Show Posts
|
Pages: [1] 2 3 »
|
11
|
Local / Nigeria (Naija) / Re: Nigeria (Naija)
|
on: August 09, 2022, 04:37:51 PM
|
I greet the house oo. I be new member for here I just join this place recently.
I been dey go through I come see this local board I say make I introduce myself. Am new here and would like to get along. 🙏🏻
Chairmo, I welcome you specially come this place. You go like am here if you nor dey do gragra. One tin wey I dey try advise new comers be say make you waka go the meta section go look threads wey dem olopka wey dey the forum dey burst users wey dey plagiarize, scam, or break the forum rules. Make you take am easy with the merit matter... see eh if you do better post you go see as merit go follow you like water. If you nor believe as Agbe. If you get any serious question you fit PM any of we brodas here, dem go help you out. Thanks bro... Maximum respect for una wey dey help to raise new ones like us up. E no easy to take out time come give to another person. I see as a lot of discussions full this place I already know say it's going to be very interesting here. Na make I dey follow up small small. I go take time to read along and check things about the rules and others.
|
|
|
12
|
Local / Nigeria (Naija) / Re: Nigeria (Naija)
|
on: August 09, 2022, 04:35:21 PM
|
Thanks baba... I really appreciate your brotherly love. To follow this place na jeje as u talk am, e no easy at all. Me sef dey wonder the way for that merit... Abeg make person show me way and help me through make I no go do wetin go cause me casala. Make una tell me the rules biko
Welcome bro, the matter no too they difficult to understand, all the rules wey you suppose know they for meta section, you go see am for the pinned/sticky threads there, go there, take your time read am for better understanding. Well to summarize am ehn, you earn merits when you make constructive posts wey other people like, them go fit give you merits for it, carry for mind say no be merit be the koko here, na your contribution, the better it is, the more likely wey merit go fit show for your side, as for the rules, one wey they most important na im be say make you no plagiarize, no copy person work, come paste am as your own without giving credit. Go check the rules for where i tell you say you go find am, anything wey you no still understand you go use the search button find am, or you drop am here, people they on ground to respond to you. I don check your posts like this, i see say na bounty reports full for there, no be say e bad oh, but make i tell you truth, e they counter-productive, time don go when bounty they productive, better things they plenty other parts of the forum in the long run, if you fit calm down and learn; na your decision sha. Senior men dem make una still show me how I go fit dey more productive than just bounty alone. I see a lot of active members, activities and so on, I hope with time o get to be on that list, but in the mean time I no go mind to dey educated from una, learn new things and better way to run matas for this forum.
|
|
|
13
|
Local / Nigeria (Naija) / Re: Nigeria (Naija)
|
on: August 09, 2022, 04:33:16 PM
|
Thanks baba... I really appreciate your brotherly love. To follow this place na jeje as u talk am, e no easy at all. Me sef dey wonder the way for that merit... Abeg make person show me way and help me through make I no go do wetin go cause me casala. Make una tell me the rules biko
Welcome bro, the matter no too they difficult to understand, all the rules wey you suppose know they for meta section, you go see am for the pinned/sticky threads there, go there, take your time read am for better understanding. Well to summarize am ehn, you earn merits when you make constructive posts wey other people like, them go fit give you merits for it, carry for mind say no be merit be the koko here, na your contribution, the better it is, the more likely wey merit go fit show for your side, as for the rules, one wey they most important na im be say make you no plagiarize, no copy person work, come paste am as your own without giving credit. Go check the rules for where i tell you say you go find am, anything wey you no still understand you go use the search button find am, or you drop am here, people they on ground to respond to you. I don check your posts like this, i see say na bounty reports full for there, no be say e bad oh, but make i tell you truth, e they counter-productive, time don go when bounty they productive, better things they plenty other parts of the forum in the long run, if you fit calm down and learn; na your decision sha. Thanks bro I really appreciate you valid boss. Na una go still help this smalar wey I be for this place so. Make I dey learn from una make una dey show me way. I go dey follow the group small small take dey learn, anywhere wey e be like e hook I no go hesitate to ask questions. Na who ask questions no dey lost
|
|
|
14
|
Local / Nigeria (Naija) / Re: Nigeria (Naija)
|
on: August 09, 2022, 01:52:21 PM
|
I greet the house oo. I be new member for here I just join this place recently.
I been dey go through I come see this local board I say make I introduce myself. Am new here and would like to get along. 🙏🏻
Baba I welcome you specially for this Naija Board. Na here wey you go feel the brotherly love wey they flow for Naija blood. Hope say you don read some of the rules of the forum so that you no go make any mistake wey go knack you for cassala. Some other rules dem no right am one place, na as you dey get experience you go dey learn more about the unwritten rules. My advice bi say make you no rush things, abeg take am jeje. You go first learn many things before your leg go strong wela for the forum. Even me sef my leg and hand still dey shake like one of Naija presidential aspirants because I still dey learn. Sometimes I dey look the kind merit and rank wey some people get for the forum and the thing go dey hungry me but when I look for their date of registration I come understand say no bi today dem begin work hard for the forum. My brother, welicome. Thanks baba... I really appreciate your brotherly love. To follow this place na jeje as u talk am, e no easy at all. Me sef dey wonder the way for that merit... Abeg make person show me way and help me through make I no go do wetin go cause me casala. Make una tell me the rules biko
|
|
|
15
|
Local / Nigeria (Naija) / Re: Nigeria (Naija)
|
on: August 09, 2022, 08:16:21 AM
|
EFCC don forget politicians, them forget those way dey spend foreign currency for them country dey focus on these men them... e no soft at all. The just dey common these days for street and e dey drop there rep. Na so SARS been stat o, soon the street go cable cable for them.
Senior man the mata worst pass as you talk sef. The issue of this efcc things na just drama for this naija. All government agencies dey function under the directive of the sitting president and friends wey dey in power. E no get any agency we dey act independently of its own. If na for oyinbo land now all this agencies like efcc and ndla abi na ndle them go get their power to act right from. Their own boss without minding say them dey fear suspension or replacement. If na for oyinbo land them go don impeach the president from day one but for here them no born them well to even say Mr president you are doing the wrong thing or Mr governor you are not working. No worry bro wait make buhari comot for that seat then you go dey hear efcc everywhere say them catch one politician, them dey find one politician them recover money wey one politician hide, how them take know all this if no be say them dey work together for that aso rock so when another president come now who he favor go come begin expose the others to save their own head. Efcc no fit do anything until the president comot another one come enter come dey give order say the past administration them chop money make efcc find them. See wetin buhari do the format efcc president, he just scak am for no reason come replace am with this 40yrs old man wey I no fit even remember him name now. Just like that president comot efcc leader without reason. He no dey happen like that for another place. Let's wait till buhari leave aso rock then you go see how active efcc go dey.
|
|
|
16
|
Local / Nigeria (Naija) / Re: Nigeria (Naija)
|
on: August 08, 2022, 10:37:16 PM
|
I greet the house oo. I be new member for here I just join this place recently.
I been dey go through I come see this local board I say make I introduce myself. Am new here and would like to get along. 🙏🏻
|
|
|
|