First of all, I go just like to say thank you for taking notice of the little growth wey dey get for we local board, and also thank God for bringing our helper & Savior in the person of
hugeblack who came to our aid when we needed a helper so urgently due to our increasing number of newbies and high quality posters. Sir, I must say you are really God sent to Nigerian local board, and we will always keep on praying for you for good health of mind and body.
So like this I want to really appreciate una for coming back with full force and this na to show say very soon we go take over some board especially that of russian because them dey always dey top.
If na all the Nigerians wey we get for this forum na dey drop the least 5 post each week for this local board, I don't see any reason why we no go beat Russian local board, but just that we get plenty Nigerians for here wey no dey drop a single post here months after months. But God dey shah
I no really go through your post as neck dey pain me to read long article like this and you for atleast try summarize your post next time especially for local board so we go catch this vibes properly.
Lolz.. @ Obari, wetin you do done use your your neck do wey neck dey pain you? So na this common post with 312 words you dey call long post, what if eh be reach 1000 words, wetin you for call am then?