Bitcoin Forum

Local => Nigeria (Naija) => Topic started by: kenpachiofficial on February 20, 2024, 08:08:15 AM



Title: NAIRA VALUE FALLS TO 1700/$
Post by: kenpachiofficial on February 20, 2024, 08:08:15 AM
My fellow Naija brothers and sisters as e be so dollar don reach 1700 today, as at this morning wey I check my binance rate na 1738. Country sad, government sad, things cost but life goes on. I urgent everybody make them find ways to earn in $ because Omo, this our currency na rubbish currency wey just the fall everyday.


You no fit the earn in naira wey you go get peace of mind as things be, except your papa na politician sha even we wey the earn in $ e get as e be. Based on how this country don tire you I urge everybody make them find way earn in $, Twitter dey pay, affiliate marketing dey pay, forex dey pay, freelancing dey pay. Plenty things dey to get money from, I no advice make you do yahoo but if na that one be your calling then fire the go since government ma no send anybody. Follow who know road, this no be time to dey idle use your head well.

And as you the follow who know road, know who you the follow, e get why. BTC


Title: Re: NAIRA VALUE FALLS TO 1700/$
Post by: Makus on February 21, 2024, 09:16:12 AM
My brother based on say you be total newbie, I go just advise you make you go back to who introduced you to this forum make you for learn the rules about this forum again before in engage in posting. Because this "Naira value" thread don too many for this local board, and na post spamming them dey call am. You fit even receive tag for this thread wey you create because una just dey litter the local board with spam posts when the main thread for discussing about the naira value still dey ground for this first page sef.
To avoid tag from DT member just look at the left bottom of this forum inside your thread and luck it.
Here is the link to the original topic:
https://bitcointalk.org/index.php?topic=5457300.0


Title: Re: NAIRA VALUE FALLS TO 1700/$
Post by: Hewlet on February 21, 2024, 09:46:36 AM
Just like @makus don advice you, before creating any thread most especially as it regards trending matters, ensure you look at the board to see if someone has posted a similar thing before you. If someone has done that, you can just contribute to the already existing discussion rather than creating a separate thread for it. If we continue to create new thread whenever the value of Dollar rises or drops down to a certain amount, it won't take time before everywhere will get flooded with similar post and it wouldn't make any sense when an outsider comes into the board to view the kind of discussion we are having here.

Follow he instruction you've been given and luck this thread and maybe you can just edit the Title of the thread and add SOLVEDto it so it wont become a distraction to serious matters that needs to be looked into.