Bitcoin Forum
June 30, 2024, 04:18:30 PM *
News: Latest Bitcoin Core release: 27.0 [Torrent]
 
  Home Help Search Login Register More  
  Show Posts
Pages: [1]
1  Local / Nigeria (Naija) / Re: Nah lack of common sense or greed?? on: October 14, 2023, 07:01:52 AM
I say make I bring this mata come here make we discuss. I wan hear our different opinions on how we fit stop this menace. We no be strangers to the dangers wey tanker wey dey carry fuel come get accident dey cause. The issue of bad roads nah another thing to consider and also, sometimes carelessness of the driver becos him go dey drive like say nah sports car him dey use.

But where the gbese dey nah on how people go dey rush to go collect fuel wey dey spill, not minding the possible danger to life wey if small spark happen, dem fit roast.
Recent incidence wey happen for Ondo state of how tanker wey dey carry fuel get accident and people go rush to pack fuel, e no end well as 15 people kpai for the ensuing explosion wey take place not too long after..

Some go say na due to the fuel scarcity nai make them rush, others go say dis na opportunity to take get money after them sell am, but my question be say how we fit stop out loved ones from this sort of risky movement? You feel say our government dey partly to blame or nah just lack of common sense dey worry us so??

For Me, I feel say the best thing we fit do for this matter na Sensitize and teach pipo the dangers wey surround accident tankers. Especially for individuals wey dey live for communities along the Expressways. Working together with the communities development committee/council and Youth. As statistics don show say na youth dey be the victims of this explosion.
Pages: [1]
Powered by MySQL Powered by PHP Powered by SMF 1.1.19 | SMF © 2006-2009, Simple Machines Valid XHTML 1.0! Valid CSS!