First of all, in order to make profit in forex you don't have or need to be greed. What did I mean by greed? Greed is when you entered the market without setting your stop loss, because you feel the market is going to move in your favor.
My brother no be lie wey u talk for here oo, greediness na one thing wey dey make many forex trader dey loss well well, because instead of them to place their take profit for were get high chances of actually taking profit(just small higher than the candlestick) them go make the distance very high from the candlestick, I nor no weda dem dey plan to buy private jet with just one trade.
Another one na their lot price, some people dey do just $50 trading and dem go set their lot price for 1,1.5,2,2.5 and so on, but dem dey forget say if the trade go beyond their prediction wey dem nor quick see all their money don go and dem go con talk say forex trading na bad thing, na all those kind people dey spoil the name of FX, dem dey forget say before u start anything you go first learn and study about that thing, normally for professional trading:
$50 for trading amount the highest risk of lot price wey u fit take na 0.10.
$100 lot price highest risk suppose be 0.20.
$200 lot price for high risk suppose be 0.40
$500 lot price for high risk suppose be 1.00
And so on but some people go go take unprofessional risk wey go make dem regret of trading at the first place.
The one wey come pain me pass na those wey never get reasonable amount of knowledge about forex wey con enter inside and the worse thing na be say dem go con go subscribe for one telegram channel wey go dey supply dem signals and dem go still dey loss their trade. Majority of telegram signal channel owners na people wey subscribe one channel wey subscribe to another channel wey subscribe to another channel.... So if one person bring out fake signal many forex traders go loose wella, normally those signal channels nor go fit guarantee ur success forever because dem go fail u well well. Some traders sef nor even sabi set stop loss and take profit.
The surest way wen i think say person fit make some reasonable amount of profit na wen the person learn well before e enter into the forex trading. I nor be forex trader oo but I don do many study about forex because at a time in my life I been dey consider am as watin I fit do to get money but till tomorrow I go still pick investment over forex trading.