Bitcoin Forum

Local => Off-topic (Naija) => Topic started by: Jamestown70 on December 21, 2023, 03:13:21 PM

Title: Glo and it's network wahala
Post by: Jamestown70 on December 21, 2023, 03:13:21 PM
my country pipo abeg I no just understand this Glo network again almost all the time them go just disappoint you even when you get enough unused data since two days now I no fit use my Glo sim way I just sub data for no be say after now wen the network come alive sef them no go even compensate us for all the troubles way we pass through these few days sef o, Omo Glo is really frustrating I no know if na only me they experience am na why I bring the matter hear make we deliberate on am because e no really gel at all make them improve their standard this na one of the major reason people believe Mtn pass them no be say Mtn no dey get network issue o but e no dey come constantly like Glo, Glo should invest heavily on mast all over the country like Mtn if them one compete with them

Title: Re: Glo and it's network wahala
Post by: Charles-Tim on December 21, 2023, 03:19:46 PM
I will advise you to have all the networks. To get each network sim card is very cheap and they do come with many offers. Go for MTN, Etisalat and Airtel and see the best one that have network in your area.

If you do not want to buy the SIM cards, look for the one that its mast is closer to your house or where you are browsing. The closer the mast the better the network.

I can recommend MTN because I have been to so many places outside my state and it remains the most reliable.

Title: Re: Glo and it's network wahala
Post by: Doan9269 on December 21, 2023, 05:52:04 PM
If you won't mind having more than two networks for your own safety and for the kind of the nature of how you place demands onnthe network efficiency with things you do online, am not making this suggestion for you to have multiple lines in other to use them for illicit activities, this is just only intended on you to have an itchfree connectivity each time you're online or having network challenge with any of the providers you're using, so i will also adopt the same suggestions given by Charles-Tim.

Title: Re: Glo and it's network wahala
Post by: Spaceman1000$ on December 21, 2023, 06:02:24 PM
my country pipo abeg I no just understand this Glo network again almost all the time them go just disappoint you even when you get enough unused data since two days now I no fit use my Glo sim way I just sub data for no be say after now wen the network come alive sef them no go even compensate us for all the troubles way we pass through these few days sef o, Omo Glo is really frustrating I no know if na only me they experience am na why I bring the matter hear make we deliberate on am because e no really gel at all make them improve their standard this na one of the major reason people believe Mtn pass them no be say Mtn no dey get network issue o but e no dey come constantly like Glo, Glo should invest heavily on mast all over the country like Mtn if them one compete with them
My brother this tin way u dey talk, I dey experience am well well for Glo network, I had data on my line but I wouldn't be able to use it, I really got frustrated, though i have other lines like MTN but omo the way them dey drain data no be here oh, i can confidently use Glo 2g for over a week, but i can never try that one with MTN, its as if they don't give you complete amount of data when you buy. Glo have their lapses but I still feel they give good amount of data that is sustainable.

Title: Re: Glo and it's network wahala
Post by: Makus on December 21, 2023, 06:07:30 PM
All this their network issues dem, na why I never still buy Glo sim, though na them be the best for data offers and Dem sabi customer. But that their network issues just too much, the worst tin wey go happen to person na make e go use Glo sim as em bank ussd transfer sim, because Glo network com join bank own, that na very big network combo ;D. Just as Mr Charles_Tim don talk, e go good make you try all the sims but I go advise make you nor even waist your time try Etisalat, because na them be the worst. Me na Airtel I dey use, and I'm satisfied with the offer wey Dem dey give me.

something times all this network issues dem na from our phones, I dey experience some kind time wey my phone network go just dey slow or nor dey even work sef wen I sti get data, so until I put the fone for airplane mode come commot am, before e go come dey operate normal. So most times you fit dey try this technique.

The the second technique wey I go recommend na say, if your fone network dey slow down, while you get data, just go your call side for the phone as if you wan dial number. Den dail *#*#4636#*#* you go come see some options, pick phone information, then just go down to where the you go see preferred network select LTE which is 4G, then just minimize go back to your browser or wattin you been dey do, you go observe say the network go come fast.

Follow the pictures direction and you'll be just fine.
Note: this one nor dey work for all phones especially Samsung, though I never try am for iOS(iphone) but e dey work for other Android device wey I don try

https://talkimg.com/images/2023/12/21/IZby8.jpeg

https://talkimg.com/images/2023/12/21/IZpb3.png

https://talkimg.com/images/2023/12/21/IZOSw.png

https://talkimg.com/images/2023/12/21/IZWs9.png

https://talkimg.com/images/2023/12/21/IZe9N.png

Title: Re: Glo and it's network wahala
Post by: Wiwo on December 21, 2023, 06:29:39 PM
my country pipo abeg I no just understand this Glo network again almost all the time them go just disappoint you even when you get enough unused data since two days now I no fit use my Glo sim way I just sub data for no be say after now wen the network come alive sef them no go even compensate us for all the troubles way we pass through these few days sef o, Omo Glo is really frustrating I no know if na only me they experience am na why I bring the matter hear make we deliberate on am because e no really gel at all make them improve their standard this na one of the major reason people believe Mtn pass them no be say Mtn no dey get network issue o but e no dey come constantly like Glo, Glo should invest heavily on mast all over the country like Mtn if them one compete with them
Best network for me is Airtel because over the time,  I have taken the time to try all the network in Nigeria in terms of internet services and how fast their are in their browsing speed. After all, many times this is what most forum members from this part of the world are experiencing in terms of internet service providers.

Aside from the Airtel, I suggested you can have MTN as a backup sim for your browsing also and these two are top on the list.

List of best mobile network
Good network
1: Airtel
2: MTN

Bad network
1: GLO
2: Etisalat

Among the worst,  Etisalat still comes worst of the worst,  you can try them in my area and many other places,  Glo may be regionally different because I can still remember when I was an undergraduate Glo was the best in that region so we can't write them off.

Title: Re: Glo and it's network wahala
Post by: Mate2237 on December 21, 2023, 07:07:27 PM
Glo is going to lose a lot of customers from their network. Their network is very bad that people are always complaining yet they are not doing anything about it. Glo network was one the top three in the country but I don't think it is in that position again. Their customer service offices are not helping matter. Last month I went to their office in location to retrieve my glo line and before I went to office I had done two network both MTN and Airtel and I did it with just a thousand naira but when I went to glo office they told me that they retrieval is 3k. Omen I left the office without retrieving.

Glo is the worst network so far in the country.

Title: Re: Glo and it's network wahala
Post by: Y3shot on December 21, 2023, 07:21:03 PM
We know how this country be, no be country wey you fit just depend on one thing say e dey reliable to always work well. No be everything dey perfectly work okay for our country. By now you suppose know say no be every network for our country dey work well, it is not only glo wey dey get network problems.  Both men and airtel dey get network issues too, the truth be say e no go make sense make person get only one network for our country because it can definitely dissapoint you one day wey be say you no go fit use it make calls or to use it to browse.

Title: Re: Glo and it's network wahala
Post by: Stable090 on December 22, 2023, 06:17:01 PM
my country pipo abeg I no just understand this Glo network again almost all the time them go just disappoint you even when you get enough unused data since two days now I no fit use my Glo sim way I just sub data for no be say after now wen the network come alive sef them no go even compensate us for all the troubles way we pass through these few days sef o,
Haaa people still dey use Glo, if you dey use glo for dis country u just dey waste time and money, most of the places wey I dey always go, na Glo dey worst pass I come dey even imagine why people still dey use am, because how network go dey but I no go dey enjoy browsing with am, Na only two network provider I know say e dey okay for dis country and na Mtn and Airtel. Glo no really make sense and na just few places na him u go dey wey u go dey enjoy Glo network, I don’t even know Wetin person wey get am dey think, dey no dey even try improve at all.

Title: Re: Glo and it's network wahala
Post by: Marykeller on December 22, 2023, 07:18:33 PM
For anyone experiencing bad network for Glo depends on where em d stay. As for my side, there is nothing like Glo network for my side, that makes people around my locality not to try using Glo at all cos using am, na soso bad bad network you go d experience d go, which no make sense.

This bad network from Glo don deny them for gaining more customers for their side more especially from people living for South East Nigeria. They will Glo d conquer ground na for North and Western Nigeria, while for East and Southern Nigeria their network no d strong compare with North and Western states.

I don't know wetin be Glo problem of not choosing to mount their network mars all over the country, no be sae them no get the funds to do so. Whatever be the case, they should try do the necessary to stand and compete with Mtn and Airtel for network. No be to the only murder their customers with Mb that's not enough, they should work on their bad network cos it's long overdue.

Title: Re: Glo and it's network wahala
Post by: iBaba on December 23, 2023, 06:21:52 AM
I will advise you to have all the networks. To get each network sim card is very cheap and they do come with many offers. Go for MTN, Etisalat and Airtel and see the best one that have network in your area.

If you do not want to buy the SIM cards, look for the one that its mast is closer to your house or where you are browsing. The closer the mast the better the network.

I can recommend MTN because I have been to so many places outside my state and it remains the most reliable.

You speak my mind too. I will definitely advise you to use different networks like I do currently. As we speak, I have MTN, Airtel and Glo Sims on my phone. One is a physical sim and I converted the rest to E-SIM (https://support.apple.com/en-ng/HT212780) and can easily switch over the esims whenever I'm in need of them. I do try to recharge them time to time and use them for calls at times just to keep them active. But since many people in Nigeria if them no reach 90% them fit near, na MTN network so when MTN network cut for his instance, you go see say many people go automatically they unreachable even if you have another line you can reach out to people with. Na the koko be that. If not, Nigeria and network glitch na 5 and 6.

Title: Re: Glo and it's network wahala
Post by: Manny@11111 on December 23, 2023, 12:14:18 PM
It's happening everywhere my brother. In my area I can't stream ordinary videos on YouTube.Was told by insider that the problem stems from mismanaged human & Financial resources by the owner of the business. They said they run the business like the way politicians are running Nigeria to the extent that diesel will not be available at BTS or some functioning parts are not available and owner refuses to approval money for replacements. Was told before you even get approval to him might take months and at the end he will not still approval as everything in the company must pass through him what department head are to be doing.

Title: Re: Glo and it's network wahala
Post by: Richbased on December 23, 2023, 03:20:26 PM
Well Inasmuch as I know, it's general not only glo network because I recalled some days back when my Airtel network was fluctuating like I was really pissed because i was doing some important things online when I started experiencing it but there is something I observe, during festive periods like this i normally experience difficulty with networks and don't know if anyone have had same experience with me so i think maybe it's as a result of the weather conditions during this period.

Title: Re: Glo and it's network wahala
Post by: Mayor of ogba on December 23, 2023, 04:11:45 PM
Op this thing no dey only happen to you for this Glo sim card. For some days now I have been having issues making calls with my Glo sim card o, I go call person e go pick I no go hear way thing the person they talk. I did not experience the data issue because I did not use Glo sim in browsing. I don comot my Glo sim card for my phone put Mtn sim card, na Mtn I they use now, and in no they worry me. No they get only one sim card so when things like this happen you go get alternatives.

Title: Re: Glo and it's network wahala
Post by: Adams0001 on December 23, 2023, 10:09:44 PM
my country pipo abeg I no just understand this Glo network again almost all the time them go just disappoint you even when you get enough unused data since two days now I no fit use my Glo sim way I just sub data for no be say after now wen the network come alive sef them no go even compensate us for all the troubles way we pass through these few days sef o, Omo Glo is really frustrating I no know if na only me they experience am na why I bring the matter hear make we deliberate on am because e no really gel at all make them improve their standard this na one of the major reason people believe Mtn pass them no be say Mtn no dey get network issue o but e no dey come constantly like Glo, Glo should invest heavily on mast all over the country like Mtn if them one compete with them

You should know which network is strong in our country, if you just need a better network buy MTN and Airtel and you will enjoy it because it is very strong and will not give you problems, you can only enjoy calling with glo sim but when you are on data he can't function very well and your data will expire without enjoying it. I believe that only MTN has a solid network because no matter where you go, you will be able to enjoy it even if there is no strong network in the side. Since I bought mtn and airtel, they have not given me wahala even if mtn misbehaves airtel will continue to perform well.

Glo Sim and Etisalat are weak networks that you can't enjoy when downloading or searching in the Internet unless you are in town that have strong network, because if you go to some village you won't get network of some network but you can get mtn or airtel inside them, so I will advise you to just buy mtn and airtel and you will enjoy it and you won't complain like you are saying Glo is doing 8)

Title: Re: Glo and it's network wahala
Post by: Obim34 on December 24, 2023, 12:51:05 AM
OP, E good say you get all the sim card network, so when need like this arise you go fit sort am out. If you dey normally change location you go understand say different places dey get good network pass the others either MTN, GLO, AIRTEL among this three one must get good network wey better pass the other. You fit change the sim use incase you want use am for something important.

Where I dey now MTN na the baba but one's I travel go IMO state GLO na him go dey preferable to use, GLO no be bad network e just depend also on the location

Title: Re: Glo and it's network wahala
Post by: Jegileman on December 24, 2023, 06:28:59 AM
GLO na network wey I don abandon for years now, wetin vex me wey I stop dey use dem na d day wey I sub my SIM with N1000 dat time. That time na big money and na 1 month subscription. Till d day the subscription go expire, even a kilobyte of dat data I no get am use. I call dem customer care tire and still nothing change oo. Na so I no use the sim again so tey dey steal the phone wey d sim dey, I just kukuma forget am because even welcome back I no do. GLO dey give better offers for data but, their network na crap.

Title: Re: Glo and it's network wahala
Post by: SmartCharpa on December 24, 2023, 03:19:58 PM
my country pipo abeg I no just understand this Glo network again almost all the time them go just disappoint you even when you get enough unused data since two days now I no fit use my Glo sim way I just sub data for no be say after now wen the network come alive sef them no go even compensate us for all the troubles way we pass through these few days sef o, Omo Glo is really frustrating I no know if na only me they experience am na why I bring the matter hear make we deliberate on am because e no really gel at all make them improve their standard this na one of the major reason people believe Mtn pass them no be say Mtn no dey get network issue o but e no dey come constantly like Glo, Glo should invest heavily on mast all over the country like Mtn if them one compete with them

Sometimes if Mtn do you strong thing, you go regret why you are using mtn, i don't know for some of una side maybe una dey experience that with Mtn too, through out a day you will be using Mtn network to browse you will not face any problem, but when is night that is when Mtn will be doing as if someone do not have any subscription on it, the best thing be say make person have all the network, at least two is even okay, if one start misbehaving you can able to switch to other one and make sure you always have subscription on it, because like i no even trust any network, sometimes people will be complaining about each network that they are misbehaving, some other times they will be praising them that, this are the best, this are the best, if not since when they have been praising glo that when it comes to browsing they are the best, they give cheap offers, till now i have not use it before and this the same network you are complaining about.  ;D

Title: Re: Glo and it's network wahala
Post by: Gozie51 on December 24, 2023, 07:15:16 PM
I will advise you to have all the networks. To get each network sim card is very cheap and they do come with many offers. Go for MTN, Etisalat and Airtel and see the best one that have network in your area.

If you do not want to buy the SIM cards, look for the one that its mast is closer to your house or where you are browsing. The closer the mast the better the network.

I can recommend MTN because I have been to so many places outside my state and it remains the most reliable.

No be lie na MTN get coverage pass for naija whether village or town if you compare the network connectivity, coverage and services na MTN still pass.

You don really give am advise to add other networks just incase and for somebody wey dey always dey online, omo the person still need to support at least one more network including MTN.

So Op, you go just need close eyes go get MTN and you go surprise say that small network coverage from MTN go better pass when you get full network indicator for your phone from other networks.

Title: Re: Glo and it's network wahala
Post by: Rruchi man on December 24, 2023, 09:48:14 PM
No be lie na MTN get coverage pass for naija whether village or town if you compare the network connectivity, coverage and services na MTN still pass.
First, MTN changed their slogan from "Everywhere you go" to "What are we doing today", because they know that they are really not everywhere like their slogan claims. MTN can sometimes and in some places as poor as Glo can be. So person for Nigeria need to get like two of more sim cards to be able to switch to the other if one has poor reception.

Glo should invest heavily on mast all over the country like Mtn if them one compete with them
It cost a lot to install a Mast, Service providers have to be sure that they can make back the money they have used to invest in these masts before they approve such a project. Some areas already dominated by other service providers and places with low population are discouraging places to set up masts.

Title: Re: Glo and it's network wahala
Post by: EluguHcman on December 24, 2023, 10:04:51 PM
People has been more attracted to quantities other than qualities. To my best of figurations, most Glo network users only using the the because of the bonuses in calls and in data for Subscriptions without while ignoring the network providers capacity in reliance. Else I don't know why anyone would go for a such an intercoms network that is obviously bridged to producing networks to its users in most specific areas.

Yet rh networking company is not improving on it at all because there are varieties of areas that could not be covered by the network comparing to the minimal areas that other networks do have bridges.
I assumes the network is not looking forth at all to take lead of the future networks stations else they would improve after much its users are being frustrated and complaining about the weaken network..

Title: Re: Glo and it's network wahala
Post by: odunybiz on December 29, 2023, 11:09:39 PM
GLO na network wey I don abandon for years now, wetin vex me wey I stop dey use dem na d day wey I sub my SIM with N1000 dat time. That time na big money and na 1 month subscription. Till d day the subscription go expire, even a kilobyte of dat data I no get am use. I call dem customer care tire and still nothing change oo. Na so I no use the sim again so tey dey steal the phone wey d sim dey, I just kukuma forget am because even welcome back I no do. GLO dey give better offers for data but, their network na crap.

Glo na grand star for data but their problem is the bad network. What I enjoyed most in their data is the ability to share the data among 5 friends. I don't know why GLO is looking at their bad network issues for years and nothing has been done. Although, Glo network are good in some area but I think they have to do something about it in other not to lose their customers.

Title: Re: Glo and it's network wahala
Post by: promise444c5 on December 29, 2023, 11:33:56 PM
Snip

I'm  not sure if all phone support this code I used to do this on my tecno before I guess the UI and features are different  from each other . Som phones don't allow or have a different way of accessing it now .

Currently  I'm having issues with both Airtel and Glo it's as if it's not getting network at all sometime,s everything will just go off without  a bar of network, I haven't  tried MTN but I think it should worth it as I've heard a lot of positive comments on it,

Title: Re: Glo and it's network wahala
Post by: Brainiac01 on December 30, 2023, 02:29:28 AM
I will advise you to have all the networks. To get each network sim card is very cheap and they do come with many offers. Go for MTN, Etisalat and Airtel and see the best one that have network in your area.

If you do not want to buy the SIM cards, look for the one that its mast is closer to your house or where you are browsing. The closer the mast the better the network.

I can recommend MTN because I have been to so many places outside my state and it remains the most reliable.

This is what is did too. I bought mifi for all the network whenever anyone is misbehaving I just switch. Although in Nigeria bad weather can mess up all the network sha.

Title: Re: Glo and it's network wahala
Post by: Baki202 on December 31, 2023, 11:21:17 AM
I will advise you to have all the networks. To get each network sim card is very cheap and they do come with many offers. Go for MTN, Etisalat and Airtel and see the best one that have network in your area.

If you do not want to buy the SIM cards, look for the one that its mast is closer to your house or where you are browsing. The closer the mast the better the network.

I can recommend MTN because I have been to so many places outside my state and it remains the most reliable.
Having all the network has one of the most interesting feelings because their different experience incase person travel go another place with bad network you fit easily switch to another sim, from the beginning I don't even like glo they no they always get better network at least mtn they every were na why I they like mtn be that. No be lie say everywhere you go na true them they everywhere but you see glory and Etisalat na problem network i they call them because if you rely on them. Person go see pepe with them oh.

Na one one places no get mtn the network sweet sha people they hardly complain about the network, so I also recommend mtn oh. People they go for other network because somtimes their offer they cheaper than mtn own. You go even get data but the internet connection bad the thing no get use be that oh.

Title: Re: Glo and it's network wahala
Post by: AVE5 on January 06, 2024, 05:14:15 PM
This is one reason why the Glo mobile network would never take the lead amongst other networks. I haven't seen anyone who basically have a Good SIM card without having an alternate SIM network. This Glo network is just so frustrating that all they do is fuelling its users is lot of Internet datas and bonuses of airtime for callings and yet the network users are trickishly denied the access to use all that benefits due to the bridges of the networks accessibility.
Aside these side data subscriptions and calls airtime benefits, I don't think anyone would ever adore to accept the usage of the shitty network. Few days ago while I and some colleagues embarked at our job place, I know about lot of Good network users who never hesitated to obtain other network that is said to be more reliable and better than that of the Glo network because of the shitty networks limitations to acquire network services.

Title: Re: Glo and it's network wahala
Post by: Bright0515 on January 06, 2024, 05:28:38 PM
Brother no be only GLO wetin we dey see for this country now mouth no go fit talk am oo different means to obsessed person una u go carry your money go buy airtime to load am go be war the way Dem dey cut airtime now come be like say na compulsory something buy hundred naira card na you no go ask person how far sef them Dom take am finish person go call u if u call am back that same moment them tell you not available you go call person una go talk finish to end call na problem sometimes phone go hang sef but credit dey go if u borrow#500 you go pay #575 naira no be business be that I mean wicked business u send message Dem go show you message sent but person no receive am but ur money Dom go wetin be that na.

Last last Dem go whine u say you get free 100mb fake lies data na big problem abeg no be only GLO but make I no mention if you dey use sim card you know wetin we dey talk about

Title: Re: Glo and it's network wahala
Post by: Makus on January 06, 2024, 06:06:00 PM
Omor no be small oo, now sef e come be like say na all the networks Dem naim dey misbehave. Because I dey use Airtel and MTN and before you go know their network don dey misbehave even for normal call sef. I think say joke until people tell me say dem don dey call me say the network dey tell them something else. Then when e comes to data, omor some kind times I just dey wish say the competition plenty pass like this so that Dem go dey provide the best network  and cheap data rates😎. Actually Dem dey try but we expect more more from what they are getting from us.

Title: Re: Glo and it's network wahala
Post by: odunybiz on January 06, 2024, 09:53:15 PM
GLO na network wey I don abandon for years now, wetin vex me wey I stop dey use dem na d day wey I sub my SIM with N1000 dat time. That time na big money and na 1 month subscription. Till d day the subscription go expire, even a kilobyte of dat data I no get am use. I call dem customer care tire and still nothing change oo. Na so I no use the sim again so tey dey steal the phone wey d sim dey, I just kukuma forget am because even welcome back I no do. GLO dey give better offers for data but, their network na crap.

Glo na grand star for data but their problem is the bad network. What I enjoyed most in their data is the ability to share the data among 5 friends. I don't know why GLO is looking at their bad network issues for years and nothing has been done. Although, Glo network are good in some area but I think they have to do something about it in other not to lose their customers.

Title: Re: Glo and it's network wahala
Post by: Miles2006 on January 06, 2024, 10:39:51 PM

The reason why a lot of people buy glo is just because of the data bundle and bonus cause I see no reason why anyone will buy glo with this kind of poor network, one thing have observed about glo, where mtn and airtel network no dey na where glo network dey and e dey surprise me most especially rural areas. If using glo network and you no dey enjoy the browsing process especially for bad weather, why not register another network and just be using both to avoid disappointment, or downloading a fast network app can help but the apps now sef no dey work some network app just dey useless, to avoid all this drama register mtn for fast browsing but e still depend on the phone cause some phones no dey fast for browsing.

Title: Re: Glo and it's network wahala
Post by: Briankimp1 on January 21, 2024, 11:51:20 AM
Na Airtel me I dey use but e take time before I switch come here as I dey like this I don use all four networks the worst for me na Etisalat after that na Glo before Airtel then Mtn but you see this oga called MTN their own problem na the speed way the data go dey fly go fit give you high bp and it's the most expensive for data.
Personally I believe the best na Airtel because them get fair data prices right now i dey subcribed to thei 1k for 5gb plan with duration of 2weeks even if I never use am reach 2 weeks before highest e don last me na a week but e serve, E get some location way dey good for Glo network but once you leave those places na their your problems start same thing with Etisalat.

Title: Re: Glo and it's network wahala
Post by: odunybiz on January 24, 2024, 10:57:35 PM
GLO na network wey I don abandon for years now, wetin vex me wey I stop dey use dem na d day wey I sub my SIM with N1000 dat time. That time na big money and na 1 month subscription. Till d day the subscription go expire, even a kilobyte of dat data I no get am use. I call dem customer care tire and still nothing change oo. Na so I no use the sim again so tey dey steal the phone wey d sim dey, I just kukuma forget am because even welcome back I no do. GLO dey give better offers for data but, their network na crap.

Glo na grand star for data but their problem is the bad network. What I enjoyed most in their data is the ability to share the data among 5 friends. I don't know why GLO is looking at their bad network issues for years and nothing has been done. Although, Glo network are good in some area but I think they have to do something about it in other not to lose their customers.
The reason why a lot of people buy glo is just because of the data bundle and bonus cause I see no reason why anyone will buy glo with this kind of poor network, one thing have observed about glo, where mtn and airtel network no dey na where glo network dey and e dey surprise me most especially rural areas. If using glo network and you no dey enjoy the browsing process especially for bad weather, why not register another network and just be using both to avoid disappointment, or downloading a fast network app can help but the apps now sef no dey work some network app just dey useless, to avoid all this drama register mtn for fast browsing but e still depend on the phone cause some phones no dey fast for browsing.

What is the essence of bonuses that isn't function well for you. To me, it's preferably for me to buy an expensive data bundle that work fast for my online activities than one that will keep delaying me online work.