dey yan this matter still on still some people nor won hear word. Them believe say all this exchange nor go fit carry their money run. If you try explain give them make them fit understand, them go clear you say this their exchange na US based and nothing dey hapun. I go just weak when I hear people talk like this, I go come dey wonder how them take get bitcoin.
PP you yan well but we have to consider some factors around the bitcoin network now. Example when someone wants to transfer 0.00043 to an exchange from an Electrum wallet and the transaction fee is about 0.00023 then how much is left for the person to receive to the exchange but if that amount or the unit of bitcoin is Electrum, the person has nothing to pay before he sell them off. Yes we all know the clause that says "Not you key not your bitcoin" but that is statement is not for the time like this because I can't be paying high transaction fee but a small amount of unit of bitcoin that I want to sell to solve small problem.

Even though we are not keeping the large of bitcoin in exchange, we can keep small unit which can be selling to solve issues at hand. But before you do that make sure you know the exchange very well. And if possible it is only for the top 5 exchanges.

Title: Re: Why it's very risky to leave your coin in an exchange
Post by: Franctoshi on January 30, 2024, 04:56:59 PM
Make we use wetin happen to FTX victims learn lesson and not wait until we experience am before we take protective measures, no matter how secure even the most secured exchange out there fit be, learn your lesson from the FTX saga because anything fit happen, And if you are a trader, ensure that you always withdraw your funds immediately after the end of trading day, do not because of the withdrawal fees that you will be charged and leave your coins over, it's better you get charged the small amount than you lose everything with the aim of trying to save withdrawal fees. Always remember, Not your keys, not your crypto.

Title: Re: Why it's very risky to leave your coin in an exchange
Post by: Kelward on January 30, 2024, 06:27:19 PM
One of di first lessons wey I learn for dis forum na "not your keys not your coins", and since dem I don memorize am for my mind, hacks and scams plenty for crypto matters, and exchanges no de immune to hacks so anybody wey de for dis forum wey still de leave dem coin for exchanges, dem name na OYO. I thank the OP for resurrecting dis topic, evendo say we don hear am many times, e still no bad to de start am as reminder topic, so newbies wey just de enter di forum new go learn and take note.

Title: Re: Why it's very risky to leave your coin in an exchange
Post by: teamsherry on January 31, 2024, 11:58:36 AM
Yes oh, this one Don happen to person wey I know although no be exchange, en own be say en go put en seed phrase for one online platform like that and now all en asset Don vamous, abeg for real make everybody dey try do the right thing, for this our crypto verse, scammers and many unpredictability fit occur, like when famous mt.gox exchange  crash, many people lose their asset, even till now many people have not been Compensated from that incident. So please make we try dey use hard wallet dey store our money, instead of to dey keep am for online exchange.

Title: Re: Why it's very risky to leave your coin in an exchange
Post by: sokani on January 31, 2024, 01:41:18 PM
Dem talk say experience na the best teacher but the real best teacher na to learn from oda persons mistake. Wen you keep your assets for exchange, e no dey your hand again, na the exchange na hin dey in charge of your coins. And na because of the heartbreaking news wey we dey hear about exchange everyday like the freezing of customers funds, hacks, bankruptcy, shutdown by government na bring about dis popular slogan "Not your keys, not your coins." So like dis na self custody na hin be the koko, make we wise up.

Title: Re: Why it's very risky to leave your coin in an exchange
Post by: Makus on January 31, 2024, 02:17:02 PM

Experience naim be really the best teacher, while learning from other people mistake is you being wise. So e dey wise if you learn from other people make the same mistake no go knack you join. We don hear of exchanges wey Dem don hack and steal people money so if you still dey keep money for exchange na you sabi, or be like you just dey wait for your own experience before you go learn. Just as baba sokani talk na self custodian wallet naim be the best especially when you dey hold long term project. Just last year the amount of hack wey we hear about too much for people to still dey loose guard keep better money for exchange, just as the name talk exchange we suppose use am for exchange alone and not for holding our coins.

Make we no let bad thing happen to us before we wise oo, na why we get elders and experienced men wey don dey this crypto network for long so that we fit ask them question and I believe say them dey deliver, something e fit no even be say na guru naim go even give you wattin you dey find, something na newbie or lower rank member, that na why we nor supposed look down on anybody and learn from them they most get something to offer wey fit solve one or two of your problems.

Title: Re: Why it's very risky to leave your coin in an exchange
Post by: Y3shot on January 31, 2024, 07:15:47 PM
Make we use wetin happen to FTX victims learn lesson and not wait until we experience am before we take protective measures, no matter how secure even the most secured exchange out there fit be, learn your lesson from the FTX saga because anything fit happen, And if you are a trader, ensure that you always withdraw your funds immediately after the end of trading day, do not because of the withdrawal fees that you will be charged and leave your coins over, it's better you get charged the small amount than you lose everything with the aim of trying to save withdrawal fees. Always remember, Not your keys, not your crypto.
This na weting they worry some people,  with everything wey don happen to some exchange in the past wey people lose their money some people never still learn but them dey wait to experience thus mistake by themselves instead of them to learn from other people's mistake. Exchange can never be trusted to be safe because it is centralized in nature . The past experience of how exchanges end up should be a lesson people needs to learn from when making decision about wallet to use.

Title: Re: Why it's very risky to leave your coin in an exchange
Post by: Zanab247 on January 31, 2024, 08:23:27 PM
Anyone that is still living his coins in the exchange market, this information is for you and, he or she is taking a big risk because that place is made for exchange but if you want to live your coins there for future use, I think the place is not safe for your coins and, if something happen to your coins you will find yourself blame.

I know newbies always fall victim to such risk in the community because, they always feel they are doing the right thing by living their coins on the exchange until something strange happen to their coins before they will know that they have been taken a big risk.

Title: Re: Why it's very risky to leave your coin in an exchange
Post by: Antotena on February 01, 2024, 08:37:12 PM
Make we just look how FTX just run into bankruptcy wey make so many people money plus life savings get K leg till today,  abeg make we thread wisely.

Just because it has not happened to you before no mean say u no go fall victim, na wetin I dy tell some people be this. I remember that time when one of my guy they show me how people were unable to withdraw their coins from the exchange and they have to watch their coin dump on the exchange, my heart was bleeding even when I wasn't a victim of what happened on the exchange. Till date, those people have not been able to have access to their money, they are putting money together to pay back victim, might take more years to accomplish the distribution because MT.gox that happened years ago are yet to distribute to the users.

If you are done with using exchange. Withdraw your coin to your personal wallet, na the only place wey you get mouth be that, nobody can have access to your wallet except you, nobody can touch your coins except you and nobody can spend your coin expect you that have the private keys.

Title: Re: Why it's very risky to leave your coin in an exchange
Post by: Churchillvv on February 01, 2024, 10:28:38 PM
One major reason why them dey always advise person not to keep him or her coin for exchange na because of hackers and scammers. some exchange na scammers build am ooh inorder not to look like scammers wey dem be them go just try make everything legal then one day when them get plenty trust and people don up to billions of assets for the exchange them go just claim say person don hack them and so them go close the exchange with your coin. so like play like play your money don go.

So as soon as you get any asset wey reach at least money wey dey significant to you like $500 or 200 self na to find wallet wey go dey reliable like electrum etc then move your coin go there for am to dey self. as for me no na to buy hardware wallet like trezor to hold my assets. So the same advise go for every body make dey careful with out money for crypto because scammers them no fey give up.

Title: Re: Why it's very risky to leave your coin in an exchange
Post by: KupaCrypto on February 22, 2024, 10:17:54 AM
Holding cryptocurrency for exchange dey very easy for trading but e get security wahala. If hacking happen, security breach, business issues, or dem no fit manage money well, e fit cause you to lose your property. For example, hackers fit thief cryptocurrency from plenty accounts if dem fit breach security, or the exchange fit crumble, wey fit make users lose their cryptocurrencies.

Unlike government-regulated money, the legal system no dey protect cryptocurrencies well. E no too sure say you go fit recover your crypto money if exchange dey hacked or declare bankrupt. So, the best way na to store most of your crypto property for hardware wallet and use exchange platform to keep the amount of cryptocurrency wey you need for transactions.