Bitcoin Forum

Local => Off-topic (Naija) => Topic started by: Bournesparks on March 16, 2024, 01:18:56 PM

Title: How to solve network issues for men and airtel
Post by: Bournesparks on March 16, 2024, 01:18:56 PM
I know say we da experience slow and low network for 4 days now due to mtn and airtel wahala. But I get one kind solution like that. Just download X VPN, Switch from AUTO TO UDP and connect. Your netwrk will significantly improve. I greet una✅

Make una try am give me feedback how e be.

Title: Re: How to solve network issues for men and airtel
Post by: Chibaba on March 16, 2024, 01:27:24 PM
I know say we da experience slow and low network for 4 days now due to mtn and airtel wahala. But I get one kind solution like that. Just download X VPN, Switch from AUTO TO UDP and connect. Your netwrk will significantly improve. I greet una✅

Make una try am give me feedback how e be.

I no dey like use vpn because of security risk

Title: Re: How to solve network issues for men and airtel
Post by: Charles-Tim on March 16, 2024, 01:54:52 PM
I will not advise anyone to use VPN that is full of ads as the VPN providers are giving your data to third party. VPN is not secure as using normal network. Or use paid VPN and the ones that has no ads.

You can still use exchanges mobile apps without VPN to access the exchanges.

Title: Re: How to solve network issues for men and airtel
Post by: Coyster on March 16, 2024, 02:26:31 PM
I no know how VPN can improve your network speed, AFAIK, VPN sev dey reduce network speed rather than to increase it. VPN na for privacy and for security, i have never known it to be for this purpose wey you talk now. The network wahala dey very frustrating, but i think the Airtel network is somewhat better today, but MTN is still very bad.

Title: Re: How to solve network issues for men and airtel
Post by: 7juju on March 16, 2024, 02:42:27 PM
I no know how VPN can improve your network speed, AFAIK, VPN sev dey reduce network speed rather than to increase it. VPN na for privacy and for security, i have never known it to be for this purpose wey you talk now. The network wahala dey very frustrating, but i think the Airtel network is somewhat better today, but MTN is still very bad.
Omo this network of a thing is frustrating the hell out of me. Like this e come be like say na my area the thing come worse pass. And na only MTN sim card I get throughout. If no be say someone calmed me down yesterday I nearly hit my phone for wall because of say the frustration too much. Na when I come manage connect to my guys hotspot I come see say na general issue.

Title: Re: How to solve network issues for men and airtel
Post by: Charles-Tim on March 16, 2024, 03:06:29 PM
I no know how VPN can improve your network speed, AFAIK, VPN sev dey reduce network speed rather than to increase it.
If you use a good VPN, it can not reduce network speed. What I can say about this is that VPN is good to bypass restriction but some people will end up using non recommended ones. But to use VPN to access centralized exchanges and gambling sites is not also advisable.

VPN na for privacy and for security, i have never known it to be for this purpose wey you talk now. The network wahala dey very frustrating, but i think the Airtel network is somewhat better today, but MTN is still very bad.
Two people told me that Airtel is not as bad as MTN. I use Glo (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5488930.msg63810829#msg63810829) and it is good. I have been using it since yesterday and works excellently.

If this is about the poor network connection, I think we should not abandon the old thread. There are some good replies there: Nor be Your Data Finish,  Na Underwater internet cable cut cause am (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5488930.msg63806078#msg63806078)

Title: Re: How to solve network issues for men and airtel
Post by: Coyster on March 16, 2024, 03:12:48 PM
Na when I come manage connect to my guys hotspot I come see say na general issue.
Yes oh, wetin cause the poor network be say Mainone's submarine cables wey dey for the Atlantic Ocean got damaged oh, and the thing come affect the network, and no be only Naija oh, some other African countries also dey affected. You fit do research on the matter, but the last time wey i check, dem talk say dey are on the matter and a solution go dey available soon, so we gats dey patient.

You fit check here to read about am: https://pmnewsnigeria.com/2024/03/16/mainone-what-we-are-doing-to-restore-full-internet-services-to-nigeria-others/

Title: Re: How to solve network issues for men and airtel
Post by: rachael9385 on March 16, 2024, 04:09:35 PM
I no know how VPN can improve your network speed, AFAIK, VPN sev dey reduce network speed rather than to increase it. VPN na for privacy and for security, i have never known it to be for this purpose wey you talk now. The network wahala dey very frustrating, but i think the Airtel network is somewhat better today, but MTN is still very bad.
Omo this network of a thing is frustrating the hell out of me. Like this e come be like say na my area the thing come worse pass. And na only MTN sim card I get throughout. If no be say someone calmed me down yesterday I nearly hit my phone for wall because of say the frustration too much. Na when I come manage connect to my guys hotspot I come see say na general issue.
   Omor @7juju this your talk no be lie oo, but in a serious note nah MTN i dey use browse the internet and I no dey get any challenge of network delay or slow internet access.
   Seriously, I dey inside bush and still I dey browse freely, this network wahala no be every where e dey worry, nah some places.
   This VPN matter, I no dey like am because the ads them too much, although, @Charles-Tim self done already talk am and no be lie, even if say person go download the VPN ads go full every where, each 5 or 10 minutes ads go pop up amd some of adverts dem too much and them too long (over 30 seconds l.
   Also, the VPN dey limited, you ko go fit use am more than the time them give, if nah 1hr na so e go stop.
   So if you need unlimited VPN and ads free you go pay money to get am, and again, some of those VPN them no dey private.

Title: Re: How to solve network issues for men and airtel
Post by: RockBell on March 16, 2024, 05:57:19 PM
I will not advise anyone to use VPN that is full of ads as the VPN providers are giving your data to third party. VPN is not secure as using normal network. Or use paid VPN and the ones that has no ads.

You can still use exchanges mobile apps without VPN to access the exchanges.
I fully agree with you since the apps are working I do not see the use of VPNs what even annoys me when using these VPNs is the ads they are too much and I know that are will be a lot of risks attached to those ads if mistakenly clicked on, and VPNs are not even supposed to be trusted no matter the condition they give and most of those apps have viruses or even malware so we have to be very careful using those apps.  and if any app should always give access to a third party then that app poses a threat to your information and your self so we should just stick to using the app as it has been advised. and if it is about stress using apps is stress-free.

and even our security agencies have issues with seeing VPN on your phone it can also implicate so we have to be very careful of the apps we use.

Title: Re: How to solve network issues for men and airtel
Post by: Fivestar4everMVP on March 16, 2024, 06:16:39 PM
When it comes to free VPN, anything outside orbot, no be me and you, and for paid VPN, cyberghost has always been the top choice for me.

Orbot is a free VPN app that was developed by Tor, the app is absolutely free and ad free as well, person fit use the app together with tor Browser if him want, but e also dey work flawlessly with for other individual apps or generally on the phone, depending on your setting and mode of operation person choose.

But then, I go still join others to advice us to dey careful with the use of VPN, some VPN no dey secure and person fit from there hack any of your online accounts.
And for free VPN wey dey display too many ads, this one even dangerous pass because you fit no know when your hand touch one ad, your phone to open the ad and virus for enter your phone from bank ground download.

And the above na one, another one be say, there are some platform wey no dey like make their users use VPN access their account, and when you forget say your VPN dey on, you go visit such platform, you fit begin dey get issues with them.

So, to be safe, make we dey managed ourselves as we see ourself ooh, 🤣, the network wahala, no be here, but atleast, e still dey open forum.

Title: Re: How to solve network issues for men and airtel
Post by: Bournesparks on March 16, 2024, 08:00:52 PM

Omo the VPN help me oo hahaha. E improve my netwrk oo

Title: Re: How to solve network issues for men and airtel
Post by: Makus on March 16, 2024, 08:41:48 PM
I no dey like use vpn because of security risk

Though VPN no bad Sha, if you use the better one. Sometimes we dey like free things, but we they forget the phrase wey say free things dey purge. Sometimes you fit decide say you wan use the VPN, but as you enter am na soso ads you go just dey see, and some of those ads fit redirect you to site wey dey harmful to your device, from there hacker fit come in. But one of the primary purpose of VPN na to change ur IP address so that when you enter some kind place the hacker no go fit get access bro your information from your real IP. But if you use the fake VPN you fit go turn victim for help wey you wan help yourself.

Title: Re: How to solve network issues for men and airtel
Post by: Jamestown70 on March 17, 2024, 02:08:58 AM
Omo na the x VPN me sef dey use the thing dey very good though sometimes e go slow but at least e better pass before

Title: Re: How to solve network issues for men and airtel
Post by: Pi-network314159 on March 17, 2024, 02:34:15 AM
I know say we da experience slow and low network for 4 days now due to mtn and airtel wahala. But I get one kind solution like that. Just download X VPN, Switch from AUTO TO UDP and connect. Your netwrk will significantly improve. I greet una✅

Make una try am give me feedback how e be.
Me I dey use portable mini WiFi wey I dey use, and Naim dey help me meet up my daily activities. Sometimes too E dey worry because of say na MTN but my Airtel dey work normally. Any body wey get money make E buy like 3 simcard MTN Airtel and glo, then come buy portable universal mini WiFi sothat if network no dey 1 you fit put 1of the remaining 2 inside the wi-fi no how wey network no go dey for 1 or 2 among the 3 simcard wey you get.

Title: Re: How to solve network issues for men and airtel
Post by: SmartCharpa on March 17, 2024, 07:06:10 PM
I know say we da experience slow and low network for 4 days now due to mtn and airtel wahala. But I get one kind solution like that. Just download X VPN, Switch from AUTO TO UDP and connect. Your netwrk will significantly improve. I greet una✅

Make una try am give me feedback how e be.

For the first time, me i think say na me dey experience this bad network issue until i saw it online wey everybody dey complain about MTN. But me i never experience such problem with Airtel because since the day wey everybody dey complain about network issue Airtel never give me problem, nothing slow for my side, my browser dey move smoothly. Since to browse no get issue again na to load card be problem, person go buy card dey go debit you and nothing go drop. Why mtn dey disappoint people so much. I no fit advise anyone to use VPN to browse we really need to dey safe, you fit use VPN do browse but you no fit use VPN to enter some app.

The best solution for this network issue be say we should try and have all the network, because now wey be say everybody dey complain about MTN and Airtel we no hear people wey dey use Glo network follow us complain about network issue. We should at least have like 3 Sim card, if we no get two phone we should put spare at the back of our phone, incase we experience this kind of issue again we no go suffer with browsing.

Title: Re: How to solve network issues for men and airtel
Post by: babagem1 on March 19, 2024, 02:20:55 AM
Omo no to just bet patient network go come back, all this vpn self go tire person and I no go well say I won use my country network and I go Dey add vpn join, abeg make the network come back fully, but Airtel Dey try small small sha so I Dey manage am like that until everything come back normal, I hear say na bandits attack the cable for water lol wahala ooo. Abeg make dem try fix this network make person see food chop abeg, some people na online be there office just like the way we self Dey here. We need network to survive. Make dem just try abeg

Title: Re: How to solve network issues for men and airtel
Post by: Makus on March 19, 2024, 04:41:58 AM

Me sef I no advise the use of VPN, currently e just like say the network done stable, MTN wey be get very bad network before, now na em I dey use take dey do all my online activities. So the network don better pass before. When I see statistics of the affected country by this network issue, e come show say Niger been no even too dey affected, the country with the highest network issues na ivory coast. If to say na we dey their shoes, e for really bad pass like this, because no wey to access the internet completely.

Title: Re: How to solve network issues for men and airtel
Post by: Charles-Tim on March 21, 2024, 12:23:57 PM
Me I dey use portable mini WiFi wey I dey use, and Naim dey help me meet up my daily activities. Sometimes too E dey worry because of say na MTN but my Airtel dey work normally. Any body wey get money make E buy like 3 simcard MTN Airtel and glo, then come buy portable universal mini WiFi sothat if network no dey 1 you fit put 1of the remaining 2 inside the wi-fi no how wey network no go dey for 1 or 2 among the 3 simcard wey you get.
I have MTN 5G router and the network was absolutely bad. I even recorded better network on phone than on the router during the time. But your other advice is good that someone needs to have other providers sim cards and not to just go for one. I am using just MTN which is the best network provider in my area. I have Airtel, Glob and 9mobile but they are not working anymore. I later had to change to Glo which solved the network issue. I changed back to MTN 3 days ago and the network has been good till now.

Title: Re: How to solve network issues for men and airtel
Post by: Nonstop_H on March 21, 2024, 02:42:29 PM
I will not advise anyone to use VPN that is full of ads as the VPN providers are giving your data to third party. VPN is not secure as using normal network. Or use paid VPN and the ones that has no ads.

You can still use exchanges mobile apps without VPN to access the exchanges.

You are absolutely right, there has to be way to solve this network issues, we are having problem for some days now, even my VPN is not even helping all this time, though  they're some online stuff you can't use VPN to work with, base on my experience my VPN doesn't work on my
 msport app, but works on my sportybet account.

Title: Re: How to solve network issues for men and airtel
Post by: Uhwuchukwu53 on March 21, 2024, 03:34:02 PM
I will not advise anyone to use VPN that is full of ads as the VPN providers are giving your data to third party. VPN is not secure as using normal network. Or use paid VPN and the ones that has no ads.

You can still use exchanges mobile apps without VPN to access the exchanges.

That's is the Best, I gree with this advice because is speak more in my heart it's very dangerous to use VPN as it make you more suspicious and give some hidden identity of person which some exchange or sight may not be supportive of, my experience with VPN making to loose my coin in one mining I did is not what I will advise person to fall victim of  such circumstances.