How you go compare the fluctuation of the price of bitcoin to price of goods in Nigeria. Price of goods for Nigeria no dey go opposite direction like I see you mistakenly understand it thar way No, the price of goods for naija dey always face up while bitcoin dey move up and down.
I no know about other areas but for my area, price of noodle don come down small.
I dey like eat noodle but no be too much so I no dey buy am for carton, I prefer to buy am small small, and as of last month, the smallest size of MIMEE noodles been dey around 250 per noodle, but the thing don actually drop now to 150 so at least something don actually drop price.
Even garri self, e dey go up dey come down, although na so garri dey normally behave, even before now, e get seasons wey garri price go shoot up ehh, then later e go come down, na that one I know say e dey behave like bitcoin well well.
For my area, as of last month too, garri been reach like 3000 per custard, sometime this month, e come drop to 2500, Omo I hear say now e Dom enter 3500 again o.