4) Bitcoin adoption/acceptance: since Nigeria economy is very weak, therefore, accepting Bitcoin will sustain the economy to some extend. In fact Bitcoin will boost the economy in the country, it will even create employment and self reliance of the youth.
Difference dey when you say Bitcoin investment and Bitcoin adoption, Bitcoin no be wealth creation tools wey you go think say immediately you accept am say all your problems are solved. Nigeria accepting Bitcoin no do much for the economy of we never resolved wetin dey truly cause our economy to dey dis poor which is bad governance. Just because Nigeria accept Bitcoin no mean say everything go begin work for the country. If you reason am well, e fit make things worst because the stealing go dey so fast and decentralized wey be say you fit no catch person wey steal am and people no go dey fear to thief again as mixers can be used to mix the money and we no go fit track am to the stealer address. Nigerian youths na hustlers so dem go always find way to chop and investing in Bitcoin na one way to chop well tomorrow.
3) Employment: Nigerian government should focus on graduates with no jobs, promoting of jobs, and investment can help to reduce inflationary pressures. In a country that employes and creates jobs to youths and citizens whereas this look like pushing money out through salary payment, this will help in reducing inflation on the country.
No be job creation be the issue but dem go fit maintain am when dey start am, me I for say make the government's assist the youths in entrepreneur programs wey be say e go teach the youths how to hustle and make money for demselfs because although na government dey make economy better due to their policies dem but the private sectors get a very important role to play for development and when a country private sectors no strong jobs go hardly dey for people to do because for every country, government alone no fit handle the no job wahala wey dey. When we dun get better entrepreneurs wey dun launch their own companies, slots go dey to hire people and reduced the stress on the government.