Bitcoin Forum
July 01, 2024, 11:54:07 PM *
News: Latest Bitcoin Core release: 27.0 [Torrent]
 
  Home Help Search Login Register More  
  Show Posts
Pages: « 1 ... 16 17 18 19 20 21 22 23 24 25 26 27 28 29 30 31 32 33 34 35 36 37 38 39 40 41 42 43 44 45 46 47 48 49 50 51 52 53 54 55 56 57 58 59 60 61 62 63 64 65 [66] 67 68 69 70 71 72 73 74 75 76 77 78 »
1301  Local / Nigeria (Naija) / Re: An official update on the deadline for the naira note palava on: November 15, 2023, 01:00:46 PM
This na very wonderful news wey you carry come, how dem go just rush us say make we start to use new naira note wey no even dey circulate well, even till now anywhere you go na old naira notes naim plenty pass, I just thank God say this our new presido and CBN governor get small sense. This na the second time I dey see say the new CBN governor dey work, the first one na when em remove FX restriction for some items and I believe say na man way understand the important of crypto currency maybe as time goes on em fit still remove the restriction wey dey for crypto, I no lie you I dey proud of em good works, em dey try.

And if to say dem no extend the date till further notice how men wan do for the new year celebration con join the hardship wet dey ground, e for just be the worst new year celebration wet I don experience.
1302  Local / Nigeria (Naija) / Re: Mempool is congested, use ViaBTC free accelerator. on: November 15, 2023, 12:43:18 PM
Baba Charles-Tim thank you very much for this solution to many problems wey concern transaction, as it stands like this I no say I don get alternative to take make my transaction fast pass the way wey e dey, reason I dey even take this thing serious na because, the day before yesterday I been dey do one transaction take upto an hour before e confirm for block chain and when the transaction been dey go one I nearly cancel am sef because I never experience this kind of long time before, but later dem come explain to me say the mempool dey very congested this period naim make, so this post na one of the best thing wey I see for this kind of period wey mempool dey congested.

But e get one question wey I wan ask those people wey don use this ViaBTC accelerator so: those wey don use am na like how many minutes your transaction take before dem verify am?
1303  Local / Nigeria (Naija) / Re: A DISCUSSION ABOUT TRAVEL OPPORTUNITIES AND THINGS YOU WOULD DO TO MAKE IT WORK. on: November 15, 2023, 11:44:52 AM
Op wattin boss Justbillywitt tell you na the truth be that them dey try make the board dey some how organized by reducing shitposts and off topics and you dey here dey create topic wey no get any benefit to person wey dey read am, if to say for this thread na cruise you dey catch e for no pain but the question you dey ask sef na personal question and beside the link wey you post wattin dem dey do there na scam, the money wey dem wan take send you go the Dubai, na thief dem wan thief am? Some kind times make we sef dey think critically before we do some kind of things and make you know say more than 95 percent of anything wey tell you to refer person for this kind of opportunities na scam.

And apart from that I dey always advise say if una wan post this kind of offtopic make una use our pidgin language make e for still hide from externals small.
1304  Local / Nigeria (Naija) / Re: How exactly does bitcoin obey the bear and bull season. on: November 15, 2023, 09:02:23 AM
Op you had a very funny funny understanding of what bull and bear rum means, and as I read that place na laugh I an laugh my belle tear. And beside, e no dey like say bear go rule for some years dem bull go come take over because inside one year sef we fit get 2 or more occurance of bull and bear marker. I dey happy say you don get satisfied answer from our able boss them the only things wey I wan add na be say I believe say as satoshi dey write bitcoin code em also add the code wey go make BTC obey this laws dem, and apart from investors buying or selling their coins other factors still dey wey dey make bitcoin dey appreciate in price and also depreciate in price.
1305  Alternate cryptocurrencies / Altcoin Discussion / Re: Government's actions against crypto on: November 15, 2023, 07:39:48 AM
Bitcoin is going more stronger so if one country see the success of other countries then there will be a possibility that every country will soon accept bitcoin. If you are still buying more and more bitcoin so it is possible that in future you will be able to take benefit from it as Bull run occurs after every four years. Restrictions will not persists always so everyone should accumulate, once bitcoin attain maximum value then there will be contrition for those who did not accumulate on time.

Yes I agree with you, El Salvador being the first country to accept Bitcoin as a legal tender, its success and growth will influence the decision of other countries to join in this Wonderful network, we just need to give dem some time and before you'll know it boom, they've removed the restrictions. The decision of accumulating more bitcoin to my portfolio will never decrease but rather I'll grow to a more aggressive accumulation as time progresses. My advise to holders is, let's keep the good work going and before you'll know, our government would have no other choice than to accept.
1306  Bitcoin / Bitcoin Discussion / Re: Make bitcoin "untouchable" for a while on: November 15, 2023, 07:17:28 AM
Well, I have my reasons.
Sometimes I tend to "panic sell" some when I see the market is going down. Or I am bored, deposit some at Poker or some sports bet site where there is a possibility to lose.
I basically want to lock it away for a certain period of time (not long, but continue locking it after the lock expired) since I don't need it at the moment and I don't want to have the "temptation" of using it for whatever.

I know how to store my bitcoin, I am not looking for that.


Op I think the solution isn't about staking your bitcoin for a duration of time that you can't get access to, first of all you staking those coin is like giving up full control or access bitcoin network guaranteed to its users. The solution is to learn to be discipline by not letting your emotions make decision for you, I taught this problem was associated to only newbies who have not gained enough knowledge about Bitcoin but here I am seeing a sr member with same issue. No matter how bored you get I don't think using bitcoin that has been planned for long term holding for gambling is a good idea because, within 24 hour you can destroy your bitcoin portfolio if you are not discipline enough. I'll recommend you use your fiat currency for gambling should in case you get bored.
1307  Local / Nigeria (Naija) / Re: Bitcoin Investment in Nigeria on: November 15, 2023, 06:54:52 AM
Op you don talk very well, I can see you have a lot of research and reading, na very good thing wey you don do so. Normally real estate business no go fit challenge Bitcoin investment minus the demerit them wey you drop about real estate investment if them say make them drop the profits from when them create the estate and the same time wey dem bitcoin, let's say na 2012 dem create the two, you go see say the gap wey bitcoin go give am e no go easy because before you start to calculate profit for real estate you GI first remove money wey you take build am so how them wan use this kind thing compare Bitcoin investment? Just as baba cryptopreneurBrainboss don talk Bitcoin investment no be 50/50 and I go like make you take this correction if na because of the bear movement you say na 50/50 make you no forget say no matter how Bearish the market dey for some time e go still rise or enter bull run and history sef fit back up this fact say na up the market dey go.

No mind our politician dem no know say wattin dem dey fight against na also solution to their problem, crypto wey every thing for inside na anonymous something so dem fit get a whole 1k BTC and no body go know and yet ignorance no go let them think reach that side.
1308  Economy / Speculation / Re: Buy every dip! on: November 14, 2023, 09:11:50 PM
HODL does not mean "hold on for dear life"

That was some no coiner gambler who came up with that characterization of HODL in order to wrongly imply some level of gambling and/or panic/stress that a HODLer needs to have."<<<<<<<

I wonder where they got the idea from that holding means "hold on for dear life" I mean how did dey arrive at this conclusion, though we know bitcoin is more of long term holding but how can someone hold bitcoin without having a plan from the start or along his/her accumulation journey, they say " if you fail to plan you plan you to fail" so a holder without a goal to achieve with his/her bitcoin by the end of their accumulation journey is either making investment for their children/next of kin, that is if they have his mnemonic phrase and private key or they are just making investment  to keep the system running if anything happens to them.

so the person is feeling pretty good about having had accumulated a whole bitcoin in three years, but feeling pretty bad because s/he had invested way more than expected into bitcoin as compared to the rest of his her investment portfolio

I don't think over accumulating bitcoin even after setting an accumulation target should make the person feel pretty bad because, having such a great bitcoin portfolio is the dream of many investors, both new and old, it should be consider a privilege because your having 1 complete original coin. Slowing down would be the worst option, why would any one reduce their bitcoin accumulation for any shitcoin?
1309  Local / Nigeria (Naija) / Re: The fall of shitcoin/altcoin, the rise of bitcoin on: November 14, 2023, 08:25:19 PM
Op this na very nice observation, e no get how any altcoin wan look good reach me and dem no get any thing to do, because plenty people never still recover for wattin altcoin do dem, na so some coins go come out you go thing say that one get better future because of the way people dey rush am but las las if the coin no crash naim be say the price go dey very low for a very long period of time, and as the people wey invest for all this kind of coins dey see the way bitcoin dey up dem go just dey regret why dem no invest for bitcoin since, las las na Bitcoin dem go come still sell their altcoin come buy. So yes I also believe say many altcoin investors dey sell their coin to buy bitcoin, and apart from the one I also believe say good news no dey dit hide forever e must burst make people for hear am, so people don dey see the important of bitcoin for their life com dey invest for am, so even though say altcoin investors no leave their sell their coins invest for for bitcoin the adoption for bitcoin for still dey increase, because no body go like go buy fake thing when em fit still buy the original with same amount but na just the quantity naim go change.
1310  Local / Off-topic (Naija) / Re: Importance of learning a skill before gaining admission into the universIty on: November 14, 2023, 08:09:12 PM
Op I like wattin you talk for this hand work matter, e dey very good for person to sabi hand work wey fit dey give am small small thing when em dey school, so that em fit dey use that one take dey manage emself before hunger use am run ground. But if every body learn hand work finish who dem go use or who dem no go use, so I leave this for only those wey like to learn, if person no wan learn no be still bad thing the only time wey e go turn bad thing na when the person no get anywhere wey money dey come from and e refuse to learn, that one na just hunger trouble naim the person dey fine. As you see me so outside this forum na electrician and plumber naim I be, and e don tay wey I get this hand work, naim I take dey survive and even when I enter school naim still me do so many things, so I no fit play with my hand work, but the issue nowadays na be say to even see work do don dey hard e no be like before wey two customers go dey call the same time, na plenty people don dey use solar for their things and those wey dey repair generator nor dey too get work like before again everywhere hard, but this one no affect does wey dey barb hair oo.
1311  Local / Nigeria (Naija) / Re: Too much transaction fee on: November 14, 2023, 06:13:13 PM
So nah because of this quote nai make I recommend binance exchange wallet give the op, as I see the matter, nah just because say the op want were em go fit sell em coins without any stress of fees or time wasted,, as the matter be so, I no really tell the op to use binance hold em coins because say e no dey safe,, so as em just want to sell em fit still use am.

I understand wattin you mean and the point wey you dey put for ground, I also buy the idea, the only thing na be say I gats dey very conscious with the amount wey I dey put for there in regard to wattin boss Franctoshi don talk so and I no go let my coins stay for exchange more that 24 hours.

i discovered that when i sent BTC the other day and set the fee to the tiniest possible, i waited long hours and wasn't confirmed, i will likely be waiting for more than 72 hours or more. but sending another transaction and this time following the recommended amount for the transaction fee. the first transaction made was also confirmed along with the 2nd. seem to work.

The thing na just be say I no go like wan experience this kind of thing na why I no wan compromise my transaction fee to smaller amount for that wallet, na why I dey look for any other means wey dey sure of less transaction fee and faster transaction confirmation for the block chain, though I don see many suggestion and alternate part wey I fit take and I go check dem out, because I no ready to play that kind money play for electrum for this kind season.
1312  Local / Nigeria (Naija) / Re: Lack of quality mindedness over flooding the board (forum) on: November 14, 2023, 05:51:20 PM
Bro I believe say before you grow to full member you start from newbie, and before you get vast knowledge of bitcoin you start from scratch, so if you see person wey do something wrong no fail to correct am but that one no mean say make the person no post, I believe say almost every body for this forum start from low quality post to some reasonable post wey fit attract merits. And make you no forget say day by day more people dey join this forum and seeing old post old post nor dey dey to interesting to discuss put most times because you don already know the kind information wey dem dey pass for there. And besides I don see case were by person no get wattin to answer for exam so em come give emself question for that same subject come still answer am and the lecturer give am mark, so to leave everywhere blank naim worst pass, e go show say the forum don dey loss attendance.
1313  Local / Nigeria (Naija) / Re: Every successful innovation is a product of a sound mind and a positive mindset. on: November 14, 2023, 05:35:24 PM
The power of the mind na wattin we suppose take very serious, because we no go fit give wattin we no get, so when you go get anything upstairs you no go fit do to other expectations, so if life damand something from you and you no get wattin to reply back na failure be that oo, and because of this reason naim make school sef dey very important even say you no wan use your school certificate take find work, if at all just go the school make you graduate e ho really help your thinking faculty and increase your exposure to many life lessons. And e dey very good make we dey positive all the time, some kind time if you dey see obstacle no reason am just dey do your normal thing dey go and before you go know you ho cone out successful. I no be motivational speaker oo but this positive and sound mind na wattin person fit use take defeat life challenges dem oo.
1314  Alternate cryptocurrencies / Altcoin Discussion / Re: Tricky situation for Altcoin investment on: November 14, 2023, 05:20:34 PM
I think by price value then you would mean that the newbie would be thinking of buying 1bitcoin because I believe they are lower price of Bitcoin that you as a newbie can buy although the profits you would get would be different when you buy an altcoin that is actually pumping because they are more probability of acquiring more from these type of investment but the fact is that it's very risky as they can drop their value any time from when you actually purchase them so thinking of using them as trading would be better and a short term trade in that matter.

Absolutely correct, many altcoins seem so tempting to invest in but the fact still remains that they are risky and might end up crashing one day, so to be on the safer side I just mind my business by investing only on Bitcoin. I see altcoins as coins for trading alone not for long term investment, the only coin I can recommend for long term is Bitcoin and aside it nothing else. Because it seem the price of most altcoins are tied to that of Bitcoin, so why then should I try to invest on altcoins when most of their price movement is influenced by Bitcoin itself.
1315  Local / Nigeria (Naija) / Re: Too much transaction fee on: November 14, 2023, 05:06:33 PM
I go like tell you to use an exchange wallet instead of the electrum wallet because exchange wallet go reduce the stress of high fee and waist of time for you.
Well, make you try binance exchange wallet, that nah another good exchange wallet for those way really dey sell their coins all the time

My sister thank you very much for this wonderful idea be like na em I go take dey do my many transactions dem oo, because e wan come be like say electrum wallet wan cut my neck commot. The only problem I get na be say normally our Ogah dem don dey advise us make we no dey too money for exchange for long, so I wan ask weda to keep for up to 24 hours na bad thing? because most times wey transaction dey come I fit dey were network no dey, I travel a lot so I wan know if e dey safe?

No be only your wallet fee high like that nah so the blockchain bee the network they congested and fee high for everybody, so if you send your transaction with fee way at least reach $1-$2 eh fit take time but eh go go and if nah just one address you they send am go, after you don send the transaction out you fit use accelerator as one of our own person been share for the local board carry accelerate the transaction to make am faster.

Mempool is congested, use ViaBTC free accelerator. by Charles-Tim
Mempool is congested. That is the reason for the high fee needed for making transaction for now.

Use ViaBTC free accelerator which is helpful. But make sure that the transaction fee is not less than 10 sat/byte (let it be around 19 sat/vbyte if you are using native segwit address).

Make sure that the size of the transaction is not more than 500 bytes.

I thank una very much for this link and the advise I go check am out, so that I go get extra knowledge to the one wey dey now, so wen I need a faster transaction I go implement am.
1316  Local / Nigeria (Naija) / Re: In Meta: We Don Ask 2 Create Sub-Boards on: November 14, 2023, 04:38:33 PM
Boss na you we go thank pass, because wattin you dey do for this our local board na truly good example to young members like me and to every body, just as you talk I go still pray make Papa God bless you for the good deeds. No be lie you talk oo as a dey see the forum sef I come like am more, now the post dem many dey point finger dey go bitcoin matter and na so e suppose dey, more of bitcointalk and less of other discussion, now even our newbies dem don dey mind the kind of post wey dem dey post and this na very good news for the forum wellbeing. Thanks to you and other boss dem wey no gree keep quite wey stand to tell us the koko come still discipline some people join am.
1317  Local / Nigeria (Naija) / Too much transaction fee on: November 14, 2023, 04:08:30 PM
Good day my fellow bitcoiners, all protocols observed. This few days I don do some series of transaction wey make me come dey wonder weda na all segwit wallet naim dey collect high fees for transaction abi na just the one wey I dey use, because na electrum wallet naim I use and the kind of transaction fee wey those people dey take charge my transaction nor dey nice at all, dem dey collect like 10% of the money wey I wan transact and this kind of thing dey short my money well well, naim make I say make I bring this problem come board weda my boss dem fit give me recommendations or direct me to any wallet wey nor dey too take much for transaction fee.
1318  Alternate cryptocurrencies / Altcoin Discussion / Re: Government's actions against crypto on: November 14, 2023, 01:22:21 PM

The government can only create laws to halt people especially traders and investors from investing in the crypto market but that would never stop the flow. We still have the option to go for what we want and how we want it. The government might be pushing for penalty for people that would break a particular law that is restricting people from making any form of investment with severe sanctions but that would never stop us. Cryptocurrency is an investment of choice and it is mostly decentralized without the permission of any government officials to determine when we are buying or selling cryptocurrency.

It was developed outside the government radar and it grows up to now, maybe yes, government can implement rules and regulation but the continuation will continue to depends from how people will support the project, I also agree that due to the decentralization this venue of investment will continue and will grow for more.

Whatever the government will try to avoid the investors and supproters will always find ways to continue.

For sure, no matter how hard they try Bitcoin accumulation and its usage will keep on increasing day by day until dey have nothing to fight with. That is, Bitcoin will became too powerful for dem to even restrict their citizens from adopting it. Because I believe that a time will come were if your economy does not accept Bitcoin you'll bee seen as a less developed and ignorant nation. Currently bitcoin and other cryptocurrencies are on restriction in my country but that does not stop me from accumulating bitcoin or increasing my crypto portfolio, they can restrict us but they can not stop us.
1319  Local / Nigeria (Naija) / Re: I just want to understand something on: November 14, 2023, 12:21:05 PM
I want to understand something about this forum concerning merit, will the amount of activity somebody have translate to merit anytime or it all depends on the one given to you by somebody?

Activity and merit na two different things, without activity you no go fit rank up and without merit you no go still fit rank up so the two of dem dey work hand in hand no be say na the same thing. Your activities na from your accepted posts for two weeks, and na only 14 post the forum dey accept wey go come turn to activity, so inside two weeks if you post 25 things na only 14 go add up to you activity. While for your merit side na if you post something wey dey very interesting to the reader then the person fit send you merit, and mind you we still get wattin dem dey call smerit= sendable merit. So every merit wey go get the half of that number of merit go give you the sendable, so if person send you 1 merit na 1/2 go dey you smerit portfolio and if dem send you 2 na 1 go dey, just like that to any number. And the smerit you no go fit use am do any thing than to send am give person for em post wey you like.
1320  Local / Nigeria (Naija) / Re: bitcoin affecting altcoins on: November 14, 2023, 12:05:10 PM
Overtime i see that whenever there is a dip in the price of bitcoin, other altcoins tends to follow suit by also dropping in their prices and whenever there is an increase in the price of bitcoin, other coin as well increase in their value.
Just as baba cryptopreneurBrainboss don talk, bitcoin naim be their master and anything wey master naim boy go do oo, if the boy go go pass em master e mean say em don dey grow wings and 70% of the time the boy no dey fly dey go anywhere. Likewise crypto we no go fit get two masters for one place, so one must lead and the other go follow if not na so so problem go dey until dem settle that matter.

One of the greatest reason why altcoins price dey tend to follow Bitcoin price na because, most altcoins dem no go fit buy dem with fiat currency so before you go buy dem you gats first buy bitcoin den convert am to the altcoins and when you wan still sell am you go still convert am to bitcoin before you fit sell am, so e just be like say na Bitcoin dem dey take do every thing wey concern those altcoins, and for normal sense na Bitcoin price dem take dey measure the price of those altcoins no be even dollar.
Pages: « 1 ... 16 17 18 19 20 21 22 23 24 25 26 27 28 29 30 31 32 33 34 35 36 37 38 39 40 41 42 43 44 45 46 47 48 49 50 51 52 53 54 55 56 57 58 59 60 61 62 63 64 65 [66] 67 68 69 70 71 72 73 74 75 76 77 78 »
Powered by MySQL Powered by PHP Powered by SMF 1.1.19 | SMF © 2006-2009, Simple Machines Valid XHTML 1.0! Valid CSS!