Bitcoin Forum

Local => Nigeria (Naija) => Topic started by: Ambatman on September 19, 2024, 01:21:33 PM

Title: What if Ton's airdrops are malware infected
Post by: Ambatman on September 19, 2024, 01:21:33 PM
Una Good afternoon or Ekasaan to the Yoruba's.
Before I go straight to the topic, I would first of all commend the changes on the board
Yes I'm barely here and barely post here but I do com to check things out once in a while and I must say
It's more organized and better than last to early this year.
All of una don try.

Now to my topic, I jam dis topic for beginners and help board https://bitcointalk.org/index.php?topic=5509679.msg64548786#msg64548786 about how Dem dey infect people device with malware through job seeking.
And e hit me, if something like this happen for tapping and airdrop project wey dey go on?
How e go be?
Like people wey go dey affected go plenty Swrs.
The cautiousness that are adviced towards this job scams e nor go bad if person still try implement such in all this project.

Like e get many things I go for like talk about or if the stuff nor dey possible
But if e dey and Dem don doan
Your device dey safe?

Title: Re: What if Ton's airdrops are malware infected
Post by: Tungbulu on September 19, 2024, 03:56:39 PM
Honestly, I don really think about this same matter, if true true say all these TON airdrops dey malware infected, then na very big trouble for people wey dey do crypto things, especially for we Naija, because majority of Nigerian population dey do one or several Tap2Earn games and airdrops wey dey under the TON airdrop, like the rate I don witness his dey surprising, both young and old people dey involved, especially after the first successful Tapswap project and then $DOG project, e don motivate plenty more people to join, so just imagine the crowd and the number of devices wey go don already dey infected by now.

Title: Re: What if Ton's airdrops are malware infected
Post by: Zigabel on September 19, 2024, 05:37:58 PM
For this our computer age wey dem dey say almost everything dey possible, e fit Happen oh, you don hear of dust for wallet? Dat na the means wey dem dey take run crypto malware sometimes, so no be very airdrop wey pesin suppose involved because some na wahala we no go know just dat d once wey I don hear of Sha dem no dey really take pesin personal information but dem go tell you to bring small money to use claim ur coin meanwhile e no go end up to fit claim am.all dis projects wey we dey c upandan make we no forget say na group of pipo dey run am so dia motive na something wey we fit no know, dem fit from dia enter us so am to dey kiaful, time been dey wey everybody been dey run tap swap maat but now e com be like say dat wan dey don shef am, na hamster and blum dey reign, me I dey advice use separate wallet wey no be ur main wallet if you dey run any of these things so just in case say na malware, e no go fit do u plenty harm, never use ur main wallet no mata how d mata sweet u reach.

Title: Re: What if Ton's airdrops are malware infected
Post by: CryptoHeadlineNews on September 19, 2024, 07:00:46 PM
Now to my topic, I jam dis topic for beginners and help board https://bitcointalk.org/index.php?topic=5509679.msg64548786#msg64548786 about how Dem dey infect people device with malware through job seeking.

And e hit me, if something like this happen for tapping and airdrop project wey dey go on?
How e go be?
Though nothing is impossible when it comes to online scams, but I think with this update, it should make us one step ahead to our personal security, by been very selective to the types of crypto airdrops we participate in, just to avoid stories that touches the heart. Because truly, if this hits the Telegram tapping ecosystem, eh go really affect lots of people, as many people now believe in this type of airdrop ever since Notcoin and Dogs got listed on major exchanges.

Hence, just as it's stated in the thread link given above about how the job scam was done by requesting users to download apps on third party websites which is not Playstore or Apple store to execute code on their mobile devices, Don't do it, just run away as it's likely to be a potential scam.

Quote
they will request to download apps or execute code for those job seekers, or for social engineer, they want the employees to execute code inside the company's internal network.
Source from the link above

Title: Re: What if Ton's airdrops are malware infected
Post by: Lida93 on September 19, 2024, 11:33:14 PM
Whetin op reason no be lie cos it dey possible say our device fit get infected by some phishing malware through all these airdrops links wey people just the share here and there for telegram. But make I just share how I try to stay safe about these telegram mini app airdrop links.

 I no dey rush jump into clicking to start any new project wey any person send me. I the just leave am there till I see and hear am from multiple people about that very project and nah from there I go just move straight to their official page on social media collect their link myself if I still get interest about it.

Title: Re: What if Ton's airdrops are malware infected
Post by: Ambatman on September 20, 2024, 12:39:24 PM
Like na e b mainstream if u nor doan everybody go feel say u nor dey serious with your life.
Sometimes I go say I nor wan sell my data for tokens Dem go ask who my data help  :'( .
I cry for them Sha but experience na d best teacher hopefully they won't experience such.
Now I know this thing Don help guys and ladies so we can consider it something  like a good thing.
We know how people dey do good thing na
Dem go spoil ahn
Just hope say the spoiling na scam and nor malware.

Title: Re: What if Ton's airdrops are malware infected
Post by: DubemIfedigbo001 on September 20, 2024, 01:06:54 PM
There is a good possibility of such things happening and should have happened very well if not for the strict practices telegram has initiated on its bots from the onset which denies bots the permission to do certain things and limits its operation to the telegram environment alone. There are key things you must note about the way bots interact with a user on the telegram platform.

- Telegram uses sandboxed environment for their bots interaction which denies the bots access to the user's devices or files and limits all activities to the telegram platform

- Users are advised to patronize more verified bots with blue ticks since only at the point of verification does telegram actually screen properly your bot for malware and other potential hazards to user

- Telegram introduces use of third party trusted payment platforms for games that needs payment and denies the bots the ability to collect user's payment details.

- All interactions with the telegram servers and bots are end to end encrypted leaving little or no chance for user's data to get into the hands on bot owners or third parties and they Protect user's data while giving everyone freedom of expression and that is why Pavel Durov is still in the cruel hands of French authorities.

- All users are advised to update their 2FAs to increase the security of their accounts

- Telegram denies automatic app downloads from bots, so they cannot give out compromised apps on the platform and also warns people when they are using links to external websites.

- Telegram notifies users of groups that are obvious scams for them to tread with caution when using such groups

In view of the above, users are also advised to verify themselves the authenticity of every bots and report scams to the telegram support so they can restrict bots where possible.

Title: Re: What if Ton's airdrops are malware infected
Post by: EL MOHA on September 20, 2024, 10:12:22 PM
Honestly, I don really think about this same matter, if true true say all these TON airdrops dey malware infected, then na very big trouble for people wey dey do crypto things, especially for we Naija, because majority of Nigerian population dey do one or several Tap2Earn games and airdrops wey dey under the TON airdrop, like the rate I don witness his dey surprising, both young and old people dey involved, especially after the first successful Tapswap project and then $DOG project, e don motivate plenty more people to join, so just imagine the crowd and the number of devices wey go don already dey infected by now.

Ok let’s agree that there is malware infection on this mini games I think most users devices will be infected but as for now there is no such thing among them, my reason been that this malwares aren’t built to stay on the device for Long without actually carrying out their aims. If you have been following telegram mini apps you will have notice that the bots which are phishing bots are easily dictated most of them are the bots for trading on the platform but they are usually phishing bots because people easily get their accounts drained so if the algorithm hasn’t caught any mini game yet then there is none yet.

But let’s assume there is actually a malware infection through this bots it will mostly affect newbies and naive people my reason been that the old or experienced investors know that the device to use with all this Should be a different device and if they get caught they can simply just format the phone without having to lose datas that much

Title: Re: What if Ton's airdrops are malware infected
Post by: Agbamoni on September 20, 2024, 10:40:38 PM
From the very beginning i no make mistake say ah they use device wey ah they use do important crypto things do these airdrops. The first airdrop wey i say make i do sef na this hamster combat and my reason for doing am na because i see say dem dey promising after i miss tapswap and dogs. To go straight to the point this notice is important for everyone here. Make we make sure we use another device wey no they connected to our crypto apps use do the mining of the airdrops from now henceforth.

Title: Re: What if Ton's airdrops are malware infected
Post by: SmartCharpa on September 20, 2024, 11:23:39 PM
Whetin op reason no be lie cos it dey possible say our device fit get infected by some phishing malware through all these airdrops links wey people just the share here and there for telegram. But make I just share how I try to stay safe about these telegram mini app airdrop links.

 I no dey rush jump into clicking to start any new project wey any person send me. I the just leave am there till I see and hear am from multiple people about that very project and nah from there I go just move straight to their official page on social media collect their link myself if I still get interest about it.

My broda, links wey dem dey share these days just dey very annoying, there's no single day wey dey no dey send me referral link from different projects, no be the one wey you see today you go see tomorrow. You're doing the best thing to avoid the links wey dem dey forward give you, ever before they introduced all this Telegram mining stuff, I no dey click on any links they sent to because I don't use to believe in all that, e just dey be like wasting of time and person fit get scam. Some of my guys don dey vex for me because if they send me any links I no dey register, I dey always complain that I no get time to waste on unnecessary projects and some of them go dey think say i dey form big man for them. ;D

The way some people carry this Tao2earn serious las las dey will begin they scam people, I've said this before all these tap to earn wey people dey see cashout now is just a main time, if all the legit airports cook finish now, we no go see any real projects again and a lot of people go still fall victim base on say $DOGS and NOTcoin did well.

Title: Re: What if Ton's airdrops are malware infected
Post by: promise444c5 on September 21, 2024, 01:35:11 AM
Well regarding this connecting of a wallet thing, some of my friends reached out to me about the message they got while connecting their wallet, a friend sent me a screenshot of him trying to connect thus airdrop and on getting to his wallet there was notification from the wallet  that the particular link  contains phishing info and might try to spend user funds without permission/with permission (not really sure about that spendingaspect )but the advice I gave him was to create an empty wallet then connect it and i warned him not use the particularwallet for officialreceive of funds or any transaction apart from that. Atleast with that there won't be any future drama, I even heard  some were requesting a minimum of amount on wallet for withdrawal, I mean isn't that fishy on its own....

Title: Re: What if Ton's airdrops are malware infected
Post by: Cryptomultiplier on September 21, 2024, 09:49:37 AM
From the very beginning i no make mistake say ah they use device wey ah they use do important crypto things do these airdrops. The first airdrop wey i say make i do sef na this hamster combat and my reason for doing am na because i see say dem dey promising after i miss tapswap and dogs. To go straight to the point this notice is important for everyone here. Make we make sure we use another device wey no they connected to our crypto apps use do the mining of the airdrops from now henceforth.

  Gbam! Na just the Koko be that.
 The alarm wey we don hear about Telegram don reach for us to use our sense apply caution, mostly when it comes to  allowing the Telegram app permissions to our device information and personal data, either when we dey register or join any project or group or  when we click on some kind of links from or to the site.

Simply just use another wallet instead of to use the wallet wey telegram provide, because no matter sef how sure we like the way Telegram dey package, make we no forget say the best apps na those wey serve one purpose, no be those wey just dey follow follow dey do, because of the wide spread adoption of cryptocurrency.

 Use normal exchange for anything crypto currency, use telegram for chats or freebies, use opera for browsing, no go do because say Dem get wallet, you come go use am DCA, na you sabi o.

Title: Re: What if Ton's airdrops are malware infected
Post by: Tungbulu on September 21, 2024, 10:25:12 AM

Ok let’s agree that there is malware infection on this mini games I think most users devices will be infected but as for now there is no such thing among them, my reason been that this malwares aren’t built to stay on the device for Long without actually carrying out their aims. If you have been following telegram mini apps you will have notice that the bots which are phishing bots are easily dictated most of them are the bots for trading on the platform but they are usually phishing bots because people easily get their accounts drained so if the algorithm hasn’t caught any mini game yet then there is none yet.
First of all, we’re not literally saying there’s malware infections on the TON projects, this is just merely an assumption and I believe you know that already. And secondly, not all Malware are built to act immediately, the malware acts based on the developer’s intentions, if the developer’s plan is to target a total of 1 million users or devices, the time frame doesn’t matter in this case anymore, whether it takes more time or less time to achieve the total number of users required doesn’t really matter. Let’s still assume the TON network is malware that’s targeting over a 100 million users in the crypto space, the network will be in existence for as long as possible until it finally achieves the required targets needed, the. It can carry out its purpose.

Title: Re: What if Ton's airdrops are malware infected
Post by: HajiBagi on September 21, 2024, 03:08:40 PM
For this our computer age wey dem dey say almost everything dey possible, e fit Happen oh, you don hear of dust for wallet? Dat na the means wey dem dey take run crypto malware sometimes, so no be very airdrop wey pesin suppose involved because some na wahala we no go know just dat d once wey I don hear of Sha dem no dey really take pesin personal information but dem go tell you to bring small money to use claim ur coin meanwhile e no go end up to fit claim am.all dis projects wey we dey c upandan make we no forget say na group of pipo dey run am so dia motive na something wey we fit no know, dem fit from dia enter us so am to dey kiaful, time been dey wey everybody been dey run tap swap maat but now e com be like say dat wan dey don shef am, na hamster and blum dey reign, me I dey advice use separate wallet wey no be ur main wallet if you dey run any of these things so just in case say na malware, e no go fit do u plenty harm, never use ur main wallet no mata how d mata sweet u reach.

Me I Don talk am before say any airdrop wey dey ask say make I put money I no dey involved, sometimes we have to think well before we join any airdrop, many scammers dey use the airdrop opportunity dey scam people and they are also using the airdrop to comfuse person, na so many airdrop take full Telegram now even the one wey good and the one no good, normally we know say airdrop dey pay but my brother's any airdrop wey go give you money chop no go stress you, let use Notcoin and Dogs do example because na those airdrop give people money wey make everybody dey create Telegram come dey do mining even the people wey no know how to read and write they are just tapping.

Notcoin and Dogs no stress anybody, them give people money chop from their mind wey people go appreciate their airdrop but you see the remaining airdrop I no trust them at all because many of them now go ask you to put money before you are eligible to get your coin, crypto Don open everybody but I no blame anybody, na the way everybody go take survive we dey find.

Title: Re: What if Ton's airdrops are malware infected
Post by: Dr.Bitcoin_Strange on September 21, 2024, 04:02:34 PM
Well, you could be right in the sense that, the way referral link in flying up and down on social media is kinda alarming and some people are just seriously clicking on those referral links, forgetting the danger to link clicking. Generally, all airdrops on the ton network can not be an attack because I sense that their are still some people that just wanted this tending opportunity for them to introduce their own project but that doesn't mean that scammers will not also join the trend.

Everybody needs to be careful and mindful of the link they are clicking. For example, when opening a referral link for those games, since it's launched on telegram, always know that the link will start with "https://t.me/name of the coin_bot/name of  referee? referee referral code. "

Example: https://t.me/Drstrange_Bitcoin_bot/Drbitcoin_strange?startapp=123635
 If you see a link that is not something close to this, then it's obviously a link that will not lead you to your telegram app.  Secondly, what some people that are seriously playing these games should understand is that, while playing those game, they usually click on some hyperlink which my fear is that a malware could be hidden in those links.

Title: Re: What if Ton's airdrops are malware infected
Post by: iBaba on September 21, 2024, 07:02:47 PM
From the very beginning i no make mistake say ah they use device wey ah they use do important crypto things do these airdrops. The first airdrop wey i say make i do sef na this hamster combat and my reason for doing am na because i see say dem dey promising after i miss tapswap and dogs. To go straight to the point this notice is important for everyone here. Make we make sure we use another device wey no they connected to our crypto apps use do the mining of the airdrops from now henceforth.

Really? But why do we think these airdrop apps particularly those telegram mini apps, have the ability to infest malwares on our crypto apps and other financial apps. I can't also remember granting those telegram mini apps an access to these apps to my phone data. I am curious to know more about the possibility of these apps to infiltrate on my phone data because I've ever had same thoughts of skeptism about these apps but do not see the vulnerability aspect clearly yet.

Title: Re: What if Ton's airdrops are malware infected
Post by: nelson4lov on September 21, 2024, 10:09:25 PM
Imo, I don't think there's anything to be afraid of when interacting with these mini-app projects because you're really not downloading anything else to your device except for the telegram application itself which acts as the underlying layer. So if you want to get malware, it has to come from telegram itself and I don't think that's a viable choice to them when stealing and selling user data will yield better ROI. If you're downloading stuffs to your devices, then that's where there should be a cause for concern but this is not the case.

Title: Re: What if Ton's airdrops are malware infected
Post by: I_Anime on September 25, 2024, 10:06:14 PM
If such happens it will be disastrous honestly, because alot of people go endup losing their valuable assets . But I never encounter any sha so far but the one wey dey common nah say most of this project dey farm their users. Like for instance some of them go dey demand for person to put money first , to get better position for the allocation while some go belike say without pay certain amount money you nor go dey eligible for the airdrops.

The only I can say is that we should be careful of the kind of project will put body put ohhh , like the other get one wey come dey ask for users personal data , I think was memfi and I believe alot of users agree to that terms, we are all know that security plays a vital role in this space to avoid any story that touches the heart .

Op thanks for this post ohh Omo nah for man to wise up , and add cautiousness for this airdrops farming stuff

Title: Re: What if Ton's airdrops are malware infected
Post by: nelson4lov on September 25, 2024, 10:32:03 PM

Yup. That's a completely different kind of risk. The risk OP dey on about na if connecting to any of those mini apps fit directly or indirectly lead to you getting malware on your device but that one don dey debunked. The one you dey talk about na about games wey dey push the "pay to airdrop" meta. The truth be say, no. Formula dey to know if any of such projects go yield tangible results. Catizen was just the first and that their revenue helped them to get a Binance listing because if they go to pitch to exchanges and other partners prior to listing, they will just say — "We made x$ in revenue. People are actually playing our game".

The current chatter on X (formerly Twitter) be say most exchanges need projects (mostly games) wey already dey make revenue.

Title: Re: What if Ton's airdrops are malware infected
Post by: CryptopreneurBrainboss on September 27, 2024, 11:40:47 PM
And e hit me, if something like this happen for tapping and airdrop project wey dey go on?
How e go be?
Like people wey go dey affected go plenty Swrs.
The cautiousness that are adviced towards this job scams e nor go bad if person still try implement such in all this project.

Shabi Hamster Kombat dun do them small bad thing, after all the tapping withing them give una again?

Na so e go be when you go lose the small one wey dey your wallet because say you dey find new ones through tapping. Incase you don't know, downloading an infected app can give them access to your phone and then fit enter any where them wan access.

No be every tapping you go tap. Some you go just get to ignore them even though e be like say everybody they do am. Infact wetin me dey tell myself say, if plenty people too know am, e no worth am again but Bitcoin no follow for this talk oh.

Title: Re: What if Ton's airdrops are malware infected
Post by: MainIbem on September 28, 2024, 07:11:05 AM

Omo many people expectations been cut short, most of them wey done dey reason to use their Hampster Kombat money buy benz na so so complain complain dey just dey complain online, wetin funny na say these people been dey see themselves as CEO, person say em be Lord for Hampster Kombat say em mine up to 1 billion HMSTR Token and when eh launch eh go buy this and that omo Hampster launch, they give am just $6, very funny. That's why people no supposed dey take most of those airdrops projects wey dey launch for Ton blockchain seriously cause just like Hampster, Catizen and some others, them no really dey sincere to their community and dey  make people waste their precious time. However wetin the OP dey reason dey very important and na something to ponder about cause since the Ton Blockchain come out you go dey see different links of airdrops lately and eh dey possible say many of them contain malware wey fit give scammers access to people privacy cause Telegram na scammers ground.

Title: Re: What if Ton's airdrops are malware infected
Post by: Moreno233 on September 28, 2024, 09:59:20 AM
I am happy that someone is thinking outside the box regarding the trending airdrops that have hit the cryptocurrency community. The proliferation of these airdrop bots and platforms is something that should  give anyone, who is experienced in this digital ecosystem, serious concerns. Scammers and bad players always use the opportunity of things like these airdrops to unleash their clandestine activities and I will not be surprised if they are already busy creating something dangerous to the community. I recur that some of the games downloaded in these airdrops are reported to be of security threat. I received one of such notification in my phone where one of the game was blocked and flagged to pose a security threat. We just have to be careful.

Title: Re: What if Ton's airdrops are malware infected
Post by: Igebotz on September 28, 2024, 12:47:37 PM
Of course, if the developers made it easier to mine, the population would increase; however, the Harmster Kombat were more concerned with building a larger community and creating buzz about their project than with the miners.

Avoid Tap and earn projects using a cheat or daily combo to gain extra coins. They always scam or airdrop a small amount to their community.

Before you join a tap and earn project, carefully investigate the team behind it to ensure they are trustworthy, well-known personalities you can rely on.