We dey this side dey run tinz ...legit work opportunities dey for does wen wan japa.. slow and steady wins! one love!
How pha na oga, you fit run one thread with regards to legit opportunities o; i sure say e go help many people and if dem get sponsorship too; na correct lambo e go be for us too. Abi how you see am ?
Good day guys i greet you all, Omo I jus de happy as i jus find out about this place and e con de sweet me say na my people de here. I no still believe my eyes say naija get their personal place like other people that mean say dem recognize us here be dat. I’m really happy joining you guys here and i wish to learn from you guys.
I greet you too; na the best platform to learn and grow more in bitcoin knowledge you de
no shaking!