Title: [Android Tutorial] PGP Signature - Encrypt/Decrypt message dem Post by: Hatchy on April 10, 2024, 10:57:34 AM Original post: [Android Tutorial] PGP Signature - Encrypt/Decrypt message (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5474187.msg63163204#msg63163204)
Author: Learn Bitcoin (https://bitcointalk.org/index.php?action=profile;u=3506304) like dis now, I don write two PGP tutorials and those ones na for people wey dey use Linux and Windows dem. I come dey think am if any app go dey for android users dem. most of my country people Dem dey use android devices. so I don come with another PGP thread, and e be like say na d last one. I no get Mac or iPhone to tay test PGP for the device. Image source: primekey.com ➥ More PGP Tutorials:
➥ Install OpenKeyChain openkeychain na Android app wey you fit see download for PlayStore. search for PlayStore or you fit try dis link: https://play.google.com/store/apps/details?id=org.sufficientlysecure.keychain after the app don install finish, open am make you follow the next step. ➥ Generate Key: use these images dem tay follow the next step below.
if you wan see your public key, you go need tap on the clipboard icon, wey go copy your pgp public key. for my case, dis wan na my mobile public key wey I generate just now: Code: -----BEGIN PGP PUBLIC KEY BLOCK----- ➥ Export Secret Key: if you wan export your secret keys, follow dis steps:
make sure say you write down your backup key. that wan na becos if you try import the secret key enter another device, e go ask for your backup key. ➥ Send Message wey dey encrypted: to send message wey dey encrypted, you go need the person PGP public key and then you go con import am enter your device so that you go fit send dem message wey dey encrypted. to import person key wey dey encrypted, you go need copy their public key. for my own now, I go copy my other key wey I take dey test. after you copy the person key wey wan receive the message, follow dis steps Dem:
now you don get the person address wey wan receive am. oya make we send message wey dey encrypted! Click the three lines wey dey top left side, and follow dis steps Dem:
now you go write your message, and if you don through, you go tap on the lock clipboard icon wey dey top right side. e go con encrypt the message and copy the message wey dey encrypted with PGP. now you fit paste am anywhere to see how e be like. see my results for here: Code: -----BEGIN PGP MESSAGE----- we don almost finish. one thing wey I no show na how to decrypt, as I dey Sure say everybody go fit decrypt message. you go first need to copy the message wey dey cryptid.>> you go con tap on the three lines wey dey top left corner>> Then tap encrypt/decrypt>>Read from clipboard>>yes you don finish like dis! una don well wey una take read! na AOBT na run dis Translation by Dem self https://raw.githubusercontent.com/AOBTranslators/Images/main/AOBT%20Logo.png (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5442314.0) Title: Receive Merit - Post your PGP key, add an encrypted message, open for anyone. Post by: Hatchy on April 11, 2024, 08:54:56 AM I say make I add this small update join this thread. For those of us wey go like try this PGP thing, una fit learn am then to practice e get one thread wey @ BitcoinGirl.Club create. For this thread you fit earn merit by encrypting any message send am give am. So make una use this one as opportunity to take learn this PGP key e dey important. See the link to the topic so you go need to first read this translation and then go the other thread go send your encrypted messages the. You fit collect small merit join.
Receive Merit - Post your PGP key, add an encrypted message, open for anyone. (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5461523.msg62624631#msg62624631) Title: Re: Receive Merit - Post your PGP key, add an encrypted message, open for anyone. Post by: Amphenomenon on April 11, 2024, 12:14:12 PM I say make I add this small update join this thread. For those of us wey go like try this PGP thing, una fit learn am then to practice e get one thread wey @ BitcoinGirl.Club create. For this thread you fit earn merit by encrypting any message send am give am. So make una use this one as opportunity to take learn this PGP key e dey important. See the link to the topic so you go need to first read this translation and then go the other thread go send your encrypted messages the. You fit collect small merit join. Aside from the earning of merits this PGP thing dey important well well to protect our BTT account in case of hack and Op do recent translation about this for here (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5490792.msg63872571#msg63872571), while another of our LB member Don first do the linux guide about this PGP thing [Pigin: Tutorial] PGP Signature - Encrypt/Decrypt message (Linux Only) (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5490792.msg63872571#msg63872571)Receive Merit - Post your PGP key, add an encrypted message, open for anyone. (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5461523.msg62624631#msg62624631) E go make sense if we try learn PGP thing so that we go still get experience knowledgeabout m |