Bitcoin Forum
May 23, 2025, 06:01:13 PM *
News: Latest Bitcoin Core release: 29.0 [Torrent]
 
  Home Help Search Login Register More  
  Show Posts
Pages: [1]
1  Local / Nigeria (Naija) / Make Banks and Exchange no con use bonus trap person o (Flash Deal) on: May 13, 2025, 09:29:27 AM
My people how una take see this matter:

(Flash Deal Alert)

I open exchange way I Dey use Dey do my buy small small Bitcoin way be DCA base on when small thing enter my hand and as I open am..na so I get one ads update from the exchange say, make I buy from First Bank of Nigeria PLC abi how them talk am.



Omo..the matter just full my head as I see am o.. because me way Dey here, I know say for this country, even if them don allow us to Dey trade crypto now..CBN never still allow banks to put body for this cryptocurrency matter yet..
E con be like trap but the trap con be say na exchange Dey collabo with bank to run am..shay na which levels be that sef..

As I no kuku Dey operate First Bank account, e kuku no concern me..But make person no go jump because of small bonus Dey risk all en BVN connected accounts them o..Because Banks never open for crypto transactions yet so make we try Dey watch them wella.
2  Local / Nigeria (Naija) / FG don pass law way recognize Bitcoin on: May 02, 2025, 11:32:37 AM
FG don pass law way recognize Bitcoin

So as we Dey round up the mouth of April, following the plenty kata kata way CBEX bring to our Nigerian people way plenty persons loss their investments, business money, loaned money and even money way them generate from property way them sell just to invest for CBEX. The thing don make FG to turn ear towards these kind of schemes to say no and even sef, them con Dey try look digital assets and cryptocurrencies way be Bitcoin amongst others to make sure say, Nigerian citizens Dey get am right.

Nigeria remains one of the top cryptocurrency innovative and adopting nation, even as the government never really open road say eh, make we Dey use am as we please. Our government stands no Dey ever Dey clear on this matter since them no ban am, neither them been really recognize am but, e be like all that one wan begin to change.

So, following update on digital assets on cryptocurrencies, FG don pass into law to recognize Bitcoin as securities. President Tinubu sign this act just last month for cryptocurrencies to Dey recognized.
You fit read more on this update for here:
https://www.forbes.com/sites/digital-assets/2025/04/30/nigerian-gov-passes-law-recognizing-bitcoin-as-a-security/

I really Dey happy to hear about this development for our country and e go be one way go encourage people way been Dey fear to welcome cryptocurrency and take up Bitcoin investments. Although, e pose certain wahala via say,

SEC go Dey look to control everything, especially at the exchange level and any cryptocurrency companies way Dey functional in Nigeria. Make we also no forget how this current government Dey wan tax gain commot inside everything but, even that one no be big matter shah.
Cryptocurrency na currency way be say, we Dey use enjoy privacy and being anonymous, among others benefits. If government Dey involved the way them want way be towards regulation, na em be say, we no go really Dey enjoy benefits way follow for the privacy side be that o. As exchanges go Dey leak information to authorities if no be watin them Dey do already.

Then again, how them wan take Dey classify undeclared or Bitcoin them way no run through recognized or licensed exchanges…?

Watin really be the possible benefits and
Challenges way this law fit bring or face as you see am?

Na the matter way I bring for una be this my people, make we talk am…
Pages: [1]
Powered by MySQL Powered by PHP Powered by SMF 1.1.19 | SMF © 2006-2009, Simple Machines Valid XHTML 1.0! Valid CSS!