Bitcoin Forum

Local => Nigeria (Naija) => Topic started by: Jessie2121 on September 27, 2023, 06:33:27 AM

Title: Why E Go Be Prayer?
Post by: Jessie2121 on September 27, 2023, 06:33:27 AM
My fellow brodas and sistas, I salute una. Abeg wetin we no go hear for this country as we dy so? Our presido com out say make we pray for the country as e be so, I no understand again. Nah any president wey enter sit go say make we dy always pray for country we them don use their hands spoil finish? Or them no know say people don start this prayer for long? If them dey chop the money them no go ask us to pray so how this prayer wan take help us? Naija nah the only country wey need prayers as e be. Wetin  presido don do to make change happen in a positive way? We go dy pray for better for the country them go dy make life hard for us, see dollar don climb skyscraper and I believe say some of us dy follow the raise of am so with all this things and some other Yama Yama wey dy go on for this country e still make sense as president talk say make we pray for the country? No be say e no good to pray but our presido need to remind us?

Abeg make una talk something, cos me I weak like this for things I gather to talk... Good morning naija!!!

Title: Re: Why E Go Be Prayer?
Post by: rachael9385 on September 27, 2023, 07:31:30 AM
Lolz, that one choke you abi? But as presido talk e good sha because nah only by God grace nai this country go take better, although some done they pray for long long time ago, say make this country better but still e never better but make we still dey hope on to God Grace.
Some days ago, one man for my street talk say the more churches dey plenty for this country nah the more corruption they increase, but I no really understand why the man talk like that and I no even care to ask am the reasons.
So this country so nah only God nai go fit help us, I know say many citizens and churches done pray tire but make we no give up. Another thing be say, as we they pray to @baba God to show grace to this corrupt nation the leaders self no they show Working say them really want the county to better, so e just dey like say our prayers nah waste.

Title: Re: Why E Go Be Prayer?
Post by: Jessie2121 on September 27, 2023, 09:13:02 AM

My broda e really choke me this morning and as e be so this country need prayers quite alright but as them talk am, God help those who help themselves and for this our critical condition wey naija dey so we no only need prayers we also need show working to help the prayers get effect like this. Leaders corrupt and e affect the nation join so if nah to say wetin our presido talk about to dy pray I no support am Biko, like you concor with me say prayers good, but make you no forget say people dy wey pray make him no enter seat oh, so this prayer go only work if them follow show working as you talk but money wey dy enter their pocket go gree them?🤔

Title: Re: Why E Go Be Prayer?
Post by: Obari on September 27, 2023, 11:35:08 PM
Lol
You dey sound like say you just come back from another country because if you dey this country, you no suppose let any of this things shock you because as a Nigerian, you supposed don dey very used to this things and one of the one wey burst my head na the one wey presido come talk about the hardship and meh, I just and conclude say our hope truly don finish and truly na only prayer we truly need for this country because nothing pass God.
Arise oh compatriots, Nigeria's call obey bit I no dey Seve any father land ogbene. And I think I don gradually don dey wish for military take over as ending dey be like democracy don already dey fail us woefully.

Title: Re: Why E Go Be Prayer?
Post by: HajiBagi on September 28, 2023, 07:09:37 AM
I be wan ask you, say na Nigeria you dey with us abi you just arrived? Nothing we no fit see for our country na, we sef Don master am, because this thing's start now no be today, this kind thing dey. Sup for Nigeria now no be today so even if the president say make we go pray, It will not be a new thing to us again, maybe things Don pass Mr president power that is why he said we should be praying, but for me I don't even have stress to pray for any country now because I never chop finish, na person wey dey see food chop any how dey pray for him country.

Everything for Nigeria now na cruise, because how president wey we suffer vote for go dey beg us for prayer wey be say na him supposed to make things better, this days no funny I swear because if he funny thing's no go dey sup like this, but we should all know that sometimes Mr president no get power on his own because as Nigeria dey like this we get some idiots elders wey be say anything wey dey talk like this na him people dey follow and even Mr president no get power to talk about it.

Title: Re: Why E Go Be Prayer?
Post by: Richbased on September 28, 2023, 10:27:24 PM
My fellow brodas and sistas, I salute una. Abeg wetin we no go hear for this country as we dy so? Our presido com out say make we pray for the country as e be so, I no understand again. Nah any president wey enter sit go say make we dy always pray for country we them don use their hands spoil finish? Or them no know say people don start this prayer for long? If them dey chop the money them no go ask us to pray so how this prayer wan take help us? Naija nah the only country wey need prayers as e be. Wetin  presido don do to make change happen in a positive way? We go dy pray for better for the country them go dy make life hard for us, see dollar don climb skyscraper and I believe say some of us dy follow the raise of am so with all this things and some other Yama Yama wey dy go on for this country e still make sense as president talk say make we pray for the country? No be say e no good to pray but our presido need to remind us?

Abeg make una talk something, cos me I weak like this for things I gather to talk... Good morning naija!!!

In as much as I know we are the architects of our failures. Though we need God to intervene at this critical time but just the bible says that faith without work is useless so how can we be expecting God to answer our prayers when we no do anything that will back up the prayers?

For me o the kingdom of God suffers violence and the violent ones took it by force, so if we know wake up now and hijack our destiny by force it will be a very big disaster to our upcoming generation. We need to hold the bull by the horn, that is, do the right thing at the right time before we seek for manners from heaven.

No farmer wey dey go harvest for where him no sow and anything wey person so na in him go reap even if you no reap am directly at least you have loved ones, relatives, children so your actions may affect these people one wey or the other so if it troubles them it will also backfire back to you. Make we remove sentiments and work selflessly towards the betterment of our society.

So definitely we need prayer but make e be say we don put something for ground before we dey expect miracle. Na the duty of you and I to redirect our selfish path and embrace a lifestyle worthy of emulation. If we no do well  e go dey hard for our children to remember us tomorrow because na person wey do dem dey remember

Title: Re: Why E Go Be Prayer?
Post by: EluguHcman on September 29, 2023, 12:26:25 AM
Bross da ur line "our Govt don run out of idea" na summary bottom line about this mata. But my expantiate small.
1st our govt put on cryptocurrency (BTC) on restrictions bcos na decentralized currency way dem no go fit in control of and dem know how biased dem dey run the economy policies via inflation and deflations aimed to enrich dem selves more & more with the touch of fear make our naira no go dey total valueless as e already dey depreciate on basis so.
The country dey always long on how dem want take penalize the common man and how the common man go work hardly den earn penny (change) bt BTC decentralization statusco purge dem.

See... B4 u pray orask  for 4giveness, den u go don cleanse and make up ur mind 4rm a most sincerity. So wetin the president want make prayer do 4 us way him no fit do am coro-coro?

Talking about Dangote being 6th richest man in the world if him invested 5% of him wealth on BTC, I doubt bcos u failed to consider if me self invested 5% of my wealth as then!
People self way invest such wealth as then no dey da rate yet
Meanwhile... Diz ur big cats no fit agitate 4 the lift of the restriction bcos dem want make us feel like dem no dey into BTC investment sector cus want want dey laws abiding but deep inside na them invest pass for there and our govts dem dey hide there loots there with the goal of making profits so dem just want set people eyes off the balls of BTC abi u neva hear say na over $56.7 billions 9ja don spend on BTC over the years til date according to a fellows update @ https://bitcointalk.org/index.php?topic=5467725.msg62885999#msg62885999
Who boasten da rate? U tink say na me and u? Of cuz na the so Big Cats.

Title: Re: Why E Go Be Prayer?
Post by: Chilwell on September 29, 2023, 08:10:43 AM

Abeg make una talk something, cos me I weak like this for things I gather to talk... Good morning naija!!!
Why E Go Be Prayer? Because na the only thing we get to hold onto, make we dey happy say our president don talk am say make we dey pray for country, this one show say he is willing to do good, and make we all know say only him no fit do am and our contribution na to dey pray for him to make am good. I want make we no say na God go answer all the prayer wey we dey pray and make we have faith say him go answer our prayers. We should have believe that things go change from worse to better, we should not give up no matter the circumstances we are facing now.

Title: Re: Why E Go Be Prayer?
Post by: Fivestar4everMVP on September 29, 2023, 08:27:47 AM
Well, not like it's a bad thing to pray, "pray for the peace of Jerusalem" is something that is written in the Bible, the Jerusalem the bible is referring to can be or mean anywhere for any body, for some, it could be their family, while for some, it could be their community, for others, it could be their state and while for the majority, it's their country.

So it's never out of place to pray, even the Bible said, men ought to pray always..

It's just that we have been praying, but we have demonic leaders who know nothing about prayer, the Bible asked a question saying "can two work together except they agree?" it simply means, we as citizens can pray, but until our leaders join us in the same prayer, and start doing what is right, our prayers may never be answered.

Title: Re: Why E Go Be Prayer?
Post by: Majestic-milf on September 29, 2023, 08:39:20 AM
Naija nah the only country wey need prayers as e be. Wetin  presido don do to make change happen in a positive way?
Naija no be d only contri wey need prayers. Other developed countries need prayers too but e come be like say na our own worse pass unto say on a daily mata dey worse. E bad say we dey para say presido dey ask for prayers for the contri wey nah  still some pipo wey sell their votes to person wey don old sotey e no fit even accurately call the name of him party. No offense to the president but him no fit operate like Joe Biden even as him dey claim say him dey younger than the American president.
 We dey always complain wen president give less than satisfactory suggestions and/or replies e no sopoz affect us again as no be now such a thing don dey happen. And for the fact say Op dey para just shows say somehow him still believe say the president fit change things. My guy abeg wake up!

Title: Re: Why E Go Be Prayer?
Post by: CryptSafe on September 29, 2023, 03:14:58 PM
Bible make me believe say prayers Na the master key. Just like our senior oga  talk here say Bible say make we "pray for the peace of Jerusalem" . So my country people if Jesus himself wey be son of God start with prayers and also end with prayers. we too go need pray na.

Naija Na our own country home, we need peace and harmony, unity and progress. Orderliness and coordination. Synergy and cooperation all these are the reasons why we need to pray for our very own country. Abi we like as our country dey restless, chaotic, and increasingly economic inflation? The answer is no. So therefore it is a call for prayer that would make things go well. Even all other religion do pray so why can't Christians pray as well.

Title: Re: Why E Go Be Prayer?
Post by: Abdulzuruku01 on September 30, 2023, 06:27:27 AM
My fellow brodas and sistas, I salute una. Abeg wetin we no go hear for this country as we dy so? Our presido com out say make we pray for the country as e be so, I no understand again. Nah any president wey enter sit go say make we dy always pray for country we them don use their hands spoil finish? Or them no know say people don start this prayer for long? If them dey chop the money them no go ask us to pray so how this prayer wan take help us? Naija nah the only country wey need prayers as e be. Wetin  presido don do to make change happen in a positive way? We go dy pray for better for the country them go dy make life hard for us, see dollar don climb skyscraper and I believe say some of us dy follow the raise of am so with all this things and some other Yama Yama wey dy go on for this country e still make sense as president talk say make we pray for the country? No be say e no good to pray but our presido need to remind us?

Abeg make una talk something, cos me I weak like this for things I gather to talk... Good morning naija!!!

You know prayer na em be the solution to any situation we see ourselves. And no be sey all the presidos wey we don get for this country get intention to do bad things, some of dem good but wetin dem dey use dere eyes see for that position no be moi moi.

For presido Bola Ahmed Tinubu go show for public sey make we prayer for this country you go know sey he don use his eyes see shege. We all know sey the man na big name for this country, but people wey dey spoil this country they inside aso rock and dem no dey ordinary. So make we try pray as he said the story fit come change and if we sey we no pray na we go still see shege because the man go still contest for second time and nothing go stop am from winning and the shege for second tenure they always come with firewood from hell fire. So as e be now ehen prayer na em be the key..

Title: Re: Why E Go Be Prayer?
Post by: iBaba on September 30, 2023, 08:58:49 AM
My fellow brodas and sistas, I salute una. Abeg wetin we no go hear for this country as we dy so? Our presido com out say make we pray for the country as e be so, I no understand again. Nah any president wey enter sit go say make we dy always pray for country we them don use their hands spoil finish? Or them no know say people don start this prayer for long? If them dey chop the money them no go ask us to pray so how this prayer wan take help us? Naija nah the only country wey need prayers as e be. Wetin  presido don do to make change happen in a positive way? We go dy pray for better for the country them go dy make life hard for us, see dollar don climb skyscraper and I believe say some of us dy follow the raise of am so with all this things and some other Yama Yama wey dy go on for this country e still make sense as president talk say make we pray for the country? No be say e no good to pray but our presido need to remind us?

Abeg make una talk something, cos me I weak like this for things I gather to talk... Good morning naija!!!

My oga, the country don almost turn upside-down o. We sha no go lose hope on top of the country because na our home country be this. Before this regime,plenty regimes don pass including during the military services. All if you factor dem together con recollect the struggles and tussles wey we don undergo, you fit come into conclusion say, na serious and deep prayers we need. And it has to be intentional and collectively.

I'm pretty sure that's what the president is buttressing on. We have been stagnant as a nation and have a very long way to go. The expectations and burdens on us as rhe giant of Africa and the different corrupt cases wey dey happen on daily basis. E reach make we enter serious prayers o. One thing wey i like na the mentioning wey mr president mention am say make we help am, help ourselves with prayers.

And as of the need to remind us. Yes. Our presido need remind us o because if you dey look for environment where dem dey injure people pass, hypocritically, na Nigerians. That's why dem talk say change begins with me and you. As far as we continue to sabotage the efforts of the government, we won't prosper as a nation. Instead, let's join into prayers.

Title: Re: Why E Go Be Prayer?
Post by: Jessie2121 on October 04, 2023, 04:16:55 PM
If una check am na this our country naija nai pray pass, na we carry Christianity for head but I no see any reason why this our government go always say make we dey pray when them know say them too follow for wetin we go pray against, like nah them be the problem to even start the prayers. If say God go punish anybody wey the public put for prayer and e happen as e dy happen for Nollywood movies eh, all our politicians go fear and begin do things right, na why them go still stand dy open mouth dy talk about prayers after all our God is a merciful God.

Title: Re: Why E Go Be Prayer?
Post by: Roseline492 on October 04, 2023, 09:27:19 PM
My dear e get some talk way you go hear for this our obodo Nigeria your head go they pain you, how our presido go say make we pray for our obodo Nigeria way na them they in charge for all the looting, corruption and embezzlement and even the bokoharam na some of the government personnel they sponsor them, so how prayer go take solve am, omo the problem self way they this country self prayers no fit solve am because even if say we pray against the government nothing go change.

Title: Re: Why E Go Be Prayer?
Post by: DubemIfedigbo001 on October 05, 2023, 05:33:52 AM
Prayer is good, and its better accompanied by good works. Its not wrong for him to ask for prayers, my problem is simply the intention of the request. is he having a positive mindset or is it just for the media to consume. The thing tire me as politicians don see asking for prayers as a means of  validating their inability to deliver on their mandate. We are praying, God is answering, but I believe that what you can do for yourself or for others, you don't need to ask for prayers to do it. You should allow God use you to answer others prayers and that's what is expected of him as the president. He's been elevated to the position, why not him use his good office to provide the answer to the prayers of people. If he's ruling properly, he doesn't even need to ask for prayers cos people go dey remember am and em activities for prayers wella as em dey favor them.

Title: Re: Why E Go Be Prayer?
Post by: Samlucky O on October 06, 2023, 08:31:42 AM
Nawao! so president get mind talk that kind thing. Anyway make we dey pray now. because na prayer Dem sabi us for. Indirect mockery, this men dey deprive us of our right and still get the mind to dey talk this kind thing.

Anyway I no blame them.i blame the youths because we don't need peace wetting we need na vaulence. Nigeria can never change except by force. The earlier we know that the better for us. If we go ft end sars we go ft end bad gorvenment. Together we stand devided we fall. Buhari said Nigeria youth are lazy.. lazy no mean say we no dey work hard but we no get that one mind to fight for our right because everybody dey fear . Say na me go come die for this useless country. And you want Nigeria to better.

Title: Re: Why E Go Be Prayer?
Post by: uchegod-21 on October 06, 2023, 05:32:21 PM
Some of the prayer points wey we dey pray for this our country sef, if things dey as e suppose be, we no go pray those kind prayers atol.
We go pray for safe journey because of bad road
Pray to gain admission because of the poor academic system
Pray to graduate in one piece
Pray to see work do
Pray make NEPA bring light
Pray make nothing carry us go hospital because of the the poor health care wey ordinary person no fit afford private hospital
Pray for kidnappers, bandits, unknown gunmen and other yeye people.
Pray for this one, pray for that one.
Now, the person wey the general affairs of the country dey e hand say make we pray for the country in general. Hope still dey like this? I no talk say prayer no good but that talk wey president talk no be solution.

Oyibo people wey bring this their religion come give us no dey pray as we dey pray sef. The country and our leaders no balance na why we dey cast and bind everytime. Na why dem dey talk say "once person japa from Nigeria, e prayer life go reduce". This na because almost everything wey we dey pray for,  dey set for obodo oyibo.

Title: Re: Why E Go Be Prayer?
Post by: Gozie51 on October 06, 2023, 05:53:47 PM
The prayer thing dey unfortunate for the country. Government dey leave substance go chase shadow. Where corruption dey swim na so dem go dey ask for prayer to deceive themselves. We know some of our governor wey dem prosecute for abroad, Ike ekweremadu and now Diezani Alison Madueke go join. The country corrupt that's why court for here no dey fit prosecute people wey thief because na man no man system It is a pity say we dey talk of praying for government wey suppose to dey heal the nation.

Title: Re: Why E Go Be Prayer?
Post by: Jessie2121 on October 11, 2023, 03:19:42 AM
The prayer thing dey unfortunate for the country. Government dey leave substance go chase shadow. Where corruption dey swim na so dem go dey ask for prayer to deceive themselves. We know some of our governor wey dem prosecute for abroad, Ike ekweremadu and now Diezani Alison Madueke go join. The country corrupt that's why court for here no dey fit prosecute people wey thief because na man no man system It is a pity say we dey talk of praying for government wey suppose to dey heal the nation.

If say na here I mean our court, that matter don die tey tey and the Ike Ekweremadu go don dy free na becos e be like say we no get system at all, all our power na money e end. Nobody wey the government fit follow hot hot say as you fuck up money no go save you only justice, but if na the common man them go select the nearest prison keep before judgement. Prayers go fit help as long as e concern God but the question na, the top oga them wey hold corruption for pocket go gree let the poor breath?

Title: Re: Why E Go Be Prayer?
Post by: Timmzzy on October 11, 2023, 08:23:57 AM
My fellow brodas and sistas, I salute una. Abeg wetin we no go hear for this country as we dy so? Our presido com out say make we pray for the country as e be so, I no understand again. Nah any president wey enter sit go say make we dy always pray for country we them don use their hands spoil finish? Or them no know say people don start this prayer for long? If them dey chop the money them no go ask us to pray so how this prayer wan take help us? Naija nah the only country wey need prayers as e be. Wetin  presido don do to make change happen in a positive way? We go dy pray for better for the country them go dy make life hard for us, see dollar don climb skyscraper and I believe say some of us dy follow the raise of am so with all this things and some other Yama Yama wey dy go on for this country e still make sense as president talk say make we pray for the country? No be say e no good to pray but our presido need to remind us?

Abeg make una talk something, cos me I weak like this for things I gather to talk... Good morning naija!!!

jagaban na crusie main main, oh u too dey follow ask the same question, prayers no fit help us for this country because like this e choke, CHOKEN'T IT  ;D ;D, things price dey fly go up no coming down  :'( :'(  workers salaries no dey top up like menhn its painful.

Title: Re: Why E Go Be Prayer?
Post by: Jessie2121 on October 11, 2023, 11:00:56 AM

That price own be like curse, I still never understand why something wey go up and we expect am to come down when things settle but we go wait till e become use to us without coming down. Abi this our president dy play with that position? Workers salary be like wetin our presido dy fear to increase but all those politicians own nai good to increase. Na so which day I see say them wan bring back the subsidy them comot later you man say I no talk oh. Like I confuse for the nation.

Title: Re: Why E Go Be Prayer?
Post by: SmartCharpa on October 12, 2023, 10:45:36 AM
My fellow brodas and sistas, I salute una. Abeg wetin we no go hear for this country as we dy so? Our presido com out say make we pray for the country as e be so, I no understand again. Nah any president wey enter sit go say make we dy always pray for country we them don use their hands spoil finish? Or them no know say people don start this prayer for long? If them dey chop the money them no go ask us to pray so how this prayer wan take help us? Naija nah the only country wey need prayers as e be. Wetin  presido don do to make change happen in a positive way? We go dy pray for better for the country them go dy make life hard for us, see dollar don climb skyscraper and I believe say some of us dy follow the raise of am so with all this things and some other Yama Yama wey dy go on for this country e still make sense as president talk say make we pray for the country? No be say e no good to pray but our presido need to remind us?

Abeg make una talk something, cos me I weak like this for things I gather to talk... Good morning naija!!!

I don't even know what they are planning is it dey want us to pray for them to last on that seat or what? No be person wey chop dey get strength to pray, let assuming say we dey pray and we no see any changes to the country we be dey pray for, is like they want us to pray for their head too because i see say na waiting them deserve be that. Goods prices dey increase every day if person want to complain you go just hear say dollar price don rise say dollar don affect market, even person wey no know anything go say dollar don rise just to sell am for you at high price.

The only prayer that remain now is for us to survive this country over everything that come, fuel prices now is getting to where we no expect am, how much be gas per kgs now 1k for my side. The country sef no come dey safe waiting never happen for my side happened day before yesterday, bandits get mind enter person shop go kill am, I was just surprised where are we heading to because e just dey happen for the first time.

Title: Re: Why E Go Be Prayer?
Post by: Zigabel on October 13, 2023, 09:04:22 PM
It's sad how even the leaders sounds like  a joke at some point in time, how the play around with issues of national concern is really appalling because I see no reason why a leader whom the whole nation has entrusted leadership with will boldly come out on national TV or other Media platforms and sound ridiculous without any form of remorse because they feel they are not accountable to anyone.

If prayer was all we needed we wouldn't border making him the president, we would have just prayed and have all these issues fix themselves, sometimes I think it's the caliber of leaders we give our mandates that usually ends up in such mess because obviously how would you expected a man who' isn't learned enough and at such old age be able to deliver credible governance if not assigning duties to his sponsors and close supporters and sit back to watch things go south ways, these men are basically there to enrich themselves, close friends and family members so anything other than that they most likely will tell the Masses to pray because we are known to be too religious than religion itself.

Title: Re: Why E Go Be Prayer?
Post by: Orpichukwu on October 13, 2023, 09:22:21 PM
Eh no get as eh wan be, we just really need to pray for the country, dem way they power go try do their part as them feel say dem fit do, we way no sabi Watin we suppose do nah to pray and hope say Watin the people way they power they do for the name of to set the country for better way go good.

So me I still no see anything way bad way the country president don talk, even with work way them wan work or security way them wan increase, opportunity way dem wan bring for employment and youth empowerment this thing called prayer don be part of the country at the end of the day after all human and material effort we they hand over everything to God hand to take control.

The country don already bad for people way hand over to The current President hand, so even if him no still do Watin onah expect am to do eh no go still be new thing but eh no go bad sha say him try they fulfill even if nah 5% of the promise way him promise the country before him enter seat, eh go help well well. In all we do make we still pray to God sha nah only him fit help change their mind and also make things way them wan do work small for us.

Title: Re: Why E Go Be Prayer?
Post by: Victorybit1 on October 13, 2023, 09:26:34 PM
Omo,wetin Presido talk nor be lie o,na only God fit help us for this country o na make we gat pray to am cus as e be so ehn we nor know where we dey go for this country, cus the country nor just balance again..
Almost everyday things dey dare and the price nor dey come down.Just imagine Gas for my area na 900 naira per KG😩.
Last week Saturday i go buy fuel,the filling station been dey sell 589 per litre i con dey happy because for my mind fuel price don dey come down,only for me to go buy fuel for that same place on tuesday them don dey sell 630 per litre na once i shock,the thing weak me....
So as all this things dey happen for our country,the only thing wey we fit do na to just pray for our country make Baba God do him miracle for this country because like this ehn some people don dey die because of poverty 😓.....
So Na For Us To Pray Oh My Brothers and Sisters

Title: Re: Why E Go Be Prayer?
Post by: Usasauki2004 on October 14, 2023, 03:30:12 PM
My fellow brodas and sistas, I salute una. Abeg wetin we no go hear for this country as we dy so? Our presido com out say make we pray for the country as e be so, I no understand again. Nah any president wey enter sit go say make we dy always pray for country we them don use their hands spoil finish? Or them no know say people don start this prayer for long? If them dey chop the money them no go ask us to pray so how this prayer wan take help us? Naija nah the only country wey need prayers as e be. Wetin  presido don do to make change happen in a positive way? We go dy pray for better for the country them go dy make life hard for us, see dollar don climb skyscraper and I believe say some of us dy follow the raise of am so with all this things and some other Yama Yama wey dy go on for this country e still make sense as president talk say make we pray for the country? No be say e no good to pray but our presido need to remind us?

Abeg make una talk something, cos me I weak like this for things I gather to talk... Good morning naija!!!

Make e no surprise you ooo, you never hear say prayer na key. Anything for this life na prayers oo, weda e favour you or not just pray. The president too don Dy see say this country no be small to rule so make we gather pray for the betterment of the country. Plenty things don happen and we no no Wen everything go stop things like corruption, kidnapping, banditry, killing and another one Dy wey Dy trend now na collection of prick (manhood). Government talk say they are doing their best to curtail everything but we no see any best wey them Dy do so the best thing be say na to pray and make you pray well. With hope, faith and prayers 9ja fit change.

Title: Re: Why E Go Be Prayer?
Post by: Y3shot on October 17, 2023, 09:24:12 AM
It is good to pray ooo, but their somethings we need to do with our common sense , no be everything we need to pray to God make God help us do. God Don already give us the human wisdom for us to handle somethings,  expecially things of the physical. It is so funny when I see our religious people for church dey pray make God help to fix the nation,  already God Don give us many resources wey we fit take manage ourselves to bring wealth and to do necessary things wey the country need. It is so funny after with all God Don bless us with we still dey expect make him come from heaven to come tell us wetin we need to do with the resources him Don bless us. Their is no wisdom praying to God to help us to come fix our country for us.

Title: Re: Why E Go Be Prayer?
Post by: Belarge on October 17, 2023, 06:45:29 PM
My fellow brodas and sistas, I salute una. Abeg wetin we no go hear for this country as we dy so? Our presido com out say make we pray for the country as e be so, I no understand again. Nah any president wey enter sit go say make we dy always pray for country we them don use their hands spoil finish? Or them no know say people don start this prayer for long? If them dey chop the money them no go ask us to pray so how this prayer wan take help us? Naija nah the only country wey need prayers as e be. Wetin  presido don do to make change happen in a positive way? We go dy pray for better for the country them go dy make life hard for us, see dollar don climb skyscraper and I believe say some of us dy follow the raise of am so with all this things and some other Yama Yama wey dy go on for this country e still make sense as president talk say make we pray for the country? No be say e no good to pray but our presido need to remind us?

Abeg make una talk something, cos me I weak like this for things I gather to talk... Good morning naija!!!
Omo, I no just understand the present situation of Naija again, the price of everything just de go up like bitcoin when e b de pump for bull season. No better food for the common man again ooh, everything scatter scatter and still yet, some people still de hope for the country to better. My people, e de worst everyday, e be like say nothing concern the influential people in power again, because dem de continues to drive exotic cars and buy private jets, travel round the world, their children de Europe de school while the poor masses can't even be confident of correct 50k salary a month, na weytin we be dey expect from the new government be this? The country hard I no go lie, to make am for this country na die.

Title: Re: Why E Go Be Prayer?
Post by: letteredhub on October 17, 2023, 10:08:05 PM
Wetin you dey expect from administration way no get blueprint on how to use run the government, or abi you hear any manifesto wey presido read for you during him election campaign time? So nah make anything them just wake up as e enter their mind them go just tok am free to air cos no directional map and that's what makes this baba administration worse bcos at the end of the four years we no get anything to use hold am accountable becos him no give you any manifesto as tins him promise to do for the country . So the administration nah anywhere belle face gofment.
My advise for my Naija people be say mk unah tie unah shoe lace and belt  very tight cos the kind marathon prayers sections we go dey enter for this Naija this one presido just tok nah introduction . Lol.

Title: Re: Why E Go Be Prayer?
Post by: Promocodeudo on October 18, 2023, 09:13:46 PM
There is confusion everywhere, are you surprised, you shouldn't be ok the leaders are even confused, corruption is fighting so hard, and that's what we are seeing today.
A country that has a lot of domestic gas, but the citizen buy it at a high price, and we keep hearing that Nigeria export cooking gas through NLNG, is it not funny, the thing is that, our leaders are funny, corruption needs to be checked but it will be gradually done, our leaders are confused because of the kind of money they have siphoned from the public coffer and it keeps tormenting them, I think we actually need God intervention.

Title: Re: Why E Go Be Prayer?
Post by: Jessie2121 on October 22, 2023, 12:48:52 PM
Omo, I no just understand the present situation of Naija again, the price of everything just de go up like bitcoin when e b de pump for bull season. No better food for the common man again ooh, everything scatter scatter and still yet, some people still de hope for the country to better. My people, e de worst everyday, e be like say nothing concern the influential people in power again, because dem de continues to drive exotic cars and buy private jets, travel round the world, their children de Europe de school while the poor masses can't even be confident of correct 50k salary a month, na weytin we be dey expect from the new government be this? The country hard I no go lie, to make am for this country na die.

All these things dey our oga them hand abeg, I no see why dem go say we are one but na them dy chop pass us, and e pain me say nothing we fit do to even win this battle becos the corruption at hand don dey win us wey first am come this contri. Nai make I no see any need why e be say nah our number 1 citizen nai go say make we pray while nah them dey enjoy pass.