Bitcoin Forum
June 15, 2024, 07:25:39 AM *
News: Latest Bitcoin Core release: 27.0 [Torrent]
 
   Home   Help Search Login Register More  
Pages: [1]
  Print  
Author Topic: Oyibo and Naija  (Read 55 times)
sotelorene (OP)
Member
**
Offline Offline

Activity: 266
Merit: 27

Eloncoin.org - Mars, here we come!


View Profile
May 17, 2024, 08:50:35 AM
 #1

Ona good day oo, I just say make I yan ona waiting I been dey think when malaria and typhoid hold me, ona know say ehn anytime malaria and typhoid hold person, person go dey think so many things ( things wey fit dey possible and ones wey no fit dey possible) and sometimes e go be like say person dey think rubbish. Waiting I been dey think na, how Oyibo and Nigeria people dey smoke and drink. If you check well ehn you go see say most Oyibo people when dey smoke finish dem go, go take treatment and dem know the effect of waiting dem dey smoke or drink but Naija own dey very different, dey no go take treatment, dey no even know the effect of waiting dem dey smoke or drink, na waiting make sometimes you see plenty mad people for road because say dem take waiting their head no fit carry some self dey die.
                       
However, make we relate this thing now to crypto, e get people wey be say before dey invest in any coin dey go first settle down come carry out analysis and even with the analysis dey no go invest anyhow but e get people wey be say as dey just here small thing concerning a particular coin dey don rush go invest regardless and if you check well na this set of people dey always say crypto no good, after dey don lost money for their own carelessness.
Ma people how ona see am.

ElonCoin.org    ElonCoin.org    ElonCoin.org     ElonCoin.org     ElonCoin.org    ElonCoin.org    ElonCoin.org
●          Mars, here we come!          ●
██ ████ ███ ██ ████ ███ ██   Join Discord   ██ ███ ████ ██ ███ ████ ██
Justbillywitt
Full Member
***
Offline Offline

Activity: 280
Merit: 234



View Profile
May 17, 2024, 09:03:19 AM
 #2

Normally na lose guarding for anybody wey dey invest in coins wey dem no properly research on unless say na btc the person dey invest on. The main purpose of us trying to make investment is to have something we are looking up to in the future, but e go come bad say some group of people come use us cash out in the name of investment. These things dey very common with all these meme coins wey don full market, project dem wey no get purpose, and day the creators tire Dem fold the company and run. My own be say e good make we check track records of project teams, have they been part of any successful project in the past? Are they well rooted in social media and their accounts verified? Any projects that has only telegram group as their only active social media accounts is a big red flag and we should avoid them. Make we no come dey hustle and others come dey reap our rewards for free.

philipabaku
Newbie
*
Offline Offline

Activity: 42
Merit: 0


View Profile
May 17, 2024, 06:47:54 PM
 #3

Abro you try but actually na the oyibo piple dey suffer for cancer and lung issues pass we the black. Wettin dey sustain we the black na say we strong pass them naturally and wettin dey kill most of the strong ones of us na due to say we no just dey smoke or drink alone, na the ways we dey mix drugs and alcohol.
Lida93
Hero Member
*****
Offline Offline

Activity: 784
Merit: 562


View Profile WWW
May 17, 2024, 06:59:54 PM
 #4


However, make we relate this thing now to crypto, e get people wey be say before dey invest in any coin dey go first settle down come carry out analysis and even with the analysis dey no go invest anyhow but e get people wey be say as dey just here small thing concerning a particular coin dey don rush go invest regardless and if you check well na this set of people dey always say crypto no good, after dey don lost money for their own carelessness.
Ma people how ona see am.
Op, e clear malaria wey been hold you really strong! Grin

Though we the focus the talk on cryptocurrency but conventionally anything investment be it real estate, bonds, stock, gold etc, wey person mind dey to invest the first thing wisdom demands be say the investor go first do him own research to obtain verifiable information about that investment before him go decide whether to put head or not based on wetin him don know.

Na ignorance the make plenty of this newbies the jump jump from one  coin to another, and na this ignorance the feed their greed for fast means of catch out.  Until newbies into cryptocurrency start to imbibe the habit of being patient and eager to learn not until then they will keep falling as prey into the hands of these shit coins with the small small money wey them get.

 Moreover sef, if you feel say you no wan  sit down the look as you don come inside the industry, then why not just first invest the small money you get into bitcoin way sure well well, while you dey learn about the industry your small investment for bitcoin the add small tin as profit way from their you go fit use the invest into other altcoins after you go don gain knowledge by then. Here no be where them the rush tins, all actions must be based on thorough calculation to avoid unwarranted losses.
Pages: [1]
  Print  
 
Jump to:  

Powered by MySQL Powered by PHP Powered by SMF 1.1.19 | SMF © 2006-2009, Simple Machines Valid XHTML 1.0! Valid CSS!