Bitcoin Forum

Local => Nigeria (Naija) => Topic started by: Amphenomenon on July 23, 2024, 08:24:45 PM



Title: Others might be getting things wrong but not anyone in BTT
Post by: Amphenomenon on July 23, 2024, 08:24:45 PM
I know any of you still doing does telegram tap to earn must have seen this image below,
https://www.talkimg.com/images/2024/07/23/4j1Il.jpeghttps://www.talkimg.com/images/2024/07/23/4jL71.jpeg

It's ironic that people doing airdrops in those WhatsApp group don't really get what this actually means they think, it's a way FOR memefi to catch those users having multiple accounts which is far from that.
Nor let them whine you they want your personal information to run ads and make more money out of you.
If other people dey get things wring we suppose dey different bcos knowledge wey we dey get from BTT nor be small, try dey read something for yourself before you go jump into conclusions or accept TOS wey fit do you harm.

Remember I talk before about doing airdrops dey buy more bitcoin and also remind whona say risks dey the airdrops and this na among thr risk, if e nor good for you nor accept am.
Also no matter how much you don make or person wey you know don male for airdrop nor dey blinded say Airdrop go give you money pasd learning skill o, airdrops na just to get money wey you fit spend with little Considerations and e nor go affect your actual earnings.


Title: Re: Others might be getting things wrong but not anyone in BTT
Post by: Coyster on July 23, 2024, 08:33:17 PM
Also no matter how much you don make or person wey you know don male for airdrop nor dey blinded say Airdrop go give you money pasd learning skill o, airdrops na just to get money wey you fit spend with little Considerations and e nor go affect your actual earnings.
Na only very small money person fit make from airdrops/faucets, so i no dey really waste my time on them. I understand say for some people, dem still need the small money wey dem fit make from airdrops, but where i draw the line is if the airdrops require KYC verification, i no think say e make sense to sumbit KYC for something wey no too dey productive, as airdrops.


Title: Re: Others might be getting things wrong but not anyone in BTT
Post by: Mate2237 on July 23, 2024, 08:51:35 PM
Na only Hamster Kombat nai I been dey do and I don get amount 4m per hour and when I calculate am with dollar omen I no dey do again. Upon all the stress, time and data na only dat small amount I don get. I give up di matter abeg. Me I know say na from di beginning I know say those companies dey use us dey make money online. Because the more population.they get the more money dem go dey get. And we no know and we dey plan to make big money from those airdrops but at di end na sikini money.


Title: Re: Others might be getting things wrong but not anyone in BTT
Post by: DiMarxist on July 23, 2024, 09:48:04 PM
Nice information. Many people don't and dem only dey tap. And really dis forum don educate us well well. And because dis forum now. I no dey fall for scam again. Before I dey do something I go verify am well well. And once I see a scammer I dey know. Me di way I even see am airdrop and bounty campaign na just waste of time. Instead use that money way you dey use dey buy date for the airdrop go invest in bitcoin and whenever di price go up u go dey get profit from there.
There are some people who dey believe airdrop die. And Notcoin nai cause the whole wahala. Op thanks for bringing this.


Title: Re: Others might be getting things wrong but not anyone in BTT
Post by: Churchillvv on July 23, 2024, 10:14:28 PM
Any airdrop after the NOTCOIN is just click bait for me, it's mostly a trending pattern to get more users to different platforms using their time and data (information) to gather traffic in the internet. so reading the TOS of any project (airdrop) is my number one priority.

Am no long too worried about my data's being used but being used for the wrong thing is where am afraid of, because basically we all have given Google consent to use our data's without our knowledge. sometimes ago I read Google personal data usage I freaked out because if it's to be traced/tracked there no way to hide because they know everything about you. but since I start using tor browser I'm beginning to hide from data usages of this nature.
Anyways thanks for reminding us how vital BTT knowledge can impact on us when doing any internet related stuff especially airdrops
.


Title: Re: Others might be getting things wrong but not anyone in BTT
Post by: Orpichukwu on July 23, 2024, 10:22:22 PM
If person no benefit anything from this forum at least things way concern security nah one of the things way all of us way active here suppose don learn and get basic knowledge about, so things like this no suppose be watin we need outsider to come teach us although everybody no go be thesame so the warning is also welcome.

Airdrop nah pattern way piple believe say them go carry make money from crypto way dem no go spend any single kobo nah true but the ones way go genuinely reward person no plenty, nah the ones way no go reward you full the internet because nah them get time to they make noise they crate awareness base on watin them get to achieve.

This access way them they request users to permit them to inside the person device they very dangerous for who know Watin privacy be, first to they do the airdrop you they help give them ads strength base on the level of interaction way they go on for their channel them go fit get higher bid for any body way dem wan run advert for. Nah from all this airdrop some of us they say we no no how come person get our email or phone number carry send us spam message we no go remember when we been they carry our hand do the hand over.


Title: Re: Others might be getting things wrong but not anyone in BTT
Post by: Mr.right85 on July 23, 2024, 10:47:33 PM
I know any of you still doing does telegram tap to earn must have seen this image below,
https://www.talkimg.com/images/2024/07/23/4j1Il.jpeghttps://www.talkimg.com/images/2024/07/23/4jL71.jpeg

This na one thing way I Dey impressed with when e comes to users on this forum and their level of awareness. For plenty people, them go feel pushed and see am as a way to even be on the good side of the project developers to get more allocations if them allow for this sort of activity.
Omo, you go just carry your hand finish yourself via say, you no know the length at which this people go dip reach all in the name of, you don permit them to access your privacy data.
Anything privacy suppose fear you o. E get why e be privacy and you no suppose allow anybody to Dey access am. Always guide yourself, e get why!


Title: Re: Others might be getting things wrong but not anyone in BTT
Post by: Hewlet on July 24, 2024, 05:43:18 AM
From what I've realized with most airdrops, before you carry out all the task that's expected of you before you eventually gets paid, you must have lost far more than what you will be paid. Visiting most of the site you're mandated to visit is risky, you're forced to invite friends into joining in the tapping thing just to get an additional points and have to grant permission to full access of your mobile device which endangers your safety in its entirety and when you even go on to calculate what your would win at the end of the whole stress it's just too discouraging and nothing that's anywhere closed to the effort you've exerted.

The manner at which the owners of these projects intentionally bring out strategies to cut off a lot of active miners from gaining from the mining is what's a total turn off for me. I mean, you help them gain visibility by being an active miner, you follow them on all social media platforms and in less than a week, they get verified on most of the media platforms and get millions of views in their videos which goes on to generate a lot of revenue for them outside of the normal revenue they hope to get if the project becomes a success. They accepts ads of which they are paid for and force you to join channels they're running ads for and all these are just in their advantage and when it's even time to pay you, you hear a lot of stories and even when you go on to calculate the millions of taps you've done and see the profit you're getting for putting such amount of time and effort into such a task, your mind go just dey.

Omo eh, at some point nothing you wan tell me oh, airdrop na better scam.


Title: Re: Others might be getting things wrong but not anyone in BTT
Post by: Kelward on July 24, 2024, 07:30:43 AM
Di success of NOTCOIN airdrop don make many people wey no get crypto experience to think say na so di whole airdrops be. I know say na so e go later happen, scammers go take advantage of people ignorance to de comot money for dem hand. Thank you for dis one wey you carry come share with us, na so people wey no know how far go take de fall victims for wetin dem no sabi how e de work. Di rate wey people take de open telegram after NOTCOIN success de very alarming, all of dem wan to tap and make money without knowing say many scam de follow am.

Dis forum na place wey experienced members de teach newbies say all dat glitters no be gold for internet. One thing wey I learn as a newbie for dis forum be say I suppose to de do research on every information wey I see online, because scams and hacks too plenty. So a person like me no de de carried away by any free money for social media, infact free money for social media na red flag for scams.


Title: Re: Others might be getting things wrong but not anyone in BTT
Post by: Stable090 on July 24, 2024, 07:33:33 PM
Also no matter how much you don make or person wey you know don male for airdrop nor dey blinded say Airdrop go give you money pasd learning skill o, airdrops na just to get money wey you fit spend with little Considerations and e nor go affect your actual earnings.
Me I no really Dey against all this airdrop, but any airdrop wey we Dey do, we suppose Dey smart and careful, because plenty one’s wey Dey outside now na scam, make e no come be like say you go don perform task tire, and anything serious no go really commot, and me I go talk say make we no Dey allow our expectations high for money wey we go get for airdrop, because you will end up being disappointed at the end.

If I Dey even participate in airdrop, I no really Dey put am for mind the amount wey I go get, till dem make distribution and I sell am.

Also because u don see people wey participate in airdrop and dem make money no mean say if you participate you go make money like them now, e fit be say na when you start better project no go Dey again.


Title: Re: Others might be getting things wrong but not anyone in BTT
Post by: CryptopreneurBrainboss on July 24, 2024, 10:35:23 PM
It's ironic that people doing airdrops in those WhatsApp group don't really get what this actually means they think, it's a way FOR memefi to catch those users having multiple accounts which is far from that.
Nor let them whine you they want your personal information to run ads and make more money out of you.
If other people dey get things wrong we suppose dey different bcos knowledge wey we dey get from BTT nor be small, try dey read something for yourself before you go jump into conclusions or accept TOS wey fit do you ham.

I saw a popular airdrop (this same tapping airdrop) dey celebrate 1 million YouTube subscribers and twitter followers and immediately they monetize these social platforms and asking for engagement from their community. People begin dey like, comment and share and na money dem dey make for this projects but then no know. Some of dem dey run this kind airdrop to use grow their social accounts and sell to other projects and we just dey lose ad we dey give them community wey dem no work for. Make we dey use our head because after one particular something dun work for this industry na so copycats we go begin get and many of them no go succeed but just waste your time.

Quote
Also no matter how much you don make or person wey you know don male for airdrop nor dey blinded say Airdrop go give you money pasd learning skill o, airdrops na just to get money wey you fit spend with little Considerations and e nor go affect your actual earnings.

Airdrop na one time chopping na but skills go pay you for life as far you fit dey develop your skills and keep it up to current standards. Like this you no need to go dey learn normal mechanics if na wetin you wan do but how to dey use machine dey check cars because manual cars dey go outdated but  automatic cars na wetin dey full market. Make we value skills pass all this quick money grabbing opportunity and we no go regret am.


Title: Re: Others might be getting things wrong but not anyone in BTT
Post by: Moreno233 on July 24, 2024, 11:59:32 PM
It's ironic that people doing airdrops in those WhatsApp group don't really get what this actually means they think, it's a way FOR memefi to catch those users having multiple accounts which is far from that.
Nor let them whine you they want your personal information to run ads and make more money out of you.
If other people dey get things wring we suppose dey different bcos knowledge wey we dey get from BTT nor be small, try dey read something for yourself before you go jump into conclusions or accept TOS wey fit do you harm.

Remember I talk before about doing airdrops dey buy more bitcoin and also remind whona say risks dey the airdrops and this na among thr risk, if e nor good for you nor accept am.
Also no matter how much you don make or person wey you know don male for airdrop nor dey blinded say Airdrop go give you money pasd learning skill o, airdrops na just to get money wey you fit spend with little Considerations and e nor go affect your actual earnings.
I will not advice anyone to release their personal data to airdrop platform that they know nothing about, not even the founders or any member of the team. It is a big risk that is too big compared to the money they plan to dash people. I know that the surge in Telegram airdrops will also carry with it scam and crimes of various proportions and this one seems to be one of them in which they want to harvest personal details of people and probably sell them for money. I will not advise anyone to fall for this because it can backfire in the future.


Title: Re: Others might be getting things wrong but not anyone in BTT
Post by: Agbamoni on July 25, 2024, 09:00:08 AM
It's ironic that people doing airdrops in those WhatsApp group don't really get what this actually means they think, it's a way FOR memefi to catch those users having multiple accounts which is far from that.
Nor let them whine you they want your personal information to run ads and make more money out of you.
If other people dey get things wrong we suppose dey different bcos knowledge wey we dey get from BTT nor be small, try dey read something for yourself before you go jump into conclusions or accept TOS wey fit do you ham.

I saw a popular airdrop (this same tapping airdrop) dey celebrate 1 million YouTube subscribers and twitter followers and immediately they monetize these social platforms and asking for engagement from their community. People begin dey like, comment and share and na money dem dey make for this projects but then no know. Some of dem dey run this kind airdrop to use grow their social accounts and sell to other projects and we just dey lose ad we dey give them community wey dem no work for. Make we dey use our head because after one particular something dun work for this industry na so copycats we go begin get and many of them no go succeed but just waste your time.

Quote
Also no matter how much you don make or person wey you know don male for airdrop nor dey blinded say Airdrop go give you money pasd learning skill o, airdrops na just to get money wey you fit spend with little Considerations and e nor go affect your actual earnings.

Airdrop na one time chopping na but skills go pay you for life as far you fit dey develop your skills and keep it up to current standards. Like this you no need to go dey learn normal mechanics if na wetin you wan do but how to dey use machine dey check cars because manual cars dey go outdated but  automatic cars na wetin dey full market. Make we value skills pass all this quick money grabbing opportunity and we no go regret am.
Na this thing wey be say me ah been wan talk. All this projects they just one gain clouts, fame and make money online using other people. All these people they smart and they don map out how them go use every body wey believe ini them make money. E they so painful wey be say people they allow themselves fall for all this kind of things. One thing for Nigeria be say if something come out once wey pay people, the rest wey go come out no the ever dey legit again but yet plenty people go still fall for the same thing over and over again.

Airdrop na one time but the one time no be even better money wey be say go change person life. Yet you go see people no go gree go work or do anything but they prefer to they tap their phone morning and night. When they come poor for life na God they go con they ask question.


Title: Re: Others might be getting things wrong but not anyone in BTT
Post by: Hatchy on July 25, 2024, 02:52:21 PM
Our young people Dem don carry d airdrop matter for head and for Dem mind now all theses airdrops go pay fortune. I no come even understand watin Dem dey think say na so cryptocurrency just simple. I no go blame Dem Sha, na all these airdrops channel I go blame. If you see where Dem dey hype d thing e go dey vex me. Dem just dey use people Tay dey grow Dem social media channels say na airdrops. Just like d previously launched one wey Dem call pixels. After all those many stress wey Dem pass through I hear say Dem gay reach some kind level to get funds. And even d people wey reach sef na just 8$. I first know say na small think remain Dem go start to dey thief people data. Fraud go so enter and ones Dem show you go come dey hear something like pay something to receive. Be like one sef tell Dem make Dem deposit gas fee to Tay claim d airdrops.


Title: Re: Others might be getting things wrong but not anyone in BTT
Post by: Juicyhome on July 25, 2024, 05:36:44 PM
It's ironic that people doing airdrops in those WhatsApp group don't really get what this actually means they think, it's a way FOR memefi to catch those users having multiple accounts which is far from that.
Nor let them whine you they want your personal information to run ads and make more money out of you.
If other people dey get things wrong we suppose dey different bcos knowledge wey we dey get from BTT nor be small, try dey read something for yourself before you go jump into conclusions or accept TOS wey fit do you ham.

I saw a popular airdrop (this same tapping airdrop) dey celebrate 1 million YouTube subscribers and twitter followers and immediately they monetize these social platforms and asking for engagement from their community. People begin dey like, comment and share and na money dem dey make for this projects but then no know. Some of dem dey run this kind airdrop to use grow their social accounts and sell to other projects and we just dey lose ad we dey give them community wey dem no work for. Make we dey use our head because after one particular something dun work for this industry na so copycats we go begin get and many of them no go succeed but just waste your time.

Quote
Also no matter how much you don make or person wey you know don male for airdrop nor dey blinded say Airdrop go give you money pasd learning skill o, airdrops na just to get money wey you fit spend with little Considerations and e nor go affect your actual earnings.

Airdrop na one time chopping na but skills go pay you for life as far you fit dey develop your skills and keep it up to current standards. Like this you no need to go dey learn normal mechanics if na wetin you wan do but how to dey use machine dey check cars because manual cars dey go outdated but  automatic cars na wetin dey full market. Make we value skills pass all this quick money grabbing opportunity and we no go regret am.
@brainboss, you talk better thing here, the energy pipe Don take dey do these telegram airdrop if them channel am to physical skills e for don earn dem big time, because if you calculate data money and time wasted, and the money the Airdrop go pay e no reach anything.  Learning skills is very necessary and e go dey with you for ever. I buy the idea. Me I get skill but I need add more because as naija be so one skill no go fit foot ur bills.


Title: Re: Others might be getting things wrong but not anyone in BTT
Post by: Marykeller on July 25, 2024, 10:26:14 PM
Na only Hamster Kombat nai I been dey do and I don get amount 4m per hour and when I calculate am with dollar omen I no dey do again. Upon all the stress, time and data na only dat small amount I don get. I give up di matter abeg. Me I know say na from di beginning I know say those companies dey use us dey make money online. Because the more population.they get the more money dem go dey get. And we no know and we dey plan to make big money from those airdrops but at di end na sikini money.
Lols. I can't stop laughing. Na this kind of unrealistic hope of yours na em make make people join this mining of coins for telegram. So many people don d dream wetin dem go use the money accumulate from tapping do before its launch date. I just d laugh at them, wey d think that Hamster Kombat go pay as Notcoin. However I believe sae this tapping of a thing go humble many to actually know that no free money in crypto. For you to make it big in crypto, you supposed learn how to invest in bitcoin or any other potential altcoins


Title: Re: Others might be getting things wrong but not anyone in BTT
Post by: Obim34 on July 26, 2024, 03:42:26 PM
Aside Bitcoin engagement, the forum has always thought us a lot of things we never knew that we supposed to know, more like staying pro reactive against scams and scammers like this. One trick about this airdrop is the greater the population the lesser chances of them paying, they can never pay as much user that are participating, Notcoin was the way opener and the rest on the list are all scam, even if they end up paying it ends to nothing valuable.

These Airdrop is becoming the latest threat, I saw a few of the airdrop handles on twitter got banned, I hope many would go same way because they now divert the attention of people from doing what most importantly generates money, now they spend more of their time tapping, with some people not understanding the risk factors while accepting every of their task.


Title: Re: Others might be getting things wrong but not anyone in BTT
Post by: Jaycoinz on July 26, 2024, 07:47:19 PM
Na only Hamster Kombat nai I been dey do and I don get amount 4m per hour and when I calculate am with dollar omen I no dey do again. Upon all the stress, time and data na only dat small amount I don get. I give up di matter abeg. Me I know say na from di beginning I know say those companies dey use us dey make money online. Because the more population.they get the more money dem go dey get. And we no know and we dey plan to make big money from those airdrops but at di end na sikini money.
All this tapswap even hamster Kombat sef for me na ways wey these projects owners dey use get am clear for for these social media platforms wey dem dey tell their participants to follow up especially with their official Twitter accounts because I believe say these coins project dey get am clear well well as their accounts are fully active which if am not mistaken Elon musk dey pay  those accounts massive funds for their Twitter accounts.


Title: Re: Others might be getting things wrong but not anyone in BTT
Post by: Richbased on July 26, 2024, 08:29:40 PM
Also no matter how much you don make or person wey you know don male for airdrop nor dey blinded say Airdrop go give you money pasd learning skill o, airdrops na just to get money wey you fit spend with little Considerations and e nor go affect your actual earnings.
Na only very small money person fit make from airdrops/faucets, so i no dey really waste my time on them. I understand say for some people, dem still need the small money wey dem fit make from airdrops, but where i draw the line is if the airdrops require KYC verification, i no think say e make sense to sumbit KYC for something wey no too dey productive, as airdrops.

Exactly, me sef I dey surprise say some of us for this forum still dey fall so cheap to this crypto games that promises airdrops because no be today way all dis tins start but e just dey baffle me say people no dey learn but I no dey too blame people sha because the way tins dey for the country now everybody dey find wia dem go achieve small thing and I don see people wey dey do this crypto games very many of dem wit the hope say if one no work the other one go work but we don big pass wia we wey dey dis forum go dey involve ourselves for everything wey we see other people dey do and anything wey involve using KYC verification I dey try as much as possible to dey avoid am because it's very risky and another tin na to dey link exchange address for the crypto airdrops because all dos tins fit lead to scammers getting access to one's assets so na just dey totally careful.


Title: Re: Others might be getting things wrong but not anyone in BTT
Post by: Agbamoni on July 26, 2024, 08:52:35 PM
Na only Hamster Kombat nai I been dey do and I don get amount 4m per hour and when I calculate am with dollar omen I no dey do again. Upon all the stress, time and data na only dat small amount I don get. I give up di matter abeg. Me I know say na from di beginning I know say those companies dey use us dey make money online. Because the more population.they get the more money dem go dey get. And we no know and we dey plan to make big money from those airdrops but at di end na sikini money.
Sometimes you look at your effort into all these new projects from tapping one day to tapping every day and you find out that is not worth it and yes, it's not worth the stress, data, and time we put into it. I started to understand that it is the same company that paid Notcoin that has those other company and the y paid Notcoin because they have the plan to spread other projects that people would believe. one thing about these companies is that once they have more population, they have more money. Nowadays the more people you have engaging in your platform the more money you get paid and that is what is happening in all the social media we join in those projects.


Title: Re: Others might be getting things wrong but not anyone in BTT
Post by: Davidvictorson on July 26, 2024, 09:48:24 PM
This one na real life review of these airdrops. And I like as na real people wey don experience am dey talk ma. Personally, I nor care wether those airdrop money dey or not wetin I know be say that method don cast. Na before before wey be say airdrop dey give better money, now aday the developers na him dey over make money.

Anyways, thank God for this forum sha e give me beta foundation cyber security knowledge. And that one na one thing wey i no go ever forget. Atleast I fit give small seminar presentation on am without fear say I need to look book dey talk.


Title: Re: Others might be getting things wrong but not anyone in BTT
Post by: Juicyhome on July 27, 2024, 03:05:46 PM
Na only Hamster Kombat nai I been dey do and I don get amount 4m per hour and when I calculate am with dollar omen I no dey do again. Upon all the stress, time and data na only dat small amount I don get. I give up di matter abeg. Me I know say na from di beginning I know say those companies dey use us dey make money online. Because the more population.they get the more money dem go dey get. And we no know and we dey plan to make big money from those airdrops but at di end na sikini money.
Sometimes you look at your effort into all these new projects from tapping one day to tapping every day and you find out that is not worth it and yes, it's not worth the stress, data, and time we put into it. I started to understand that it is the same company that paid Notcoin that has those other company and the y paid Notcoin because they have the plan to spread other projects that people would believe. one thing about these companies is that once they have more population, they have more money. Nowadays the more people you have engaging in your platform the more money you get paid and that is what is happening in all the social media we join in those projects.
They're just using people to cashout on their media space, once they achieve their goals or have more money they will abandon the project, and many hope will lost for those that real believe on their projects.  The worst thing is that you won't convince anybody to stop tapping, they will see you as enemy of progress, so you better just let them do their things, country hard everyone just dey put head to where them go see money. No doubt the energy and time wasted on these projects if well utilise on good skills it will benefit them.


Title: Re: Others might be getting things wrong but not anyone in BTT
Post by: SmartGold01 on August 01, 2024, 07:24:44 PM
This is one problem with not reading before proceeding some form of signing up in most of these site especially airdrops that doesn't hold any future or that won't worth something rewarding after joining them, if people keep reading ToS then they wouldn't fall for such thing by agreeing to use personal information to personalized their site or used them for any marketing purposes. I barely join these airdrops of a thing because I know that it's fake and can't rewards someone something meaningful, including tap and hamster kombat.


Title: Re: Others might be getting things wrong but not anyone in BTT
Post by: HajiBagi on August 02, 2024, 06:43:35 PM
Also no matter how much you don make or person wey you know don male for airdrop nor dey blinded say Airdrop go give you money pasd learning skill o, airdrops na just to get money wey you fit spend with little Considerations and e nor go affect your actual earnings.
Na only very small money person fit make from airdrops/faucets, so i no dey really waste my time on them. I understand say for some people, dem still need the small money wey dem fit make from airdrops, but where i draw the line is if the airdrops require KYC verification, i no think say e make sense to sumbit KYC for something wey no too dey productive, as airdrops.

Even if some people still need the small money wey airdrop Dey pay them suppose get sense na, no be every airdrop be airdrop,  nothing I fear pass airdrop because from the airdrop na e you go start to Dey get involved in some things wey go lead you to the scammers hand, normally I believe in some airdrop and I no fit stop anybody because some people don master with am and them Dey see money chop from the airdrop but we need to be careful in the process, no anything online that they are not scamming people so be wise and don’t waste your time for any airdrop wey Dey commot this days.

The reason why I said that is that some airdrop na wasting of time, you go tap tire and at the end they will not launch their coin for people to see money chop, many of fakes airdrop are using the opportunity of the legit airdrop to make money from people so before tapping on any airdrop make sure you know more about the airdrop so that you won’t waste your time.


Title: Re: Others might be getting things wrong but not anyone in BTT
Post by: Mr.suevie on August 02, 2024, 07:27:43 PM
Na only Hamster Kombat nai I been dey do and I don get amount 4m per hour and when I calculate am with dollar omen I no dey do again. Upon all the stress, time and data na only dat small amount I don get. I give up di matter abeg. Me I know say na from di beginning I know say those companies dey use us dey make money online. Because the more population.they get the more money dem go dey get. And we no know and we dey plan to make big money from those airdrops but at di end na sikini money.
E be like this hamster Kombat sef don turn another thing oo because the way dem dey use different task out e come be like say dem no really dey serious with the launch and with watin I dey even see sef e be like many per don already hang leg for this their crazy projects but a friend of mine call me yesterday sef about one of the project call avacoin wey don also launch.


Title: Re: Others might be getting things wrong but not anyone in BTT
Post by: Barikui1 on August 08, 2024, 09:20:57 AM
I know any of you still doing does telegram tap to earn must have seen this image below,
https://www.talkimg.com/images/2024/07/23/4j1Il.jpeghttps://www.talkimg.com/images/2024/07/23/4jL71.jpeg

It's ironic that people doing airdrops in those WhatsApp group don't really get what this actually means they think, it's a way FOR memefi to catch those users having multiple accounts which is far from that.
Nor let them whine you they want your personal information to run ads and make more money out of you.
If other people dey get things wring we suppose dey different bcos knowledge wey we dey get from BTT nor be small, try dey read something for yourself before you go jump into conclusions or accept TOS wey fit do you harm.

Remember I talk before about doing airdrops dey buy more bitcoin and also remind whona say risks dey the airdrops and this na among thr risk, if e nor good for you nor accept am.
Also no matter how much you don make or person wey you know don male for airdrop nor dey blinded say Airdrop go give you money pasd learning skill o, airdrops na just to get money wey you fit spend with little Considerations and e nor go affect your actual earnings.
My brother, you don talk well, the knowledge wey dy we dy get for free in this forum surpose serves us well outside of this forum, especially in the tech industry, no body say doing airdrop na bad thing oo, just that as we dy do am, make we dy security conscious of ourselves, especially those airdrop wey dy demand for our personal data, to me oo, any airdrop wey we dy do wey ask us of such information, make we just know say them get a different motives, because I dy very certain say airdrop wey go pay you better money no go stress you and them also no go demand for ur personal information.

Though on my own part, I no dy too do airdrop because the stress too much, and most times, them no go still pay you after everything, so because of that, if I dy do any airdrop now, I dy always dy sure first say Dem go pay, before I even engage, and if I dy connect any wallet, na wallet wey nothing dy inside I dy connect am with, because I no wan hear stories that touch for my money.