My good people of Naija, I hail all of unah all the way from port Harcourt city, for inside river state.
I don lap this forum since July 2021 but nothing come out for me and I believe say nah because my eye no really reach ground for the forum. Even as I Sabi my boss/name sake @cryptobrainboss, I only Sabi am say him be bounty manager, I no even know say him creat child boad like dis way they answer naija since 2019.
But nah because of those two post below way I see for Bitcoin discussion nah Im direct me come here. (
https://bitcointalk.org/index.php?topic=5408081.msg60652115#msg60652115 ---------->
https://bitcointalk.org/index.php?topic=5121680.msg60641685#msg60641685)
I thank baba God say In carry me come here oo to meet good bosses for the forum way I fit learn better things from and fit get some good opportunities/knowledge.
@cryptobrainboss nah Im be the only senior man way I still Sabi so far, I believe say with time I go get to know other big oga them for the club.
Most of unah fit they wonder why I really answer the name "Sodiumdicromate" 🤠
But the answer be say I just finished my first degree this year and nah "CHEMISTRY " way I read. Abeg I dey Open to get opportunity for the position of a chemist ⚗️🧪 from any of my bosses here oo at same times base on how this country hard, I say make I dey hustle here too.