Bitcoin Forum

Local => Nigeria (Naija) => Topic started by: philipabaku on May 26, 2024, 03:18:54 PM

Title: Crypto farmers
Post by: philipabaku on May 26, 2024, 03:18:54 PM
I say make I bring this one to our notice. Recently, Naija and other African countries don dey recognise as the world largest crypto farmers. So tay e affect many of our business men and women for society. With the way things dey go so no body for our country wan dull am again, about 70% of the youths don dey farm sites like tapswap, hamster combat, yes coin etc

Title: Re: Crypto farmers
Post by: Gozie51 on May 26, 2024, 04:12:11 PM
I believe say this crypto market things don make people no dey put eye for government work like them dey do before because at least some people don dey take cryptocurrency wey be side hussle as something wey dem fit still take hold themselves or build capital wey dem go still take do better thing or reinvest inside crypto. Naija youths no dey carry mining play again oo even though say them sabi say no be all go still pay but dem still want try as dem don see how people really cash out from Notcoin. Just recently, Notcoin give some people money and their friends begin dey choke eyes join wey make some of the other mining apps begin get some hype like the tapswap wey you mention, over wallet still dey there, buffalo dey etc . Make we see the one wey go still make people cash out again but we go still need to dey careful. If person ask you for money for one thing or the other for the mining stuff make you ask questions oo because mining is usually free, it takes your effort to do their assignment and follow them using your data.

Title: Re: Crypto farmers
Post by: Marvelockg on May 26, 2024, 04:35:17 PM
I say make I bring this one to our notice. Recently, Naija and other African countries don dey recognise as the world largest crypto farmers. So tay e affect many of our business men and women for society. With the way things dey go so no body for our country wan dull am again, about 70% of the youths don dey farm sites like tapswap, hamster combat, yes coin etc
at least 80% of the youth that recently become too interested in mining only joined the train because of the recent notecoin gain and would go out of the system if tap swap and some of these recent airdrops didn't do so well. The real people that are really into crypto will continue to stay even after these hypes about airdrops.

Being a crypto peron doesn't mean that you can't go into real farming or that you can't consider other sectors that can still fetch reasonable ton of money. I still know that there are lots of people on this forum that are actively trading and are still in an active signature campaign but refuse to allow these things to hinder them from gaining from other bouyant sectors of our economy. Most airdrops allows you to use some bots that do the mining for you while you just come to occasionally claim them. They are not excuses to not facing other sector if you do please. Let's understand that some of our youths always allow themselves to get caught up in ponzi schemes and that's why they just jumped into tapswap without necessarily knowing how it works.

While you're doing your normal crypto mining, I don't think it's right to look at it as a source of your livelihood. In addition to it, you've got get yourself involved in other real sectors like the agricultural sector, the engineering, medicine and other viable sector that will help us grow as a nation.

Title: Re: Crypto farmers
Post by: Zigabel on May 26, 2024, 04:52:15 PM
I say make I bring this one to our notice. Recently, Naija and other African countries don dey recognise as the world largest crypto farmers. So tay e affect many of our business men and women for society. With the way things dey go so no body for our country wan dull am again, about 70% of the youths don dey farm sites like tapswap, hamster combat, yes coin etc
The thing now be say this kind thing now dey bring opportunity for bad pipo dem to dey fit enter the mater now dey develop link wey b say go fit cause person wahala so dat dem go fit get chance enter person phone and collect information wey be say dem go fit use scam the person as a result of say dem dey try make dem fit farm coin because them don c d ones wey work in recent times like ICE, NOT COIN  and others, i just hope say these pipo no dey use Africans dey push traffic for their projects dem because dem know say after those ones wey just happen recently wey pay pipo, most pipo go wan do any one wey come out again which go means good traffic for them.

Me i go adice say as we no wan carry last and all of us wan gain from all these new projects, make we try dey careful make we no go loose our money where we dey try find more money and den we go regret, any of these project wey dey ask u for money or your personal informations, make we avoid them so that we no go be victim of any form of scam or say dem com hack us com collect our funds.

Title: Re: Crypto farmers
Post by: Zanab247 on May 26, 2024, 05:40:56 PM
Quote from: philipabaku
I say make I bring this one to our notice. Recently, Naija and other African countries don dey recognise as the world largest crypto farmers. So tay e affect many of our business men and women for society. With the way things dey go so no body for our country wan dull am again, about 70% of the youths don dey farm sites like tapswap, hamster combat, yes coin etc
If u no no before, Naija don go far in crypto industry op, if not dat our government dey do things wey dey make crypto users not to show themselves in public, I guess Naija suppose be d first or second position among d largest crypto users in Africa.

Some of d businesses u see around your environment, is owned by crypto users just dat u will not know now until federal government make crypto legal tender in d country before u go no dat even your parent are into crypto.

This is d reason why our government come too late, to stop crypto from d country because people has go far to discovered many sites dat is bringing crypto to users in land and many people have made plenty money from all those coins.

Title: Re: Crypto farmers
Post by: Amphenomenon on May 26, 2024, 06:35:24 PM
I say make I bring this one to our notice. Recently, Naija and other African countries don dey recognise as the world largest crypto farmers. So tay e affect many of our business men and women for society. With the way things dey go so no body for our country wan dull am again, about 70% of the youths don dey farm sites like tapswap, hamster combat, yes coin etc
You have a misconception about Crypto farming, which is also called yield farming, It is the lending or staking of crypto currency to earn high returns or rewards.
The Tapswap and it likes are just airdrops were you are required to tap or swip your screen to earn these coins or token, this also should not be confused as mining since no computational is used in it.

Though after the launching of recent airdrops notably notcoin, many Nigerians are venturing into the crypto space and now its no longer the youth but both old and youngs which is amazing because this is how many of us started from Airdrop and bounty hunters to what we are now, though aside this fact I love it from the fact that this occur when the cbn government made a restriction to crypto activities in Nigeria which should have cause some to quit or not to  venture into cypto space out of fear and ignorant, the recent cashout has made many see that na who dull for crypto update na looseguard.

Anyway with this we know with time they will come to know about the truth in the cypto space and about why bitcoin is a better investment than all though we can facilitate this by telling others who we see tapping and are ready to learn about Bitcoin and other truth in the crypto space
 
Title: Re: Crypto farmers
Post by: Cityhunter34 on May 27, 2024, 08:30:35 PM
I say make I bring this one to our notice. Recently, Naija and other African countries don dey recognise as the world largest crypto farmers. So tay e affect many of our business men and women for society. With the way things dey go so no body for our country wan dull am again, about 70% of the youths don dey farm sites like tapswap, hamster combat, yes coin etc
Naija youths don go far well well in Cryptocurrency but na just because of our yeye government wey no dey like hear anything about Bitcoin na him make our youths know dey like talk about Bitcoin in a public, because you know no weather the person wey dey their na government agent, so na him make our youths no dey like tell people wey no dey into Bitcoin say them dey do crypto work, as our country dey now na just person wey you no say in dey into the game wey fit open up about Bitcoin because him too no the KoKo.

Title: Re: Crypto farmers
Post by: Jegileman on May 27, 2024, 10:52:32 PM
I say make I bring this one to our notice. Recently, Naija and other African countries don dey recognise as the world largest crypto farmers. So tay e affect many of our business men and women for society. With the way things dey go so no body for our country wan dull am again, about 70% of the youths don dey farm sites like tapswap, hamster combat, yes coin etc

Wetin dey really happen now na revolution into the crypto space by the Nigerian youths. E don tey wey dis cryptocurrency dey and na now wey d government wan dey take strict action on dem na him dem come dey even get stand pass, come dey make am more popular within the people. Cryptocurrency dey more dan tapping wey dem dey do now, and we wey don get the idea before know say e broad pass like dis. Make we try tell people wey wan know more about am and how e take dey work, that one go increase him mass adoption and use for d country. For the government, e dey obvious say dem go fail for dis one wey dem wan take make cryptocurrency enemy of the people. E don come to stay and make we dey see how e go take sup soon.

Title: Re: Crypto farmers
Post by: Samlucky O on May 28, 2024, 03:54:26 AM
I say make I bring this one to our notice. Recently, Naija and other African countries don dey recognise as the world largest crypto farmers. So tay e affect many of our business men and women for society. With the way things dey go so no body for our country wan dull am again, about 70% of the youths don dey farm sites like tapswap, hamster combat, yes coin etc
My brother crypto adoption no be tap swap, notcoin and many other airdrop project. Believe me 98% of those project na scam and E go later mislead many people. Though those project na eye opener for some people wey never know wetting cryptocurrency be, maybe as dem dey hear cryptocurrency, dem dey think say na tapswap and notcoin, not knowing say that one na just prenursery of it.  But I know say that thing go drag them come the system and then go come sabi the father of them all wey be bitcoin. Even me when I start the cryptocurrency matter na some shitcoins carry me come, then I come from there sabi bitcoin so na normal thing. Truely the way Africans take that farming serious no be small but with my level of understanding about Cryptocurrency I no see anything for that thing I just see am as a way of scammers to drag people attention. See scammers always device a new technique every year just like MMM them go use their money fund the project at first, people go cashout them go come later come with a different pattern wey go required people to use money payback in one way or the other. One thing I deslike About Our African people be say dem dey see every opportunity as a get rich quick scheme, and E go drive them mad to the extent dem no go even smell danger ahed. onyibo man say "not all that glitters are gold" when everybody dey do a particular thing hoping to become rich just know say danger dey ahead. So my advice to our people be say make we dey careful for any new trends because na easy trap of scammers to put people to their web. When them see say their previous trick don expire, them go device another strategy but if you dey smart you go ask yourself where those money people dey rush to collect dey come from?

Title: Re: Crypto farmers
Post by: Cryptomultiplier on May 28, 2024, 07:40:23 AM
I say make I bring this one to our notice. Recently, Naija and other African countries don dey recognise as the world largest crypto farmers. So tay e affect many of our business men and women for society. With the way things dey go so no body for our country wan dull am again, about 70% of the youths don dey farm sites like tapswap, hamster combat, yes coin etc
E for good well well, if to say you add the link wey carry this kind news, because for me, e be like say na just contrast based on the things wey Binance officials and the company as a whole dey face currently for this Naija and the cryptocurrency users no dey excluded from the picture too.
I continue to maintain my mouth as pertaining the issue with f crypto currency adoption for this country and e be say after all this gra gra wey government dey do, Dem go finally license crypto currency operations and farming and even support create awareness after this Binance saga don dey concluded. Na watin I wan add be dat o.

Title: Re: Crypto farmers
Post by: SmartCharpa on May 28, 2024, 09:16:09 AM
I say make I bring this one to our notice. Recently, Naija and other African countries don dey recognise as the world largest crypto farmers. So tay e affect many of our business men and women for society. With the way things dey go so no body for our country wan dull am again, about 70% of the youths don dey farm sites like tapswap, hamster combat, yes coin etc

As our governments no remember us again, we are on our own now, so make we look for another way to survive because no be only by government person fit make am for this life. No be only the youths don dey the farm site, most of all us wey dey this country don dey for the sites because no body want make them left him behind. Nobody wan dey dull for this country now as the sufferness don too much, nobody go see another way to get free money and talk say him no dey do, although me I believe say there's a lot of people who don't believe on this tapswap or hamster because them reason am say those projects no go end well, but na here we dey wey many people wey no sabi anything about crypto cashout on notcoin.

But as this tapping matters dey be we don dey carry that thing go another level, I dey see some post online wey some people go dey borrow money say they will pay back after dey withdraw from their tapswap, some people do not know about cryptocurrency and this airdrops go teach some people lesson. If you have another hustle no leave am say another update to make money don arrived make some people no go regret am later because we too like awuf.

However, our government be dey think say if they take action against Cryptocurrency some of the youths may give up because some would not like to end up in jail, they don try with many ways e no gree work, even some of our local banks sef don give us notice. I dey wonder if they can use that energy for us to have a better Nigeria again because all their gra gra is for nothing, na them go later give up.

Title: Re: Crypto farmers
Post by: Judith87403 on May 28, 2024, 11:05:04 AM
Recently almost everybody has been drone into crypto mining and airdrop, funny enough even those who does not understand what crypto is all about and there is a high chance for them to become victim on the process, though my point is not to discourage people who are into crypto mining or airdrop but however people should be very careful with the kind of mining they venture into because some are just strategy use to hack people because last week I saw a man complaining bitterly on how he was hacked through mining, according to him he said he was asked to link his email on the platform and when he did a verification email pop-up for him to confirm and immediately he confirmed  he was log out from the mail and from there they managed to hack his other account that has some money inside.

So people should be very careful especially those ones that involves linking of mails because they can use your email for there fraudulent act, although I'm not saying that their are no good crypto mining or Airdrop but what I'm saying is that people should be very careful because I noticed that at the moment most people were able to cash out some money from Nutcoin almost everybody out there became convinced that all the mining and Airdrop may likely end up the same way without knowing that it doesn't work that way.

Reference: https://bitcointalk.org/index.php?topic=5498015.msg64137050#msg64137050

Title: Re: Crypto farmers
Post by: Hatchy on May 28, 2024, 11:23:22 AM
I say make I bring this one to our notice. Recently, Naija and other African countries don dey recognise as the world largest crypto farmers. So tay e affect many of our business men and women for society. With the way things dey go so no body for our country wan dull am again, about 70% of the youths don dey farm sites like tapswap, hamster combat, yes coin etc

Well, the airdrops don help many of our people wey be dey desperate for money this period. Though at first, no body being dey take all these things seriously but now as evidence don show say na sharp update many of our countri people don put hand for the crypto matter.
The only thing wey I wan address na e be say, yes we know say the update sharp, but dis one don dey put the wrong idea of some people head say na so crypto take dey easy. D other day, I dey waka I come hear some people dey talk say, if to say na Bitcoin Dem dey tap like dis, Dem for don blow. Like aba the thing really dom dey put wrong impressions for we people head. Crypto no dey easy like dat o and to mine Bitcoin sef no be childs play. I just hope say these airdrops Dem go still dey teach people watin crypto really dey about than make Dem think say na so e easy.

Title: Re: Crypto farmers
Post by: Mr.suevie on May 28, 2024, 11:44:42 AM

Omo this whole matter no be chaise because even people wey I been dey tell about Bitcoin and Crypto wey been dey snub or ignore me now don dey take the matter extremely serious but the only sad thing be say most of them get the wrong view about the whole matter especially with Bitcoin but I do believe say e no go take long as the involvement don already dey massive their eyes go open and them go get am clear base on the legit update about cryptocurrency in general.

Title: Re: Crypto farmers
Post by: Mate2237 on May 29, 2024, 06:20:42 PM
I say make I bring this one to our notice. Recently, Naija and other African countries don dey recognise as the world largest crypto farmers. So tay e affect many of our business men and women for society. With the way things dey go so no body for our country wan dull am again, about 70% of the youths don dey farm sites like tapswap, hamster combat, yes coin etc
Many people were not farming airdrops before and because of the NOTcoin outbreak make many Nigerians to farm on airdrop and di NOTcoin airdrop made people to cash out well so when hamster Combat and Tapswap came out people come dey mine steady and I been dey hear say dem no go do the prelaunch of Tapswap again tomorrow and I also believe am because the news no dey like di time when dem launched NOTcoin. And if really dis airdrop is launched den Nigerians go make am oh.

Title: Re: Crypto farmers
Post by: philipabaku on May 30, 2024, 05:37:58 AM
Aah my guys e go soft for everybody gon.. If you watch out nigerians are taking all this very seriously

Title: Re: Crypto farmers
Post by: DubemIfedigbo001 on May 30, 2024, 06:03:27 AM
I say make I bring this one to our notice. Recently, Naija and other African countries don dey recognise as the world largest crypto farmers. So tay e affect many of our business men and women for society. With the way things dey go so no body for our country wan dull am again, about 70% of the youths don dey farm sites like tapswap, hamster combat, yes coin etc
Crypto don seriously liberate youths from hunger and joblessness, the  real koko be say the thing dey very  rewarding if you put your mind wella, do the ones wey dey very promising. You got cash out big time, me sef go like advise people say these shit coins no dey stable at all, most of them fit dissolve tomorrow, so no leave your coins for so long as shit coin unless their projects dey very promising enough say your mind strong. If not, you fit cash out for your shit coin, use the funds continue your bitcoin investment so em go dey  more profitable and safe for you.

If you notice, criminal rate don reduce sotey we dey hardly hear say them snatch person bag or even go house robbery now.  All those jobless boys don find job for crypto and e dey pay them well pass street hustle, so crypto indirectly don make the environment safer, this na wetin our government no fit achieve. I wish say e get as crypto education go take reach them so they know how to take invest rightly so them no go lavish their money come fall back to the streets.

Crypto is one thing everybody should take seriously now, if not you'll be left behind and with regrets when others are smiling

Title: Re: Crypto farmers
Post by: Uhwuchukwu53 on May 30, 2024, 03:12:14 PM
The recent inflow of naija people and some African citizens to crypto is alarming the matter no be bad one shall if they are adopting the real crypto as many lack good knowledge about this crypto of a thing which is another open door for scammers, I am not saying that airdrop is totally Erin as some genuine one is there but given much attention to airdrop and shiltcoin and altcoin such adoption is nothing but hell many scam has already taken place within just a few weeks after the release of notcoin as many jump into telegram tapping all manners of work using some AI or tapping bot.

In my view a wrong foundation must surely collapsed to avoid hard I know it's better to go into the real crypto that quick money like airdrop  because crypto farming on airdrop mostly telegram may be a wrong step entirely.

Title: Re: Crypto farmers
Post by: CryptopreneurBrainboss on May 30, 2024, 11:46:26 PM
I say make I bring this one to our notice. Recently, Naija and other African countries don dey recognise as the world largest crypto farmers. So tay e affect many of our business men and women for society. With the way things dey go so no body for our country wan dull am again, about 70% of the youths don dey farm sites like tapswap, hamster combat, yes coin etc

Na tap tap tap full everywhere now and I just dey pity people because dem go just dey waste their time they tap nonsense as no be every airdrops wey you go dey tap go come you money like notcoin, wetin make notcoin blow na say people no been believe am and it was among the first airdrop to use the mechanism wey others they try duplicate like this so. Alot of marketing went into notcoin wey make top tier A exchange begin dey list am because of their community so make we no just dey think say na tapping go give us the money wey we dey hustle for.

Make we leave airdrop farming first and concentrate on investing as na their sure pass. I know say you go dey ask how people go take get the money to invest, na to double your hustle na. You fit still dey try tap your way to success oh maybe one day God go remember you and the coin wey you dey tap go blow but no put mind for there brother. Scams go dun full the tapping business already and soon majority of the project doing this tapping of a thing go just be a waste of your efforts.

Title: Re: Crypto farmers
Post by: Btcdeybodi on June 02, 2024, 08:36:24 PM
Recently almost everybody has been drone into crypto mining and airdrop, funny enough even those who does not understand what crypto is all about and there is a high chance for them to become victim on the process, though my point is not to discourage people who are into crypto mining or airdrop but however people should be very careful with the kind of mining they venture into because some are just strategy use to hack people because last week I saw a man complaining bitterly on how he was hacked through mining, according to him he said he was asked to link his email on the platform and when he did a verification email pop-up for him to confirm and immediately he confirmed  he was log out from the mail and from there they managed to hack his other account that has some money inside.

So people should be very careful especially those ones that involves linking of mails because they can use your email for there fraudulent act, although I'm not saying that their are no good crypto mining or Airdrop but what I'm saying is that people should be very careful because I noticed that at the moment most people were able to cash out some money from Nutcoin almost everybody out there became convinced that all the mining and Airdrop may likely end up the same way without knowing that it doesn't work that way.

Reference: https://bitcointalk.org/index.php?topic=5498015.msg64137050#msg64137050

it is very bad how some people  just doesn't even want to understand what they are venturing into but they prefer to join because they see others doing it without trying to find out the basic necessity needed to guide them to know if they are doing it the right way simply because of hypes this airdrops get makes people think that other Airdrops mining will also do the same more especially if they succeeded in previous airdrops and it worked for them and because of this hypes they have this FOMO then they rush to invest immediately and the risky aspects is how some of them make their personal wallets vulnerable to attacks because they use it on untrusted sites or connect it with social apps and social wallets just because they want to claim airdrops.

A lot of advice have been given about airdrops and some fake crypto projects but yet people still keeps on falling victims even before you claim some airdrops you must have done a lot of tasks and sometimes you can still end up not claiming it. I know that everything about cryptocurrency is risky but we should be careful with the kind of risks we take on cryptocurrency so that we don't fall victim to scams.

Title: Re: Crypto farmers
Post by: Zigabel on June 02, 2024, 10:27:28 PM
I say make I bring this one to our notice. Recently, Naija and other African countries don dey recognise as the world largest crypto farmers. So tay e affect many of our business men and women for society. With the way things dey go so no body for our country wan dull am again, about 70% of the youths don dey farm sites like tapswap, hamster combat, yes coin etc
This na because say dem see wetin been happen for Not coin a d many people no been quick get the update Maka them for follow join make money as Not coin take bless pipo wey quick join am, so na why as this one's come now, every body now come follow put body make dem too no go miss am when the thing go finally lunch, because na for lunching the money for all this coins dem dey come out.

Normally Africans a d Naija pipo no dey take ear bear anything crypto wey go pay them well in the long run, them go make sure sy them collect all the best wey dem fit collect and na why e com b like say for d world na we dey push the whole coin mata pass most of oda pipo dem.

Title: Re: Crypto farmers
Post by: Fiasem20 on June 15, 2024, 12:32:52 PM
Normally dem go always recognize Naija when it comes to cryptocurrency.Immediately Notcoin pay,na the time cyptro farming con increase for Naija as na tapping levels we dey so.Airdrops na project wey most people no get interest for because of the way scam airdrops don plenty for the crypto space nai make as Notcoin come out pipo no use am call something but as e pay most cyptro users don dey tap airdrops with FOMO.The funny part about all these airdrops be say the one wey look like scam nai dey turn out to be legit,na just luck,most times you fit follow their white paper and the coin back to back to dictate if whether na legit or scam.

Title: Re: Crypto farmers
Post by: rachael9385 on June 15, 2024, 02:27:13 PM
I say make I bring this one to our notice. Recently, Naija and other African countries don dey recognise as the world largest crypto farmers. So tay e affect many of our business men and women for society. With the way things dey go so no body for our country wan dull am again, about 70% of the youths don dey farm sites like tapswap, hamster combat, yes coin etc
Moreover work no dey the country again and e come make pipo no come put their mind for school like before but thank God say this crypto space done make many pipo dey k ow say them no need put much interest for government jobs again and them still see were them go out capital then still get profits again so them they also use their profits dey see themselves through school. I like African (mostly Nigerians as a whole) we no dey take last for anything wey dey bring money for us at all because nah only God nai know the kind of stuffer wey we done suffer for each and everyone country. From beginning e no actually dey easy to be an African person and on a norms Africa nah big name so we suppose fo as the name dey.  Make we talk about Nigeria alone first, this our country nah free man country and based on the kind of lessons wey our politicians with their fake promises done do us, we fine wise up to not to take anything wru go bring profits to us for granted. And from before before we done dey hear about crypto currency but we no take am too serious nah as the government jobs no dey again nai we cin focus on crypto currency (Bitcoin).

Title: Re: Crypto farmers
Post by: Jaycoinz on June 15, 2024, 02:43:45 PM
I say make I bring this one to our notice. Recently, Naija and other African countries don dey recognise as the world largest crypto farmers. So tay e affect many of our business men and women for society. With the way things dey go so no body for our country wan dull am again, about 70% of the youths don dey farm sites like tapswap, hamster combat, yes coin etc
Well watin you expect? Cryptocurrency is all the rave now in Nigeria sef to be specific because I don't see any other African country that has the massive population of crypto users and consumers like Nigeria and plus say na one of the biggest population for the world at large sef. Crypto currency don really help the youth and also so many businesses for Nigeria and Africa at large and anytime I hear about this particular trend of notcoin, hamster combat and so many others it just makes me think back to the glory days of airdrop and some good crypto projects where in just a twinkle of an eyes someone can farm lots of profits.

Title: Re: Crypto farmers
Post by: Iamcrypticguy on June 15, 2024, 04:27:17 PM
Normally dem go always recognize Naija when it comes to cryptocurrency.Immediately Notcoin pay,na the time cyptro farming con increase for Naija as na tapping levels we dey so.Airdrops na project wey most people no get interest for because of the way scam airdrops don plenty for the crypto space nai make as Notcoin come out pipo no use am call something but as e pay most cyptro users don dey tap airdrops with FOMO.The funny part about all these airdrops be say the one wey look like scam nai dey turn out to be legit,na just luck,most times you fit follow their white paper and the coin back to back to dictate if whether na legit or scam.

Omo no be small thing.  Even old woman da farm hamster, tapswap and the rest. Naija no da carry last.

Title: Re: Crypto farmers
Post by: Abbatty on June 18, 2024, 02:46:52 PM
One thing wey I know for this country be say we like de follow the trend, anything wey de trend at that time most Nigerians go jump into a without even making proper enquires. Just take the pos business as an example for this country, like practically every household get who de do pos. The thing is Nigeria get very bad economy and again most youth de very lazy to think of a new business idea, like once we see say Watin another pasin de do and e de pay am others go just rush into am without even making proper research about it. So most individual run into airdropping and mining not even making research about the particular project they are airdropping.

Most of this people wey recently join telegram for mining and airdrop join am because of the north coin wey pay and dem no even really make research about the ones they are mining now, I know most of dem go still run comot for the mining and airdrop if this Tapswap fails to pay or pay below expectations.

So the thing he say most Nigerian youth no wan think out of the box dem just wan go Watin everybody Dey do to make am, na why most of them de into yahoo, they are just brain lazy, dem no wan think of something different.

Title: Re: Crypto farmers
Post by: Spaceman1000$ on June 18, 2024, 07:21:55 PM
I say make I bring this one to our notice. Recently, Naija and other African countries don dey recognise as the world largest crypto farmers. So tay e affect many of our business men and women for society. With the way things dey go so no body for our country wan dull am again, about 70% of the youths don dey farm sites like tapswap, hamster combat, yes coin etc
Omo I dey see how people dey tap tap their phone watin no nice this period oh, my take is that, everybody should be allowed to do what they feel will give them something, wether the token is fake or not, na to just allow them, because even the one way go come out something, we don't even know it, nobody been believe say NOTCOIN go later turn out to be something good. The only thing be say naija thing we too dey over do things, some persons self no one takes a second to research about the project to see the level of authenticity, them go just dey tap dey go ahead ahead.

Title: Re: Crypto farmers
Post by: Grace333 on June 18, 2024, 08:33:13 PM
I say make I bring this one to our notice. Recently, Naija and other African countries don dey recognise as the world largest crypto farmers. So tay e affect many of our business men and women for society. With the way things dey go so no body for our country wan dull am again, about 70% of the youths don dey farm sites like tapswap, hamster combat, yes coin etc

Sincerely speaking, threads like this should have links to the source, as this isn't just a regular, at least we ought to have a glance on the mentioned claimed by the op. I can't tell for sure but I believe Nigeria would not joke with any update that brings money. Almost everyday I receive referral from friends and colleagues to start tapping since it's the current trend. Our government are one amongst the major reasons why we haven't being ranked top 3 across the world. We can be innovative and if given the opportunity Nigerians would utilise it with pleasure.

Title: Re: Crypto farmers
Post by: HajiBagi on June 19, 2024, 08:43:47 PM
I say make I bring this one to our notice. Recently, Naija and other African countries don dey recognise as the world largest crypto farmers. So tay e affect many of our business men and women for society. With the way things dey go so no body for our country wan dull am again, about 70% of the youths don dey farm sites like tapswap, hamster combat, yes coin etc

Waiting we Dey think before, the thing wey the youth put hand this day sef go shock the government, waiting the government Dey try end na e come dey plenty again, why the youth no go plenty wey Dey site like tapswap, Hamster, yes coin and others wey government no give them work, more than thousand of graduates never get work and make the ones wey be say them never graduate they expect say them go get work? That one no go Dey possible na, many people come Dey tap tap including the government workers and business men because as everybody hear say them they make am online na so everybody take am serious oh.

Na who give up fuck up oh because you no fit just Dey look make your fellow human being Dey make money and I will be looking you with my two eyes, I don talk am before say all this things wey government Dey do say them go ban Naija people from cryptocurrency na play because them go just suffer nii and waiting them want no pass money,after them don allow Binance and KuCoin ban Nigerians na e people still come Dey interested on crypto again, nice one god no go shame us.

Title: Re: Crypto farmers
Post by: Marykeller on June 20, 2024, 06:06:07 PM
I say make I bring this one to our notice. Recently, Naija and other African countries don dey recognise as the world largest crypto farmers. So tay e affect many of our business men and women for society. With the way things dey go so no body for our country wan dull am again, about 70% of the youths don dey farm sites like tapswap, hamster combat, yes coin etc
My brother crypto adoption no be tap swap, notcoin and many other airdrop project. Believe me 98% of those project na scam and E go later mislead many people. Though those project na eye opener for some people wey never know wetting cryptocurrency be, maybe as dem dey hear cryptocurrency, dem dey think say na tapswap and notcoin, not knowing say that one na just prenursery of it.  But I know say that thing go drag them come the system and then go come sabi the father of them all wey be bitcoin. Even me when I start the cryptocurrency matter na some shitcoins carry me come, then I come from there sabi bitcoin so na normal thing. Truely the way Africans take that farming serious no be small but with my level of understanding about Cryptocurrency I no see anything for that thing I just see am as a way of scammers to drag people attention. See scammers always device a new technique every year just like MMM them go use their money fund the project at first, people go cashout them go come later come with a different pattern wey go required people to use money payback in one way or the other. One thing I deslike About Our African people be say dem dey see every opportunity as a get rich quick scheme, and E go drive them mad to the extent dem no go even smell danger ahed. onyibo man say "not all that glitters are gold" when everybody dey do a particular thing hoping to become rich just know say danger dey ahead. So my advice to our people be say make we dey careful for any new trends because na easy trap of scammers to put people to their web. When them see say their previous trick don expire, them go device another strategy but if you dey smart you go ask yourself where those money people dey rush to collect dey come from?
Na you talk am finish. Many Nigerians no know sae this mining of crypto coins with phone wey d evoke na mainly scam, the ones wan go d legit na prenursery of wetin crypto be all about. Anyway, I d laugh out loud to people wey d tap day in, day out with their phones, believing sae the millions of shitcoins wey dem get go elevate their financial status(poor mentality). Na wetin lack of basic knowledge of crypto d cause sha.

However, make we dey see how this farming of coins with phones go kukuma end up to, as the Tapswap wey many Nigerians d hope on to launch their token soon don talk sae their token allocation to users has been indefinitely postponed

https://www.talkimg.com/images/2024/06/20/hQkA8.png

Title: Re: Crypto farmers
Post by: SmartCharpa on June 20, 2024, 06:50:05 PM
Na you talk am finish. Many Nigerians no know sae this mining of crypto coins with phone wey d evoke na mainly scam, the ones wan go d legit na prenursery of wetin crypto be all about. Anyway, I d laugh out loud to people wey d tap day in, day out with their phones, believing sae the millions of shitcoins wey dem get go elevate their financial status(poor mentality). Na wetin lack of basic knowledge of crypto d cause sha.

However, make we dey see how this farming of coins with phones go kukuma end up to, as the Tapswap wey many Nigerians d hope on to launch their token soon don talk sae their token allocation to users has been indefinitely postponed

https://www.talkimg.com/images/2024/06/20/hQkA8.png

Many Nigerians go regret say them waste their time over this tap tap tap of a thing. Most particularly this Tapswap, ever since they announced that it was no longer going to launch on the Solona blockchain, from their I start to dey doubt them say this project no dey cook at all, they just want to waste time of those people wey believe say this project na legit. Waiting dey do our Nigerian brother and sister? Dem suppose don know say this project na scam because they don asked people to make a payment, one Ton to double their coin balance 2x and the project never know the blockchain to launch their token.

Another red flag on this project be say they launched new tasks to 3 Nigerian channels, I was just wondering Nigeria wey we dey? That everyone is just fighting to rip each other? Let's just continue to dey watch how the project go end up.