Bitcoin Forum
September 10, 2024, 03:12:52 AM *
News: Latest Bitcoin Core release: 27.1 [Torrent]
 
  Home Help Search Login Register More  
  Show Posts
Pages: [1]
1  Local / Nigeria (Naija) / 📆 Mark your calendars! The campaign kicks off on August 21st at 6PM UTC and run on: August 25, 2023, 02:20:29 PM
I don de reason dis matter for some time now, about how di signature campaigns de take make money for inside bitcointalk forum. Aldo I never reach full member rank for di forum, to understand as dem de take operate, so I reason say as I de privileged to get older members wey de run things with dem, say make I ask una how? Di main reason wey I wan know be say for my small experience about businesses, di main reason wey dem de take advertise na to reach a wider audience wey new people go de see dem products everyday, so dem go de get new customers to de patronize dem. But na only members wey de for di forum alone de see dis adverts or campaigns. So how di campaigns de take increase sales and recover di payments to members, as na only dem and junior members de see di adverts.

I de wonder weda dem de pay members to de advertise  and create awareness for dem products or dem de pay members to de patronize dem products? Lastly weda dem products de promote bitcoin?

Abeg if dis na forbidden question, our ogas dem fit to lock di thread. But if na correct question, make una help me chuk mouth for di matter?
Pages: [1]
Powered by MySQL Powered by PHP Powered by SMF 1.1.19 | SMF © 2006-2009, Simple Machines Valid XHTML 1.0! Valid CSS!