For this country if you lose your friends for one yeye politicians then I ahswear you be mumu!!!
Tinubu been support Atiku for presidential ambition for like twice, they are very Good friends na em correct guy. Peter obi been do Atiku Vice aspirant before na Good friends them be. You con they here they fight your correct guys, friends wei be say you suppose they build wealth with. Make we no lose guard oh for this country.
People stupid normally, abi na today you dey realized am. People dey fight and kill demselves because you no get the same political reasoning like dem. Dem dey forget say this politicians wey dey fight for morning like dis dey meet for night seat down drink one or two beer or whatever drinks dem like. U mumu go come dey block your friend for whatapp because him no support OBI or your candidate, continue (in mama patience voice). Politics is a game and only those that knows how to play it wins. Some country the game no dirty but it didn't start like dat. You see country wey dey 100's of years older, you wey dey just 60+ wan go compete with them when your illiteracy levels na die.
Before Nigeria go get a free and fair election, alot of things needs to be achieved like our educational level need increase, our wellbeing, human right awareness etc and this things need reach everywhere no be only youths matter. One thing self wey make you an educated person na wen you fit understand say people fit get different opinions about life which politics is a big part of but yet that doesn't make them not educated. When It's politics even the republican and democrats dey fight for wetin go favor them yet dey still do what's good for the country and na so e supposed be for Nigeria as well. Make u no go lose a friend wey fit be your helper tomorrow because of OBI or tinubu wey dun make am already for life and dey steadily relate.