A very bad mess indeed if this is actually same thing that happens in our interstate boarder as everything you don talk here so far na exactly wetin Dey go on for our country but my Oga I no think say writing in plain English language na the best option at this point wey we get plenty externals wey Dey the board and this alone the send a very wrong and bad signal to other strangers or torrist wey maybe Dey use style observe talks from this board but and this alone for make them feel very discouraged but is just the bitter truth and I still wonder why our boarder Dey porous like this but yet things still Dey cost Abi na only humans no get restrictions to enter as long as you fit pay 200
Well done Mr Obari because na my mind you just talk so, our language to the externals dey some how anonymous because we never get translator, so na kind of advantage for us to take dey discuss coded issues. All this kind of topics dem no need to use English take write dem make we no go gbolo our cover, like this na cast we just dey cast our country for others " no be say na our own bad pass oo" and e nor good. Apart from sending bad signal to tourist, like this u don sell useful information give people wey get bad intention like kidnapping, robbery and drug trafficking, I go advise make u for translate this topic to pidgin.
To the topic info, omor our olokpa dem dey fuvk up, only dem naim use their mouth say bail is free but that una big lie, when dem been arrest my brother because of mass arrest activity wey dem been carry out, in the morning wey we go to bail am na 25k we pay before dem release am.