My country people I greet una,as I wake up dis morning na I see dis news for my browser,I con say make I share dis news with my country pipo.
A trucking company owner has been sentenced to 23 years in prison for a $54M ponzi scheme that swindled 2,000 investors.
Dis 45 years old man wey him na Singh swindle 2000 investors for about $54 million,omo see as pipo dey invest on ponzi scheme,if dem tell dem now to invest on bitcoin dem go dey say bitcoin returns no dey quick,now make dem see the result of quick returns,di man con dey even use their money take dey pay previous investors.The punishment of di man be say him go spend 23 years for jail,nai be say before him go come out for jail him go don approach 68years,see as pipo dey waste their life for jail because of their wrong financial decisions.Dem fit dig deep into the mata seriously because him victims no be small pipo,just imagine that 66 year old victim wey write letter file am go court,when you scam big person you no go scot free,that one na for sure.
My country pipo make una contribute if whether the punishment dey fair or not?