With all being said, it's still all about making profits if we're actually hodling for investment the difference motive of bitcoin is the alternative means to execute payments.
It's normal for investors being sentiments with the market changes but the truth is that your grieved emotions wouldn't make different to the market price.
The reason why person dey do investments nah because em want to get profits, so as Bitcoin investment dey concern, nah profits nah person wey invest in am still want. But watin I gets to talk be say, when you want profits from Bitcoin investment, make you also know say no be something wey go come quick quick because Bitcoin investment no dey like that, and you go also make sure say you constantly dey invest and accumulate for long term, like 5 to 6 years or 10 years if possible.
For Bitcoin investment, you really need to get enough patience because if you no get patience, when Bitcoin price go reduce you fit go sell your coins out of fear say all your money to loss. So patience nah something wey Bitcoin investors really need, and if I am not mistaken, nah this patience wey some pipo no get nai make them dey go into Bitcoin trading.
However, to dey look market all the time no be my kind of thing as I like am at all because I feel am say most of the times when you dey look am, e no dey motivated mostly when Bitcoin price dey reduce. Although I know know for others but e dey obvious say person wey dey do long term investment no supposed to dey always look the market as sometimes e fit make am not to buy.
Because of these fears wey dey inside some investors mind nai make DCA method be the best method them go use dey buy Bitcoin as DCA method make anybody buy Bitcoin even when price dey high or dey low.