E get as e be wen you dey use P2P exchanges, patience na key. I recently see one post for forum
https://bitcointalk.org/index.php?topic=5467496.msg62876913#msg62876913 wey talk say no release your money until you confirm the transaction when you dey use P2P exchanges. I reason am say this matter go help our newbies wey dey hux, so I come decide say I go share am for our local board. As we all Sabi watin p2p be say na the kind exchange we buyers and sellers dey tay exchange coin for money and vise versa.
I recently get one experience with Binance when I be dey try exchange some coins to Naira. I don follow all the normal steps before we dey to sell coins to buyer for Binance. I sidon dey wait for the transaction to finish, but after small time, the buyer say e don send money, and I suppose confirm and release my coins. I check my Opay app, but I no see any money . I con decide to wait for like 20 minutes, still no alert. After some time, I come receive one message from Binance wey talk say make I confirm the transaction if I don collect money. I still just relax because I never see any money for my account.
Later, I come notice say the problem dey come from my side because I use one new Opay account wey I never upgrade, and normally e get some amount wey you suppose upgrade before you fit transact am. After I upgrade am, I come collect my money and release the coins.
The thing wey I dey yan be say sometimes, you fit find yourself for this kind situation. If you dey doubt, no release your money until you sure say you don collect the payment. No dey rush or panic, because e fit make you lose your coins. Sometimes dem go tell you make you ask the person wey wan buy from you make e send screenshot of the payment, but sef that one fit dey edited to make you think say you don receive your money, or your bank fit dey give network issue. As long as you dey patient and dey careful, your money go dey safe for Binance.
I dey always recommend say make people use banks like Opay, Kuda, or any other virtual microfinance bank for P2P transactions because them dey quick for payments. Some other banks fit get wahala with their network. also if you wan select buyer, try dey check the wan wey gat verification, many persons for all these exchange fit be scam so check the ones wey get verification and better review before you start your transaction. Make we dey act smart and get patience when dealing with p2p.