Bitcoin Forum
June 22, 2024, 01:47:56 AM *
News: Voting for pizza day contest
 
  Home Help Search Login Register More  
  Show Posts
Pages: « 1 ... 13 14 15 16 17 18 19 20 21 22 23 24 25 26 27 28 29 30 31 32 33 34 35 36 37 38 39 40 41 42 43 44 45 46 47 48 49 50 51 52 53 54 55 56 57 58 59 60 61 62 [63] 64 65 66 67 68 69 70 71 72 73 74 75 76 »
1241  Local / Off-topic (Naija) / Re: Fake life in naija on: November 21, 2023, 07:24:13 PM
Welcome to naija where pesin wey no get money they go borrow clothes and shoes just to comot go party,  pesin wey no get shishi go borrow clothes dey waka to impress people.  Pesin boss go give him driver make him go service or wash but e go shock you say driver go carry him boss car go flex and go come dey claim car owner.
This country na cruise sha, you go see pesin wey no get house go dey claim big girl or big boy for street,  you no get food for house you dey select food mean while the pesin no even get something to eat. Too many things dey happen for this our country oooo but I come dey wonder waiting be the need of all those lifestyle.

make i shock you say some persons no be say dem dey form, na just their normal lifestyle to dey select food even though say them never eat anything, dem prefer to stay hungry than to eat wattin dem no like, but the one wey pain me pass na those people wey their ogah give them car to go wash but dem go come end up using the car go flex and most times this flexing dey sabi purge dem, maybe the car go come get issue or get scratch and before you go know dem don loss the job wey dem dey manage. then concerning the cloths own i get one friend wey sabi live this kind of fake life, em go fit borrow both top and trouser like 5 from different persons take do fine boy. but i wan still clear your doubt say no be only naija this kind of things dey go on, na every where e dey most especially for this part of Africa.
1242  Local / Nigeria (Naija) / Re: What financial advice would you offer? on: November 21, 2023, 05:32:00 PM
Buy bitcoin before the halving event, you might even choose to use DCA to accumulate before the halving or use lump sum. Never you invest in any of those altcoins that do not have a good reputation without first having a good looking bitcoin portfolio. I will also advice to keep some of your savings in bitcoin rather than using fiat, except it will not take long before you exhaust the money, reason I say so, like in Nigeria our currency is dropping value on a daily bases now naira to dollar rate in the black market is N1139 so its not advisable to keep your savings in fiat due to inflation.
1243  Local / Nigeria (Naija) / Re: HOW TO TAKE MAKE BETTER QUALITY POSTS. on: November 21, 2023, 10:12:50 AM
Op I like as say you na newbie and you come carefully state this kind of lovely point wey fit make person become a very good or better poster for this forum, but I get one good question to ask you, I hope say you sef go follow this principles wey you state oo? So that spam posts dem go reduce for this forum. Aside that I go also like yo add some few point join the ones wey you don put for ground

1 to become a better poster e go good make the writer think critically first on which board go value that post first before em post am for any where. For this forum I don see many post wey If to say e dey the right place e for collect enough merit, sometimes post wey supposed to dey for bitcoin discussion, you go see am for beginner and help board, no be say some of this post them no dey get merit oo, but the main place where e  for take get enough merit no be the poster go Post am.

2 some newbies for this forum dey develop some fictional story wey no dey exist and dem go come publish am like say na real story, in other words make we no dey lie lie anyhow for this forum, because eyes dey wet dey watch you, some person fit spend the whole day dey watch newbie account and if dem find any fault e no dey hard dem to report make dem for give you tag or ban.

3 wattin Boss Charles-Tim talk no be lie oo, say some post with reference still dey get beta merit I no ague that one, but most merit source no dey like make your post no dey original, if you observe sef you go see say for some of their merit give away thread dem, dem dey always say make you no add link to post wey na news. Dem nor dey too like am so e for good make your post always dey original, and If you wan get this kind of quality just do enough study and reading then ideas of good posts go just enter your head.
1244  Local / Nigeria (Naija) / Re: Bitcoin the best place for retirement savings. on: November 21, 2023, 09:45:24 AM
Gozie51, no be lie wey you talk oo, after bull run comes correction and this correction na one of the reason wey dey expose baby investors wey go sell everything then after some time dem go come still buy same quantity with higher amount of money, wattin I recommend for this part if you dey in need of money na to just sell your profit then leave the remaining one for there, with time na up e dey go. But wattin I no like for wattin you talk na when you say "bitcoin as retirement benefit... Na risk wey pass investment itself" how??? Wattin be the difference between you investing for 7 years then use the money take feed after retirement and to invest for 7 years still use the money take feed or buy some things? Bitcoin no be like other altcoins or shitcoin oo, naim be the original, and with history em don prove say no matter how long the bear market take em main direction na up e dey go, so how you take see am as big risk. And besides we no dey talk about short term investment for here na long holding wey fit give person better profit if em no dey touch em investment anyhow.
1245  Local / Nigeria (Naija) / Re: Bitcoin the best place for retirement savings. on: November 21, 2023, 08:56:11 AM
Op na the coco wey you talk so, person wey do according to the way you talk no go dey think too much after em retirement make em for no go die quick. If at all say the person practice DCA for like 10% of em salary every month, let me say dem dey pay am N500,000 every month then em 10% go be just 50,000 so em still get 450,000 to take flex with em family till month end again. If the person invest that 50,000 for 7 years before em retirement, e mean say that person go get more than 1BTC if we use CBN rate while na just $370 naim commot from 1BTC if we use black market rates, the total amount of money wey em go put for the investment for 7 years na N42,000,000 and we never talk about the main part which is the profit for that 7 years wey fit add extra 50% join the invested amount.
1246  Local / Nigeria (Naija) / Buy bitcoin before the halving on: November 21, 2023, 08:26:02 AM
Good day my country people, compliment of the season. I carry one ogbonga advise come board today to share with my fellow bitcoiners. Normally we know how things hard generally no be only for our country but na for everywhere, and to even see food chop sef na by the grace of God. But I still gat advise say make we no fail to remember or forget say next year na the halving event go take place, and based on history the halving dey prove to boost the price of bitcoin, and the sweet part na be say even for those wey dem just like to do trading and not long term holding, the halving still dey bless dem. So my advise na be say make we no fail to buy bitcoin before the halving so that, by the end of next year we go dey guaranteed of say small thing add for our bitcoin investment and anything wey you like to do with am na your choice, but e for still good make we continue to hold for long term.

Just as I been talk before, the country hard, the country hard, but that one no mean say make we sitdown look this opportunity pass our eyes, normally Bitcoin no be do or die but for those wey fit make this sacrifice, I believe say we no go regret am most especially for those wey fit do small long term holding, like from now until January of 2025. Also as we dey hold for this period make we no let the happiness of the season allow us to loose focus to sell our precious coin any how oo, and make we no still keep our private key and seed phrase any how, because if you keep am anyhow or you fail to backup, your coins go loss for good.

This advise na mostly for the newbies, please be carefully who you tell about your bitcoin investment or holding.
1247  Economy / Reputation / Re: [v2][Self Moderated] In Merits, Count Down To Your Next Rank... on: November 21, 2023, 07:35:05 AM
My countdown to full member rank
Number of Merit(s) left: 24 21 11
1248  Economy / Gambling discussion / Re: Is this a good advice? on: November 21, 2023, 06:06:07 AM
The idea of keep trying in the mind of gamblers is one of the reason some of them turn to addicted and irresponsible gambler, gamble is not one of the ways to get rich except your can manage the risk properly without getting too irresponsible with your gambling stakes, often times, this idea is the reason some persons loose every thing they have. While gambling, I know my limit and I tend not to exceed my limit like making extra stakes, even if I am on a winning  strike, I quit when I am a bit satisfied with the loses or wins. People who act towards the idea of keep trying oftentimes end up in regrets after losing everything they have.
1249  Local / Nigeria (Naija) / Re: How feasible will it be for our government to invest in bitcoin? on: November 21, 2023, 05:48:24 AM
rachael9385, I understand your points, and I know where you're heading to, all of us know how corrupt our government dem dey and wattin dem fit do their citizens without thinking twice, sometimes sef I dey think weda dem don forget say dem dey owe others loannnn, because since dem collect that loan I never hear anything like say dem dey plan to play back. Every government wey come go just mind em business thief em own commot for sit.

But where I no agree with you na where you say bitcoin investment no go good for our government to take carry pay this loan, yes I know say dem fit convert the opportunity of anonymous transaction to their own favour to take dey dupe the country, but make you no forget say bitcoin na one of the solutions to our world today, and if them no fit use am now dem wan take allow their citizens to use am.
1250  Local / Off-topic (Naija) / Re: Is Ai a threat to Nigerias educational system on: November 21, 2023, 05:30:02 AM
Well said mr DubemIfedigbo001 its so sad knowing that even our Nigerian lecturers also help in the promotion of Ai unknowingly by not doing their duties properly, you see when we talk about corruption in our country, we are talking about everything inside the  country, meaning nothing is left out. And because of this same corruption many lecturers seem to just use this opportunity to extract money from their student without proper check on their writings. This things dey vex me well well because I get broder wey dey complain almost every week say dem wan buy this and that or dem wan pay for something, las las dem go graduate and dem go still tag university as school wey no get good educational quality. We no say AI come to help us oo, but the abuse naim be the thing wey dey very bad wey we dey do.
1251  Economy / Gambling discussion / Re: When does the moment come when the gambler loses control? on: November 20, 2023, 03:29:24 PM
The both ideas of gambling dependence is true but I believe the first idea is the most occurring and correct reason for dependence in gambling, the excitement that comes from using a small amount to make a win more than 12x the staked amount is something else. It gives the gambler hope of making more wins, even for some who claim to gamble for fun, before you'll know it, they've turned to aggressive and irresponsible gamblers. Only few gamblers with the experience of big wins tend to gamble responsible, even if they experience some terrible losses. Aside that when gamblers experience some losses the idea of playing more to rise to their previous state is quite tempting but it can not be compared to when a gambler makes big wins. Mind you, gambling dependence and irresponsible gambling are separate thing so don't get it twisted.
1252  Alternate cryptocurrencies / Altcoin Discussion / Re: Eloncoin will be massive. on: November 19, 2023, 10:14:35 PM
Op it seem your are quite correct on your statement concerning the influence of elon musk on other altcoin, but I must say that those coins in which his influence has impacted their adoption greatly have not yet grown to my expectations but, they are doing fine. Considering the same influence and more on his coin, he will surely make out the best of it, due to his innovative ideas I believe with time he'll make his coin worth the title of a trusted altcoin rather than a shitcoin.
1253  Bitcoin / Bitcoin Discussion / Re: Treating bitcoin as a teenager. on: November 19, 2023, 03:42:11 PM
I am sure that only 10 years holding is enough for change the life of any people with only invest 10% of his income.

10 years is a lot for someone to get enough profit from Bitcoin investment provided that, the person holding the coin does not behave like a newbie investor by selling his coins when its not yet time as regards to the pre planned investment schedule. And besides 10% from some persons income can be quite a huge sum, so based on the comment the bitcoin holder would be practicing DCA which is know to be one of the best accumulation strategies in Bitcoin investment. Mr SAHASAN you are absolutely correct with your statement 10% of income for 10years is enough for a live changing event.
1254  Local / Off-topic (Naija) / Re: Is Ai a threat to Nigerias educational system on: November 19, 2023, 03:23:42 PM
To talk the major truth, ai na one of the thing wey dey make our students of nowadays lazy well well, just like wattin Justbillywitt talk say this matter no be only for the educational sector e for dey worry, e dey also affect almost every part of our live. E get one seminar wey I partake concerning Ai projects for the engineering field and wattin dem been dey tell us na be say, dem wan use Ai take replace human being for their work, just imaging the kind of disaster wey dem dey plan, yes e fit make their calculation dey more accurate oo, I give Ai that credit but dem go first gats sack people papa from work first and by so doing dem dey increase unemployment rate for the country. Then when we talk about the educational sector, students of nowadays na soso AI text generator dem take dey write their school project.
1255  Other / Archival / Re: I am a newbie on: November 18, 2023, 04:38:00 PM
Op you are very much welcome to the forum and its good knowing that you are ready to learn and open for new ideas, I think you are in the write place. I can see that you have already been supplied with materials for study, all I have to say is that you should check them out and get the very best from them as they will help you through out your journey in Bitcoin and in this forum. I'll also add that when you start your bitcoin holding ensure to follow the proper storage procedure and keep your coins in a bitcoin wallet rather than using an exchange to keep your coins.
1256  Local / Nigeria (Naija) / Re: Ontop the matter of Bitcoin fee on: November 18, 2023, 03:51:09 PM
Normally na mempool congestion dey cause the issue of high transaction fee just as other people don talk, the mempool congestion they happen when too many unconfirmed transaction dey wait for confirmation for the blockchain and because of that e go come dey use the bigger the fee the faster the confirmation for the block chain. Plenty people go see am like big disadvantage oo but, I still dey see small merit for inside, because plenty transaction mean say people wey dey use the network many or dem fit don add join the current number so to some extent na very good news to the bitcoin network adoption. But I think this one na old version bitcoin don reach to use lighting network for all em transaction because no be small network wey em be again.
1257  Local / Nigeria (Naija) / Re: Is Nigeria a failed project ? on: November 18, 2023, 03:27:36 PM
My brother no be only you this country tire oo, we many when if say opportunity dey we for don match comot for this country, because wattin man eye dey see em mouth no go fit talk am, e come be like say na children our government dem dey handle with, this our country na one of the most blessed nation for this world, but that pride nor dey fit come out or showcase emself because of selfish leaders wey we get.
Just imaging wattin I see the day before yesterday for village, them bring palliative food come village for night, I been just dey one corner dey observe, before I know dem don send two boy to carry two bag of rice go another location wey no be there dem dey offloads the palliative dem, omor wen I see am em, na there e con really clear for my eye say the corruption don reach both the citizens dem. So for corruption to end for this country no go fit dey possible, because e don sink reach the heart of the country.
1258  Alternate cryptocurrencies / Altcoin Discussion / Re: Altcoins profits or bank profits, which best? on: November 18, 2023, 07:04:13 AM
I assume you are interested in altcoins, that's a good choice.

I can't find any trace of word showing that I am interested in altcoin, so why assume that I am interested in altcoin when I stated clearly that, I don't do altcoin or recommend then to any one. The reason I choose altcoin over fiat bank investment is because, some crypto seem to appreciate in value with time and patients while fiat currency suffer from high inflation which makes it not worthy for investment. So how can i, seeing their differences go for fiat investment.
1259  Alternate cryptocurrencies / Altcoin Discussion / Re: Altcoins profits or bank profits, which best? on: November 17, 2023, 09:31:33 PM
Despite the fact that I don't do altcoins or recommend then to any one, I still won't choose fiat bank investment over crypto, no the rates or return a fiat bank gives, its still nothing compared to some altcoin, and mind you I meant some altcoin which means, some are worthy while others are not, though I might be difficult to know all the worthy and unworthy altcoin to play with. With time and patients crypto has always shown its greater than fiat bank investment, when making some altcoin investment all you need is good patients,
1260  Alternate cryptocurrencies / Altcoin Discussion / Re: Altcoins profits or bank profits, which best? on: November 17, 2023, 09:09:23 PM
Despite the fact that I don't do altcoins or recommend then to any one, I still won't choose fiat bank investment over crypto, no the rates or return a fiat bank gives, its still nothing compared to some altcoin, and mind you I meant some altcoin which means, some are worthy while others are not, though I might be difficult to know all the worthy and unworthy altcoin to play with. With time and patients crypto has always shown its greater than fiat bank investment, when making some altcoin investment all you need is good patients,
Pages: « 1 ... 13 14 15 16 17 18 19 20 21 22 23 24 25 26 27 28 29 30 31 32 33 34 35 36 37 38 39 40 41 42 43 44 45 46 47 48 49 50 51 52 53 54 55 56 57 58 59 60 61 62 [63] 64 65 66 67 68 69 70 71 72 73 74 75 76 »
Powered by MySQL Powered by PHP Powered by SMF 1.1.19 | SMF © 2006-2009, Simple Machines Valid XHTML 1.0! Valid CSS!