Bitcoin Forum

Local => Nigeria (Naija) => Topic started by: Su-asa on January 22, 2024, 07:48:45 AM

Title: No because of say you no get profits now take sell your coins.
Post by: Su-asa on January 22, 2024, 07:48:45 AM
Happy new week to us all.

The thing be say many of us dey like to dey put all our hope for everything way we dey do, I no talk say e no dey good OH but on one side e no dey good.
Many of us fit dey put our whole mind for investment wey we get, and that one show say person fit get high pretention if e con be say watin em plan no work.
Just like the way wen gambler go bet high on gamble and at last the game con letter cut e go make the gamblers mind dey up because e go just dey like say all the plans them wen em get done spoil finish.
Moreover no be only gamblers e dey happen to, both Bitcoin investor and many business people, some investors (especially those of us wey just start to dey invest for Bitcoin new). We fit dey try to dey accumulate Bitcoin with the small capitals wey we get hoping say Bitcoin go reach $150k for years when we don predict by ourselves and leter leter e no con be the way we think, many of us go talk plenty plenty things while some go even run, them no go invest or hold again.

Title: Re: No because of say you no get profits now take sell your coins.
Post by: Charles-Tim on January 22, 2024, 08:01:48 AM
This is what will come the mind of some people and be coward to invest. This is also what some people will think and be procrastinating to invest which will make them keep postponing the time to invest. It is true that bitcoin investment is very risky, but it is worth going for at the right time. If you can not go with all your money that you want to use to invest in it, why not DCA. In 2024/2025, be expecting all-time-high and also we are expecting six digits.

Title: Re: No because of say you no get profits now take sell your coins.
Post by: AVE5 on January 22, 2024, 08:09:07 AM
Putting your hope at your source of income is extremely essential because your seriousness mandate is exceptionally required to achieve your goals rather what is not right is the scenero where someone relies on just one Source of income because things wouldn't go as planned or expected on your basis.

Title: Re: No because of say you no get profits now take sell your coins.
Post by: Churchillvv on January 22, 2024, 08:12:31 AM
This is common to most of us, panicking when we notice a little change from our expectations which will lead to either selling prematurely or Lossing all out of fear. It's good for everyone of us here that holds Bitcoin to hold it as longs at they can because the market price is temporary as show from price history and will still perform it's best soon, so it's better to hodl than sell to make profit.

Most of this advise is for people like me as a newbie, I know senior colleagues in this LB already know this. So for those of us here tryna make profit from Bitcoin.... "Hey it's not time yet, hodl and witness the ATH.

Title: Re: No because of say you no get profits now take sell your coins.
Post by: Makus on January 22, 2024, 08:43:49 AM
Mostly all these kind of things na newbie they fall pass, though experts themselves still dey fall for all this kind things oo, but more of the newbies. Before the bitcoin ETF approval, wattin been dey my mind na be say, the price of Bitcoin go fit increase to like $50k come settle for there until the halving. But to my greatest surprise, after the ETF approval the price come even come down to $41k where e don settle for a while. Them say every disappointment Is a blessing, after this shock, I come realize say, this na another opportunity to buy more at $41k because this fit be the lowest dip before the halving.

Title: Re: No because of say you no get profits now take sell your coins.
Post by: Samlucky O on January 22, 2024, 10:57:30 AM
Wetting you bring come na true and E dey always happen to most of us. Whenever we get investment na there our hope they always dey. Imagine the first time you hold like #1m cash or you get am for bank account, na every time you go dey check am either E still dey there. Na poverty me I see as the reason behind why most people dey put money for something and there mind no go comot for there. If person get like #10m for account and him dey invest #30k every week you no go dey reason anyhow. If Bitcoin price like make E drop or high your own na make you just dey invest. But if you no get money and the small one wey you get Naim you use to invest for Bitcoin na there your mind go dey na. Person wey dey reacieve salary of #40k, carry 25k play 2 odd game you think say him go sleep? Him no go sleep because him they expect much from the investment him don do. And if e cut E go pain am well well. Except say na #200 game him play.

Investment dey two types:
1. investing wetting you fit afford to lose . This one na when you invest with little amount and you no care wether you loos or win like 50/50
2. Investing with all you get. When you invest amount wey be say em dey give you concern and if anything happens you go enter HBP.

Title: Re: No because of say you no get profits now take sell your coins.
Post by: camilocollin6 on January 22, 2024, 01:36:20 PM
If you no dey chop money now with your coins, think about to sell am as I yarn. But I don see many of my padi talk say just hold on for 6 months, you go see sweet profit wey fit make you happy.

Title: Re: No because of say you no get profits now take sell your coins.
Post by: AYOBA on January 22, 2024, 03:02:26 PM
Many people experience things like this since some people are impatient and some people don't believe in it. That's the reason it frequently occurs to some people, if not because I have to invest during the period that suggests it would be preferable for me to retain whatever currency I have purchased and simply wait for the all-time high to occur in order to make a sizable profit. However, some individuals fail to realize that everything in life requires patience, and if they do that, they would constantly worry and check their wallets.

Morever It would be preferable for someone who lacks patience to put their money in a regular bank instead of investing it, allowing them to easily withdraw it whenever they need it without risk. Because of this, it's beneficial for anyone who is serious about investing in Bitcoin to have another source of income, as any investment will simply ignore market tactics.

Putting your hope at your source of income is extremely essential because your seriousness mandate is exceptionally required to achieve your goals rather what is not right is the scenero where someone relies on just one Source of income because things wouldn't go as planned or expected on your basis.
You are correct, it is recommended to everyone who want to attain his or her financial goals. But some people do not plan before beginning what they introduce themselves to, they are unaware that preparing is essential to success. To invest in time is even more advantageous, because once you have invested the amount of money you can afford to lose, the next step is to monitor the market, but some people come to regret it when the coins they want to acquire have risen in value.

Title: Re: No because of say you no get profits now take sell your coins.
Post by: Jaycoinz on January 22, 2024, 03:52:22 PM
Well that one no be for everyone and I think na people wey never understand watin Bitcoin investment dey about nai dey put their hope for the money wey dem put for Bitcoin to grow up. Bitcoin Investment na something wey person no supposed even expect profits for a start so that him no go dey worried everytime wey the market no favour am and this results na watin dey also cause many people to trade their coins and we all know how that one dey end as na 50/50 chance nai dey.

Title: Re: No because of say you no get profits now take sell your coins.
Post by: Moreno233 on January 22, 2024, 04:03:58 PM
Happy new week to us all.

The thing be say many of us dey like to dey put all our hope for everything way we dey do, I no talk say e no dey good OH but on one side e no dey good.
Many of us fit dey put our whole mind for investment wey we get, and that one show say person fit get high pretention if e con be say watin em plan no work.
Just like the way wen gambler go bet high on gamble and at last the game con letter cut e go make the gamblers mind dey up because e go just dey like say all the plans them wen em get done spoil finish.
Moreover no be only gamblers e dey happen to, both Bitcoin investor and many business people, some investors (especially those of us wey just start to dey invest for Bitcoin new). We fit dey try to dey accumulate Bitcoin with the small capitals wey we get hoping say Bitcoin go reach $150k for years when we don predict by ourselves and leter leter e no con be the way we think, many of us go talk plenty plenty things while some go even run, them no go invest or hold again.

The summary for this post be say make we dey invest for long term and not because say we wan make quick profit. I know say as our blood dey hot, plenty people dey follow Bitcoin with sharp sharp profit, this  one no be bet9ja so that pattern no go work. Anybody wey want am sharp sharp should go and play bet.

Bitcoin na long term be the gain, na there the profit sure pass.

Title: Re: No because of say you no get profits now take sell your coins.
Post by: Miles2006 on January 22, 2024, 07:50:44 PM
This bitcoin investment no be work so I no see why person go put hope for bitcoin investment, bitcoin na digital currency and the major reason why people dey hold bitcoin na the volatility nature and na hedge against inflation, sometimes when people procrastinate about their investment that one na their concern cause na wetin go bring benefit and yet you still dey procrastinate. Profit or not any person wey choose bitcoin investment suppose know say bitcoin price dey fluctuate and patience na the best when dealing with investment like this.

Title: Re: No because of say you no get profits now take sell your coins.
Post by: DaNNy001 on January 22, 2024, 08:28:39 PM

Thank you my sister/brother, you don talk well because me just tire for the matter oo, if to say you wan trade the coins I go understand because you go know say that one no be investment again because if you invest in Bitcoin and you trade am sef na very big risk be that. So you putting your hope say the investment wey you dey do go give you huge profits in a specific period na just plain misunderstanding to watin Bitcoin investment dey about.

Title: Re: No because of say you no get profits now take sell your coins.
Post by: Su-asa on January 22, 2024, 08:44:49 PM

Excellent talks.
Una done talk well for this matter and this talk and lots of the talks way dey concern this discussion self really dey important.
The truth be say some people no go still understand the things way we dey talk for here, just like if e enter right ear e go con from the left ear comot. But anyone way really won get the whole points go try listen to watin we dey talk here.
Although, anything way person dey put em money that thing no dey comot from the person mind just because of say em money dey inside, so I still dey feel am say e go dey hard for many pipo to relate this discussion. Like @Miles2006 talk am say the set of pipo way dey always they think about their investment nah those way put all their money for inside the investment or business. So this one shows say every body when won go into any business or investment no supposed to use all the money when em get take put for the things. And again, e just dey like person way get 3 million naira and the person use the whole 3 million naira take go buy plot of land, so after em buy the land and em no get money to take survive for this hard economy, em go just they think about the land and emergency case fit hit am the way when em go won sell the land for any amount wen em see, so the best thing way I think go dey safe for this situation nah just for person to no use all the money way em get take put for one thing at once.

Title: Re: No because of say you no get profits now take sell your coins.
Post by: EL MOHA on January 22, 2024, 09:20:17 PM

Most of this advise is for people like me as a newbie, I know senior colleagues in this LB already know this. So for those of us here tryna make profit from Bitcoin.... "Hey it's not time yet, hodl and witness the ATH.

You see that bolder part, na there i Dey always advice people or investors on top. If you invest into bitcoin no Dey wait for maybe ATH if you know say you no fit hodl for long. The best thing for cases like this na to set your own personal target wey you know say you go take profit, maybe you fit decide say if the thing do 2x from your entry price then comot like any amount you wish to and then leave the rest inside bitcoin you fit use that money again self enter back at lower price or use am for something important but talking say till you meet new ATH, he no bad oo but no am seriously, just get your target.

Well that one no be for everyone and I think na people wey never understand watin Bitcoin investment dey about nai dey put their hope for the money wey dem put for Bitcoin to grow up. Bitcoin Investment na something wey person no supposed even expect profits for a start so that him no go dey worried everytime wey the market no favour am and this results na watin dey also cause many people to trade their coins and we all know how that one dey end as na 50/50 chance nai dey.

Boss make i cap you something nothing anybody put money inside wey he no Dey expect profit or something from an he no Dey and even bitcoin no Dey left out. The advice na just be say make we use money wey be say if you lose an he no go hit you bad and if the profit delay make worries no kill you. This na the reason why dem Dey advice to use small funds

Title: Re: No because of say you no get profits now take sell your coins.
Post by: Stable090 on January 22, 2024, 10:57:19 PM
Just like the way wen gambler go bet high on gamble and at last the game con letter cut e go make the gamblers mind dey up because e go just dey like say all the plans them wen em get done spoil finish.
Moreover no be only gamblers e dey happen to, both Bitcoin investor and many business people, some investors (especially those of us wey just start to dey invest for Bitcoin new). We fit dey try to dey accumulate Bitcoin with the small capitals wey we get hoping say Bitcoin go reach $150k for years when we don predict by ourselves and leter leter e no con be the way we think, many of us go talk plenty plenty things while some go even run, them no go invest or hold again.
If you dey invest, definitely your mind go dey ur investments now, and u dey talk about bitcoin hitting $150k, e fit no reach that price now ooo, but e go reach am later. If you dey invest in bitcoin or other coins, then e go better make you no use all your money invest, and make you get other sources of income, make your investment no be your main focus, if you get other things wey u dey do, your eye no go even go the investment wey u get for bitcoin, but if you have other things wey money dey take enter, you go fit hold your bitcoin for a long time.

If you wan even invest in bitcoin, and you don’t have other things wey u dey do, e go hard wey you for fit hold that bitcoin for long time, because if anything just dey happen, maybe you need emergency money, Wetin your mind go first go na d bitcoin wey you dey hold. So if you wan accumulate bitcoin for real and you wan really hold am, then make u get another thing wey u go dey do.

Title: Re: No because of say you no get profits now take sell your coins.
Post by: Gozie51 on January 23, 2024, 06:56:21 AM
For newbies wey dey hear of bitcoin investment and say e do this and that and how e go make dem rich, make una dey play. Make we remember say na how you invest in something na so you go carry get profit. I wonder how many people fit buy 1btc because if you invest heavily den when the bull hit am the profit margin go also rise but if na small fraction wey you buy, na still small profit go enter your hand.

If you buy coin and you dey expect automatic increase for you to cash out it means you are greedy. Na timing be everything and season come and go, there is bear and bull for this crypto market so na to look at the right time wey you go invest and not to hastily invest for profit and back out early. Make we take chill pill because this bull fit land us into 6 digit price by den you wey don sell early go still dey regret. From April now we go get halving and soon between then and 2025 we suppose see very good volatility wey go push price high, so no panic sell if you don't have need for the money.

Title: Re: No because of say you no get profits now take sell your coins.
Post by: Mayor of ogba on January 23, 2024, 04:11:13 PM
This is why it is good not to invest in bitcoin because of FOMO. You will be disappointed because you don't get what you were expecting from your bitcoin investment, and you may even sell your bitcoin at a low price because of the volatile part of bitcoin. Before we invest in bitcoin, we should have a little knowledge about bitcoin and know the things to put in place before starting our bitcoin accumulation journey so that we will not sell our bitcoin if there is a little drop in bitcoin price.

Title: Re: No because of say you no get profits now take sell your coins.
Post by: Obim34 on January 23, 2024, 05:15:23 PM
No matter how we paint it to become, we all set targets to our investment but not necessary occupying a total mindset of it getting to such mark. Everybody loves to see their investment grow and when the price begins to DIP there is this displeasure and disastification felt, but should not be considered the better option to stir panic causing one to sell off.

Title: Re: No because of say you no get profits now take sell your coins.
Post by: Mate2237 on January 23, 2024, 11:12:28 PM
Op I don't know how you see am, he dey good to put your mind on weti you dey do so dt you focus weti dey happen and do well with weti you dey do. And I dey tok dis thing from the second paragraph of your thread because you make it general and not specific. It is the third paragraph dat you come tok specific on investment and if someone put all him money for one investment then he has to wait for the long time because investment is not for short term. And if him dey patient him go make because bitcoin investment e no dey lost. And di high blood pressure go come when you buy high and come think say him go sell when him go high but before him know di price come down well well. But if him understand di market him no supposed fear because him go definitely go up again.

And no be everyone go invest oh... Some go like to invest but money no dey while so e dey fear am and na so everything dey for the crypto life. We, we don see am finished.

Title: Re: No because of say you no get profits now take sell your coins.
Post by: Y3shot on January 23, 2024, 11:37:44 PM
Wetin dey make why many people no dey fit end up with a successful investment is because dey depend too much on their investment,  instead of them to look for something wey fit give dem source of income. People don't need to depend on bitcoin because  it is s long-term investment which it can't provide for people every day.  E dey make sense make person invest in bitcoin remove your mind, with this it is possible to make good profit from Bitcoin.

Title: Re: No because of say you no get profits now take sell your coins.
Post by: Makus on January 24, 2024, 03:01:00 AM
Currently even like this wey price don go down people still dey sell their coin to loss, forgetting say Bitcoin investment na based on patient and nothing else. If you really dey come into Bitcoin, e dey advisable make you study wattin you wan buy before you start to buy am, so that you go know the worth of wattin you dey buy. If to say them know wattin Bitcoin be, them go see this as opportunity to buy more coin rather than selling to loss, and when it comes to the part wey Dem dey sell because of hunger, that na why we say make you get source of income before you start Bitcoin investment, so that you investment no go suffer when hunger strike.

Title: Re: No because of say you no get profits now take sell your coins.
Post by: Uhwuchukwu53 on January 24, 2024, 06:00:06 AM
Happy new week to us all.

The thing be say many of us dey like to dey put all our hope for everything way we dey do, I no talk say e no dey good OH but on one side e no dey good.
Many of us fit dey put our whole mind for investment wey we get, and that one show say person fit get high pretention if e con be say watin em plan no work.
Just like the way wen gambler go bet high on gamble and at last the game con letter cut e go make the gamblers mind dey up because e go just dey like say all the plans them wen em get done spoil finish.
Moreover no be only gamblers e dey happen to, both Bitcoin investor and many business people, some investors (especially those of us wey just start to dey invest for Bitcoin new). We fit dey try to dey accumulate Bitcoin with the small capitals wey we get hoping say Bitcoin go reach $150k for years when we don predict by ourselves and leter leter e no con be the way we think, many of us go talk plenty plenty things while some go even run, them no go invest or hold again.

To everything one do in life in order to succeed one must put hope , because that hope stand as motivator to do more, beside what you don't expect can never come to you . It's what you think,expect and hope that you can succeed on. Success come  through faith, how can you do investment and have no hope or faith on that investment, once your hope is dead in any investment , it means the interest to invest more or take other similar investment risk will not be there. I see investment as risk also as a package items one is buying without knowing the content, it can be good or bad, but you the buyer have the hope or believe that is of good content. Take away on investment is to initiate fear and procastination which courses failure, because the investor will double minded which is unstable. Also this lead to criticism as hope is loss any small change can criticize of incredibility of the system it invested.

Title: Re: No because of say you no get profits now take sell your coins.
Post by: Dailyscript on January 24, 2024, 08:40:19 AM
Anybodi wey sell him coins because him never get profit yet, to me no get sense. Is like people no they understand weting investment be. They just they hear investment everywhere con jump inside am when dey never get proper orientation on how investment they work. If person wan invest him supose done mark him investment duration, investment target and lastly strategy to investment. But these days you go see person go just go carry the last money wey they him account go buy one coin like that wey him no no con dey expect say magic go happen.

And e no make sense say we invest inside cryptocurrency, we no get back-up funds; normally, we know say na emergency fund. At least if person done whail himself based on weting him dey end at the end of the month, make him make good savings for like 6 months before em dey think to invest for cryptocurrency so that incase of any shake shake for road him go run to that back up funds. Becuase cryptocurrency market fit give person heart attack o when you see say your coins done they fall and no be everybody fit withstand that pressure.