Lesson
Always inform your piple about your movement if you trust them or find person wey you fit tell like wife or parent or pikin if u no trust any friend.
Na better remainder you come with so, as the country no safe again at least make we dey try inform our love ones our movement especially if we dey travel, If dem know where we dey go e dey put dere mind at rest. Anytime wey i dey travel even if na 1day journey I dey try inform my parents because dere prayer dey important, so if you be child wey know wetin you dey do try dey tell ur love ones your movements make you use dere prayer guide body because our country no dey safe again..
Last two weeks, a 400-level student from a university in my state went missing. They looked for her everywhere, but she was nowhere to be found. It was only yesterday that they discovered her dead body. This shows that not only not only kidnappers we should pray against, but also friends, boyfriends, and some family members.
Always pass busy road, bush road wey be shotcut naim keep people for inside bush for seven days with beaten wey wrestlers self no collect for their life.
Some times na we dey do ourselves for Naija we like shortcut and most of our shortcut road for Naija today na problem, I don't see the reason why I go pay driver full money and the driver go wan dey manage fuel sey e wan carry me follow shortcut wey no safe
If you wan talk dem go sey na God dey protect us my brother as God dey protect you try do your own part.
This advice good ooo, kidnappers no go enjoy your Bitcoin money leave you for hunger ooo. Shae una kno say, kidnappers dey work with information, so keep your Bitcoin investment from people wey you no trust make them no keep u for bush then collect your investment.
That one na true I no fit tell anybody about my investment, because not everybody dey happy with your success and some friends even dey even if you no tell dem about your things dem good in monitoring so we should dey careful with people we call friends