Bitcoin Forum

Local => Nigeria (Naija) => Topic started by: Chilwell on June 02, 2024, 01:43:49 PM



Title: Identity Security: A Newbies' Priority
Post by: Chilwell on June 02, 2024, 01:43:49 PM
Original Topic: Identity Security: A Newbies' Priority (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5384625.msg59174190#msg59174190)
Author:KingsDen


Preamble:
Plenty times I don see say people care about the security of their Bitcoin, security of their other assets too, even security of job. Some times because of ignorance we no dey to care about the security of our personal data.
So I go dey talk about this matter for the following sub headings;
1. My identity mistake (na motivation for this thread)
2. how de fit take know you through your Bitcoin address
3. how to take hide who you be
4. why e dey good to hide who you be.

who go fit benefit from this topic?
  • Newbies wey never make Identity mistakes before
  • others wey no too send their Identity security like that
  • Readers, to dey learn as per say no knowledge is a waste

My identity mistake (na motivation for this thread):
If you don dey this forum for more than 3 years, congratulations! Na you be the smartest person for your mate. This forum na place wey be say knowledge boku e full.
Before I join this forum I been dey careless about my identity(offline and online). I been dey  see things for differently and wrongly. For instance now I dey think anybody wey dey avoid KYC na criminal.
I believe am because I dey think say since I no be criminal to dey release my data no go cost me anything because I dey sure say I no go ever turn criminal for future.
I dey wallow for my own ignorance till I enter this forum.
Few weeks for this forum two things just hit my brain;
  • why Satoshi the Bitcoin creator go just dey concerned about privacy and Identity, so tey he con successful remain pseudonymous and anonymous even for this information and technology era.
  • why e be say almost everybody dey against KYC wey me I see as means to take fight cyber crime. E mean say everybody for this forum na criminal?
My quest to take quench this my thirsty thought con give me better knowledge to take answer the above questions.
But before I fit arrive with this knowledge (before I join this forum) they don already scam me with KYC.
My mistake
They invite me say make i con buy share of one UK company for ISO stage, KYC been dey optional that time. Later they con say KYC na major requirement to take get shares if e don mature. I no con get choice than to submit my international passport con even still sign and scan my signature in lieu of my biometrics. I dey convince say my identity no longer dey secured, because they get synchrony between my travel documents and my local documents. Meanwhile my official email address and phone number still dey with them. The overall con be say the project na scam. Before now I don already do verification with plenty non reputable exchanges. I honestly dey wish say I fit reverse my identity mistakes.

why you go dey hide your identity:
  • Your identity dey unique once e dey  compromise, e don dey compromised for life.
  • Dey fit buy your personal data con still  sell am for scammers.
  • If your identity dey hidden e go hard make them know the amount of Bitcoin or assets wey you get
  • They fit even still steal your identity from reliable platforms by hackers
  • Your online identity fit dey  linked or related to your real identity

How dey fit take reveal your identity your Bitcoin address:
  • If you publish your Bitcoin address alongside your real name, either in your website, offline shop or social media
    Such address fit dey linked to your personal self.
  • Your identity fit dey tied to your Bitcoin address when you complete your KYC for exchange with your real data. You mean say them dey house your personal data for their database And e fit dey compromised knowingly or unknowingly
  • With the use of hosted wallet: No matter how friendly or less complicated hosted wallets be your data security no dey assured.  This na because say your Bitcoin address and your IP address no dey visible to anybody wey they operate the server.  So dey fit give your data out without your consent, especially when governments need them.

How to hide your identity when you dey use Bitcoin:
  • Try make you no dey repeat bitcoin address: If you no do am your identity go dey leaked through your address. Ensure say you generate new address for every transaction as e  dey recommended by Satoshi for Bitcoin
     whitepaper  (https://Bitcoin. org /Bitcoin.pdf)
  • Use a VPN: If you underestimate am, e go sweet you to know say your IP address, information as zip code and your house location for map dey fit get am?
  • Use a stealth address for your transactions.
  • You fit consider to mix the coins If you know trust it flow. Dey still get more to am as e go need make you pay some fees
 
Conclusion:
I no get am for plan to make this topic long pass this one, na the reason why I wan provide few points with short explanations. Then, remember say your identity no dey change, so protect am the way you take dey protect your bitcoin. This na because say, to get  bitcoin con de allow yourself de vulnerable, You fit no live to enjoy your Bitcoin.
If you dey think your password dey compromised, you fit reset your password. But if your identity dey compromised, e dey compromised for life.


Title: Re: Identity Security: A Newbies' Priority
Post by: Coyster on June 03, 2024, 08:55:20 PM
E make sense wella to take privacy very seriously oh, even as our government don dey attack cryptocurrencies, make person dey very careful with their personal information, so you no go turn scapegoat wey dem don dey find for sometime now.

If you dey follow people talk well well, you go discover say some of dem no believe say the loss of privacy fit bring trouble come for them in this industry, they believe that if dem no be criminals, then dem no get anything to dey hide. That one na big lie, e get many ways wey e go fit affect you and i dey happy say many people don dey sabi the truth and this topic go help more people.


Title: Re: Identity Security: A Newbies' Priority
Post by: Abbatty on June 04, 2024, 07:16:29 PM
  • why Satoshi the Bitcoin creator go just dey concerned about privacy and Identity, so tey he con successful remain pseudonymous and anonymous even for this information and technology era.
  • why e be say almost everybody dey against KYC wey me I see as means to take fight cyber crime. E mean say everybody for this forum na criminal?
Na true you talk, because if e no get any risk wey go de involved satoshi himself no go too de concerned about privacy but with the way him de hide so e mean say exposing your identity naa very risky something. E get plenty things wey don enter my mind so about this privacy something and me sef been de like OP, i been de reason am say how person wan take use my identity and wetin him wan use am do until i read something about privacy one time and the dangers of revealing personal information online, na that time i con know say e de risky to reveal personal information online.

One of the main purpose wey dem invent bitcoin na to give us financial freedom and to carry out online transactions while being anonymous and the introduction of kyc don spoil everything, exchanges that request for Kyc de try reduce the rate of scam on their platform and with or without kyc scam can never be stopped fully. Me sef de against kyc and i no like the idea of kyc at all

How to hide your identity when you dey use Bitcoin:
  • Try make you no dey repeat bitcoin address: If you no do am your identity go dey leaked through your address. Ensure say you generate new address for every transaction as e  dey recommended by Satoshi for Bitcoin
     whitepaper  (https://Bitcoin. org /Bitcoin.pdf)
  • Use a VPN: If you underestimate am, e go sweet you to know say your IP address, information as zip code and your house location for map dey fit get am?
  • Use a stealth address for your transactions.
  • You fit consider to mix the coins If you know trust it flow. Dey still get more to am as e go need make you pay some fees
 
These na better points wey you don drop so and from wetin i been read one time like that e no too get different from wetin you don outline so. E de very important to de change address if you wan maintain privacy and also sometimes use of VPN is also useful. I know plenty people go learn from this post so and @Chilwell thanks for translating this topic and making it visible to us in this local board because all my waka so far i never jam this post before.