Bitcoin Forum

Local => Nigeria (Naija) => Topic started by: Adbitco on November 09, 2025, 03:05:57 AM



Title: How do you change their mindset and narratives towards bitcoin
Post by: Adbitco on November 09, 2025, 03:05:57 AM
Morning my people how una dey for una side?
Okay, na just small thing I want make we yearn this morning though I knows many of us still dey romance our beds sha but we go need to put heads see what possible majors we fit take to change people mindsets especially, those people wey dey around us wey no too much understand how the system function or how bitcoin investment dey work.

The main reason why I bring up this whole matter be say, e get one friend I get although him no too get interest for bitcoin sha because of him experience for MMM, I know say many of us sabi this one and in facts na through MMM wey many of take discover bitcoin and this forum, keep that aside this my guy begin see me with system sometimes how i dey work, and when him come him go begin say senior man you don dey bomb oo, show me road na or make we work together but i still dey yearn am say me no dey run street.

The dey him come settle down come meet me up, I open mind dey explain how bitcoin dey function and how him fit make profits from bitcoin and so many things wey explain give am, the next thing I hear from am be say "Bro leave that thing, we know as e dey be because na so MMM come with the same legs come pack we money run till date we never hear anything about and now you come dey tell me something about online again to make investment". Him further go ahead dey ask me weda I don see Satoshi face to face? And I said No, Them him come say before him go put interest for anything with this our digital currency him gat to wait till Satoshi bring himself out so that any money wey person go invest him go know where the money dey go.

Now, to sum up the whole things here, na like this way many people out there or even we President fit dey reason or those wey for don venture into this industry years ago dey feel say e go happen to them. Like this, I know say investment no be by force oo and we also know say na self willingness and preparation before them go start investment so that any money them lose e no go too affects them again. But then if na you see this kind thing or even get people wey dey reason like this wetin you go do or you go let them be or trying harder to make them understand system?

I just bring open question for the flow so that we fit put heads see how we fit dey help out people and to change their mindset to understand more better about bitcoin and, how is not the same as Ponzi Scheme they think.
Make una shuck mouth.


Title: Re: How do you change their mindset and narratives towards bitcoin
Post by: Hypnotizer on November 09, 2025, 05:50:51 AM
Omo, to change those kind people mindset regarding bitcoin dey hard but e still dey possible, personally I get di way I dey take run am to change their narrative and mindset regarding bitcoin with just some simple steps of explanation.

Firstly, I dey start by explaining Wetin the kind Ponzi scheme wey dey fall victim of be and the pattern wey dem take dey run Ponzi scheme, like the promise of higher return and lesser risk. Then I go try differentiate the Ponzi scheme with bitcoin, by letting dem know say bitcoin nah very risky investment and e no dey promise anybody higher return but if your are patient enough to hodl or if you sabi trading well well, you will see the result your self and bitcoin no dey need you to refer anybody 😂, like most of the Ponzi scheme do

E dey very important to outline the pattern of Ponzi scheme to dem and try much to differentiate it with how bitcoin dey run, because bitcoin dey work based on mathematics and it is not controlled by any party or group like most of the Ponzi scheme which are in most cases controlled by a person or a group of persons. And bitcoin is very transparent not like most of the Ponzi scheme because every transaction in  the Bitcoin network is recorded on the blockchain and everyone can see it.


Secondly, to further prove to dem that bitcoin is not like what dey think it is, e dey important to tell dem say even USA dey Hodl bitcoin for their strategic reserve and some other countries as well. Most people usually believe in something when dem see the government doing it, so by showing dem that even developed countries Hodl bitcoin as a reserve, e fit change their narration about it. And also everybody knows that the government can never invest in any Ponzi scheme, so e fit dey clear to dem say bitcoin no be Wetin dem dey think.


Lastly, e dey important to provide them with the resources wey dem go fit use run their own research, make dem sef see for their sef. Because DYOR nah important thing for this space and if dem do am, e go help them understand more. Wetin you fit do for dem be say, make you explain am basically for dem make dem know say bitcoin no be di Ponzi scheme to change their narrative and mindset about bitcoin, the rest and dem suppose know by doing their own research.
 


Note: e also dey important to differentiate altcoins and bitcoin to dem.



Title: Re: How do you change their mindset and narratives towards bitcoin
Post by: Evergreenpost on November 09, 2025, 06:37:26 AM
It is not easy to convince people to invest in or change their mindset about Bitcoin. I would first explain the meaning of Bitcoin and its importance, the difference between traditional currency and cryptocurrency, the purpose for which Bitcoin was invented, and how someone can benefit from it.

I would begin by discussing how inflation has affected our local currency and how Bitcoin can help prevent or reduce the rate at which inflation devalues money.

Keeping money in the bank is no longer safe, as there are many charges and taxes (such as VAT) to pay. Instead of leaving money in the bank to lose value due to inflation, it may be better to explore options like Bitcoin, which can help preserve or even increase the value of your funds over time.


Title: Re: How do you change their mindset and narratives towards bitcoin
Post by: AVE5 on November 09, 2025, 06:52:06 AM
But then if na you see this kind thing or even get people wey dey reason like this wetin you go do or you go let them be or trying harder to make them understand system?

If i was in your shoes Op, after explaining to him with how much I can, I'll just leave it there because talking further may be interpreted to be marketing skills with an interest was to convince him but bitcoin. paraventurely that he develops interests to buy, then I go stretch further to explain to him more including the risk factors.
Him giving the impression that until he sees Satoshi Nakamoto in reality is only when he can buy bitcoin shows a very high level of unseriousness. So there's nothing you can do than let him be.
Those kinds of people usually falls scam because if someone indicates to be Satoshi Nakamoto online with that his mentality, he's definitely going to be mislead because he'll never see Satoshi Nakamoto.


Title: Re: How do you change their mindset and narratives towards bitcoin
Post by: Orpichukwu on November 09, 2025, 08:35:18 AM
Diz type of person way say eh go wait for Satoshi to come out before eh go invest for Bitcoin don already show say eh really no understand watin Bitcoin be and eh no ready to understand if eh still get the mentality say when you invest for something nah the owner of the project you they give the money, eh go really hard to convince that kind person.

Me I they only try make I share small knowledge way I get to who already they interested no be for me to go inside debate with person way no want hear anything aside from the one way eh already don conclude for in head, I no they try convince people again I go only tell you how things be eh dy left with u make u agree or disagree.


Title: Re: How do you change their mindset and narratives towards bitcoin
Post by: SatoPrincess on November 09, 2025, 10:55:26 AM
E dey hard to convince person way don lose money tk crypto scam before say bitcoin na real. Wetin I dey do be say I go try my best to explain how bitcoin dey work and the opportunities way dey inside. I go just tell you the fundamental stuff I no dey go personal to tell you say bitcoin don change my life, that one no be anybody business. If you no dey convinced with the things I don tell you, I go allow you do your thing them no dey pay me out so why I go lose sleep over am.